You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. 'Because my uncle get Coronavirus pipo for my street dey avoid me'

  2. Senior UN official say make dem ban all wildlife market for di world

    DI UN's biodiversity Chief don call say make dem ban all wildlife market around di world to prevent anoda future pandemic.

    Elizabeth Maruma Mrema tell BBC say to dey buy and sell wild animals for market fit put danger on human health and even to species wey don dey rare.

    ‘We sabi say ova di last 60 years di majority of di new diseases wey dey come from zoo na because human beings dey bring wild animals enta town and e dey increase transmission of infections.”Mrema tok.

    “We need make sure say market dey well regulated, clean and make dem no do illegal trade of wild animals.

    “ She still add am say she know say many rural communities around di world dey depend on wildlife trade “for economic and food security reasons.

    “ China don temporarily ban Im kontri pipo to dey chop wild animals afta reports say di Coronavirus Pandemic bin start from di market wey dey Wuhan. Even as proof neva dey say na from di market di outbreak start from.

  3. New Coronavirus cases for China don dey increase

    China don report dia highest number of new daily cases afta almost six weeks.

    Out of di 108 cases on Sunday, 98 na pipo wey come from abroad, wey come dey make dem fear say infected travellers fit start another wave of di virus for di kontri.

    Di Chinese city of Wuhan wia di disease bin start from just reopen dia city last weeks after 11 weeks lockdown.

    Di kontri still record two deaths on Sunday, wey make di total number of death for di kontri to climb to 3,341.

    DI kontri still record some new cases of 61 pipo wey no dey show symptoms but China no too count dem as confam cases.

  4. COVID-19 cases hit 566 for Ghana

    158 new COVID-19 cases for Ghana push country total number of infections go 566.

    Ghana Health Service say de sharp increase in de figures be sake of dema enhanced contact tracing in de past 13 days.

    So far 10 regions for Ghana record de infections.

    Greater Accra dey lead plus 452, Ashanti region record 49, Eastern get 32,

    Northern region too get 10.

    Volta Region also be one of de new regions wey record 9 new infections,

    Upper West too record 7 wey 4 people for Upper East get de infection.

    North East, Western den Central region all record 1 case each.

    So far 4 people recover for Ghana wey 8 people die.

  5. Una Goodmorning!

    Welcome to our live coverage of all di tori ontop coronavirus and how e dey affect di world.

    For tori from Sunday, make una scroll down.

  6. Na here we go march break!

    Na here we go end our today coverage of coronavirus and how e dey affect di world.

    No forget to scroll down for Sunday tori dem.

    But before we go, make dis video from di Lagos State Ministry of Health ginger you.

    Goodnight!

  7. Breaking, Nigeria don record five new cases of coronavirus

    Nigeria don record five new cases of coronavirus.

    Dis na according to di Nigeria Centre for Disease Control, NCDC.

    For dis latest five confam cases, two na for Lagos two for Kwara and one for Katsina

    With dis latest figures, di number of confam cases of di virus for di kontri don rise to 323.

    Meanwhile, dem don discharge 85 patients and 10 pipo don die.

  8. In case you just dey join us...

    Dis na di latest updates from around di world.

    • Ghana don extend dia lockdown for two more weeks.
    • 737 more pipo don die with coronavirus for UK hospitals, dis wan make di total recorded death toll 10,612.
    • Dem don discharge UK PM Boris Johnson from hospital afta im land intensive care with Covid-19.
    • Christians celebrate Easter, despite lockdowns wey see hundreds of millions of pipo tanda for dia homes.
    • Pope Francis broadcast Easter Sunday Mass online from empty St Peter's Basilica.
    • Italy record im lowest daily death toll in more dan three weeks.
    • Dem don confam some 1.8 million cases globally, according to Johns Hopkins University
    • More dan 112,000 pipo don die while 415,000 don recover.
  9. Who fit go for Covid-19 test for Nigeria?

    Di Nigeria Centre for Disease Control, NCDC, don release informate ontop dia twitter handle as to who fit test for Covid-19 for di kontri.

    Any pesin wey just return to Nigeria and dey get fever, cough/difficulty in breathing within 14 days, any pesin wey get contact with confam cases and dey show dis symptoms and any pesin wey also get di symptoms and dey live for area with high or moderate record of Covid-19.

  10. Ghana Prez Akufo-Addo extend ban on public gatherings, Accra den Kumasi dey enter week three of lockdown from Monday

      • Author, Favour Nunoo
      • Role, BBC Pidgin

    President Akufo-Addo extend de ban on social gatherings by two more weeks.De President extend de ban after he signed Executive Instrument (EI) wey dey extend de duration of restrictions.

    Dis go affect church activities, Islamic worship, political rallies den all other activities which dey bring more than 25 people for one place.

    Director of Communications for Presidency, Eugene Arhin reveal say de two week ban go take effect from Monday, April 13, 2020.Meanwhile, residents of Accra den Kumasi too dey start third week of partial lockdown morrow as part of plans govment dey take fight COVID-19.

    Ghana so far record 408 COVID-19 cases out of which 4 people recover, wey 8 die.

  11. Dem don discharge Boris Johnson from hospital

    UK Prime Minister Boris Johnson don comot from hospital afta im land intensive care with Covid-19, dis na according to Downing Street.

    Johnson bin dey receive treatment for coronavirus for St Thomas' Hospital for London since last Sunday.

    Johnson go continue im recovery for Chequers, wia be di prime minister country residence for Buckinghamshire, Downing Street tok.

    “On di advice of im medical team, di PM no go return immediately to work,” one tok-tok pesin tok.

    On Saturday,Johnson wey be 55 say, e owe im life to di NHS staff wey dey treat am for coronavirus.

    Johnson test positive for di virus on 27 March.

  12. 'I owe my life to NHS staff'- Boris Johnson

    UK Prime Minister Boris Johnson say im owe im life to di NHS staff wey dey treat am for coronavirus.

    For inside statement wey No 10 release, di prime minister wey be 55 years, thank di medical officers for St Thomas' Hospital for London, wia im still dey recover afta im spend three nights for intensive care.

    Dis dey come as dem dey expect UK deaths from di virus to pass 10,000 on Sunday.

    On Saturday, UK record 917 new coronavirus deaths, wey carry di total hospital death to 9,875.

    Ministers dey beg pipo to sidon for house during di Easter weekend to reduce di spread of di virus, even though say di weather across parts of UK dey warm and sunny.

  13. 'If you stay for your house and mesef stay for my house, coronavirus go go im house'

  14. Coronavirus: Cameroon don confirm 836 positive Covid-19 cases

    Cameroon don reach 836 cases, afta 16 new cases for Covid-19 weh kontri confirm for April 11.

    Just now, 98 pipo don recover and 12 pipo don die from Covid-19.

    Goment disinfect Olembe housing complex for wusai deh bi isolate 43 pipo and 37 bi recover from Covid-19 go back for house.

    For dis Easter Sunday, authorities say deh glad for de measures weh churches take for celebrate dis day for respect rules for fight Covid-19.

    Health authorities don continue for advice kontri pipo for bi careful and observe hygiene rules.

    Wash hands wit soap and running wata or use hand sanitiser, cover nose and mop or use elbow before cough, avoid contact wit pesin weh e get signs for Covid-19, keep social distance, only komot for important tins and wear mask.

    Authorities di vex as some pipo share fake news weh e di make pipo panic for social media. Goment say e di make sure say dhe give pipo correct informate, make deh call 1510 or 677893359/677894354.

  15. #HappyEaster trend as pipo dey celebrate online ontop lockdown

  16. US don overtake Italy as di kontri with di highest death from coronavirus for di world

    United States don overtake Italy as di kontri wey get di highest death from coronavirus for di world.

    According to di latest informate wey John Hopkins university release e show say 20,000 pipo for US don die from di virus.

    Dis dey come afta US become di first kontri for di world to record more dan 2000 virus death in one day.

    Di govnor of New York, Andrew Cuomo tok on Saturday say di state death toll don dey stabilize.

    Dem announce 783 new death under 24-hours, im say dem don see dis same number for some days now.

    New York state na di place wia di disease dey worry pass for US, dem record more dan 180,000 of di kontri estimated 520,000 cases.

  17. Nigeria don confam 318 cases of coronavirus

    Nigeria don confam 13 new cases of Covid-19 on Saturday night to make di total confam cases for di kontri to be 318.

    Di cases wey dem report na eleven for Lagos, one for Delta and one for Kano State.

    Dem don discharge 70 patients with 10 confam deaths.

  18. Una good morning!

    Welcome to our live coverage of all di tori ontop coronavirus and how e dey affect di world.

    And all of us here, we say Happy Easter to our Christian faithful!

    For tori from Saturday, make una scroll down.

    But first, make dis proverb from Emeka Uchendu ginger you dis morning.

  19. Una goodnight!

    Na here we go march break ontop our coverage of di coronavirus palava and how e dey affect di world today.

    We go see you tomorrow. Make you no forget to scroll to see Saturday tori.

  20. President Buhari beg Nigerians to stay for house, hint say lockdown go kontinu

    Nigeria president Muhammadu Buhari don beg Nigerians to stay for dia house as im say lockdown measures dey essential to defeat coronavirus pandemic for di kontri.

    For inside press statement, President Buhari say di lockdown go last as long as sabi pipo advise am say e dey necessary.

    President Buhari say "di freedom wey Nigerians dey give up today as e be for oda kontris dey essential to stop and defeat di spread of di virus."

    “No elected goment fit ask more of di citizens of di kontri wey elect dem than today we ask of you. But we must ask you - once more - to observe restrictions on movement wia e dey in place, and follow di instructions of our scientists and medical advisers: stay home, wash your hands, save lives.

    “Di freedoms we ask you to willingly forsake today go only last as long as our scientific advisers declare say e dey necessary. But dem dey essential - world over - to halt and defeat di spread of dis virus."

    President Buhari also add say dem don announce different measures to help assist pipo wey di lockdown affect the most with grains and small money.

    Di statement also tok say “All di Government dey ask you to do na to endure because nowhere in di world today wey anybody sabi how to defeat dis pandemic. Vaccine no dey. And that means there are choices to be made: between continuing as usual, or accepting di restrictions even wen they come with consequences wey we no plan.

    “But as for dis darkest hour, e remain our duty to offer you di full and naked truth: Dis na global pandemic. 210 kontris and territories across di globe dey affected. We no fit expect odas to come to our assistance. No one dey come to defeat dis virus for us.

    “Instead, di defeat of di virus for our kontri dey for our hands, alone. We no fit wait for odas. We fit only depend on ourselves now. And so we must - and we will - end di outbreak ourselves as Nigerians, togeda”.