Children fit spread coronavirus if schools reopen?
All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.
Live Coverage
Daniel Semeniworima
How Vaccines dey work
Madagascar Herbal drug: Nigerian goment to take delivery of herbal drink to treat coronavirus

Di Republic of Madagascar herbal mixture wey dem claim say fit cure di novel coronavirus go soon land for Nigeria.
Di Chairman of di Presidetial Taskforce, Boss Mustapha say president Muhammadu Buhari don give am permission to fly di drug enta di kontri and subject am to thorough test.
Di herbal drug accoding to di goment of Madagascar dey prevent and cure covid-19 and dem don cari Nigeria portion go Equitorial Guinea and from dia Nigeria go pick am to Abuja, di Nigerian capital.
Although oga Mustapha no tell tori pipo di exact day wey dem go bring di herbal drink to di kontri but dat arrangement don dey ground to fly di herbal drug from Equitorial guinea to di kontri
E say di president also give am mandate make dem subject di drugs to proper validation process and e go dey in accordance to how oda merecine, syrup, or vaccine wey dem produce internally dey go through before use.
Earlier, di Minister of Health, Osagie Ehanire say di Madagascar goment bin don promise dem say dem go get drug for testing and wen e land dem go make available to Nigeria scientific and research community to examine di drug.
We hear say dem make di herbal drugs from artemisia plant wey we get boku for Nigeria and we go like am make dem bring along dia sample so we go test am and compare wit wetin we get for Nigeria.
As e be now, all kontris for di world dey look for cure for covid-19 and we no go dey left out but before we give di drugs to our pipo, we go make sure say e dey safe for our pipo.
Kano goment don share 1 million masks to local goments

Wia dis foto come from, Abubakar Ibrahim
Wetin we call dis foto, Govnor Abdullahi Ganduje at di distribution centre Kano state goment for northwest Nigeria on Monday share 1 million face masks to 8 local goments wey dey inside Kano city on top di fight against coronavirus.
Some of di local goments wey colet dia share inside di distributed face masks include Kumbotso, Nasarawa,Dala and Tarauni wey be say na dem get pipo pass for Kano and di LGs go organise days to share to dia pipo.
Na on Sunday Govnor Ganduje announce say e don make wearing of face masks compulsory for di state and any pesin wey break di law go enter jail.
Kano get 602 cases of covid 19 with 50 discharged and 26 deaths.
How Coronavirus make sex toy market blow for Port Harcourt
'I go prefer make African drug kill me than one western vaccine'
UK Goment advice on how you fit prevent transmission
Di UK goment don tok say even as you dey wear face mask for places were no too get space, pipo also fit follow dis guidelines to lower di risk of transmission of Covid-19.
- Stand side-by-side - "You fit lower di risk of infection if you stay side-to-side instead of to face pipo."
- Wash your clothes regularly - di new guidance tok say "some evidence that di virus fit stay ontop clothes for a few days don dey, although e dey shorter."
- You must to make sure say air dey enta your rooms well well. Evidence don suggest say di virus fit no pass or stay for room or house wey air dey well well.
Dem also advice to maintain a 2m distance from pipo outside your house and make you wash your hands regularly.
Wetin executive order mean and how governors suppose dey use am
In case you just dey join us...
See di latest updates from around di world.
- Some parts of Europe don begin dey ease dia lockdown small-small
- For France, pipo fit walk outside for di first time in weeks without permit. Reports from Paris suggest say parts of di public transport system dey struggle to maintain social distancing
- Dem go publish one 50-page document wey outline how UK plan to reduce dia lockdown later today
- Russia now get di third-highest number of confam cases for di world, dem overtake UK and Ital
- China report 17 new virus cases on Monday, dia second back to back double-digit increase
- Five of di new cases na from Wuhan, wia di virus first come out, and concern dey over outbreak for di north
Governor Wike announce temporary lifting of lockdown so pipo fit buy food and medicine
Article Information - Author, Karina Igonikan
- Role, BBC Pidgin

Wia dis foto come from, Rivers State Government
Rivers State Governor, Nyesom Ezenwo Wike don announce temporary lifting of di total lockdown for Obio/Akpor and Port Harcourt local goment Areas for two days only, with effect from Tuesday 12 May 2020.
Governor Wike announce dis one for State broadcast for di night of Sunday 10 May say, di total lockdown go dey lifted on Tuesday 12 May and Wednesday, 13 May, 2020 before e go continue again on Thursday 14 May, 2020 till further notice.
"We don consider wetin well-meaning citizens of di State dey tok and after we review di situation, we decide to implement partial relaxation of di lockdown measures, to allow residents get small fresh air and replenish dia foodstuffs and medicines.”
Dis mean say shops, supermarkets, and malls fit open to di public for Tuesday and Wednesday, 12 and 13 May 2020 and all hospitals and banks fit also open and provide full services to di public.
Di Governor say oil and gas companies go submit di list of dia staff wey dey on essential duties to goment, come add say ban no dey for lifting of petroleum products from depots and other receptacles.
Di Governor come add say all oda restrictions wey di Executive Orders give on top social distancing still dey ground like compulsory wearing of face mask or scarfs for vehicles and public places, closure of all land, sea and air borders and entry routes into di State, closure of all open markets, including slaughters, hotels, guest houses, cinemas, bars and restaurants and di ban on gathering, including public burials, weddings, and religious gathering of more than 50 persons.
Zambia hail sex workers wey dey help dem do contact tracing

Wia dis foto come from, AFP
Wetin we call dis foto, E dey common for lorry drivers to dey sleep wit many women Sex workers for Zambia dey help goment trace pipo wey don catch coronavirus as number of pipo wey get di virus dey increase for di border town of Nakonde.
Di kontri health minister Chitalu Chilufya, say 76 out of di 85 new cases for di north of di kontri na sex workers or lorry drivers.
"Sex workers dey cooperate no be small and dem dey give us all di informate wey we need,"
Na so so lorries wey dey comot Zambia or enta Tanzania na im full Nakonde streets according to BBC Kennedy Gondwe for Lusaka.
Authorities say di lorry drivers na high-risk group because dem dey stop for several towns along di way and dem dey get multiple sex partners.
"Dem [sex workers] dey very co-operative for our investigations, and we no wan shame or discriminate against dem. Dem dey very useful with contact tracing," Di kontri health minister Chitalu Chilufya tok.
"We get one case wia one of dem get symptoms and tell us about one client wey be lorry driver of foreign jurisdiction and even give us im contact number. We call dat number and dem tell us say di pesin we call get Covid-19," di minister add.
Zambia get 267 confam case of Covid-19 infection and seven pipo don die.
Ghana students build low-cost ventilators to fight coronavirus
Kontris across Europe don begin reduce dia lockdown

Wia dis foto come from, AFP
Across Europe, kontris don dey ease di lockdown, as dem dey hope say e no go lead to anoda wave of infection.
For France, primary schools go start with small numbers of pupils today, and clothes shops, bookshops, hair salons and florists go reopen. Restaurants, cinemas and bars go still dey closed.
For Belgium, most business go open on Monday plus dem go still dey do social distancing. Restaurants, bars and cafes no go open.
For di Netherlands, dem go partially open primary schools today. Libraries, physiotherapists, driving schools and hairdressers go also open.
For Switzerland, both primary and middle schools go reopen but dem go reduce di number of pipo wey go dey for class.Restaurants, bookshops and museums sef go open but e get some restrictions wey follow.
For some regions of Spain, dem go allow di gatherings of up to ten pipo and outdoor spaces for restaurants fit reopen with social distancing measures.
For di UK, England go ease some of di lockdown measures dis week, but other parts of di UK go get stricter guidelines.
For Denmark, shopping centres fit reopen on Monday but for Poland, hotels fit reopen dis week - although foreign tourists wey wan come go quarantine for two weeks.
Other European kontris like Germany, Austria and Italy don already start to dey ease their lockdown restrictions.
Liberia don partially lift ban for mosque and church
Liberia president George say im go partially reduce restriction for pipo to go pray for church and mosque.
Inside statement, di presido say beginning from May 15, pipo fit go pray for mosque and church go start on May 17 even though di lockdown for di kontri go continue for anoda two weeks.
Di ban include no movement from one county or state to anoda, business wey no be essential work still dey close and kontri pipo must continue to obey stay-at-home order.
Ghana extend ban on public gatherings to May 31
Article Information - Author, Favour Nunoo
- Role, BBC Pidgin
Ghana extend the ban on public gatherings which dey include religious activities, conferences, political campaigns den stuff.
The ban dey take effect from Monday 11th May, 2020 through to end of the month of May.
“The ban on public gatherings like holding of conferences, workshops, parties, night clubs, drinking spots, festivals, political rallies, religious activities, sporting events.
All educational facilities private and public, go remain closed,” Prez Akufo-Addo talk.
He make dis revelation during en ninth address to Ghana on how govment dey fight the infection and spread of Covid-19.
Covid-19 cases for Ghana continue dey rise as total infections now catch 4,700.
Out of dis number, 494 people recover wey 22 die. Ghana do total of 160,501 Covid-19 tests out of which 4,700 people test positive, 494 recover wey 22 people die.
Good morning!
Welcome to our live coverage of coronavirus and how e dey affect di world.
But first make dis proverb Ayo Tope Martins, ginger you.

Wia dis foto come from, Getty Images
Una Goodnight
Na for here we go gbab break with our today live coverage ontop coronavirus and how e dey affect di world.
No forget to scroll down for today tori dem and no also forget to join us tomorrow.
Make you remember to wash your hands.
UK Prime minister Boris Johnson don reveal new plan ontop coronavirus for di kontri, Oga Johnson say primary schools go begin reopen in June

UK PM Boris Johnson don announce "conditional plan" to reopen society as di coronavirus lockdown dey continue.
Oga Johnson unveiled wetin im call ‘threat level alert’ system for England wey consist five levels.
- From Wednesday pipo go fit do more outdoor exercise in England
- Primary schools go begin reopen in June, even shops dem, and some of di hospitality industry go fit reopen in July
- Im say pipo for England suppose dey "actively encouraged" to go to work if dem no fit work for house
- Oga Johnson say e go"soon be the time... to impose quarantine on pipo wey dey enta di kontri by air"
But leaders of Scotland and odas bin don reject Johnson's new "stay alert" advice. Dem want am to keep di "stay at home" order.
Rivers lockdown: Why Govnor Wike demolish di two hotels?
Di way wey Rivers State goment demolish two hotels for Eleme local goment still dey totori pipo as to why e happen like dat.
Tori be say, some pipo bin do party for Prodest Hotel wey make pesin report give di Covid19 taskforce wey come and di PDP Youth leader come beat up one of di taskforce members wen dem come confront dem.
But one indigene of Alode Community, Jeremiah wey see wetin happen tell BBC Pidgin say di demolition of di hotel dey surprise am and im no dey happy.
Jeremiah explain say na on Saturday 9 May, 2020 evening as di PDP Youth leader, Princewill Osaroejiji come village, pipo come welcome am and im house dey opposite Prodest Hotel for Alode.

Wia dis foto come from, Princewill Osaroejiji/Facebook
“You know as big man, wen im come home like dis, pipo go come greet am as im na man wey dey take care of evribodi and as tins be wey evriwia dry, pipo come and e give dem something to chop and drink.
Around evening time naim dis taskforce boys come say dem hear say something dey happen here make dem give dem N100,000.
Naim di Youth leader say nothing dey happen here so why im go pay dem N100,000. Dem come say if im no pay di money dem go report to Wike and demolish di hotel. We tell dem say nobody dey stay di hotel so make Wike imsef come see by imsef because if pesin dey di hotel dem go put on generator na.
So we surprise when we hear say goment don declare di Youth president wanted put N5million naira for im head. And today dem don come demolish di hotel.”
Jeremiah say im no like wetin happen as di owner of di hotel no be Eleme man, but na Ogoni man and im no dey around.
Dem don arrest di manager of Edemete Hotel for Onne, di second hotel wey goment demolish because say dem disobey di lockdown order wey ban all hotels for Rivers State make dem no do business because of coronavirus.

Wia dis foto come from, RSGH
Wetin we call dis foto, Edemete hotel for Onne 'Many cases of coronavirus for di state come from pipo wey stay hotel’ Wike tok.
Governor Wike after im supervise di demolition of di hotels tell tori pipo say, “we say make no hotel operate, unfortunately di PDP Youth leader for Eleme join odas to disobey di order. We dey do wetin we tell pipo say we go do.“
Wike say di reason dem dey focus for hotels na because say one of di Covid19 cases for di State spread from hotel.
“See di rate of infections, most of di pipo you fit see dem for hotel. See di man wey die, im bin dey Mingi Hotel for Rumuomasi and because of am, we get seven oda cases. Make pipo help us and support Goment so Rivers pipo go dey safe.
Security Council go meet to review di strategies and achievements or setbacks and see di way forward. All dis na to protect our pipo” Na so Wike tok.
Nigeria don get additional three labs to test for coronavirus

Wia dis foto come from, Twitter/NCDC
Three new labs na im Nigeria goment don include join di special laboratory wey go dey test for coronavirus inside di kontri.
Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) tok say di three additional lab na;
- University of Port Harcourt Teaching Hospital (UPTH) lab Port Harcourt
- Rivers State University Teaching Hospital (RSUTH) satellite lab, Port Harcourt
- University of Benin Teaching Hospital (UBTH) PCR laboratory, Benin.

Wia dis foto come from, Twitter/NCDC
Dis don bring di number of lab inside Nigeria wey get di capacity to test for Covid-19 to be 23.

