Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Lifting of lockdowns must happun small-small - WHO

    Di WHO Headquarters for Geneva

    Wia dis foto come from, AFP

    Wetin we call dis foto, Di WHO Headquarters for Geneva

    As plenti kontris dey look to end or partially end their lockdown. Di World Health Organization don warn say make e be gradual process.

    Dem say make dem relax di lockdown small small make e for no lead to another outbreak of new Covid-19 infections.

    “At least until vaccine or ogbonge treatment dey, di process go become di new normal thing “ Takeshi Kasai, wey be Regional Director for di Western Pacific tok, e even add am say lockdown measures don work well-well.

    Any goment wey dey think to relax lockdown must plan to do am stage by stage as dem dey continue to monitor di situation. "Individuals and society need ready to face di new way of living.” he tok.

    Kontris like Japan and Singapore don see recent increase for new infections wey don make us dey concerned over second wave of Covid-19 cases.

  2. Face mask fit dey compulsory from next week for Lagos

    Lagos state Governor, Babajide Sanwo-Olu

    Wia dis foto come from, Lagos state government

    Lagos state goment for south west Nigeria say dem dey consider to give order make every body dey wear face mask for public space from next week, dis na to control di spread of coronavirus.

    Govnor Babajide Sanwo-Olu tell tori pipo on Monday say dem don order mass production of face masks wey dem go distribute to reduce community transmission of di virus.

    Lagos record her highest number of new cases on Sunday wit 70 new case, but dem no witness any new case di next day wey be Monday.

    Di state govnor advise residents to stop to dey stigmatize pipo wey don recover from di virus as dat one don make pipo begin hide dia status and begin go private hospital for treatment.

    E say sample collection stations don dey close to di pipo now for local goment areas, say make pipo take advantage of arm to go do test and know dia status. As at Monday night, Lagos get 379 confirmed cases, 14 deaths and don discharge 98 pipo wey don recover.

  3. America go suspend 'all' immigration to di kontri sake of di pandemic

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    President Donald Trump say e go sign executive order to temporarily suspend all immigration to di US because of di coronavirus pandemic.

    Trump tok for Twitter say na sake of di " attack from di invisible enemy" wey e dey call di virus, and di need to protect di jobs of Americans, but e no give details.

    E no dey clear which programmes fit dey affected and whether di president go fit carry out di order.

    Some pipo don chook mouth say di goment dey use die pandemic as excuse to chook eye for immigration.

    Over di last four weeks, more dan 20 million Americans don claim say dem dey jobless. Dat one na roughly ike di number of jobs wey employers say dem don add over di previous decades.

    US get over 787,000 confam cases of Covid-19 and more dan 42,000 deaths, according to

    Johns Hopkins University, which is tracking the pandemic globally.

  4. A total of 22 pipo don die with coronavirus for Nigeria

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    Nigeria don record thirty-eight new cases of coronavirus to bring di kontri total to 665.

    Di new cases na for Kano, Gombe, Kaduna, Borno, Abia, FCT, Sokotom and Ekiti.

    As at 20th April, 2020, di kontri don dischrage 188 and 22 don die.

  5. Una good morning!

    Welcome to our live updates ontop coronavirus and how e dey affect pipo and kontries around di world!

    But first take dis proverb take ginger yoursef.

    Proverb of di day

    Wia dis foto come from, Getty Images

  6. Na here we go march break today

    Na here we go end our live updates on top coronavirus and how e dey affect di world.

    Abeg make una join us again tomorrow.

    But before we go make we leave you wit this NCDC tweet ontop how dem dey collabo to fight dis virus.

    Una good night! And stay safe!

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  7. Rivers State Goment don unseal Caverton Helicopters Premises

    State goment statement wey unseal dia office

    Wia dis foto come from, Rivers state house

    Wetin we call dis foto, State goment statement wey unseal dia office

    Rivers State Government don unseal di business premises of Carveton Helicopters, after dem apologise and say dem go work well.

    Attorney-General and Commissioner of Justice for Rivers State, Professor Zaccheus Adangor say Governor Nyesom Wike approve di re-opening of dia business premises on Monday come directly tell Chairman of Obio Akpor local goment to go comot di seal.

    Na on 9 April, 2020 naim Chaiman of Obio Akpor local Goment area, Solomon Eke bin go seal di office of Caverton Helicopters after Governor Wike for broadcast declare dem persona non grata, say dem no dey allowed to do business for di State as dem break di Executive Order wey restrict flights and movement for di State, come fly in 10 passengers for Air Force Base Port Harcourt.

  8. Italy active infection don reduce

    Authorities for Italy say di number of pipo wey dey infected with coronavirus don reduce for di first time since di outbreak start.

    "For di first time we see new positive development, di number of pipo currently wey dey positive don reduce". na wetin Civil protection chief Angelo Borelli tell tori pipo.

    As at Monday na 108,237 pipo wey dey hospital or dey recover for dis house afta dem test positive for Covid-19. 20 less dan di day before- na small but symbolic drop.

    On Sunday,di increase of active cases na 486.

    Italy get di third highest number of Covid-19 cases for di world afta Spain and US.

  9. Coronavirus: Rivers State Goment don sign Executive Order for Taskforce to man borders

    Govnor Nyesom Wike

    Wia dis foto come from, Rivers state house

    Wetin we call dis foto, Govnor Nyesom Wike

    Rivers State Governor, Nyesom Wike don sign di Executive Order to establish Task Force wey go man di state borders to ensure say Rivers pipo dey protected from coronavirus.

    "Dis na di third Executive Order wey I go sign since di coronavirus pandemic start. Dis third Executive Order dey very important because we suspect sabotage for dey on di part of security agencies.

    Dat na why we dey appoint a Task Force to man our borders. We owe our people di duty to protect them. Our Task Force go dey di borders to protect our people".

    Govnor Nyesom Wike

    Wia dis foto come from, Rivers state house

    Wetin we call dis foto, Govnor Nyesom Wike

    Governor Wike say di laws on restriction of movement na for di safety of evribodi for di State, come emphasise say na ogbonge Nigerians wey intervene naim make dem release di 22 Exxon Mobil staff dem bin arrest on Sunday morning as Exxon Mobil sign and agree to return dia staff to Eket as condition for dia release.

    Im say on Sunday, dem also arrest some staff of BOA wey violate di law and dem don arraign dem for court and dem dey remanded, as di coronavirus no dey respect anybody so e dey important to dey more vigilant.

    On top Dumping of Waste for Public Places (Prohibition) Bill 2020, Governor Wike announce say di State Goment go employ 3000 environmental sanitation Marshals wey go implement di law to keep di State clean.

  10. Shey Neem leaves fit cure COVID-19?

  11. Kano goment dey deport almajiri children

    Almajiri children

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Almajiri children

    Kano state goment for north of Nigeria don begin deport almajiri children wey no come from di state.

    As di number of coronavirus cases dey increase for di state, di state Director general for media and communications, Salihu Yakasai, say di deportation go reduce di rsik of exposing dem to di virus.

    Kano wey get plenty population pass most states for Nigeria, don record 36 confam cases of di virus.

    Di state close dia borders to make sure say pipo wey get di virus no from oda states cari am enta Kano.

  12. Kenya wan make pipo dey pay for quarantines if dem disobey lockdown

    Kenya lockdown

    Wia dis foto come from, AFP

    Wetin we call dis foto, Soldiers for Kenya lockdown

    Di goment don announce plans to make pipo dey pay for dia quarantine as plenti pipo don dey go against lockdown orders.

    Over di weekend, Kenya Police arrest pass 100 pipo wey go against lockdown rules.

    Police arrest forty women for wedding and even enter bars dem wey suppose dey closed for dis period.

    As at now, dem dey fine pipo wey go against di stay at home order but goment believe say di quarantine stay for dia own pocket go fit keep pipo for house.

  13. Rwanda pipo go start to dey wear mask outside dia house

    Rwanda pipo go dey wear mask evriwia

    Wia dis foto come from, AFP

    Wetin we call dis foto, Rwanda pipo go dey wear mask evriwia

    As from today, Rwandans wey dey comot dia house go wear face mask to pause di spread of coronavirus.

    Dem announce dis informate even as di kontri currently dey for lockdown situation.

    But BBC find out say for di kontri capital for Kigali, some pipo no dey wear mask and police no too dey push di mata on top say face mask wey pipo fit afford no too dey for di kontri.

    Rwandans don dey lockdown now for weeks even as goment don extend am for anoda two weeks and dem only fit go outside for medical care, to buy food, for bank service or to work for those kain tins.

    Rwanda don report 147 confam cases but no pesin don die from am

  14. How pipo di live wit fear for bullet and Corona for Anglophone regions

  15. Ali Baba foundation donate more coronavirus testing kits to Africa

    Ali Baba oga, Jack Ma

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Ali Baba oga, Jack Ma

    Nigeria and fifty-three oda African kontris go collect 500,000 coronavirus testing kits plus 300 ventilators wey Ali Baba Foundation donate give Africa Union kontris.

    Dis go be round three medical supplies donation wey Oga Jack Ma dey give Africa kontris since di coronavirus outbreak.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    Oda tins wey im donate na 200,000 set of cloth, 200,000 face shield, 2,000 thermal guns wey dem dey take check temperature.

    E no end dia, im also send 100 scanners wey dem dey take check body temperature plus 500,000 set of hand gloves.

    So far, Africa don record more than 22,300 confam cases, about 5,400 pipo don recover while more dan 1,000 don die from Covid-19.

  16. Seven ways Ghana plan to fight coronavirus without lockdown

  17. Kano anti corruption board arrange committee to monitor Covid-19 money

      • Author, Mansur Abubakar
      • Role, BBC Pidgin, Kano
    Some members of di Kano anti corruption commission

    Wia dis foto come from, Abubakar Ibrahim

    Anti corruption and Public Complaints Commission wey dey for Kano, North West Nigeria say dem don arrange pipo wey go dey monitor how coronavirus committee wey dey di state dey spend money.

    For statement wey di board release, dem say dem send pipo to go monitor di committee to make sure say any mago-mago no enter di mata as dem wan start to dey share food items and money to poor pipo for di state wey dey on lockdown.

    Vice chancellor of Bayero University Professor Yahuza Mohammed na im be di chairmo for di Kano Covid 19 relief fund wey don gather over N400 million from donations.

  18. South Africa police arrest man wey 'smuggle' im girlfriend inside car boot for lockdown

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    Police for South Africa done arrest one man wey smuggle im girlfriend for di booth of im motor during nationwide lockdown according to one official from di province of Guateng.

    Faith Mazibuko tweet say authorities bust dia plan wen dem catch dem for security checkpoint as di man bin dey carry her go e house for Mpumalanga province

    Dem also arrest di woman because she "agree make dem smuggle her," Mrs Mazibuko add.

    South Africa begin lockdown on 24 March for three weeks but di authorities don extend am until di end of April.

    Travel across di kontri no dey allowed for everybody except those wey dey provide essential services, based on who di goment see as essential worker

  19. Di latest updates from around di world

    Kontris for Europe don dey begin to reduce dia lockdown measures – though officials insist say di outbreak dey far from over.

    Dis na di latest:

    • Restrictions don start to ease across Europe, as Germany reopen some shops, school children don begin return to kindergarten for Norway, and Poland dey allow pipo to visit parks and forests.
    • For Denmark - wia school children return to primary schools and nurseries on Wednesday - businesses like hairdressers, dentists and tattoo parlours don dey reopen.
    • Spain daily death toll on Sunday na 410 according to reports, dis na dia lowest for nearly one month, but di kontri no get plans to end dia lockdown yet.
    • French Prime Minister Edouard Philippe insist say di crisis “never dey over” for im kontri, as di death toll near 20,000. Face masks go soon become compulsory to wear for public transport, and di goment plan to produce enough masks for everyone wey wan wear one.
    • For Australia, most beach for Sydney including di world-famous Bondi beach, still dey closed sake of di kontri lockdown, but three beaches just re-open afta dem close for three-weeks. Pipo now dey allowed to go exercise for Coogee, Maroubra and Clovelly beaches - although social distancing rules still dey in place.
  20. Why di number of confam coronavirus cases for Lagos dey increase?