Children fit spread coronavirus if schools reopen?
All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.
Live Coverage
Daniel Semeniworima
120 Covid-19 patients recover for Ghana

Wia dis foto come from, Getty Images
21 new Covid-19 patients recover for Ghana, dis dey push de total recoveries go 120.
De total number of Covid-19 infections rise catch 1,154 according to Ghana Health Service.
Meanwhile, health officials conduct a total over 90,000 tests through contact tracing out of which 1,154 be infected.
Ghana Prez dis week lift three-week lockdown wey he place on parts of de country, but ban on public gathering still dey remain.
We don deny several requests from governors to fly - Nigeria goment
Even though say Nigeria dey on lockdown, airports and land borders still dey closed, some governors bin apply to travel according to Nigeria Minister of Aviation, Hadi Sirika.
Oga Sirika say di ministry don deny request from five governors since dem close airports and President Muhammadu Buhari announce lockdown becos of Covid-19.
Di minister say governors no big pass pipo wey di lockdown and airport closure order affect as dem also dey among.
Im tok dis one during di Presidential Task Force on Covid-19 briefing on Tuesday.
"Exception no dey for governors. I don deny several of such flights. Including two governors from di South-South, two from di South-East and by di way, three of dem na members of di All Progressives Congress. I tink one na from North-Central. "For us to approve any flight, e must show say e follow due process. E must dey essential, relate to Covid-19 or other essential flights like cargo wey go bring in medicines or equipment or other things related to COVID-19 or our whole wellbeing like food.” Oga Sirika tok.
E also add say one percent of flights wey dey fly now na becos of diplomatic request. “A few others, maybe 1% fit be either repatriation request from diplomatic community which must go through foreign affairs or fit be repatriation due to illness of another kind. “And those repatriations go also need di stamp of teaching hospital."
Kenya police dey find pipo wey escape from quarantine centre

Wia dis foto come from, AFP
Kenya President, Uhuru Kenyatta don tok say dem go arrest those pipo wey video capture as dem dey escape from di mandatory quarantine inside di capital, Nairobi and return dem back to finish dia isolation period.
Di president tok dis one today, just hours afta pipo share di video online.
Di video show some pipo wey dey jump ova di fence for one of di quarantine centres. Local media report say di number of those wey escape na 50 but di goment neva confam di figure.
President Kenyatta tok say di goment know di identities of all those wey escape and dem go arrest and take dem back to di quarantine centre.
On Tuesday evening, di ministry of health tok say police dey investigate di escape.
Kenya Citizen TV station tok say di break out happun during early dinner wen rain dey fall and guards comot from post go hide because of di rain.
Di Daily Nation newspaper tweet one video of some pipo wey dey jump down di wall:
Skip X postAllow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
More than 400 pipo na im dey under by force quarantine say dem disobey curfew orders and drinking upon di closing of bars.
Authorities extend di quarantine period of some of those wey fly come di kontri before di ban afta di ministry tok say some isolation centres neva make sure say social distancing dey.
Those for di centres don bin complain about poor hygiene conditions, dem even say dem fit contact di virus dia.
Di world dey at risk of biblical famine because of coronavirus - UN

Wia dis foto come from, reu
Wetin we call dis foto, Millions across di world already dey rely heavily on food aid to survive United Nations don sama warning say di world dey at risk of widespread famines just like di one for bible because of di coronavirus pandemic.
David Beasley, wey be head of di World Food Programme (WFP), tok say di world need urgent action to avoid disaster.
One report estimate say di number of pesin wey dey suffer from hunger fit go from 135 million to more than 250 million.
Pipo wey dey more at risk na those for 10 kontries wey get conflict, economic crisis and climate change dey affect. World Food Program says.
Di fourth annual Global Report on Food Crises tok more about Yemen, Democratic Republic of Congo, Afghanistan, Venezuela, Ethiopia, South Sudan, Sudan, Syria, Nigeria and Haiti.
For South Sudan, 61% of di population dey affected by food crisis last year, di report tok.
Even before di pandemic come, parts of East Africa and South Asia don dey already face serious food shortages wey drought cause plus also di worst locust infestations for 10 years.
How one Lagos coronavirus testing centre dey operate
Una good morning!
Welcome to our live coverage ontop di coronavirus pandemic and how e dey affect di world.
But first, our proverb of di day.

Wia dis foto come from, Getty Images
Una goodnight!
Na here we go end our live updates on top coronavirus and how e dey affect di world.
Abeg make una join us again tomorrow. But before we go, make we leave you with dis video from di NCDC.
Make una stay safe o.
Skip X postAllow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
US state, Missouri, sue China for wetin coronavirus cause dia economy

Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, Missouri dey sue China ontop coronavirus Missouri on Tuesday don sue Chinese goment for di way wey dem take handle di coronavirus outbreak.
Missouri na one state for America and dem go be di first state for di US wey go sue di Chinese goment.
Dem tok say China’s response to di outbreak wey start for Wuhan city, naim cause di kata kata wey dey happun to di economy of di state.
Di civil lawsuit, wey dem file for di federal court, dey accuse China of negligence, and some other claims.
Dem tok say Missouri and di pipo wey dey live dia don suffer about tens of billions of dollars in economic damage, and dem come dey ask for cash compensation.
“Di Chinese government bin lie to di world about di danger and contagious nature of COVID-19, dem silence whistleblowers, and dem no do anything to stop di spread of di disease,” dem tok
U.S. President Donald Trump, bin don initially praise China and President Xi Jinping for dia official response to di outbreak, wey don affect more than 2.5 million pipo for di world.
But Trump don tag am di “Chinese virus”.
China bin dey face similar lawsuits wey some US business pipo dey also accuse dem. But ogbonge sabi law pipo tok say to hold China responsible for di coronavirus wahala for court, go dey really hard.
Sex and dating while lockdown dey happun
How you fit survive pregnancy during dis coronavirus pandemic
Handheld scanners fit find pipo wey dey infected wit COVID-19?
Man Utd players suffer cooking burns and dog bites during coronavirus lockdown
Nurses protest for safety gear outside US White House

Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, Nurses from di National Nurses United union for US dey protest Nurses from di National Nurses United union dey hold protest outside di White House for United States, dem dey call on governors and federal officials dem to provide safety gear for medical staff fighting di coronavirus pandemic.
“We dey demand that you immediately get PPE to nurses, doctors and healthcare workers on di front lines of dis pandemic.
"If you don’t protect us, we no fit protect our patients.”
Protesters bi hold photos of nurses and doctors who don have die from Covid-19, and signs wey dey show: "20 seconds no go scrub 'hero' blood comot from your hands."

Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, Nurses from di National Nurses United union hold foto of colleagues wey don die 
Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, Nurses from di National Nurses United union hold foto of colleagues wey don die Di union bin include 150,000 nurses, and im be di largest association of registered nurses in di US.
How Ghana dey use drone technology fight Covid-19 disease
Ten pipo chop jail sentence for Niger ova lockdown protests
Ten people don enta prison for Niger afta police bin arrest dem during several days of protest wey turn violent, against di restrictions wey goment bin put sake of di coronavirus pandemic.
Young ppio bin set up barricades for streets to protest against di overnight curfew and di ban on pipo wey dey gather to pray.
Di police say more dan 100 people naim dem arrest for di kontri capital, Niamey.
Officials say dem catch motorcycle riders wey dey distribute cans of petrol and several neighbourhoods naim dem set on fire and private property destroyed.
Di police bin use tear gas to chase comot residents for di capital who dey try to organise prayers for one mosque on Sunday.
'I bury 34 corpses in just four days for Kano'
Coronavirus: Anthony Joshua say isolation no be new tin
Article Information - Author, Fiona Equere
- Role, BBC Pidgin
"Isolation no dey new to me"
Dat na wetin two time heavy weight boxing champion Anthony Joshua tok.
But how you dey cope with isolation?
Enta awa social media platforms for Facebook, Instagram and Twitter to share wit us

Wia dis foto come from, Anthony Joshua/Instagram
Lagos confam say two more patients die with coronavirus
Lagos state goment don confam di death of two more coronavirus patients for di state isolation centres.
Di commissioner for health, Prof. Akin Abayomi wey share dis informate for twitter say one of dem na one 45 year old Nigerian man wey return from India for January 2020.
Di second death na one 36 year old Nigerian woman wey no get any travel history or contact wit any of di confamed cases but she get serious health conditions.
Di total number of deaths from Covid- 19 for Lagos don reach 16 as at 20th April.
Skip X post, 1Allow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Skip X post, 2Allow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Madagascar president claim say one locally made herbal tea go cure Covid-19

Wia dis foto come from, @SE_Rajoelina
Di president of Madagascar, Andry Rajoelina don officially launch one locally made herbal tea wey im claim say na for both prevention and cure for coronavirus.
Skip X postAllow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Upon di fact say health experts don say no cure or vaccine for covid-19 yet, President Rajoelina claim say prove dey to show say di herbal tea dey work and dem don use am cure two patients for di kontri.
Di liquid wey dem name, CVO or Covid- organic dey come from one plant wey dem call, Artemisia wey dem don dey use for centuries for traditional Chinese medicine and na di source of one ingredient wey dem dey use for malaria treatment.
In front of diplomats and di media, oga Rajoelina tok say dem go make di herbal tea available free of charge to do those wey dey more expose and for very low price to anyone else wey wan buy am.
According to worldometres, presently Madagascar don record 121 cases of coronavirus but dem neva record any death.
