How Nigerians, world leaders celebrate Buhari

INEC, di electoral joinbodi for Nigeria don declare President Muhammadu Buhari of di All Progressives Congress, APC, di winner of di 2019 presidential elections.

Live Coverage

Daniel Semeniworima and Nduka Orjinmo

  1. Kasala don burst for Lagos and Rivers states

    Nigerian army don show to catch thugs for di Aguda area of Lagos state wey wan scata voting wey dey go on.

    Tori be say di thugs break bottle for di area and put fear for di mind of voters wey show face before army come.

    For Rivers state, south-south Nigeria, heavy shooting bin happun for Ubima, near di polling unit of Chibuike Amaechi, wey be di kontri Minister of Transport. Nobodi sabi who di gunmen dey work for, but dem use force take carri voting materials comot.

    army

    Wia dis foto come from, Other

    Wetin we call dis foto, Army show face for Aguda area of Lagos wia thugs bin dey worri
  2. Our card readers prove imsef for dis elections - INEC

    Election bodi INEC enta Twitter to nack dia chest for how dia card readers taker perform on Saturday.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  3. , Dis old women wey don dey vote since 1970s

    Wetin we call dis Video, Dis old women don dey vote since 1970s
  4. "Dem must extend di time by two and half hours"

    Wetin we call dis Video, Kingsley Moghalu wan make INEC add more time for voting

    Presidential candidate of di Young People's Party Kingsley Moghalu no too happi wen e land im polling unit to vote.

    Im say INEC go need to add more time for di whole thing.

  5. , Dis voter for Rivers State dey happi say she don vote

    Wetin we call dis Video, "Bodi sweet me wella as I vote"
  6. Tubaba pin to vote

    Skip Instagram post
    Allow Instagram content?

    Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of Instagram post

  7. Women wey dey break egusi for line

    Dis women voters for Benue state dey break egusi as dem sidon dey wait for dia turn to vote.

    Benue women
  8. Nigeria veepee don vote

    Vice presido of Nigeria, Prof. Yemi Osinbajo don vote for im polling unit for Lagos State. Voting bin no start early for dis area for Victoria Garden City of Lagos.

    Osinbajo
  9. Manual voting for Benue State

    Na manual voting dem dey use for dis polling station for Makurdi, Benue State wia card reader wey dem suppose use to authenticate pipo for election no work.

    Dis don make di process slow and di line long wit pipo wey wan vote.

    voters
  10. Bola Tinubu don vote for Lagos

    Di national leader of di All Progressives Congress Bola Tinubu don cast im vote for Lagos.

    Tinubu
  11. Adams Oshiomole dey line to vote

    Chairmo of di ruling All Progressives Congress Adams Oshiomole dey line to vote for im polling unit inside Edo State.

    Oshiomole
  12. Wia Nigerian celebs dey for dis election period

    Nigerian celebs no carri last for Saturday elections as many of dem come out to vote.

    Nigeria musicians like 2Baba, Falz show dem sef even as actors like Omoni Oboli, Yul Edochie no carri last.

    Nigerian singer, 2baba go cast im vote

    Wia dis foto come from, Instagram/@official2baba

    Wetin we call dis foto, Nigerian singer, 2baba go cast im vote for Festac, Lagos.
    Skip Instagram post, 1
    Allow Instagram content?

    Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of Instagram post, 1

    Skip Instagram post, 2
    Allow Instagram content?

    Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of Instagram post, 2

    Skip Instagram post, 3
    Allow Instagram content?

    Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of Instagram post, 3

    Skip Instagram post, 4
    Allow Instagram content?

    Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of Instagram post, 4

    Skip Instagram post, 5
    Allow Instagram content?

    Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of Instagram post, 5

    Skip Instagram post, 6
    Allow Instagram content?

    Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of Instagram post, 6

  13. Breaking, I be democrat - Atiku Abubakar

    Atiku Abubakar wey be di presidential candidate of di People's Democratic Party don vote for di election wey dey go on for Nigeria.

    Im vote for Ajiya, Yola North local goment area for Adamawa State.

    Wen tori pipo ask am weda im go accept di results of di election, im say: "I be democrat".

    Atiku
  14. Former Presido Jonathan say e no like di election environment

    Nigeria former presido, Goodluck Jonathan tell tori pipo say e no like di election environment as e go vote for Bayelsa State wit im wife.

    Im say as Nigeria neva get di technology to pick goment well, make pipo at least pick leaders di way wey world go gree wit.

    Wetin we call dis Video, Former Presido Jonathan say e no like di election environment
  15. 65 year old madam Esther Sola Awodiran just finish her vote process around 10am for Lagos State. She tell us say she bin vote last election and di process, like dis year own, no give am any stress at all.

    voter
  16. Papa for Edo state wan vote for beta Nigeria

    Waka or walking stick no stop dis papa make e enta polling booth for Elele for Edo State cast im vote.

    Im tok say e dey vote so beta leaders fit to continue di beta work wey dem dey do.

    Wetin we call dis Video, Papa for Edo state say e wan vote for beta for Nigeria
  17. APC party agent dey tell voters who to vote

    BBC tori pesin see APC party agent for polling units 1,2,3 for ward 10 for Iyamu, Edo State dey show pipo which party to vote for.

    Dis dey against di rules of election bodi INEC.

    party agent
    party agent
  18. , If you get anything you go like report to Nigeria Police, see dia numbers

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  19. Voting neva start for Yemi Osinbajo ward

    For di Victoria Garden City ward of Nigeria vice-presido Prof. Yemi Osinbajo, voting neva still start as at 10:02am.

    dss oficer
  20. , Latest pishures of how voting dey happun

    Voting
    Wetin we call dis foto, Dis na di polling unit of di leader of di APC party Bola Tinubu for Lagos. Di 'jagaban' neva show, but oda voters dey ground.
    Elderly
    Wetin we call dis foto, Dem dey give old pipo, women wey carri belle and disabled pipo quick pass to go vote.
    corper
    Wetin we call dis foto, Dis corper for Lagos State dey explain give those wey dey ground how things go take be for di voting
    Voting
    Wetin we call dis foto, For vice-presido Yemi Osinbajo ward for Lagos, voting nave start but INEC officials dey ground