Commonwealth games 2022 open for Birmingham with style
Live updates from Nigeria, Africa and across di world.
Live Coverage
Scroll down for Tuesday tori!, Una bye-bye!
Na here we go end our live updates of di tori dem from across Nigeria, Africa and di world.
Join us again on Wednesday by 9:00am
Meanwhile, you fit scroll down for Tuesday tori.
Covid origin studies show say evidence point to market
Russia foreign minister don land Ethiopia

Wia dis foto come from, MFA/Twitter
Wetin we call dis foto, Russian Foreign Minister Sergei Lavrov dey for Addis Ababa Russian Foreign Minister Sergei Lavrov don Ethiopia's capital, Addis Ababa wey also be di African Union headquarters on di last leg of im African tour.
Di foreign ministry tweet fotos of im welcome.
Di reason for im visit na to strengthen Moscow ties wit di continent, where many kontris bin dey reluctant to take sides and bin condemn Russia on top di invasion Ukraine.
Oga Lavrov dey expected to meet senior government officials, members of di diplomatic community and officials from di African Union Commission.
Preparations for di upcoming Africa-Russia Summit dey scheduled to take place for Addis Ababa later dis year also dey on di agenda.
Skip X postAllow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
How to check your poo weda you get bowel cancer
Election, rule of law, details of wetin President Buhari tok for Liberia
'Buhari don do all and even more dan wetin dey expected on security'- Aide

Wia dis foto come from, State House
Nigeria Presidency, dey reassure dia kontri pipo say di president don do all, plus even more wetin dey expected of am as Commander-in-Chief.
Inside statement wey Senior Special Assistant to di President on Media and Publicity, Garba Shehu say:
"Di President don do all, and even more dan wetin dey expected of am as Commander-in-Chief by way of morale, material and equipment support to di military and im expect notin short of good results.”
Oga Shehu tok dis one inside statemen wey im title di “latest version of terror propaganda and military readiness.”
E say di kontri security and defence forces “no dey clueless or helpless.”
Dem get dia plans and ways of doing tins wey dem no go fit display for media.
Talking about di specific case of train terrorists, Oga Shehu say goment no go fit fulfil di call of di angry pipo wey want make dem bomb di locations wia di kidnappers dey becos di hostages dey innocent.
Archbishop of Canterbury do U-turn on same sex marriage afta Bishops outcry

Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Di Archbishop of Canterbury na di leader of di global Anglican communion Di Archbishop of Canterbury don withdraw one motion wey ask Anglican bishops around di world to kick against same-sex marriage.
Justin Welby bin respond to one strong criticism from dozens of progressive bishops wey describe di motion as outdated.
The Guardian report say di Archbishop of Canterbury inside statement say im don consider di comments wey some bishops make about di Lambeth Calls, e say di subgroup wey dey coordinate di process go meet wit am to discuss di concerns dem raise and go issue further statements later.
Di bishops dey among di 650 bishops wey gada for di Canterbury for di first Lambeth Conference wey dey happun in 14 years.
Di 15th Lambert conference 2022 go begin for 26 July to 8 August and bishops go discuss issue of same sex marriage.
For inside di Lambert Calls, Guidance and study documents for 1998, e state say “Na di mind of di Anglican Communion as a whole say same gender marriage no dey allowed. Lambeth Resolution I.10 (1998) state say “legitimizing or blessing of same sex unions” no dey advised. Na di mind of di Communion to uphold “faithfulness in marriage between a man and a woman in lifelong union” (I.10, 1998).xxviii Na also di mind of di Communion say“all baptized, believing and faithful persons, regardless of sexual orientation are full members of di Body of Christ” dem go dey welcomed, cared for, and treated wit respect (I.10, 1998).
Homosexuality na deeply divisive issue among Anglicans, and socially conservative Church leaders from Nigeria, Rwanda, and Uganda wey don boycott di meeting for southern England on top di gay marriage issue.
Di Lambeth conference dey expected to include discussion on topics, like climate change, poverty, and peace.
Buhari request Senate confirmation for 19 RECS nominees

Wia dis foto come from, State House
Nigeria President Muhammadu Buhari don write Senate to confam 19 nominees as Resident Electoral Commissioners (REC) of di Independent National Electoral Commission (INEC).
Di president make di request for confirmation inside one lettee letter dated 25 July 2022.
Senate President, Ahmad Lawan, read di letter for plenary.
President Buhari, for di letter want di house to confam di nominees according to di provisions of Section 154 (1) of di Nigerian Constitution.
For di letter im explain say di nomination of five Resident Electoral Commissioners na for renewal, while di oda 14 na fresh appointments.
Di nominees for confirmation go be REC for Adamawa, Cross River, Taraba, Ogun, Kogi, Imo, Sokoto, Oyo, Katsina, Ebonyi, Benue, Delta, Kaduna, Kano, Enugu, FCT, Bauchi, Anambra and Yobe.
Russia wan comot from International Space Station

Wia dis foto come from, ROSKOSMOS
Wetin we call dis foto, Russian cosmonauts for ISS recently display di flag of di self-declared Luhansk Pipo Republic Russia say dem go withdraw from di International Space Station (ISS) afta 2024 and build dia own station instead.
Di new head of Russia space agency, Yuri Borisov, say Roskosmos go honour all dia obligations until then.
Di US and Russia, along with oda partners, don successfully work togeda on di ISS since 1998.
But di relationship don sour since Russia invade Ukraine, and Russia don before now threatened to leave di project because of Western sanctions against dem.
Di ISS - wey be one joint project involving five space agencies - don dey in orbit around Earth since 1998 and authorities dey use dem to conduct thousands of scientific experiments.
E dey approved to operate until 2024, but di US bin want to extend that for six more years with di agreement of all partners.

Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, Di ISS don dey orbit Earth since 1998 For one meeting with Russia President Vladimir Putin, oga Borisov tok say dem take di decision to quit di project afta 2024.
"I think say by dis time we go start to dey put togeda one Russian orbital station," oga Borisov tok, adding say di new station na im agency top priority.
"Good," Putin reply.
E no dey immediately clear wrtin di decision mean for di future of di ISS, with one senior Nasa official wey dey tell Reuters say dem neva officially inform di US agency of Russia plans.
U.S. accuse China say e dey increase South China Sea 'provocations'

Wia dis foto come from, Reuters
United States on Tuesday accused China say e dey increase im "provocations" against im rival wey follow am dey claim territory for South China Sea and oda states wey dey operate for dia.
"E get clear and upward trend of People’s Republic of China provocations against odas wey follow dey claim South China Sea and oda states wey lawfully dey operate for di region,” Jung Pak, deputy assistant secretary for East Asia for U.S. State Department, tok for U.S. think tank event.
Pak tell di Centre for Strategic and International Studies say Chinese aircraft dey increasingly engage in unsafe intercepts of Australia aircraft for international airspace above di South China Sea and for three separate incidents for di last few months im don challenge marine research and energy exploration activities wey dey exclusively inside di economic zone of Philippines.
Why Lagos goment declare four work free days for public servants, Each goment worker dey entitled to di free work days
Article Information - Author, Andrew Gift
- Role, BBC Pidgin, Lagos

Wia dis foto come from, Lagos govt
Wetin we call dis foto, Lagos govt logo Goment for Lagos state southwest Nigeria don declare four work free days for workers to go register or collect dia Permanent Voters Cards PVC as di kontri general election don dey reach.
For statement di state head of service Hakeem Muri-Okunola say di goment dey use dis means to encourage workers to perform dia civil rights.
Independent National Electoral Commission INEC recently tok say out of over 15 million pipo wey dey Lagos, only seven million don register for PVC.
According to di statement workers for different grade levels go get one free day each to go do di registration starting from Tuesday July 26 to Friday July 29 2022.
Di statement say dem dey expect say workers go return back to work with dia PVC.
Similarly, goment for Ogun state also declare Tuesday July 26 as work free day so di state workers go fit go register or collect dia PVCs.
Nigeria dey prepare to hold her general elections for 2023.
Di kontri dey expected to elect a new president wey go lead di kontri for di next four years.
Buhari write Senate to ask confirmation for new CJN

Wia dis foto come from, Nigeria Presidency
President Muhammadu Buhari don ask Senate to confam Justice Olukayode Ariwoola as di Chief Justice of Nigeria (CJN).
Di President request bin dey inside one letter wey Senate President Ahmed Lawan read for di beginning of plenary on Tuesday.
Di request for confirmation, na according to Section 231(1) of di 1999 Constitution of Nigeria.
Although Buhari bin appoint and sworn in Oga Ariwoola as acting CJN capacity last month, e dey mandatory say du Senate go confam di appointment.
Di president appoint di new CJN some weeks back afta im predecessor, Muhammad Tanko, resign sake of im health condition.
We no dey inherit pipo enemies - Uganda President chook mouth on Russia/Ukraine conflict

Wia dis foto come from, AFP
Wetin we call dis foto, Russian Foreign Minister Sergei Lavrov (R) say im appreciate di position President Museveni (L) take on di Russia/Ukraine conflict Uganda, President Yoweri Museveni say im no go pick side for di Russia/Ukraine conflict.
Di Ugandan leader tok dis one for one joint press conference wey e togeda do wit Russian Foreign Minister Sergey Lavrov wey dey on tour to four African kontris.
“We no believe to be enemies to somebody enemy. No, we wan make our own enemies, we no wan fight oda pipo enemies, dis na our doctrine,” e tell tori pipo.”
E add join say Uganda wan trade wit Russia and with all kontris for di world.
Oga Lavrov say Moscow appreciate di position wey Uganda take regarding di conflict for Ukraine, e say e dey “well-balanced and responsible”.
E deny am again say Russia no dey to blame for di global fuel and grain shortage.
Last week, Russia and Ukraine sign one agreement to allow grain shipments from Ukrainian ports to resume.
Oga Lavrov last stop na Ethiopia, where dem go expect am to lay di ground for di next Russia-Africa summit.
Speaker Nigeria House of Representatives go school for US amidst ASUU strike

Wia dis foto come from, Femi Gbajabiamila/Twitter
Wetin we call dis foto, Speaker Femi Gbajabiamila back to school Speaker of di Federal House of Representatives, Femi Gbajabiamila don go back to school for di United States of America
Di speaker for im official Twitter handle post pictures of where im pose for di Harvard Kennedy School, John F. Kennedy School of Government.
E tweet say “Back to class. In a leadership course for @Harvard @Kennedy School."
Meanwhile for im home kontri Nigeria, Nigeria Labour Congress dey on two-days nationwide protest to support di Academic Staff Union of Universities wey don dey on strike for di past five months.
Di labour unions ask dia members to enta di streets to demand make goment resolve di strike by public university workers since February.
NLC say dem fit begin a three-day warning strike from Thursday afta di countrywide demonstrations.
Nigerian students also join for di protest.
Di Academic Staff Union of Universities, bin begin strike on February 14 2022 to demand for beta condition of service wey dem agree for 2009 agreement.
Skip X postAllow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
15 pipo die for big anti-UN protest inside DR Congo

Wia dis foto come from, AFP
Wetin we call dis foto, Dem lite fire outside di UN HQ for Goma on Monday At least 15 pipo don die during protests against one UN peacekeeping force for Goma for di Democratic Republic of Congo, police tok.
Seven of di dead pipo na civilians while di odas na UN personnel.
Local tori pipo dey report say na di peacekeepers shoot di protesters.
But the UN mission, Monusco, neva respond to dis reports.
Recently violence don rise for di area and area pipo dey accuse UN say dme no dey try
Demonstrations continue to protest for second day, demanding say make di peacekeeping force (Monusco) leave.

Wia dis foto come from, AFP
Wetin we call dis foto, Di chaos continue on Tuesday for one UN base Di protests, wey di goment youth wing call for, turn into violent wen demonstrators storm di mission local headquarters and logistical base.
Chaotic scenes of burning and looting na dey go on. Graphic image wey pipo share on social media show one protester lie down for ground as odas dey shout shout say UN forces don shot am.

Wia dis foto come from, AFP
Wetin we call dis foto, Some areas wey dem loot Local media report on Monday tsay UN forces fire live bullets to prevent protesters from attacking di premises.

Wia dis foto come from, AFP
Wetin we call dis foto, Protesters loot one UN warehouse on Monday... 
Wia dis foto come from, AFP
Wetin we call dis foto, Dem lite fire for di scene afterwards “We no get anything to say now, we dey for bad times,” Monusco spokesperson Khady Lo Ndeye tell di BBC wen dem ask am about di reports of casualties.

Wia dis foto come from, AFP
Wetin we call dis foto, Protesters accuse di peacekeepers of failing to deal with rebels Di goment say dem don ask di army and police to restore calm for Goma.

Wia dis foto come from, AFP
Wetin we call dis foto, Soldiers try to control di situation on Tuesday Dem don deploy di UN force to di volatile region, where more than 100 active rebel groups dey, for more than 20 years
Local dey criticise dem for failing to restore peace, especially for time wey resurgence of di M23 rebel movement dey happun.
DR Congo accuse neighbouring Rwanda of supporting M23 - but Rwanda deny.
Three weeks ago, tdi kontri two leaders agree on "de-escalation process" for eastern DR Congo.
Japan execute man wey kill pipo sake of online bullying

Wia dis foto come from, STR/AFP VIA GETTY IMAGES
Japan don execute one 39-year-old man wey kill seven pipo for Tokyo for 2008 during one stabbing rampage.
Tomohiro Kato commit wetin be one of di most shocking mass murders for di kontri recent history.
Im be 25 wen im drive a truck enta one lunch-time crowd of pedestrians for Akihabara shopping district, kill three pipo.
Im later stab passers-by wit one dagger, kill four and wound eight pipo.
Police later catch am for di scene and im later admit im crimes for im trial, say na online bullying vex am.
Di crime bin don cause plenty debate for Japanese society at dat time ontop random killings, online influence and di failures in mental health support for young pipo.
Authorities also tighten di laws on knife ownership sake of am.
Govnor Diri don approve increment of subvention to tertiary institutions.
Article Information - Author, Karina Igonikon
- Role, BBC Pidgin, Port Harcourt

Wia dis foto come from, Gabriel Inam Emmanuel
Wetin we call dis foto, Bayelsa State Governor say students must go back to school so dem get understanding with ASUU Bayelsa State Governor, Sen. Douye Diri don approve increment of subvention to tertiary institutions for di State.
Di Governor tok dis one wen im address protesting members of Nigeria Labour Congress NLC wey do solidarity rally to support Academic Staff Union of universities wey dey on strike for Goment House gate in Yenagoa.
Di Governor commend NLC, ASUU, di Student union and oda unions wey participate for di solidarity rally for dia peaceful conduct.
Governor Diri say e no dey happy as universities dey shut down for over five months and so e identify with dem.
Direr come assure dem say e go send dia message to di presidency both by writing and evri oda means wey dey legitimate to ensure say dis problem between ASUU and di Federal Goment dey resolved.
E add say becos dem want di students to go back to school, dem invite ASUU during dis strike for meeting wia dem resolve say despite say Bayelsa dey do solidarity strike, di State Goment go continue to pay dia salaries.
E add say for di State level, dem get some local ASUU matters and e don set up committee to resolve am and di committee dey work well.
Eight schoolchildren die inside Tanzania bus accident

Wetin we call dis foto, Tanzania map Eight children, one teacher and one driver don die afta one minibus wey dey carry dem go school fall inside pothole for southern Tanzania.
Nineteen other pupils from King David School injure for di accident on Tuesday morning, di police chief of di Mtwara region, Nicodemus Katembo, tok.
Dem don carry pipo wey injure go Mtwara Referral Hospital for treatment.
Authorities dey torchlight di cause of di accident.
Tanzanian President Samia Suluhu Hassan don tok sorry to di family of pipo wey die.
ASUU - Nigeria public university lecturers strikes since 2009


