Super Eagles captain deny tori say e get Covid-19

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria footballer and national team captain, Ahmed Musa don put sand-sand for tori wey say e test positive to Covid-19.
Di Super Eagles captain say instead, im and e family dey on 14 days self isolation as dem just return from Saudi Arabia.
Musa deny di tori for post wey e make for im Instagram handle as im advice pipo to "Stay safe, maintain social distance" and "avoid fake news."
27-years-old Musa recently return to Nigeria together with Nigeria international John Ogu and bin say e go begin self isolation, dis one come make some tori pipo to report say im get coronavirus.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
For di Instagram post, Musa add say: "Dis na pandemic wey dey take many pipo life and e dey sad say some pipo wan use am to gain followers or views to dia pages by spreading fake news.
"My family and me come from Saudi Arabia and decide to follow di goment rule of isolation for 14 days, no be because any of us get di virus. We dey perfectly okay and never test positive to di virus." Im tok.
Musa currently dey play im club football for Al Nassr for Saudi Arabia.











