Commonwealth games 2022 open for Birmingham with style

Live updates from Nigeria, Africa and across di world.

Live Coverage

  1. Na here we go march break for our live updates today.

    Join us again tomorrow by 9:00am.

  2. Algeria, Nigeria and Niger don agree to build one gas pipeline

    Map

    Algeria, Nigeria, and Niger don sign one memorandum of understanding to build gas pipeline across di Sahara.

    Algerian Energy Minister Mohamed Arkab tell reporters afta di ceremony say "di three kontri go continue tok-tok to undertake di project as soon as possible".

    Di pipeline wey go link Nigeria to Algeria through Niger go get di capacity to supply 30 billion cubic metres of gas to Europe, in desperate need to diversify im gas supply sake of Russian action following di invasion of Ukraine.

    Dem estimate di moni to build di 4,000km (2,500 mile-) pipeline at $13bn (£10.7bn).

    Dem don first sign one earlier agreement for 2009 for di construction of di pipeline but dem no tok about am again later.

  3. Ghana presidency and police respond to Corruption Perception Report

    Ghana President Nana Akuffo-Addo

    Wia dis foto come from, Presidency

    Wetin we call dis foto, Ghana President Nana Akuffo-Addo

    Ghana Presidency and di police don disagree wit one corruption perception report wey rank dem as di most corrupt institutions for di kontri.

    Deputy Director of communications for di Presidency, Jefferson Sackey tell BBC say di surveys na perceptions and no reflect reality.

    E say President Nana Akuffo Addo don take steps to strengthen anti-corruption institutions and dis include establishment of di office of a special prosecutor wey go deal wit corruption.

    Di police for inside statement also question di methodology dem use for di rankings.

    Di Inspector General of di Ghana Police Service, Dr George Akuffo Dampare agree say, although some officers dey indulge in corruption, but dem put measures in place to address di problem.

    Oga Dampare add say risk dey say di ‘research fit dey affected wit di eye wey pipo dey carry look police for di past.’

    Separate surveys on corruption perception rank di presidency and di police as di most corrupt institutions for di kontri.

  4. Man wey be 66 years become fourth pesin to dey cured of HIV

  5. World Cup 2022: Ghana go face Switzerland in warm-up for Qatar

    Ghana play friendlies against Japan and Chile last month

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Ghana play friendlies against Japan and Chile last month

    Ghana go play Switzerland for di pre-World Cup friendly match for United Arab Emirates as build-up to di World Cup 2022.

    Di meeting between di Black Stars and di Swiss on 17 November for di Baniyas Stadium for Abu Dhabi go be di first time di kontris go face each oda for di senior international level.

    Ghana Football Association say di game go serve as perfect preparation for coach Otto Addo ahead of dia World Cup Group H opener against Portugal seven days later.

    Na only one-week window of preparation remain for di 32 kontris wey go compete for Qatar as players dey join up wit dia national teams from 13 November.

  6. US economy shrink again ontop recession alarms

    US Economy

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Di US economy don shrink for di second quarter in a row, dis na one milestone wey dem go consider economic recession for many kontries.

    Dis no be di case for di US, wey dey use additional data to make dat call.

    But di contraction, for annual rate of 0.9% for di three months to July, don draw widespread attention as worries about di economy dey grow.

    Prices for groceries, petrol and oda basics dey increase for di fastest pace since 1981.

    As di US central bank raise borrowing costs quickly to try to cool di economy and ease price pressures, fears dey increase say recession dey come - if e neva even start officially already.

    US President Joe Biden don try to make di case say di economy remain sound, noting dat di unemployment rate remain at low 3.6% and hiring remain strong.

    Dis week, ahead of di data from di Commerce Department, e tell reporters say di economy "no go dey in recession". Dis one prompt im opponents for di Republican party to accuse di White House of trying to redefine di term.

    "White House recession 'rebrand' no go reduce Americans' suffering," dem tok.

  7. India health worker vaccinate 30 India students wit one injection

    India compulsory one injection per pesin vaccination drives

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, India compulsory one injection per pesin vaccination drives

    Dem don dey investigate one health official wey vaccinate 30 students wit one injection for di central Indian syate of Madhya Pradesh.

    Di mata happun for one school for Sagar district wia dem dey give children di Covid- 19 vaccine.

    Jitendra Rai, wey dey vaccinate di children, tell tori pipo say na only one injection di health department give plus im just dey follow orders.

    Parents wey follow dia children go school na dem notice di issue and report to di school authorities.

    Wen state officials reach di school, oga Rai don japa from di school and switch off im fone.

    Di state health department bin don register one case of negligence against am.

    E don also start inquiry against di official wey dey responsible for dispatching equipment for di vaccination drive.

    India health ministry compulsory "one needle, one syringe, only one time" protocol for Covid-19 vaccines.

  8. Tanzania ban popular sex-enhancement herbal drug

      • Author, Alfred Lasteck
      • Role, BBC News, Dar es Salaam

    Tanzania health authorities don ban di use of one popular traditional herbal treatment dem dey call Hensha wey dem sell on di basis say e help to improve male sexual performance.

    Di Traditional and Alternative Health Practice Council chairman, Prof Hamisi Malebo, say di decision to ban am come afta recent investigations.

    E say laboratory tests ontop di herbal compound show say e get elements of di drug sildenafil, wey dey better known as Viagra. E say Hensha dey unsafe and im producer no abide by di council regulations.

    Di herbal powder dey usually made from a blend of leaves, roots and bark of a Mkongo tree, found in East Africa.

    Other producers dey sell am under different brand names.

    Dem don ask di producers of Hensha to immediately withdraw am from di market.

    Prof Malepo say promotion of traditional medicines, herbs or alternative drugs without "having di registration and certification of di council na offence".

    Tanzania dey encourage di use of traditional medicine and for 2020, approve di sale and use of five traditional treatments for di market to boost sexual performance.

    Di herbal drug

    Wia dis foto come from, Jamii Forums

  9. Kano Court sentence school owner to death for murder of Hanifa Abubakar

  10. Ghana Presidency and police dey corrupt - New report

    Ghana Presidency and police dey corrupt - New report

    Wia dis foto come from, Ghana Presidency

    Ghana Presidency and police na di most corrupt institutions for di kontri, new report tok.

    Dat na according to one new report by di Ghana Centre for Democratic Development, one research and advocacy think tank.

    Out of 100%, di police score 65% wey make am di most corrupt institution while di Presidency score 55% as di second most corrupt institution for public perception survey.

    Dis report dey come afta dem establish di office of one special prosecutor to fight corruption.

    Tori be say wen President Akufo-Addo assume office for 2017, im promise to protect di public purse and fight corruption.

    But im goment dey face allegations of corruption, something wey dem don deny.

    Goment statistician Professor Samuel Kobina-Annim bin suggest say about $500 million bin dey paid as bribe last year for another survey.

    Di latest afrobarometre report show say perception of corruption among public officials and institutions don increase by ova 20% since 2019.

    And public officials including MPs, judges, magistrates, tax officials and di electoral commission na dem dey among di most corrupt institutions.

    Only 30% of Ghanaians believe say dem fit report corruption cases without fear of retaliation.

    Meanwhile Ghana Armed Forces (GAF), religious leaders and traditional rulers dey perceived as di most trusted institutions for di kontri.

    Ghana Presidency and di police disagree wit dicorruption perception report wey rank dem as di most corrupt institutions.

    Deputy Director of communications for di Presidency tell BBC say surveys be perceptions and no reflect reality.

    Jefferson Sackey say President Nana Akuffo Addo don take steps to strengthen anti-corruption institutions including di establishment of di office of a special prosecutor to deal with corruption.

    Ghana police service inside one statement also question di method used in di rankings.

    Inspector General of di Ghana Police Service admit say although some officers dey involved in corruption, measures dey in place to address di problem.

    IGP George Akuffo Dampare add say risk dey say di ‘research fit dey affected by a historically pervasive stereotyping of di police’ - meaning a wrong way of viewing di police for a long time.

    However, separate surveys on corruption perception don rank di Presidency and di police as di most corrupt institutions inside di kontri.

  11. Court grant former Accountant General of Nigeria bail to di tune of five billion naira, Court adjourn di trial to 10th and 11th of August, 2022.

      • Author, Tamara Ebiwei
      • Role, BBC News Pidgin
    Ahmed Idris

    Wia dis foto come from, BBC Hausa

    Di Federal Capital Territory (FCT) High Court don grant Nigeria former Accountant General of di Federation, Ahmed Idris, bail.

    Justice Ajayi Adeyemi wey be di Presiding Judge, give di ruling afta she hear di bail applications of di defendants.

    Ahmed Idris, di suspended head of Nigeria treasury and two oda pipo go now comot from di Kuje prison wia dem bin dey since on Friday.

    Justice Adeyemi also give dem bail on di terms and conditions of di administrative bail wey Nigeria corruption police, EFCC bin give dem.

    Di conditions be say Idris go bring di sum of five billion Naira and two sureties, one of di sureties must be Permanent secretary while di oda surety must be Director.

    Di second and third defendants go bring two billion naira each wit two sureties wey must be directors.

    Di court warn di defendants make dem no travel out of di court jurisdiction; say if dem try am witout court knowledge, dem go cancel dia bail.

    Justice Adeyemi also draw ear for dem say make dem no go kolet anoda passport, say if dem try am, di court go revoke dia bail.

    Di former Accountant General of di Federation, wit Godfrey Olusegun Akindele, Mohammed Kudu Usman and Gezawa Commodity Market and Exchange Limited dey face 14 count charges of stealing, criminal breach of trust to di tune of over 109 billion naira.

    Di EFCC drag dem to court on July 22, 2022

    All of dem plead not guilty to all di 14 count charges.

    Di court adjourn di trial to 10th and 11th of August, 2022.

  12. Morocco dey misuse trials to silence journalists - HRW

    Morroco

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Two of di most prominent cases be those of Omar Radi and Soulaimane Raissouni

    Morocco dey imprison journalists afta flawed trials on non-political charges in order to silence dem, Human Rights Watch tok.

    Di New York-based group say two of di most prominent cases be those of Omar Radi and Soulaimane Raissouni, both chop sentence dis year on sexual abuse charges to at least five years for prison.

    Anoda journalist, Taoufik Bouachrine, dey jailed for 2018 for 12 years, sake of accuse of rape and pipo-trafficking.

    All di three bin don dey critical of di authorities, and don deny di charges against dem.

    Morocco don insist say dia justice system dey independent and say di cases bin get "nothing to do" wit di journalists' work.

  13. Beyhive dey vex ontop leaked Beyoncé album

    Beyoncé

    Tori don comot say Beyoncé next studio album wey she call Renaissance don leak online.

    Beyoncé fans, wey dey popularly known as di Beyhive hala on top di news say make no bod try to listen to or download di leaked audio.

    Plenti gist don comot on top wetin cause di link, including say na certain pipo wey dem send di album to early leak am, but none of dem don sure yet.

    Beyoncé dey release her sixth studio solo album, Renaissance afta six years.

    Di album dey drop July 29.

  14. Hanifa murder: Court room full as pipo dey wait for judgement

      • Author, Mansur Abubakar
      • Role, BBC Pidgin, Kano
    Hanifa murder: Court room full as pipo dey wait for judgement
    Wetin we call dis foto, Anoda view from Kano high court

    Pipo don full court for Kano state for northwest Nigeria wia judge go deliver judgement on top di kidnap and murder of five-year-old girl Hanifa Abubakar.

    Na for January police arrest owner of di school wey Hanifa dey attend Abdulmalik Tanko and two odas over her kidnap and murder and for six months now di case don dey court.

    At di moment legal representatives of goment wey dey prosecute di case and di defence wey come from Legal aid council dey seated and na only Justice Sulaiman Na Abba dem dey wait for.

    Security pipo full ground for di court and di suspects already dey ground although dem neva enter di courtroom.

    Di suspects risk capital punishment based on di penalty for dis kain mata.

    Hanifa murder: Court room full as pipo dey wait for judgement
    Wetin we call dis foto, Pipo for court dey wait for judgement
    Hanifa murder: Court room full as pipo dey wait for judgement
    Hanifa murder: Court room full as pipo dey wait for judgement
  15. Four women wey sweet Nigerian belles dis week

    Tems, Asisat Oshoala, Ese Brume and Tobi Amusan

    Wia dis foto come from, Getty Images

    A lot of tins happun for Nigeria dis week wey leave bitter taste for plenti pipo mouth.

    Howeva even inside all di gbege for Nigeria, four ladies tanda for di world scene to show say tue true, Naija no dey cari last.

    Musician Tems wey her real name na Temilade Openiyi ginger Nigerians spirit wen she reveal say her voice go dey di Part 2 of di Black Panther franchise wey dem call, Wakanda Forever.

    Tobi Amusan break multiple records for di just concluded Athletics World Championships.

    She gbab world record time for 100m Hurdles and then carry denge pose to become di first Nigerian athlete to win gold for di competition.

    Skip Instagram post, 2
    Allow Instagram content?

    Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of Instagram post, 2

    Ese Brume also for di Athletics World Championship gbab di silver medal for her long jump.

    Ese Brume na one of di Nigerian athletes wey don dey five Nigerian pipo joy back to back.

    Dis na afta she gbab Bronze as one of di only medals wey Nigeria get from di Tokyo 2020 Olympics.

    Skip Instagram post, 3
    Allow Instagram content?

    Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of Instagram post, 3

    Super Falcons star, Asisat Oshoala start di week well-well wey she gbab di Africa female Player of di year.

    Dis dey come even afta injury pursue am comot di WAFCON competition.

    Skip Instagram post, 4
    Allow Instagram content?

    Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of Instagram post, 4

  16. Kenya VP alone for presidential debate afta im rival snub

    Kenya election debate

    Wia dis foto come from, AFP

    Two of Kenya four presidential candidates make good dia threats as dem no show face for one TV presidential debate for Tuesday night wey media owners organise ahead of next month elections.

    Former Prime Minister Raila Odinga, one of di two frontrunners, and George Wajackoyah don separately complain about di formality of di debate.

    Deputy President William Ruto, di oda frontrunner, and David Mwaure Waihiga show for di debate, but each of dem tanda alone dey answer questions afta dia opponents withdrawal.

    Di debate suppose be two-tier, meaning say Mr Odinga and Mr Ruto suppose face each oda afta Mr Wajackoyah and Mr Waihiga - wey each don score less dan 5% for opinion polls don debate.

    Prof Wajackoyah bin land for di debate venue wit im wife, but commot afta e confam wit organisers say im demand say make all candidates debate for one session dey rejected.

    For di debate, di deputy president task be on goment disobedience of court orders and lack of transparency for public infrastructure contracts.

    Mr Ruto also dey pinned on di source of im huge wealth and "how much dey enough", e bin answer say "enough dey enough".

    Post-debate analysts bin appreciate Mr Ruto say e honour di invitation and criticise Mr Odinga say e boycot di debate.

  17. Largest rare diamond in 300 years unearthed in Angola

    170 CARAT PINK DIAMOND

    Wia dis foto come from, Lucapa Diamond co.

    Miners for north-east Angola don discover one rare, pure pink diamond wey dem believe say be di largest rough diamond of im kind to dey unearthed inside 300 years.

    Di Australian site operator name di 170-carat stone Di Lulo Rose.

    Dem say di diamond go sell for international tender by di Angolan state diamond marketing company.

    Di find for di Lulo alluvial mine dey welcomed by di Angola goment.

    “Dis record and spectacular pink diamond wey dem recover from Lulo kontinu to showcase Angola as one important player on di world stage for diamond mining," Minerals Resources Minister Diamantino Azevedo tok for statement.

    Dat kind stones, once dey cut and polish am, don sell for record-breaking prices.

    Di Pink Star, one 59-carat pink diamond, bin sell for $71.2m in 2017 - di most expensive ever.

  18. Buhari summon emergency meeting of Nigeria Service Chiefs

    Nigeria president don summon di Service Chiefs to one emergency security meeting today.

    Muhammadu Buhari, tok tok pesin, Femi Adesina na im announce di meeting.

    Yesterday opposition Senators of Nigeria parliamet ask Buhari to fix security palava within weeks or face impeachment.

    E dey follow attack on di Presidential Brigade Guard and oda places inside Abuja, di kontri capital.

    Buhari summon emergency meeting of Nigeria Service Chiefs

    Wia dis foto come from, Nigeria presidency

  19. INEC don begin investigate PVCs hunters discover for Bayelsa, INEC dey check di PVCs with dia BVAS machine if dem be genuine or cloned cards

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Port Harcourt
    Permanent voter cards

    Wia dis foto come from, INEC Bayelsa

    Wetin we call dis foto, Some of di permanent voter cards hunters discover for bush for Yenagoa handover to INEC

    Di Independent National Electoral Commission INEC Bayelsa State don begin check weda di permanent voter cards wey some hunters discover return to dem na genuine ones.

    Head of Voter Education and Publicity for INEC Bayelsa State, Wilfred Ifogah tell BBC Pidgin say na 315 permanent voter cards and six temporary voter cards di hunters hand over, wey dem say dem discover from one uncompleted building for bush along di AIT/Elebele Road for Yenagoa.

    E add say dem go test di PVCs with dia BVAS machines to see if dem be genuine ones or cloned cards and if na real ones, dem go also check dia records to see weda na cards wey dem don give to di owners or not.

    INEC still dey wait for di result of di investigation by police and DSS ontop tori of some PVCs some pipo allegedly discover from one drainage for Port Harcourt, di Rivers State capital.

  20. Nigeria police confirm anoda gunmen attack for Owo, Ondo state, Massive shooting wey happun for Owo last month kill at least 40 pipo

      • Author, Andrew Gift
      • Role, BBC Pidgin, Lagos

    Police for Ondo state southwest Nigeria don confirm say anoda shooting happun for di Owo community in di state and some victims collect injuries.

    Dia tok tok pesin Olufunmilayo for statement say di attack happun for di Craneburg Construction Company site for Owo.

    She say dia officers don take over di location and di victims dey collect treatment for hospital and dem dey stable condition.

    Di statement no tok how di attack happun and how many victims dey involved.

    Massive shooting happun for St Francis Xervier Church for Owo community few weeks ago kill at least 40 pipo and injure plenti pipo.

    Till date goment never arrest nor prosecute anyone ontop di shooting. Attacks of different kinds don dey happun for Nigeria in recent times.

    Recently attack happun for Kuje prison wey lead to di escape of plenti inmates.

    Anoda attack happun dis week near Nigeria law school for Abuja, di kontri capital.

    Di military say some of dia men collect injury during di attack

    Victims of Owo shooting in June
    Wetin we call dis foto, Victims of Owo shooting in June
    Victims of Owo shooting in June
    Wetin we call dis foto, Victims of Owo shooting in June