Commonwealth games 2022 open for Birmingham with style
Live updates from Nigeria, Africa and across di world.
Live Coverage
'We dey here today sake of goment careless attitude to education'
We dey for Goment House for Port Harcourt Rivers state, south south Nigeria wia di Nigeria Labour Congress, university unions and oda civil groups don gada to protest di five-months old university lecturers strike
Bank of Ghana speak on ‘illegal Ghc22 billion money printing’ claims
NLC solidarity protests for Abuja to hold on Wednesday, Di mega rally na in solidarity to end ASUU strike
Article Information
Author, Tamara Ebiwei
Role, BBC News Pidgin
Nigeria Labour Congress nationwide protest wey dey happun across di kontri today go climax on Wednesday 27th July, 2022.
NLC General Secretary Bello Ismail for statement describe di protest as 'Mega Rally' and na for Unity Fountain dem go gada early mor-mor.
About 40 affiliate Unions dey expected to participate for dis solidarity protests wit Academic Staff Union of Universities (ASUU) wey don dey on stake for 5 months now.
Meanwhile, some member unions dress go di Labour House for di FCT, thinking say di protest go happun today.
But meet disappointment wen dem hear say na tomorrow (Wednesday) be Abuja own.
NLC Protest pictures as e dey happun across Nigeria
Fotos of how di umbrella union of Nigeria civil servants two-day nationwide protest dey go don show.
Nigeria Labour Congress (NLC) ask dia members to enta di streets to demand make goment resolve di strike by public university workers since February.
NLC say dem fit begin a three-day warning strike from Thursday afta di countrywide demonstrations.
Dis pictures display how di protest dey happun around di kontri.
Wia dis foto come from, bb
Oda groups follow join di NLC to protest di continuous strike by ASUU wey Federal goment neva fit solve.
Wia dis foto come from, bbc
Wetin we call dis foto, Constriction Workers Union follow for di protest
Wetin we call dis foto, NUPENG chook hand
Wetin we call dis foto, Nigeria Union of Teachers join
Wetin we call dis foto, Even musician, Falz chook mouth for di mata
Wia dis foto come from, bbc
Wia dis foto come from, bbc
Activist Femi Falana address Lagos NLC protesters
NLC dey tok wetin be dia demands as dem dey protest for Lagos.
Activist Femi Falana address Lagos protesters.
NLC protests: Live feeds from Kano
Students don join protesters for Kano state as dem dey waka go di state goment house to demand make goment find solution to university lecturers strike.
NLC protest on ASUU strike, some nationwide protests wey shake Nigeria
Russia dey wage gas war wit Nord Stream 1 cut - Zelensky
Wia dis foto come from, Reuters
Ukraine don accuse Moscow say dem dey wage "gas war" against Europe and cut supplies to cause "terror" on pipo.
Russia energy company Gazprom announce once again say dem dey reduce gas flow to Germany to allow work on one turbine on di Nord Stream 1 pipeline.
But Ukraine President Volodymyr Zelensky say e be simply "gas blackmail" against Europe.
Di Nord Stream 1 pipeline, wey dey pump gas from Russia to Germany, bin dey run wella below capacity for weeks.
Earlier dis month, Russia biggest European pipeline dey completely shut down for one 10-day maintenance break, spark fear for Europe say shipments fit no resume at all.
Shipments no restart five days ago - though still for reduced capacity.
But on Monday, Gazprom announce say dem go still cut dia gas supply further once again.
Tunisia referendum: President Saied celebrate expected win
Wia dis foto come from, epa
Wetin we call dis foto, President Kais Saied supporters celebrate but turnout dey low
Tunisia President dey celebrate im victory for one referendum for new constitution wey give am almost unlimited powers.
Kais Saied bin show for front of supporters afta exit poll show say more dan 90% of those wey vote support di president plan.
But turnout be only 27.5%, wit main opposition parties boycotting di poll.
Di president opponents say im changes go just establish di personal powers e bin seize one year ago.
Mr Saied said turnout - announced by the country's electoral commission - have been higher if voting had taken place over two days.
E bin promise say Tunisia go now enter one new phase after one decade of political deadlock.
But im opponents go cite di low turnout as denying legitimacy to wetin dem see as worrying move back towards autocracy.
Five tins Ramaphosa say im go use fix SA power outage, Away from di NLC protest across Nigeria dis be some updates from South Africa.
Wia dis foto come from, AFP
Wetin we call dis foto, Pipo no dey see light for South Africa for up to six hours hours a day
Afta three weeks of di worst power outage wey South Africa don see, President Cyril Ramaphosa don announce decisions wey im go put for ground to help solve di kasala.
Dem go include to improve di power utiiy Eskom performance nad open di business of electricity generation give private companies.
Dis dey come afta 10 days of ogbonge tok-tok with energy sabi pipo wey go affect di short and long term needs of di kontri electricity.
Dem include:
To increse di utility maintenance budget so dem go fit fix di power stations wey don old.
Goment go buy more electricity from independent power producers to carry put for di national grid.
Eskonm go also source electricity from Botswana and Zambia with di Southern Africa Power Pool.
Comot di business red tape for renewable power projects and give pipo an businesses dem ginger to install and sell power give di national grid
For future, Eskom go coexist with private companies to get diversity of electricity supply even though di national grid na di state go still own am fully.
LIVE: NLC protest begin for Port Harcourt
Article Information
Author, Karina Igonikon
Role, BBC Pidgin, Port Harcourt
We dey for Labour House for Port Harcourt Rivers state, south south Nigeria wia di Nigeria Labour Congress, university unions and oda civil groups don gada to protest di five-months old university lecturers strike.
LIVE: NLC Lagos protest begin
Article Information
Author, Andrew Gift
Role, BBC Pidgin, Lagos
Members of di Nigeria Labour Congress (NLC) dey do solidarity protest ontop di ongoing strike by di kontri university workers wey don reach five months.
Currently, di group dey Ikeja for Lagos, southwest Nigeria.
LIVE: Kano NLC protest
Article Information
Author, Mansur Abubakar
Role, BBC Pidgin, Kano
We dey for Mundubawa Kano state, northern Nigeria wia di Nigeria Labour Congress, university unions and oda civil groups don gada to protest di five-months old university lecturers strike
Nigeria labour begin nationwide protest
Wia dis foto come from, Twitter
One
umbrella union of Nigeria civil servants wan start two-day nationwide protest today.
Nigeria
Labour Congress (NLC) ask dia members to enta di streets to demand make goment resolve
di strike by public university workers since February.
NLC
say dem fit begin a three-day warning strike from Thursday afta di countrywide demonstrations.
Follow
dis website for all di latest updates.
Una Good Morning
Shey bodi dey inside cloth wella?
Oya siddon well-well as we bring una all di latest Nigeria, Ghana, African and world tori as e dey hot.
Today, we go give special attention to Nigeria Civil Servants Union, NLC nation-wide protest ontop ASUU Strike.
France Macron dey Cameroon to begin Africa trip - Dis be what to expect
'My papa burn my training gear' - Amusan
Ghana govment re-introduce toll collection on new roads
Scroll down for Monday tori!, Una bye-bye!
Na here
we go end our live updates of di tori dem from across Nigeria, Africa and di
world.
Join us
again on Tuesday by 9:00am
Meanwhile,
you fit scroll down for Monday tori.
Experts don find out di likely cause of mystery child hepatitis outbreak