Commonwealth games 2022 open for Birmingham with style

Live updates from Nigeria, Africa and across di world.

Live Coverage

  1. Africa centres for disease control get $100 million from World Bank

    Africa centres for disease control get $100 million from World Bank

    Wia dis foto come from, AFP

    Africa's main public health body, di Africa Centres for Disease Control and Prevention (Africa CDC), go receive $100 million from di World Bank to help African kontris to prepare for, detect and respond to disease outbreaks.

    Di Africa CDC don play a major role advising African kontris during di COVID-19 pandemic and dem dey also provide guidance on diseases like monkey pox.

    Di World Bank tok for one statement say di financial support go help boost di Africa CDC's technical capacity and include investments to increase di number of epidemiologists and outbreak responders.

    "Di project go help to cultivate regional capabilities wey dey critical to ensure a resilient and prepared continent. E go do dis by helping to build and maintain a robust public health workforce across kontris' health systems," di bank tok.

  2. Court fine Signatious Hotel, Kenneth Gbagi N1million against staff e parade naked

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Port Harcourt
    Gbagi and Ephraim

    Wia dis foto come from, Gbagi/Victor Ephraim Screenshot

    Wetin we call dis foto, Victor Ephraim happy say di judgement don redeem I’m image but Gbagi wan go on appeal

    Justice Vera Agbodje of Delta State High Court don award di sum of N1 million against Kenneth Gbagi and im hotel, Signatious Hotel for Uvwie Local Goment Area for case wey one Victor Ephraim bring against dem.

    Di claimant, Victor Ephraim dey among four former staff of Signatious Hotel wey owner of di hotel bin parade naked around di Hotel on accuse say dem thief money wey one guest bin pay for 2020.

    Ephraim through im lawyer, Kunle Edun for di case say on 17 and 18 September 2020, security aides of Gbagi under im instruction, dehumanize and torture im and three oda female staff of di hotel, after dem accuse dem say dem divert money wey one guest pay to lodge for di hotel.

    Justice Agbodje for di judgment dismiss di arguments of Gbagi, say e dey false and unbelievable and she award N1million in favour of di claimant, Victor Ephraim.

    But Kenneth Gbagi, wey be di governorship candidate of di Social Democratic Party, SDP for Delta State say e go appeal against di judgment.

    Victor Ephraim tell BBC Pidgin say e happy well-well with di judgement of di court as e don redeem im image as im don suffer many losses sake of dat incident.

    Lawyer to Ephraim, Kunle Edun happy say dem get di judgement as e show say justice don prevail even though dem no happy with di amount di Court award to di claimant.

    But I understand say Signatious Hotel and Chief Kenneth Gbagi wan go on appeal, dat one dey welcome as na im right but once im do dat one, we go cross-appeal on damages so di Court of Appeal go increase di quantum of damages as we actually ask for N5billion naira.

  3. Sri Lanka: Forces raid anti-government protest camp for Colombo

    Sri Lanka: Forces raid anti-government protest camp

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Security forces for Sri Lanka don raid di main anti-goment protest camp for di capital Colombo and dem don begin pull down tents.

    Dis dey come hoursafta Sri Lanka swear in dia new President Ranil Wickremesinghe.

    Many troops and police commandos move on di protesters outside di presidential office hours afta dem dey expected to leave di area.

    Di army beat one BBC journalist and snatch im phone to delete videos.

    Police arrest nine pipo including two pipo wey get injury.

  4. New York report first US case of polio for nearly 10 years

    Polio: New York report first US case for nearly 10 years

    Wia dis foto come from, Getty Images

    One young adult for New York don become di first US resident for nearly 10 years to catch polio, state health officials tok.

    Di unnamed patient for Rockland County no longer dey contagious but im don develop paralysis from di virus.

    Officials say di pesin dey unvaccinated, and e dey probably exposed to one pesin wey receive vaccine wey contain di live virus wey weak.

    Di last known US case of di highly contagious virus dey recorded for 2013.

  5. Police dey find gunmen wey kill one South African mayor

    Gunmen shoot and kill South African mayor

    Wia dis foto come from, @SAPoliceService/Twitter

    Gunmen don shoot and kill di mayor of one town for northern South Africa and wound im son during one raid for dia home on Thursday night, according to police.

    Moses Maluleke, 56, na di mayor of di Collins Chabane municipality for Limpopo province.

    Dem take im 18-year-old son to hospital afta di attack, local media outlets report.

    Police tok say na three suspects carri out di attack and dem don appeal to di public for information.

    Dem say father and son refuse to comply wit di attackers wen dem demand for money, one police tok-tok pesin reveal.

    Police don mobilise 72-hour action to gbab di suspects.

  6. N109bn Fraud: Ex-AGF Ahmed Idris don plead not guilty to fraud charge

    Ahmed Idris

    Di former Accountant General of Nigeria Ahmed Idris don plead not guilty to di 14 count charge of fraud wey di Economics and Financial Crimes Commission EFCC sama am.

    E and di three oda defendants wey dem dey stand trial together plead asy dem do dey guilty wen dem appear before Justice A.O Adeyemi Ajayi of di federal hight court, Abuja on Friday.

    E dey face 14 count charges of stealing and criminal breach of trust to di tune of N109bn Fraud alongside three odas: Olusegun Akindele, Mohammed Kudu Usman and Gezawa Commodity Market and Exchange Limited.

    Ahmed Idris
  7. South Africa University expell white student wey urinate for black student property

    Stellenbosch University students do protests demanding action against di suspected racial incident

    Wia dis foto come from, AFP

    South Africa Stellenbosch University don expel one first-year student wey dem film as e dey urinate inside di property of one black student.

    Dem suspend di white student afta di suspected racial incident as di university launch investigations into di mata wey happun for May.

    Plenti students do protests to demand quick action against di student.

    Di university do disciplinary hearing from 15 May, and conclude on 23 June.

    On Thursday, di Central Disciplinary Committee (CDC) find di student guilty of contravening di university disciplinary code for students.

    “Di findings lead di CDC to conclude say dem no get any alternative but to expel [di student] with immediate effect from di university,” di university tok for one statement.

    Di student get five days to appeal against di decision.

    Commenting on di outcome of di probe, di university deputy vice-chancellor, Prof Deresh Ramjugernath, say di university dey view di issue under “a very serious light”.

    “Di university take zero-tolerance approach to racism, discrimination, prejudice and conduct wey attack di dignity of anoda pesin,” e tok.

  8. Meet Zambia 'Johnny Walker' wey wan ban alcohol

    Meet Zambia 'Johnny Walker' wey wan ban alcohol

    Wia dis foto come from, Getty Images

    One Zambian medical doctor don begin 140km walk to campaign for ban of alcohol consumption for di kontri.

    Brian Sampa wey pipo don begin call "Johnnie Walker" say alcohol na source of many problems for Zambia.

    “Most gender-based violence cases na sake of alcohol, all non-communicable diseases dey linked to alcohol, even mental health,” e tell di BBC.

    “If we want increase productivity, alcohol gass dey banned sake of say na business wey aim to enrich few pipo."

  9. Ex-policeman chop 2 years jail term for role in George Floyd killing

    Thomas Lane: Ex-policeman chop 2 years jail term for role in George Floyd killing

    Wia dis foto come from, Getty Images

    One ex-policeman don chop two-and-a-half years jail term for violating di civil rights of George Floyd, wey im death for Minneapolis lead to protests.

    Thomas Lane, one of di officers wey try to arrest Mr Floyd, chop sentence afta im February conviction.

    Dem find di white man guilty of showing "deliberate indifference" to di medical needs of Mr Floyd, a 46-year-old black man.

    Federal prosecutors bin tell di court to give Lane more dan five years in prison.

    But im lawyers ask for just over two years sake of say Lane bin suggest to push Mr Floyd to im side and attempt to revive am.

    "E dey terrible," one of George Floyd's brothers, Philonise Floyd tell reporters afta di sentencing.

    "Dis whole criminal system gass dey torn down and rebuilt."

    Derek Chauvin, di former police officer wey video show as im kneel on Mr Floyd's neck for more dan nine minutes, dey currently serve a 22-and-a-half-year sentence.

  10. Ukraine accuse say Russia dey sell steel wey dem steal from di kontri for Africa

    Azovstal steel plant dey under Russian siege for three months

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Di head of Ukraine largest steel company don accuse Russia of looting more than $600m worth of di metal from ports and factories inside Ukraine.

    Yuriy Ryzhenkov, wey be di chief executive of Metinvest, tok say Russia now dey sell Ukrainian- produced steel to Asia, Africa and oda parts of di world - upon say customers for Europe don already paid for thousands of di steel.

    Russia neva comment for di mata.

    Oga Ryzhenkov say 300 workers don die for di Azovstal plant inside Mariupol, wey Russian forces besiege for three months.

    E say di site and anoda nearby facility produce 40% of all Ukraine steel.

    "Wetin dem dey do na basically looting. Dem dey steal not only our products, but also some of those products wey already belong to di European customers."

    "So basically, dem no dey only stealing from us, dem dey steal from di Europeans as well," oga Ryzhenkov tell di BBC.

    E say di company dey document as much of di theft as possible and dey prepare to take future legal action.

    "At some point in time, Russians go face not only di international courts, but also di criminal courts. And we go gio afta dem with anything wey wey get."

    BBC don approach di Russian Ministry of Defence for comment, but dem neva respond to di accusations.

  11. Oshoala, Mane, odas win big for Caf awards

    Oshoala, Mane, odas win big for Caf awards

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Super Falcons player Asisat Oshoala don win her fifth CAF Women Player of di Year Award.

    Di Barcelona striker beat Grace Chanda of Zambia and Ajara Chout Njoya of Cameroon to win di award for Cameroon yesterday.

    Di 27-year-old player dedicate di award to her teammates.

    “Na record-breaking night for me as an Individual and for Africa as a whole. Na five I get, five," she tok.

    Oshoala, Mane, odas win big for Caf award

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Anoda player wey win at di Confederation of African Football awards ceremony for di Moroccan capital Rabat na Senegalese footballer Sadio Mane.

    Mane become di Africa Footballer of di Year for di second time running.

    Di awards return for di first time in three years afta Confederation of African Football (Caf) suspend sake of di coronavirus pandemic.

    Oshoala, Mane, odas win big for Caf award

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Desiree Ellis wey be di coach of di South Africa women national team win di women coach of di year award.

    Oda winners na:

    Men's Club of di Year: Wydad AC

    Women's Club of di Year: Mamelodi Sundowns

    Interclub Player of di Year (Women): Evelyn Badu

    Interclub Player of di Year (Men): Mohamed El Shennawy

    Women's Young Player of the Year: Evelyn Badu

    Men's Young Player of di Year:Pape Matar Sarr

    Men's National Team of di Year: Senegal

    Goal of di Year:Pape Sakho

    Coach of di Year (Men's):Aliou Cisse

    Oshoala, Mane, odas win big for Caf award

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Desiree Ellis receive her award as di Women coach of di year.
  12. ASUU strike: Federal goment beg NLC to cancel planned protest

    ASUU strike: Federal goment beg NLC to cancel dia planned protest

    Wia dis foto come from, FESTUS KEYAMO/TWITTER

    Di Federal Goment don appeal to di Nigeria Labour Congress to cancel dia planned protest sake of di strike by Academic Staff Union of Universities (ASUU) and oda university-based unions.

    NLC wan protest sake of di strike by Academic Staff Union of Universities (ASUU) and oda university-based unions to show solidarity to dem.

    ASUU don dey on strike since 14 February sake of say goment fail to meet di agreement wey goment sign wit dem for 2009.

    Minister of Labour and Employment Senator Chris Ngige make di appeal on Thursday for one meeting wit di leadership of NLC for im office.

    Di Minister of State, Labour and Employment, Festus Keyamo, SAN and di Permanent Secretary of di Ministry, Ms. Kachollom S. Daju also attend di meeting.

    Ngige update di labour leaders on di efforts di federal goment don make so far to resolve di issue and assure dem say efforts still dey go on.

    Di minister remind di NLC leadership say im incorporated dem into di tripartite conciliation wey dey go on for im ministry, and dem dey aware of efforts of di goment to resolve di issue. E say e no expect dem to embark on protest or rally.

    E tell di labour leaders say di Federal Executive Council (FEC) mandate am to notify dem of di serious security implication of dia planned protest.

    According to Ngige, one security report wey di Department of State Services (DSS) send to im office strongly warn against holding di protest wey dem plan to hold on July 26 and 27.

    Di minister urge NLC National Executive Council (NEC) to reconsider di planned rally as hoodlums, opposition politicians and fifth columnists fit take advantage of am to cause trouble for di kontri.

    Both di Deputy President of NLC, Comrade Najeem Usman Yasin, and General Secretary, Comrade Emmanuel Ugboajah assure di goment say di protest go dey peaceful and dem assure say pipo wey wan cause trouble no go dey allowed to participate.

  13. Meet smart 13-year-old wey design flyover bridge and how govnor bless am with millions of naira

  14. Una bye-bye!

    Na here we go end our live updates of di top tori dem from across Nigeria, Africa and di world today.

    Join us again tomorrow by 9:00am.

    Meanwhile, you fit scroll down for today tori dem.

  15. WHO and Gavi, invite Ghana, Kenya, Malawi oda developing kontries to apply for malaria vaccine fund

    WHO and Gavi, di Vaccine Alliance, don invite developing kontries like Ghana, Kenya and Malawi to apply for funding to access di RTS,S malaria vaccine.

    International support worth $160m (£133m) from 2022 to 2025 na im de go make available to di kontries, wey pilot di jab for 2019.

    Oda kontries wey dey affected by malaria fit apply for di funding from September.

    WHO recommend di widespread use of di RTS,S vaccine for October 2021, wey don lead to more kontries expressing interest in am.

    But di jab dey only provide 30% protection.

    To date, about 1.3 million children don receive at least one of di required four doses of di vaccine since dem pilot am in 2019.

    However, di supply remain limited for di continent.

    Africa need at least 80 to 100 million doses annually, according to di WHO.

    Di manufacturer GSK say dem fit only produce about 15 million doses every year until 2028.

  16. Anger as pipo gada burn woman to death inside park

  17. JAMB cut off mark 2022 for university, polytechnic and college of education

  18. Super Falcons boycott training for Morocco sake of unpaid allowances

    Super Falcons

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Fomer Super Falcons player Rachael Ayegba say e dey embarrassing to see di Nigeria women team dey boycott training for Morocco.

    Di Super Falcons squad yesterday no gree comot dia hotel room to train for Friday third place WAFCON match against Zambia on top non payment of bonuses and allowances.

    Di players say dem neva collect dia bonus from di Nigeria Football Federation (NFF) say dem qualify for di tournament, as well as allowances wey dem agree to pay dem and oda $10,000 wey dem owe each of di squad member for di three victories dem get for Morocco.

    Ayegba tell BBC Sports Africa say, "I dey really surprised and disappointed because I bin expect say di NFF go don pass dis kain levels by now. Because dis tin don dey happun for ova 18 to 20 years now, yet na di same tin we dey face."

    She reveal say e happun to di team for di 2019 Women's World Cup for France.

  19. NCAA suspend Dana Airlines operations license and certificate till further notice

    Dana Air staff stand beside dia plane

    Wia dis foto come from, Dana Airlines/Facebook

    Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA) don suspend Dana Airlines Air transport License (ATL) and Air Operator Certificate (AOC) until further notice.

    Inside statement wey NCAA release before midnight on Wednesday on dia Twitter page, dem say di suspension begin wit immediate effect dat same midnight Wednesday 20 July.

    Meanwhile for dia response, Dana Airlines for dia Twitter page announce say dem don cancel all dia flights plus apologise to dia customers for any inconvenience.

    Skip X post, 1
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 1

    Di decision NCAA say, na sake of di financial and economic health audit wey di authority do on di airline show say e no longer dey for position to meet, conduct safe flight or meet im financial obligation.

    “Di decision na di result of financial and economic health audit wey di authority don on di airline, and wetin we discover for di investigation wey we do on di airline flight operations recently, wey reveal say Dana Airlines no longer dey di position to meet im financial obligations and to conduct safe flight operations.”

    Di suspension na according to Section 35(2), 3(b) and (4) of di Civil Aviation Act, 2006 and Part 1.3.3.3(a)(1) of di Nigeria Civil Aviation Regulations (http://Nig.CARs), 2015, e tok.

    Di NCAA audit happun immediately afta one of Dana Air planes do emergency landing for Abuja international airport on Tuesday.

    Di plane land sake of one of im engine bad but nobody injure for di landing.

    Skip X post, 2
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 2

    Skip X post, 3
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 3