How Nigerians, world leaders celebrate Buhari

INEC, di electoral joinbodi for Nigeria don declare President Muhammadu Buhari of di All Progressives Congress, APC, di winner of di 2019 presidential elections.

Live Coverage

Daniel Semeniworima and Nduka Orjinmo

  1. Wetin some voters take eye see for Lagos

    Dis na how some pipo take record wetin happun for dia polling unit for di Okota side of Lagos State.

    Election bodi INEC say dem go cancel election some some polling units inside Lagos and Rivers States.

    Wetin we call dis Video, Kata-kata nearly scata election for Nigeria
  2. Banky W don win im election?, #Banky

    If you follow twitter pipo mouth, you go think say di musician and actor don win im House of Representatives election for Lagos State.

    But na still gada dem dey gada results, INEC neva tok anything about who win for Eti-Osa constituency.

    Skip X post, 1
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 1

    Skip X post, 2

    End of X post, 2

    Skip X post, 3

    End of X post, 3

    Skip X post, 4

    End of X post, 4

  3. Wetin dey trend for Twitter?, #BuhariIsWinning

    Dis wan na supporters of Presido Muhammadu Buhari, di candidate of di All Progressives Congress dey push am.

    Dem camp hia dey throw informate upandan say dia candidate don win di election. Again, INEC neva tok pim sef about results.

    Skip X post, 1
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 1

    Skip X post, 2
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 2

    Skip X post, 3
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 3

  4. Wetin dey trend for Twitter?, #AtikuIsWinning

    Na supporters of PDP presidential candidate Atiku Abubakar camp for inside dis hastag to make am trend.

    Dem dey claim victory for dia candidate, even though say election bodi INEC neva declare anything yet.

    Skip X post, 1
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 1

    Skip X post, 2
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 2

    Skip X post, 3
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 3

  5. Wetin dey happun now?

    Dem still dey count results for some polling units wey no start vote early. For areas wia dem don count finish, dem go begin move di result sheets from polling units go collation centers inside each local goment area.

    Dat one fit don already happun for some states wia katakata no dey and everything happun jejely.

    Voters

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Some voters keep vigil to make sure say dem see di counting of dia votes.
  6. Goodmorning to you and welcome

    Afta all di everi-evri of Saturday presidential and national assembly election for Nigeria, Sunday don come. Na hia we go give you all di informate of wetin go happun and dey happun across di kontri.

    Lagos
  7. Na here we go march break until later on Sunday

    Make we leave una wit dis photo of Atiku Abubakar wey we see for Facebook

    Atiku Abubakar and im supporters for one airport afta di election.

    Wia dis foto come from, INEC

    Wetin we call dis foto, Atiku Abubakar and im supporters for one airport afta di election.
  8. Osinbajo loss for im polling unit

    For ward 4 unit 033 VGC, Lekki Ikate Lagos wia Professor Yemi Osinbajo bin vote on Saturday, im APC party loss to di main opposition PDP.

    PYO Ward 4 unit 033 Presidential

    ANN : 39

    APC: 197

    PDP: 384

    Unit 033A Presidential

    ANN: 2

    APC: 32

    PDP: 41

    YEMI Osinbajo

    Wia dis foto come from, YEMI Osinbajo

  9. Atiku win Buhari for Aso Rock villa

    Afta recount of ballot papers for Presidential villa

    Cummulative for 021 and 022 Polling Units inside Aso Rock villa, Abuja

    Presidential:

    APC - Buhari: 1017

    PDP - Atiku: 1027

    Senatorial:

    APC 1009

    PDP 1082

    Muhammadu Buhari (Left) and Atiku Abubakar (Right)
  10. Two people die for shooting inside Delta State election day gbege

    2 pipo die for Delta, gunmen burn community hall wia election materials dey.

    Two pipo die for shooting and one oda wonjure badly for one polling units inside Amukpe area of Sapele town, Sapele council area of Delta state.

    Deputy police PRO for Delta State ASP Chuks Orisewezie confam di tori give BBC Pidgin.

    "E get one argument wey happun between some members of different political parties and di DPO for di area later settle di quarrel. But later unknown gunmen carry waka come back to di voting centre and begin shoot anyhow give di voters. One pesin die on di spot and di oda pesin die for hospital wia dem bin rush am go. Anoda third pesin injure."

    Orisewezie say anoda gbege also happun for Udu wia pipo vex sake of say di card reader no dey work well.

    "As di card reader dey malfunction, di pipo come dey vex and some unidentified gunmen come du place and begin pursue pipo comot, burn di community hall for Owede along wit election materials but di card reader and ballot boxes no dey affected."

    Delta State voters
  11. Tinubu deliver APC inside im Lagos polling unit

    Bola Tinubu dey vote for im Lagos voting unit.

    National Leader of APC Bola Ahmed Tinubu deliver victory for im party wia im cast im vote on Saturday for Lagos.

    APC beat PDP for Junction of Kafi/Awolowo Way Alausa polling unit 047 wey be di point wia Tinubu vote for Alausa/Oregun/Olusosun area inside Ikeji, Lagos.

    Result:

    APC - Buhari: 122

    PDP - Atiku: 93

    INEC RESULT SHEET
  12. 7:00pm na im voting just end wia Yemi Osinbajo vote

    7:00pm na im voting just end for VGC Ward 4 Polling Unit wia Yemi Osinbajo, APC Vice Presidential Candidate vote.

    Wia Yemi Osinbajo, APC Vice Presidential Candidate vote
    Wia Yemi Osinbajo, APC Vice Presidential Candidate vote
    Wia Yemi Osinbajo, APC Vice Presidential Candidate vote
  13. Atiku win Donald Duke inside im polling unit for Calabar

    SDP candidate Donald Duke

    PDP presidential candidate Atiku Abubakar dust SDP candidate Donald Duke inside di unit wia Duke vote AME Zion School unit 005 for Calabar, Cross River State, south-south Nigeria.

    APC - Buhari: 98

    PDP - Atiku: 291

    SDP - Duke: 6

    INEC Result sheet
  14. Buhari win for Atiku polling unit

    APC Presidential candidate Muhammadu Buhari win im main challenger Atiku Abubakar of PDP by 19 votes for wia Atiku vote.

    Buhari get 186 while Atiku score 167 votes for Ajiya unite 02 for Yola, Adamawa state.

    Result sheet for Atiku ward
  15. INEC suspend election for parts of Rivers State

    INEC Voting poster

    Reports from Andoni local goment area for Rivers State say di jaguda pipo don kill di former local goment chairman, Mowan Etete and im broda and sister for Asarama town.

    Oda places wia gbege happen na Ahia Ogbakiri for Emohua local goment, Ubima for Ikwerre local goment, and Buguma for Asari Toru local goment area.

    For Akuku Toru and Bonny local goment area wia election no hold sake of violence, INEC say election go hold dia for anoda day and for some part of Okrika wia election materials miss.

  16. Cameroon rights defender pray for Nigerian elections

    Based on say 'wetin reach eyes affect nose', dis na wetin Cameroon rights defender Agbor Nkongho tweet about Nigerian elections:

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  17. Dem don begin count votes for some polling units

    vote counting
    Wetin we call dis foto, For dis polling unit for Masallacin Murtala area of Kano State, counting don start
    BBC
    Wetin we call dis foto, Party agents tanda to watch as di vote counting dey happun
    voting
    Wetin we call dis foto, For Makurdi Benue State, corpers don also begin count vote for dis polling unit
    voting
    Wetin we call dis foto, Dem dey show pipo wey dey ground di ballot papers to make sure say wayo no wey
    vote sorting
    Wetin we call dis foto, For ward E, polling unit O62 for Alimosho area of Lagos State, voting don finish and dem dey ready di arrangement to begin do counting
  18. Voting
    Wetin we call dis foto, Voting don end for di Masalacin Murtala area for Kano State, but INEC officials dey gree-die wit party agents onto di number dem suppose allow inside for counting
    voting
    Wetin we call dis foto, Voting end by 1:30pm for dis polling unit for Makurdi, Benue State for northcentral Nigeria.
  19. "Dem flog us say make we vote for only APC"

    Wetin we call dis Video, "Dem dey flog us to vote for APC"

    Dis voter for di Aguda area of Lagos State say thugs use cane flog pipo wey come vote.

  20. Breaking, INEC don extend time for voting

    voters

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Election bodi INEC say dem go extend di time for voting.

    Di national Commissioner of di commission, oga Festus Okoye, na im yan tori pipo dis one for Abuja.

    Voting suppose start by 8am, end by 2pm, but e no start on time for some places.

    “Wetin di commission don decide na say for ay of those States wia voting start by 9’o clock, e go extend for one hour," im tok.

    “"By 12noon for everiwia for Nigeria, we don record 100% start to vote, some we record over 90%," im tok.

    “For Anambra as at 12 noon 90% of all di polling units don open; for Edo state, 97%; for Ekiti, 100%; for Abuja FCT 73%; for Katsina, 100%, for Kebbi, 100%, for Kogi, 91%, for Kwara, 96%, for Niger 99.35%, for Ogun, 74%, for Ondo, 100%, for Osun state, 100%, for Taraba, 69%, for Yobe, 69%.

    Oga Okoye gree say dem get wahala of smart cards wey no work well, say dem get security challenge, absence of result sheets and late arrival of road transport workers for some states.