Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Roma players 'donate dia four months salary' to help di club

    Some Roma players

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Roma chief executive Guido Fienga don praise im players’ “superb gesture” after dem volunteer to no take dia four months’ salary to help di club during di coronavirus pandemic.

    Di players, manager Paulo Fonseca and im staff go also pay di difference to ensure all club staff wey dey on leave of absence go receive dia full salary.

    Roma captain Edin Dzeko na im lead di team togeda with coach Fonseca to tell Roma big ogas of dia decision.

    "We always tok about unity for Roma,” na so Fienga tok. “To volunteer to cut dia salaries for di rest of di season, di players, di coach and im staff, all don prove say we really dey dis tin togeda.

    “Edin Dzeko, all di players and Paulo don demonstrate say dem understand wetin dis club stand for and we also thank dem all for dia superb gesture towards di employees for dis club.”

    Roma never play football since 1 March, just days before dem postpone di Serie A season.

    Inside letter to Fienga, di players tok say: “We players dey ready to start playing as soon as possible, giving di maximum to achieve our goals, but we also realise say all dis no go dey enough to face di economic consequences of di current emergency.

    “With di hope of doing something wey go help di company to better restart di Roma project wey we all share, we offer dis financial proposal.”

    Italy currently get di highest number of pipo wey don die from coronavirus for Europe, with more dan 23,000 confam deaths.

  2. ‘Prez Akufo-Addo decision to lift coronavirus lockdown be bad move’ - Ghanaians react

  3. Nigerians react to increasing number of Covid-19 cases in Lagos

    Nigerians don enta social media to react afta di kontri Centre for Disease Control, NCDC, drop di latest figures of confam cases of coronavirus for di state.

    For di latest report, NCDC confam 86 new cases of di virus for Nigeria, and 70 na form Lagos alone.

    Skip X post, 1
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 1

    Skip X post, 2
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 2

    Skip X post, 3
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 3

    Skip X post, 4
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 4

    Skip X post, 5
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 5

  4. Nigeria record 86 new cases of Covid-19 in one day, Di kontri now get 627 cases

    Di total number of confam coronavirus cases for Nigeria don climb to 627 afta di kontri record 86 new cases in one day.

    Dis na di highest di kontri go ever report so far in one day.

    Inside dis new cases, 70 na from Lagos alone.

    Dis one dey come as di state goment reveal over di weekend say dem don increase dia capacity to test and set up testing centre for local governments to help with community testing and tracing of di disease.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  5. Davido fiancee 'test negative for coronavirus'

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    Nigerian musician, David Adeleke, wey pipo sabi as Davido, say im fiancee, Chioma Rowland, don test negative two times now to Covid-19.

    Di musician go social media to make di announcement di same way e announce am on Friday night, March 27, 2020, ontop im official Instagram page, say Chioma test positive to di virus.

    Im fans and well wishers don dey wish am congratulation.

  6. Una good morning!

    Welcome to our live coverage of di coronavirus and how e dey affect di world.

  7. Na here we go march break today

    Na here we go end our live updates on top coronavirus and how e dey affect di world.

    Abeg make una join us again tomorrow.

    Good night!

  8. Covid – 19: Eight more cases show for Kenya

    Kenya goment extend di compulsory quarantine period by 14 days

    Wia dis foto come from, Reuters

    Wetin we call dis foto, Kenya goment extend di compulsory quarantine period by 14 days

    Kenya don confirm eight more covid19 cases for di kontri.

    Dis don bring di total to 272. Three of the confirmed cases na from quarantine facilities, while the rest no get any travel history at all.

    Di virus don kill 14 pipo for di kontri and seven pipo don dey discharged.

    Di goment don single out di capital Nairobi and the port city of Mombasa as epic centres for di virus as na dia number plenty pass.

  9. Coronavirus: Bayelsa declare a 5-day curfew

    Bayelsa state govnor, Duoye Diri

    Wia dis foto come from, Bayelsa State Ministry of Information and Orientation

    Wetin we call dis foto, Bayelsa state govnor, Duoye Diri

    Governor Douye Diri of Bayelsa State don approve imposition of dusk to dawn curfew as way to prevent Covid-19 pandemic for di state.

    Statement wey Permanent Secretary Ministry of Information and Orientation, Freston Akpor sign say di curfew wey start from Sunday 19 April, 2020 go restrict movement between seven o'clock in di evening to six o'clock in di morning and na way to emphasize di ban on social gatherings particularly night clubs, beer palour, bar and religious activities for night to enhance social distancing.

    Di 7pm to 6am curfew na for di whole state and security pipo dey high alert to ensure compliance.

  10. And from Nigeria and di rest of Africa...

    • Goment for Lagos state don set up coronavirus sample collection stations for 20 LGA’s for di state.
    • Director General of di Nigeria Centre for Disease Control (NCDC), Dr. Chikwe Ihekweazu don commend di Rivers State Governor, Nyesom Wike for di leadership dem show to check di spread of coronavirus for di State.
    • Kenya don confirm eight more covid19 cases for di kontri.
    • Zimbabwe don extend di lockdown wey suppose end today night go another 14 days.
    • Police for Kenya arrest four pipo wey fake as mourner to disobey lockdown order
  11. If you just dey join us...

    See di latest update from across di world.

    • New York Govnor, Andrew Cuomo say coronavirus outbreak don dey reduce small-small for di state.
    • NHS Nightingale hospital don discharge dia first patients wey recover from coronavirus
    • New York govnor Andrew Cuomo don sign one law wey go allow pipo to marry online.
    • Wuhan quarantined footballers don return home. Di squad bin stay for dia winter training camp for Spain, wen Wuhan dey under lockdown.
    • UK Education Secretary, Gavin Williamson say plans no dey for schools for di kontri to resume soon.
    • Plenty staff wey dey work inside Afghanistan presidential palace don test positive to coronavirus.
    • Di Irish department of health say di number of pipo wey don die wit coronavirus for di Republic of Ireland don enta 610.
    • Lady Gaga, Paul McCartney and Billie Eilish join oda celebrities to celebrate health workers.
  12. Zimbabwe extend lockdown for anoda 14 days

    AFP

    Wia dis foto come from, AFP

    Wetin we call dis foto, Zimbabwe for lockdown

    Zimbabwe don extend di lockdown wey suppose end today night go another 14 days.

    Di kontri President, Emmerson Mnangagwa warn say di kontri neva meet di conditions wey go make dem lift di lockdown order.

    Zimbabwe get 25 cases of Covid- 19 even as di World Health Organization don sama warning say make Africa ready as di number of pipo wey go catch di virus go increase.

    Di Presido say di decision dey hard but e dey necessary and no be wetin dem fit avoid.

    Zimbabwe still dey try to increase di number of testing centres and number of treatment centres wey dem get.

    Di lockdown no go include pipo wey dey do mining and manufacturing operations, make di kontri economy for no fail.

    Di WHO warn say difficult times still dey say make pipo no remove di lockdown ban for dia kontris.

  13. See where you fit do coronavirus test for Lagos

  14. Coronavirus: NCDC wan strengthen response to COVID19 for Rivers State

    NCDC oga and Govnor of Rivers State

    Wia dis foto come from, Rivers State Government House

    Wetin we call dis foto, NCDC oga and Govnor of Rivers State

    Director General of di Nigeria Centre for Disease Control (NCDC), Dr. Chikwe Ihekweazu don commend di Rivers State Governor, Nyesom Ezenwo Wike for di leadership dem show to check di spread of coronavirus for di State.

    Dr. Ihekweazu tok dis one for goment house wen im come working visit with pipo from World Health Organisation, WHO, to see how dem fit support and strengthen di achievement wey di state don record so far for di fight against coronavirus.

    Officials from WHO & NCDC

    Wia dis foto come from, Rivers State Government House

    Wetin we call dis foto, Officials from WHO & NCDC

    Di NCDC DG say because of di unique nature of di virus, all stakeholders gatz work in unity as no country fit do am on dia own, so dem need to share information across states to make sure say evribodi know di new developments, strategies, wetin fit work and wetin no dey work for detection, prevention and treatment.

    Im add say as dem no fit continue lockdown indefinitely, stakeholders gatz begin work to gradually reopen di economy in a way wey no go put di population for danger, come add say private sector suppose now dey focus more on how to help di states build dia capacity to respond to di virus.

    Rivers Commissioner of Health, Prof. Princewill Chike

    Wia dis foto come from, Rivers State Government House

    Wetin we call dis foto, Rivers Commissioner of Health, Prof. Princewill Chike

    Rivers State Commissioner for Health Prof. Princewill Chike wey tok for Rivers State Goment say with di proactive leadership of di Governor, di State no get any current confam case of coronavirus and di two cases for di state don recover and dem don discharge dem.

    Im add say all public hospitals for di local goment areas get Covid19 centres wey go hold suspect cases before di intervention of di State Rapid Response Team on Covid19.

    Di Rivers state goment come ask make federal goment take steps to stop oil companies so dem no go violate di state executive order on restriction of movement as e fit jeopardise di fight against coronavirus.

    Dem also request make federal goment also establish laboratory to handle coronavirus testing for di State.

  15. Actor, Matt Damon dey film for Ireland ontop lockdown

    Matt Damon
    Wetin we call dis foto, Matt Damon

    Lockdown for Irish village of Dalkey, one rich neighbourhood for Dublin don turn to anoda tin since di residents dia discover say Matt Damon dey stay dia.

    Di Bourne Identity star dey Republic of Ireland to film, 'The Last Duel', wey Ridley Scott go direct, foto of di actor for Dalkey during dis lockdown dey social media.

    Because of am tori pipo from New York Times dey ask pipo wey dey Dalkey wetin e dey like to get di actor for dia neighbour during dis pandemic.

    "Anybody wey dey live for Dalkey get right to dia privacy. Leave am alone, jesus, na human im be,”na wetin one pesin tok for Facebook.

    Damon act for di 2011 film Contagion - about di spread of one virus wey dey spread from respiratory droplets - with Kate Winslet, Jennifer Ehle and Laurence Fishburne.

    For March di stars of di film release public service announcement to tell di public about social distancing and washing of hands.

  16. Coronavirus: New York govnor sign order to allow pipo marry online

    One Jewish wedding wey happun for New York before di lockdown

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, One Jewish wedding wey happun for New York before di lockdown

    New York Govnor, Andrew Cuomo don sign one order wey go allow pipo for im state to marry online as many weddings don cancel sake of di lockdown order.

    From now on, pipo for di US state fit apply for marriage licences remotely and clerks wey dem gree to arrange di ceremonies allowed to conduct ceremonies.

    Mr Cuomo wit joke tok say di decision mean say excuse no dey again for couples wey wan marry.

    Di decision dey come afta New York state extend di lockdown measures go 15 May. More dan 13,000 pipo don die of coronavirus for New York city alone.

    Na mixed reaction greet dis decision for social media.

    Some pipo question why couples go choose to do dia weddings when dia families and friends no go fit join dem, demsay why di govnor no consider oda pipo decision.

    But oda pipo reason am say during dis pandemic, marriage go fit allow make couples use di same health insurance.

    New York no be di first place wey go go internet go find legal solution.

    Di United Arab Emirates (UAE) too bin announce say dia citizens and and pipo wey dey live there go fit marry online. Dis na afta di justice ministry do website for couples to submit necessary documents.

  17. Fake mourners wey disobey Kenya travel ban chop arrest

    Di group bin dey pretend to go burial

    Wia dis foto come from, AFP

    Wetin we call dis foto, Di group bin dey pretend to go burial

    Police for Kenya wey dey make sure say pipo follow di coronavirus restriction order don arrest four pipo wey pretend like say dem be mourners wey dey carry deadi body go bury.

    Dey don comot for di capital, Nairobi, and travel reach 370km (about 230 miles) west with empty coffin for inside motor before dem gbag dem, di health minister tok on Saturday.

    For like two weeks now, dem don restrict travel for in and out of Nairobi wit another three regions wey dem consider fit be coronavirus hot spot.

    Di group of fake mourners don manage to pass through several checkpoints before some officers for Homa Bay County suspect dem come open di coffin, Health Minister Mutahi Kagwe explain.

    Di driver later test positive for Covid-19, di respiratory illness wey di virus dey cause. His three passengers don dey for quarantine.

    Di minister tok say official dey torchlight all di magomago wey pipo dey do to break di travel ban, dem go also investigate report wey say pipo dey bribe police for roadblocks.

    Di East African nation don record 262 cases of Covid-19, including 12 deaths.

  18. Rivers state don release 22 Exon Mobil staff wey disobey lockdown order

    Isolation centre

    Wia dis foto come from, Rivers State Government House Press

    Wetin we call dis foto, Isolation centre

    Rivers State goment for south-south of Nigeria don release di 22 Staff of Exxon Mobil wey dem arrest afta dem disobey di executive order wey restrict movement inside di state.

    Di attorney Attorney-General and Commissioner of Justice, Professor Zaccheus Adangor release di Mobil staff without any charge on Sunday.

    Di Attorney-General say di state goment no go press charges against dem.

    Im say dem release dem afta some ogbonge Nigerians chook mouth inside di mata.

    Di Attorney-General say im monitor di release of di 22 Exxon Mobil workers from di state Isolation Centre for Yakubu Gowon Stadium, Port Harcourt.

    Im say di state goment dey committed to follow di executive order wey dem give to check di spread of coronavirus.

    Tori be say security agency bin arrest 22 staff of Exxon Mobil wey enter di state from Akwa Ibom afta dem disobey di state executive order.

    Di order be say health authorities must to check di coronavirus status of anybody wey de enta di state.

  19. UK deaths don pass 16,000

    Di number of covid-19 patients wey don die for UK hospitals don rise reach 16,060 as at Saturday.

    Di Department of Health and Social Care tok say that na increase of 596 deaths in 24 hours.

    As at Sunday, dem conduct 482,063 tests, with 21,626 tests wey dem do on Saturday.

    A total of 372,967 pipo don dey tested of which 120,067 don test positive.

  20. In case you just dey join us...

    Dis na di latest tori from around di world.

    • UK minister Michael Gove don say e too early to commot restrictions on movement for UK
    • For night, di One World: Together At Home show include more dan 100 artists wey perform live from dia homes
    • Na Global Citizen movement and WHO organise di eight-hour event
    • Lady Gaga, wey help organise di concert, also perform
    • President Donald Trump praise di production of hospital goods for US: "V for victory, V for ventilator!" Im tok, for im White House briefing on Saturday evening.
    • Britain Queen Elizabeth don say made dem no do gun salutes to mark her birthday for Tuesday
    • World coronavirus deaths don pass 150,000, and more than 4.5 billion pipo dey under lockdown to slow di pandemic.