Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Police arrest 39 strippers and pipo wey go night club

      • Author, Andrew Gift
      • Role, BBC Pidgin, Lagos

    Police for Nigeria commercial capital Lagos don arrest 39 strippers plus pipo wey go night clubbing despite di lockdown wey dey for di state.

    Police tok-tok pesin Bala Elkana for statement say na for Idimu area naim dem gbab di offenders.

    Dem also gbab one Imam for Sheik Central Mosque Mile 12 unto say e hold evening prayers for di mosque wit large number of pipo.

    Between April 21 to 26, police don gbab 620 pipo wey violate lockdown order for Lagos state. Dem include commercial drivers wey dey do interstate transportation plus pipo wey hold party wit large crowd.

    Meanwhile di state goment wan begin enforce law to make pipo dey wear face masks outside compulsory as di state don record over 700 confam cases of Covid-19.

  2. Tips parents fit use ginger dia pikin during coronavirus lockdown

  3. Rivers State don begin disinfect bus stop and public places

      • Author, Karina Igonikan
      • Role, BBC Pidgin

    Rivers State goment don begin disinfect bus stops and oda public places as way to take check di spread of Covid19 for di State.

    Commissioner for Health, Prof. Princewill Chike say one private company, dey support di State goment to fumigate and disinfect public places like bus stop because dat na one area wey plenti pipo dey gada as dem dey waka enter or come down from commercial bus and taxi.

    Oga for di company, Ibifiri Bobmanuel say dem get approval from di oment before dem disinfect di bus stops as dia contribution to fight coronavirus for di State.

    Im add say dem don already disinfect 60 bus-stops for Port Harcourt and Obio Akpor local goment.

  4. Ghana Covid-19 recoveries hit 155, total case count cross 1,500

    Ghana record 21 more Covid-19 recovery cases, dis push total recoveries go 155.

    Meanwhile total case count for de country hit 1550, wey one more person die pushing total deaths to 11.

    Ghana Health Service reveal say de virus hit 12 out of 16 regions for de country.

    So far, Greater Accra dey lead plus 1347 cases of Covid-19.

    Ghana govment remove partial lockdown from citizens sake of dem wan manage Covid-19 without lockdown.

    Dem ban public gatherings like churches wey wearing of nose masks be compulsory for all Ghanaians.

  5. Coronavirus for Kano vs Mass deaths: Wetin we know so far

      • Author, Mansur Abubakar
      • Role, BBC Pidgin, Kano
    Police man for Kano

    As pipo dey continue to tok about Kano and di different reports wey dey show say plenti pipo don die for di north westedn state of Nigeria in di last few weeks, wetin BBC Pidgin know be say many hospitals wey suppose dey treat pipo no dey operate normal.

    12 big pipo for di state die on Sunday wey increase wetin pipo dey tok about weda na coronavirus especially as e be say no testing happun for Kano for three days.

    One Salma Ahmed for her Whatsapp voice note wey go viral for di state say dem carry her pikin go different hospitals for di state wey no gree accept am and by di time dem carry am go Aminu Kano Hospital e die after small time.

    Some of di pipo wey tok to BBC Pidgin about dia relatives wey die in di last one week tok say na either diabetes or heart problem make dem die.

    But WHO don warn say pipo wey get health complications dey at risk of di new coronavirus - meaning say dem dey more likely to die from di Covid-19 if dem catch di disease.

    Abu Garzal wey im 92 year old papa die last week tell BBC say dem dey go hospital for di last four years on top im paralysis mata.

    “For di past four years, we dey go hospital for im treatment but im situation worse recently and we carry am go hospital wia e die.”

    Govnor Abdullahi Ganduje continue dey yan say di high numbers wey some media dey parade na propaganda.

  6. Latest updates from Nigeria, Africa and Around di world.

    Goments for Lagos and Osun States inside south west Nigeria don give order make evribodi wey dey enta public space for di states wia face mask or face di law.

    Di face mask order go take Immediate effect and states goments do set laws to punish pipo wey disobey rules wey goment put to stop di spread of coronavirus.

    South Africa dey beg International Monetary Fund (IMF), World Bank, New Development Bank to helep dem wit five billion dollar

    Di kontri National Treasury Director-General same dem need am to reduce di effect of coronavirus for dia economy.

    India health ministry say 45 pipo don die wit Covid- 19 and 1,990 pipo test positive to di virus.

    Di na di highest di kontri don record inside one day.

    Even sef di total number of active cases for di kontri don enta 19, 868.

    Supermodels like Naomi Campbell and plenty artists for Africa dey go online to entertain dia fans for dis coronavirus pandemic period.

    Dis celebs believe say dem go fit make pipo happy and teach dem new skills.

    Israel don allow some businesses for di kontri to open

    Dis dey happun as goment say dem consider if schools fit reopen too.

    Shops wey dey for street fit open, but shopping malls and market must remain closed

    Wetin we call dis Video, Coronavirus: Naomi Campbell and African artists entertain fans online
  7. Modi tell India make dem remain at alert

    India coronavirus

    Wia dis foto come from, Reuters

    Wetin we call dis foto, India coronavirus

    India Prime Minister Narendra Modi don ask im kontri pipo to maintan di lockdown as di coronavirus cases for di kontri continue to dey increase.

    Di kontri don record 2,000 cases inside 24 hours. So far, more than 26,000 cases na im dem don record and pipo wey die don pass 800.

    For nationwide radio address on Sunday, Modi say make pipo maintain social distancing and stop di habit of to dey spit for public.

    “I beg, make una know get over confidence and believe say coronavirus neva reach our city, our village, for our streets, inside our office,” he tok.

    For Saturday, dem gree make small shops open wit 50% of dia staff as long as dem maintain social distancing and di staff wear masks.

  8. Learn di correct way to use face mask

  9. Coronavirus updates from around Nigeria, Africa & around di world, ·New York wey be di epic centre of coronavirus outbreak for America go begin allow pharmacies dey do test for Covid-19 virus.

    ·New York wey be di epic centre of coronavirus outbreak for America go begin allow pharmacies dey do test for Covid-19 virus.

    ·Imo don become di latest state for Nigeria to record COVID- 19 disease.

    Di south eastern state record 1 of di total of 87 new cases wey Nigeria Centre for Disease Control confam around midnight

    For di breakdown 33 cases don add for Lagos and 4 for Kano.

    ·Meanwhile one person don die of coronavirus for Lagos wey get di highest cases of di Covid-19 disease for Nigeria.

    Dis state Ministry of Health announce dis for Saturday and add say dem don discharge 10 oda pipo.

    ·For Kenya, one travel ban wey goment place in and out of capital, Nairobi and three oda towns including Mombasa go extend by anoda three weeks.

    President Uhuru Kenyatta na im extend di dusk to dawn curfew for another 21 days.

    ·South Africa goment say more than 1.5 million pipo for di kontri go fit begin work

    And dem go allow pipo wey dey deliver hot food to continue dia business.

    But dem say di strict lockdown restrictions go still continue.

    ·South Africa dey plan to reopen dia agriculture sector and allow some manufacturing and retail to resume.

    Dis na di measure to help di kontri balanceproduction for dia economy and stop di spread of coronavirus.

    Yes, na di trade minister Ebrahim Patel tok dis one on Saturday.

    ·New York wey be di epic centre of coronavirus outbreak for America go begin allow pharmacies dey do test for Covid-19 virus.

    Di govnor, Andrew Cuomo wey give dis informate, say dem give permission to 5,000 pharmacies to make dem fit provide 40,000 Covid-19 test results for New York everyday.

    ·WHO don draw ear give governments all over di world say make dem no sign anything give patients wey don recover say di Covid-19 no fit catch dem again.

    World Health Organization say in order to reduce lockdown restriction, some governments dey give some pipo assurance wey no hold water.

    ·India don allow small local stores to reopen after one month wey di kontri lockdown sake of coronavirus.

    Di interior ministry say na only half of staff wey dey work for di stores must come to work and dem must wear mask and observe social distancing.

    ·Meanwhile, death toll for UK don pass 20,000 after di kontri add anoda 813 death for di last 24 hours.

    Na di kontri Department of Health and Social Caregive di informate.

    ·Chelsea don ask im first-team squad to support pipo wey dey help odas instead of contributing money to di club during dis coronavirus palava.

    Premier League don dey suspended since coronavirus and dis dey affect di club because dem no fit sell ticket for matches.

    ·Arsenal football club say dem go allow dia players begin train for Colney from next week

    But dem go follow social distancing rule oh.

  10. Online classes go start for Lagos State higher institutions

    Lagos State University students
    Wetin we call dis foto, Lagos State University students

    Lagos State Govnor, Babajide Sanwo-Olu don approve special e-portals wey go allow tertiary institutions for di state begin online lectures.

    Goment announce say di move na to reduce how di new Coronavirus Covid- 19 disease take dey affect education for di south west state wey be di economic capital of Nigeria..

    Di govnor also approve virtual classes to make sure say distance dey between students and dia lecturers.

    E say make students use dis opportunity take keep themselves busy for di lockdown.

    Skip X post, 1
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 1

    Skip X post, 2
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 2

  11. Welcome to Sunday tori, Good Morning!

    Na here we go begin our live updates on top coronavirus and how e dey affect di world.

    Kack make Annette Arotiba and Daniel Semeniworima give you all di latest gist as e dey hot dis morning.

    Make we all start di day wit today proverb from Desmond Scott Younglord - If you sabi di meaning, enta we social media pages go tell us.

  12. 'Lagosians must use face mask from now on or face di law'

  13. Nigeria FIRS ask supermarkets for tax inside lockdown becos dia 'market dey sell well-well'

  14. Cameroon don confirm 88 new cases for Covid-19

      • Author, Leocadia Bongben
      • Role, BBC Pidgin, Yaounde
    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    Cameroon don confam anoda 88 new cases for Covid-19 disease for de nine out of ten regions weh deh confirm de sick.

    Health Minister, Malachie Manaouda say 768 active cases dey for west central African kontri, 28 pipo dey for oxygen alias ICU, 207 for hospital out of over 1500 total Covid-19 cases for kontri.

    Also, 697 pipo don well but 53 don die of Covid-19, majority inside community.

    Just now, five cases dey for Northwest region and govnor Adolphe Lele L’Afrique weh na head of response team for Northwest say one of dem na woman weh e komot Douala.

    “De woman say deh reject e for three hospital for Douala so e bi get for travel go for Bamenda for test, weh eh komot positive”, governor tok.

    Lele L'Afrique add say de woman wish make e massa na four pikin dem kam do dia test for Bamenda.

    E nova stay weh governor bi sign note say make pipo weh deh bi travel for some Moghamo white 70-seater bus No. NW 960 BC for April 17 from Douala to Bamenda show up for test.

    Covid-19 no bi sick weh e di bring shame, so make pipo treat demselves for correct hospital Malachie tok.

    For dis stage, health minister say de major action na for block spread for dis sick, watch over helpless pipo.

    Priority na for protect hospital staff.Manaouda di worri as 40 hospital workers and three doctors don die from Covid-19.

  15. "No take disinfectant for Coronavirus"

  16. Kenya extend curfew and travel ban for 21 days

    Kenya goment extend travel ban, curfew for anoda 21 days

    Wia dis foto come from, Reuters

    Wetin we call dis foto, Kenya goment extend travel ban, curfew for anoda 21 days

    Kenya President Uhuru Kenyatta don extend travel ban in and out of Nairobi and four oda towns for another 21 days.

    Dem also extend di nationwide curfew from night to morning by anoda 21 days.

    Di president announce say Kenya now get 343 confam cases of Covid- 19 and 98 patients don recover.

  17. Ex-Kondengui prisoners get Covid-19

      • Author, Leocadia Bongben
      • Role, BBC Pidgin, Yaounde
    Front of Kondengui prison

    Wia dis foto come from, Human Rights Watch

    Wetin we call dis foto, Kondengui Central prison

    Some prisoners weh komot for Kondengui di sick of Covid-19 for military stadium treatment centre, Human rights lawyer, Christian Bissou tell BBC News Pidgin.

    President Biya for April 15, 2020, ‘pity’ some prisoners reduce dia prison time, odas get total freedom.

    Christian Bissou, president for human rights and freedom commission for Cameroon Bar Council say deh free 450 prisoners for Yaoundé Central Prison, 666 for Douala, 55 for Bafoussam, and 117 for Ebolowa.

    “Covid-19 dey for Kondengui because some pipo weh deh free dey for military stadium treatment centre di sick of Covid-19”, Bissou insist.

    Some inmates Weh deh don get de sick dey for isolation centre prison clinic. Public health official don confirm for BBC Pidgin say Covid-19 dey for Kondengui, but e prefer make na Justice minister tok.

    Today, prisoners deny for take some drugs weh authorities claim say deh go treat a Covid-19. Cameroon don confirm 1430 positive cases, 668 pipo recover, 719 active cases, 120 pipo dey for hospital and 43 pipo don die.

    Bissou say President Biya e grace no fit free prison for seka say as deh free 450 kondengui na 5300 prisoners, e no di change anyting for prison weh deh build for 1500 pipo. Ministry of Justice get for finds way for manage dis Covid-19 crisis for Kondengui.

    Also find way for reduce population prisons for prisons. “Tell judges make deh stop for send more pipo for prison, make deh pass judgment fast for helep plenti pipo weh deh dey waiting trial for long.

    Human Rights Watch bi don warn say trouble go dey if Covid-19 enta Kondengui.

  18. Some states begin reopen for US as death toll pass 50,000 for di kontri

    Woman siddon for salon

    Wia dis foto come from, Reuters

    Wetin we call dis foto, Dem allow salons and spas to reopen for Georgia.

    Three US states don allow some shops to begin reopen afta dem put up some measures to stop di spread of di coronavirus, as di kontri death toll pass 51,000.

    Salons and spas fit reopen for Georgia and Oklahoma while Alaska don lift restrictions ontop restaurants.

    On Friday, President Donald Trump waka leave one briefing wey even short pass di normal one, e no gree ansa questions.

    Pipo dey criticise am afta e suggest say to inject patients with disinfectant fit help.

    Doctors don condemn im tok as something wey dey dangerous.

    Disinfectants na dangerous substances wey fit be poisonous if pesin take am, e fit even dey dangerous to di skin, eyes and respiratory system if pesin dey exposed to am.

    Mr Trump tok on Friday say im comments - wey e make for one news conference one day earlier - na something wey pipo take out of context.

  19. Twin sisters Katy and Emma Davis die with Covid-19

    Di twin sisiters, Kate and Emma

    Wia dis foto come from, Zoe Davis

    Wetin we call dis foto, Katy Davis (left) and her identical twin Emma always believe say dem go die together, according to dia sister, Zoe

    Twin sisters don die within three days afta each oda afta dem test positive for coronavirus.

    Children nurse Katy Davis, 37, die for Southampton General Hospital on Tuesday.

    While her identical twin Emma, wey also be former nurse, die for di same hospital early on Friday.

    Dia sister, Zoe, say: "Dem dey always say dem come into di world together and go comot together as well."

    She say di "amazing" two, wey bin dey live together, get oda health conditions and bin no well for some time now.

    "Words no dey to describe how special dem be," she tok.

    "All dem bin ever wan do na to help oda people. Ever since dem dey young...dem go pretend say dem be doctors and nurses wey dey take care of dia dolls.

    "Dem give dia everything to all di patients dem looked afta. TDem be ogbonge pipo."

    Katy, wey work for Southampton Children Hospital, test positive for Covid-19 on admission to hospital and die on Tuesday evening.

    Emma Davis bin work for di same hospital as her sister for di colorectal surgery unit for nine years until 2013.

  20. Court for Rivers keep 33 pipo wey break lockdown order for isolation centre

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Lagos
    Some market women wey di Rivers Taskforce gbab

    Wia dis foto come from, Rivers State Goment House Press

    Chief Magistrate Court for Port Harcourt, Rivers state Nigeria, don sentence some pesins wey violate di State Quarantine Coronavirus (Covid-19) and Other Infectious Diseases) Regulations and Executive Orders.

    Di accused pesins plead guilty to five count-charge office wey di Attorney General of Rivers State bring against dem and di court say make dem pay fine.

    But di oda 33 defendants wey plead not guilty, dey remanded for di Rivers State Isolation Centre to undergo screening for Covid-19 pending wen di court go consider dia bail applications and trial.

    Some market women wey di Rivers Taskforce gbab as dem hide inside container truck enta Rivers State from Anambra State to come sell market dey part of those wey dem accuse.

    Di market women wey enta Rivers from Anambra to come sell

    Wia dis foto come from, Rivers State Goment House Press

    Wetin we call dis foto, Di market women wey enta Rivers from Anambra to come sell