Commonwealth games 2022 open for Birmingham with style

Live updates from Nigeria, Africa and across di world.

Live Coverage

  1. Italian PM Mario Draghi resign afta a week of kasala

    Mario Draghi wave goodbye for parliament

    Wia dis foto come from, Reuters

    Mario Draghi don resign as prime minister one year-and-a-half afta dem appoint am Italy unelected head of a unity goment,

    E tell President Sergio Mattarella say e dey stand down afta three parties for im goment refuse to back am for one confidence vote di night before.

    Di president ask am to remain as caretaker leader and early elections dey expected to shele dis autumn.

    Oga Draghi, wey be 74 years old, na popular choice as prime minister, dem nick name am Super Mario for di way e take handle di eurozone crisis as head of di European Central Bank.

    For February last year, dem give am di task of guiding Italy through di Covid pandemic and economic recovery.

    Oga Draghi don first tender im resignation one week ago wen one populist party for im broad-based goment refuse to back one economic package for businesses and families.

    President Mattarella bin ask am to stay in di post and afta days of silence, Draghi tell di upper house of parliament e go continue.

    But now e don finally resign.

  2. US President Joe Biden test positive for Covid

    US President Joe Biden test positive for Covid

    Wia dis foto come from, EPA

    Wetin we call dis foto, US President Joe Biden test positive for Covid

    US President Joe Biden don test positive for Covid-19 and dey isolate for di White House.

    Di 79-year-old wey dey fully vaccinated and don collect di booster jabs two times dey experience "very mild symptoms" and go continue to carry out all im duties, press secretary Karine Jean-Pierre tok inside statement.

    Di statement add say di president dey take di antiviral medicine, Paxlovid.

    She say e go take part for meetings via telephone and Zoom.

    As e dey wit di White House protocol, di president go continue to work in isolation until he test negative, Ms Jean-Pierre tok.

    First Lady Jill Biden test negative wen she dey Delaware.

  3. CIA chief say no intelligence informate say Putin no well

    Russia President Vladimir Putin

    Wia dis foto come from, Getty Images

    E no get any intelligence informate say Vladimir Putin dey unstable or no well, director of di US Central Intelligence Agency don tok.

    Plenty tori without confirmation bin dey fly upanda for media say maybe Oga Putin, wey go turn 70 years dis year, dey suffer from sickness, possibly cancer.

    But William Burns say e no get any evidence to suggest dis, im joke add say Putin appear "too healthy".

    Kremlin don once again dismiss tori say Putin no well as "notin but fake".

    Di tok dey come as US announce say e go provide Ukraine wit more long-range weapons.

    Earlier Russia Foreign Minister Sergei Lavrov say Russia military focus for Ukraine now, no be "only" di east and suggest say Moscow strategy change afta di West supply Ukraine wit dis kain weapons.

  4. Key Russian pipeline don resume pumping gas to Europe

    Nord Stream 1 run under di Baltic Sea from Russia to Germany

    Wia dis foto come from, Alamy

    Russia don resume pumping gas to Europe through dia biggest pipeline afta warning say dem fit stop supplies altogeda.

    Di Nord Stream 1 pipeline restart afta one 10-day maintenance break but at reduced level.

    On Wednesday, di European Commission advise kontries to cut gas use by 15% ova di next seven months in case Russia switch off Europe supply.

    Russia supply Europe with 40% of dia natural gas last year.

    Germany na di continent largest importer for 2020, but don reduce dia dependence on Russian gas from 55% to 35%. Dem dey even plan to stop using gas from Russia altogeda.

    Russia invasion of Ukraine for February make wholesale gas prices climb up for Europe.

    Di European Commission say retail electricity prices for households inside EU capitals dey up by 44% for May 2022, compare to May 2021.

    Di highest rise na for Netherlands (up 167%), Austria (up 122%) and Italy (up 118%).

  5. Ugandan President Museveni tok why e no dey give subsidy

    Ugandan President Museveni tok why e no dey give subsidy

    Wia dis foto come from, Reuters

    Ugandan President Yoweri Museveni defend im goment decision not to give subsidies or reduce taxes as cost of living dey increase.

    Oga Museveni say subsidies dey mislead pipo to tink say goment get plenty money and e go reduce di kontri foreign reserves.

  6. 'Wen I born my pikin doctor no tell me weda na boy or girl'

  7. Who be di Christian clerics wey attend Kashim Shettima unveiling?

  8. South Africa hospital use robot to perform surgery

    South Africa hospital use robot to perform surgery

    Wia dis foto come from, Reuters

    Wetin we call dis foto, One nurse positions di robot called DaVinci wey dey perform delicate operation for South African surgeons Dr Tim Forgan and Dr Imraan Mia at di Tygerberg hospital for Cape Town, South Africa on 15 July, 2022

    One surgical team led by Dr Tim Forgan uses di da Vinci Xi robot to assist in removing one cancerous rectal tumour from a female patient at Tygerberg public hospital for Cape Town, South Africa.

    Di robot, wey get four 'arms' dey controlled in real time by Forgan via an immersive 3D consul, and na di most advanced surgical robot for Africa.

    Na one of di only two robots in Africa for dat purpose, and both of dem come from South African public hospitals in Cape Town.

    Dem dey use dem mainly for complex urological, gynaecological and colorectal surgeries for dis hospitals.

    Di first operation using di newly-acquired robot dey performed at Tygerberg hospital for February, and dem don successfully complete oda operations since den.

  9. Sri Lanka don swear in dia new president

    President Ranil Wickremesinghe

    Wia dis foto come from, Reuters

    Sri Lanka don swear in dia new President Ranil Wickremesinghe.

    Di 73-year-old take im oath at di parliament complex on Thursday under heavy security.

    Oga Wickremesinhe take ova from Gotabaya Rajapaksa wey run komot from di kontri and resign sake of mass protest.

    Sri Lanka dey currently battle mass unrest over an economic crisis.

    Plenti blame di Rajapaksa administration for mishandling di crisis and see Mr Wickremesinghe as part of di problem - but few demonstrations dey di streets di day after Mr Wickremesinghe win di parliament vote.

    However security still dey tight around goment buildings for di capital.

  10. NYSC DG tok sorry to families of corpers wey die for road accident

    National Youth Service Corps oga Brigadier General Muhammad and one oda man

    Wia dis foto come from, Nigerian Army

    National Youth Service Corps oga Brigadier General Muhammad Kaku don tok sorry to di families of corps members wey die for accident.

    Di corps members get accident on dia way back home to Kaduna northwest Nigeria afta di orientation course for north-eastern state of Adamawa.

    General Fadah twale di patriotic spirit of Corps Members wey die while serving dia fatherland.

    Di Director-General also carry waka go visit two Corps Members wey survive di accident but receiving treatment for di 44 Military Hospital in Kaduna.

  11. Magnus Abe don dump APC, Sen. Abe na di latest member to dump di APC as many of di party bigwigs don resign comot in recent times.

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Port Harcourt
    Sen. Magnus Abe

    Wia dis foto come from, Sen. Magnus Ngei Abe

    Wetin we call dis foto, Sen. Magnus Abe don join many odas to dump Rivers APC

    Di former Senator wey represent Rivers South-East for di Nigerian Senate, Magnus Abe, don announce im resignation from di All Progressives Congress for Rivers State.

    Abe however still pledge im support for di presidential bid of Asiwaju Bola Tinubu.

    “Yesterday, e get some funny letters wey bin dey for internet say I resign from di APC because Asiwaju refuse to intervene for di politics of Rivers state. Dat one dey ridiculous. All politics dey local. I no get any interest for APC in Rivers state."

    Sen. Abe add say im leave di party for di state to pursue im political ambitions for anoda party even though im no tok di political party.

    E don join many oda popular members of di APC wey don comot from di party for Rivers State in recent times and dis dey make pipo wonder wetin really dey go on for di party wey make pipo dey resign comot.

    Meanwhile, State Publicity Secretary of di APC for Rivers State, Chris Finebone, say na since dem dey expect Abe to resign from di party so dis im resignation now no surprise dem.

    E say, “Rivers APC go now breathe a sigh of relief from di sustained attacks by Senator Abe. We wish am well as im go join di SDP. We pray say im go take evritin im exhibit for APC, particularly im nuisance value, go im new party so dat di world go see am as im truly dey."

    Finebone come say di tori say di Former Minister of Transportation, Chibuike Rotimi Amaechi sef don comot from di party na fake news to spoil im image.

    On di recent resignations by members of di party, di Rivers APC tok tok pesin Finebone say dem fall into two categories: "to di ones wey add value, we wish dem well, but to di odas, we say good riddance.”

  12. Gleison Bremer: Juventus sign Brazilian defender from Torino

    Gleison Bremer: Juventus sign Brazilian defender from Torino

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Juventus don sign Brazilian defender Gleison Bremer from Torino on a five-year contract in a deal wey worth 41m euros.

    Di 25-year-old dey replace Netherlands international Matthijs de Ligt wey join Bayern Munich on Tuesday.

    Bremer make 110 appearances for Torino afta joining from Brazilian side Atletico Mineiro in 2018.

    Im bin start 33 of dia 38 league games last season and dem name am Serie A's best defender for di 2021-22 campaign.

  13. Nigerian woman chop arrest afta allegedly stealing one-day old baby

    Nigerian woman chop arrest afta allegedly stealing one-day old baby

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Police for Ondo State southwest Nigeria don arrest one woman for Sagamu wey specialise in stealing babies.

    Dem gbab am afta she steal one-day old baby on July 13 and police say she confess say she steal anoda baby last year January but di baby die few days later.

    "During interrogation, she confess say she steal anoda baby in January 2021 but di baby die few days later. Her format na to beg for where to pass di night and di next day she go run wit di host baby," police tok.

    Police don advise parents to dey careful on who dem leave dia children wit and be vigilant.

  14. Ivana Trump burial hold for New York City

    Ivana Trump's burial hold for New York City

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Donald Trump Jr, Eric Trump and Ivanka Trump alongside dia families at di burial

    Dem don bury di first wife of former US President Donald Trump for New York City yesterday.

    Ivana Trump die last week at di age of 73 and her burial bring family togeda as dem pay dia last respect.

    Among pipo wey attend na Donald and Ivana's three children, Ivanka, Eric and Donald Trump Jr, wey give tributes.

    Donald Trump and Ivana Trump marry for 15 years between 1977 and 1992.

  15. Chad goment ban young girls from leaving di kontri

    Chad goment ban young girls from leaving di kontri

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Chad goment don ban young girls from leaving di kontri witout parental permission.

    Security Minister General Idriss Dokony Adiker say many young girls dey leave di kontri for di purpose of exploitation.

    Di announcement go prevent airlines and transportation agencies from taking young girls on board.

  16. Nigeria Super Falcons no attend training sake of unpaid bonus

  17. Why goment ask native doctors and spiritualists to register for Anambra

  18. Una goodnight!

    Na here we dey march break on our coverage of top stories from across Nigeria, Africa and di world today.

    Join us again by 9:00am on Thursday.

    Goodnight!

  19. NBTE neva send us any license revocation notice - Abia Poly

    Di goment body wey dey in charge of Polytechnic Universities for Nigeria, di National Board for Technical Education (NBTE) say dem don collect back di accreditation right wey dem give Abia State Polytechnic to be full-fledged university.

    One top official for NBTE on Thursday explain give BBC say dem revoke di accreditation sake of di school neva pay workers salaries for two and a half years.

    Wen BBC Igbo call di Abia state Commissioner for information, Eze Chikamnayo, for fone, im say make dem call am back but im no dia calls again.

    Tok-tok pesin for di school, Nwakanma Stella, refuse to comment on di cancel of di license as she say: "Di truth be say, NBTE neva send us letter say dem revoke our license to be university in full, education still dey go on."

    She add say: "Na di school principal or im deputy fit speak about dis mata."