Langley shootings: Police confam death of multiple victims for British Columbia

Wia dis foto come from, Reuters
Police don confam multiple victims for di early morning shooting spree wey happun for Canada province of British Columbia.
Authorities issue emergency alerts few minutes pass 06:00 local time (13:00 GMT) to warn pipo of "multiple shooting scenes" for downtown Langley, one city wey dey about 25 miles east of Vancouver.
Police don carry one lone suspect enta custody.
Police no identify any motive for wetin now be active investigation.
One Royal Canadian Mounted Police (RCMP) tok tok pesin no immediately confam any deaths for di Monday attack, but say e get "several victims and several different scenes throughout di City of Langley, and one scene for di Township of Langley".
Di victims bin be homeless pipo and police believe say di attack dey targeted.





















