Children fit spread coronavirus if schools reopen?
All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.
Live Coverage
Daniel Semeniworima
One million test kits to meet Africa's 'big gap'
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Africa CDC go provide test kits
Di Africa Centre for Disease Control and Prevention (Africa CDC) don announce say dem go give one million coronavirus testing kits to Africa.
Di organisation’s director John Nkengasong say testing rates for di continent dey low.
He say di Africa Union (AU) go distribute di testing kits from next week make African kontris dem for test.
"Ova di next three months or six months, we go need like 15 million tests, but, journey of 1,000 miles dey start with di first mile," he tok.
So far more than 17,700 cases of infection don dey confam for 52 kontris. About 915 pipo don die and more than 3,500 pipo don recover from di disease.
Nigeria’s second largest state don begin 7 days lockdown
Wetin we call dis foto, Medile area for Kano dey dry
Friday, na di first day of seven days lockdown wey Kano, northwest Nigeria go enter after di state record 21 coronavirus cases in 5 days.
Govnor Abdullahi Ganduje wey announce di lockdown on Tuesday yan say di 7 days lockdown na to stop di spread of di virus and e add say only pipo wey dey do essential work na dem dey allowed to move.
Wetin we call dis foto, Sheka wey also get plenti pipo no get activity
BBC Pidgin visit high population areas like Sheka and Medile but pipo dey dia houses dey observe di lockdown.
Commissioner of Police for Kano CP Habu Sani wey release statement on Thursday, yan say security pipo full everywhere for di state to make sure say pipo obey.
Wetin we call dis foto, Shagari Quarters area for Kano
As e be say na Friday, no jumuat prayers for di state wey be say na mostly muslims.
Coronavirus Lockdown - Young pipo for Lagos dey defend dia area as police blame fake news for all di Kata kata wey happen
Coronavirus: Khartoum governor chop sack ova prayer ban
Di Sudanese prime minister, Abdalla Hamdok, don sack di
governor of di capital Khartoum after he oppose ban on religious gatherings wey
goment bin impose to try to stop di spread of Covid-19.
General Ahmed Abdun Hammad Mohammed refuse to implement di
decision to ban prayers for mosques and churches wey suppose start on Saturday.
On Thursday, police bin teargas supporters of
di sacked President Omar al-Bashir.
Dem dey demonstrate against di goment austerity programme.
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Di ban on prayers for mosques and churches go start on Saturday
Health program for Africa go suffer ontop US decision to stop WHO moni
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, WHO draw ear say to stop immunisation for many kontris go bring wahala
Programs to stop Polio, fight against HIV and malaria for Africa go suffer if America President Donald Trump no change im mind ontop decision to stop to dey fund di World Health Organization.
Di WHO Africa Head, Dr. Matshidiso Moeti dey beg di US to reconsider dia decision.
Di US na di largest contributor to WHO.
Di kontri don commit to give 151 million dollars to WHO, for dis dia current two-year funding period.
Inside dis plenty money, WHO don collect 50 million US dollars, but now wey oga Trump don say di kontri no go give WHO moni again, di organisation work for Africa don dey shaky.
Immunization na one of di programs wey go suffer.
40 Sub-Sahara African kontris go enjoy debt suspension
Di G20 kontris don suspend debt payment for di world’s
poorest kontris, and most of dem be Sub-Saharan Africa kontris.
Dis na to help dem get through di economic impact of
Coronavirus.
Na di G20 finance ministers and central bank governors of
di world’s largest economies reach dis agreement to freeze loan repayments for kontris wey get low income till end of dis.
76 kontris go benefit from dis agreement and 40 of dem dey
Sub-Saharan Africa. Nigeria,, Kenya, Ethiopia, South Africa and small economies
like Burundi, Liberia, and Zimbabwe go enjoy am.
Nigeria confam 35 new cases of COVID-19
Di Nigeria Centre for Disease Control, NCDC, bin confam
anoda thirty five new cases of coronavirus on Thursday night plus including di
kontri 13th death.
Di NCDC say dia door to door contact tracing for possible
cases for Abuja don discover patients with COVID 19.
However dey draw ear give pipo say make dem no stigmatise
those wey don dey tested as e fit discourage others wey wan come forward to get
help.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Una Goodmorning!
And thank God na Friday! Welcome to our live coverage of all di tori ontop coronavirus and how e dey affect di world.
For tori from Thursday, make una scroll down.
In di meantime make you see wetin Okorhi David tok for today proverb. Wetin e mean? Abeg drop your comment for Facebook, Twitter or Instagram @bbcnewspidgin
Wetin we call dis foto, Proverb of di day
Na hia we go march reak for Thursday tori
Make we stop hia for today 16 April, 2020.
On Friday we go still show again. Until then, you fit scroll down take time read all di tori we don cover for dis coronavirus as e dey hot.
We go leave una wit awa special video of how to take care of pesin wey dey self-isolate sake of Covid-19 disease - yes you fit learn new tips inside dis video.
From Ronke, Faith, Princess & Daniel, una goodnight!
Wetin we call dis Video, How to take care of pesin wey dey self isolate for house
Ken Saro-Wiwa son don die of Covid-19
Article Information
Author, Karina Igonikon
Role, BBC Pidgin, Lagos
Wia dis foto come from, Noo Saro- Wiwa
Di
son of di late Ogoni environmental activist Ken Saro-Wiwa, don die of
Coronavirus for London.
Tori be say Menegian Saro-Wiwa die on Monday of Covid-19
combined wit oda health issues im bin get, according to im sister Noo Saro- Wiwa
announce im death on Thursday.
Noo Wiwa say her brother Menegian or Gian for short, na im smart
pass among dem and na sprinter for school, poet, artist, and upcoming engineer,
wey teach imsef guitar and piano.
"Mental health issues limit im life from since im dey age
16, although di side-effects of di medicine im dey take change im bodi small,
dis foto I take of am before still capture di wetin Gian represent, wey be kind
and beautiful soul, wey always want di best for im family, always dey pray for
our future success and im dey hope about im own and, of course, im love im
music." She write for her Facebook page.
She say Gian wey dem born for 1970 get one son wey im name na
Louis. Gian na di second pikin of di late Ogoni environmentalist wey don die as
im first son Ken Jnr. Saro-Wiwa bin don die for 2016.
Lions don take ova road sake of coronavirus lockdown
Lockdown palava don kill more pipo dan coronavirus for Nigeria
See cartoon to teach Nigerian pikins how to survive coronavirus
More supplies to helep Nigeria fight against Covid-19 pandemic don land
Wia dis foto come from, UN
United Nations announce on
Thursday say receive di delivery of important health supplies as part of
donation to support di fight against Covid-19 Pandemic for Nigeria.
Di supplies come from di European
Union and IHS Nigeria. Dem add say di plane wey carry di supplies come na one
ogbonge shipping company APM Terminals pay for am
Di supplies include 10,000
test kits, 15 oxygen concentrators and plenti personal protective equipment
(PPE), special injections alias vaccines IEHK/PEP kits and oda ogbonge health
supplies wey go support Nigeria response to di COVID-19 outbreak.
E go still helep di work wey
Unicef dey do help children and families for Nigeria.
Dem tok say dem still dey
expect more supplies in di coming days
Di personal protection
equipment (PPEs) go protect medical personnel and ancillary staff wey be di
first responders for di Frontline, na dem dey provide care and treat pipo wey
di virus dey affect.
Di test kits go also helep
healthcare workers to test pipo wey dem suspect say e get di virus and know dia
status….
“Wesabi say If dem wan reduce di spread of di
virus, e dey important to test as many pipo as possible especially those wey
just travel enta di kontri and pipo wey don near dem.”
“These test kits go support
Nigeria effort to control di spread of di virus.“Edward Kallon, wey be di UN Resident
Coordinator for Nigeria tok.
Since di outbreak of di
coronavirus for Nigeria foe late February, di UN don dey support di goment of
Nigeria through risk communications, community engagement, infection prevention
and control, surveillance and management of di coronavirus cases.
Meet di Navy officer wey only himself do passing out parade sake of self-isolation
Article Information
Author, Olaronke Alo
Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin
Wia dis foto come from, Royal Navy PA wire
One British naval officer
don make history as im do passing out of training by himself.
Sub Lt Matthew Poxon no fit
make di official ceremony for Britannia Royal Naval College for Devon as im dey
for self-isolation.
Dem hold separate parade for
am and dis na di first solo passing out parade wey di college don ever do since
157 years wey dem establish di college.
"At least as I no fit
dey out of step with di rest of my division,” he tok.
President Paul Biya: 'E dey alive and e di work'
Since weh Coronavirus enta Cameroon for March 6, kontri pipo di wait make president Biya address dem, and de mata don turn na debate and mockery for social media.
Maurice Kamto, di leader of opposition Cameroon Renaissance Movement, CRM declare vacancy for post of president.
President Biya now don receive Christophe Guilhou, di French Ambassador for Cameroon and deh tok management for Covid-19 for kontri, France and de world.
Now weti you get for tok for dis mata?
Enta BBC News Pidgin Facebook Page to join di debate.
Japan don declare state of emergency for Covid-19
Japan Prime minister Shinzo Abe don declare
state of emergency for di kontri
Dis na as coronavirus cases don
dey increase.
Abe don face plenti backlash on top of di way
wey im handle di pandemic as dem don get ova eight thousand confam cases.
Botswana forgive 149 prisoners to prevent coronavirus spread
Botswana Presido Mokgweetsi
Masisi don forgive 149 prisoners to prevent di spread of coronavirus for di
kontri.
Dem say dem go first do Covid-19 test for di prisoners
wey dem forgive before dem release dem give dia famiy.
Botswana don currently dey on 28 day lockdown.
"Nigeria no dey owe IMF"
Coronavirus: Lagos wan do cash transfer to at least 250,000 residents
Article Information
Author, Olaronke Alo
Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin
Wia dis foto come from, Twitter/@jidesanwoolu
Di govnor of Lagos State
south west Nigeria Babajide Sanwo-Olu say by di end of di week im goment go
transfer moni to a minimum of 250, 000 poor and vulnerable families for Lagos.
Oga Sanwo-Olu tok say dem dey clean up
dia data alias information from dia social register to know di pipo wey really need di moni.
Na at least 20 million pipo dey live inside Lagos wey be di economic capital of Nigeria.
Di city don dey on lockdown for almost three weeks out of di four weeks
lockdown to take stop di spread of coronavirus for di state and dis dey affect
businesses for di state.
Insecurity for di state don
also increase during di lockdown as some area boys dey tiff moni and food from
residents.
Lagos dey face di highest number of coronavirus infections for Nigeria wit at least 235 cases of di virus and 8 pipo don die.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.