You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Lagos Govnor promise security for dis lockdown

    Lagos state govnor Babajide Sanwo-Olu say security pipo go increase dia patrol for every area of di state for dis lockdown period.

    Di govnor give dis tok afta im meet wit di state security council to find solution to how arm robbery work don plenty and how peace no dey for communities wey get boundaries.

    Plenty tori na im dey of how jaguda pipo dey raid pipo for dia house to collect dia money and food for dis lockdown period.

    Lagosians for social media don lament how dis jaguda pipo dey terrorize dem for dia area, collect dia money, foodstuff and property. Dey beg di govnor say make he help dem.

    But di Police Public Relations Officer for Lagos, Bala Elkana tell BBC say di tori say jaguda pipo dey attack some areas for di state no be true as dem don receive plenty calls and wen dem reach di area, dey see say noting dey happun, na panic call because of di rumours wey dey fly upandan for social media.

    Oga Bala say dem dey respond to all di calls, but if dem reach there ask how far, dey go say dem still dey expect dem. Because of that, many youths don turn vigilante begin carry cutlass and burn tyre for street say dem dey guard dia area. But the question na how you go take know which youth get pure mind?

    He say dem don follow community leaders and landlords for different communities tok, to select pipo wey dey trust to do vigilante. Meanwhile oga Bala say di Inspector General of Police don send one Deputy Inspector General of Police come di state, he also send special force unit wey join body wit Lagos security force to ensure say everywhere for di state dey safe.

  2. How donation to WHO wey President Trump order to stop fit affect Africa

    E hard to say how much of di moni wey United States dey send give World Health Organisation suppose come directly to Africa.

    Africa na im dey collect di lion share of all di moni wey kontris dey donate give WHO, and now wey US president Donald Trump don give order make im goment stop to give WHO donation, e neva clear how dis decision go take affect am.

    US na im dey give WHO di biggest donation and last year alone dem give am more dan $400m.

    Di plan for di current 2020 and 2021 budget na for Africa to collect reach one billion dollars.

    Majority of dat moni bin suppose go to help Africa get beta healthcare plus to fight pandemic like coronavirus.

    President Trump bin accuse WHO say im dey favour China wey donate only $89m give am inside two years, 2018 and 2019.

  3. If you just dey join us...

    Di world don record more dan 2million confam cases of coronavirus.

    Inside dis two million Africa get ova 17,000 confam cases wit almost 900 dead pipo.

    As e be so, more dan 3,300 pipo for Africa don recover from di disease.

    Almost 500,000 pipo n aim don recover from Covid-19 for di whole wolrd.

  4. Kano record 5 new cases of Covid-19

    Kano don confam five new cases of Covid-19 for di state.

    Di state ministry of health naim confam am and as e be di total number of confam cases reach 9.

  5. Saudi Arabia don deport more Ethiopians despite UN warning

    Saudi Arabia still dey deport Ethiopians wey be illegal migrants even though UN don draw dia ear say dat kain flight dey risk di spread of Covid-19.

    Saudi goment don deport almost 3,000 Ethiopia pipo since di outbreak begin even though planes don stop to fly since March.

    For more dan two years now dem don dey deport Ethiopia pipo.

  6. US President Donald Trump give order to stop WHO funding

    US presido Donald Trump say im don give order make in goment stop to dey give WHO moni.

    Oga Trump accuse UN say dem no manage di pandemic well, on top of dat dem cover up di spread of di virus afta e show for China.

    Im don first accuse UN say dem dey do partia wen e concern China.

    “I don direct my goment to stop to give moni as wey dey chook eye for di part wey World Health Organisation play to seriously mismanage and cover up di spread of di coronavirus,” Oga Trump tok.

    For im reaction to wetin oga Trump tok, UN Secretary-General Antonio Guterres say now “no be di time” to dey reduce moni from WHO.

    US dey give WHO moni pass, e give am $400m last year, dat na about 15% of im budget.

  7. Coronavirus: Situation for 30 pipo for Cameroon serious as deh dey for oxygen

    Cameroon Health Minister, Malachie Manaouda don suggest say situation for 30 pipo dey serious for kontri as deh bi for Oxygen for different hospitals.

    As minister bi don tok before, na pipo weh deh dey for oxygen for hospital bi serious and de rest dey for centres laik Olembe.

    Just now for Cameroon over 165 pipo don recover, 17 don die and centre for emergency say Cameroon don confirm over 1000 cases for Covid-19.

    “Goment go continue for play e part for control Covid-19 weh e di spread for Cameroon and de whole world”, Manaouda tok.

    De rest na for kontri pipo for continue for respect rules for block Covid-19. Wash hands wit soap and running wata, use hand sanitiser, wear masks, no gada for one place more dan 50 pipo, respect social distancing.

    Cameroon go soon open new centres weh deh create, two for Yaoundé for military stadium and Zoe round-about, Mbappe-Leppe stadium and Yassa for Douala for treat pipo weh deh test positive for Covid-19. Minister appoint de sabi pipo weh deh go bi in-charge.

  8. “Pipo tok say I wan spread di virus” - Recovered Covid-19 patient

  9. Nigeria record 30 new cases of COVID-19

    Nigeria record di most plenti case of coronavirus on tuesday pass any oda day.

    Di kontri confam 30 new cases and di total reach 373 cases plus including 11 deaths.

    Di Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) announce 19 new cases of di virus then add anoda 11, one hour after di first announcement.

    Lagos record 25 out of di 30 new cases.

    Nigerian President Muhammadu Buhari on Monday bin extend di lockdown for di capital Abuja, Lagos and Ogun state to anoda 14 days.

  10. Una Goodmorning!

    Welcome to our live coverage of all di tori ontop coronavirus and how e dey affect di world.

    For tori from Tuesday, make una scroll down.

    Make we ginger you with today proverb from Hannatu Somshida Ali Gizo. How you see am?

  11. '72% of Nigerians dey fear say hunger go wire pipo sake of Covid-19 lockdown'

  12. Coronavirus: Nigeria oil rich State extend lockdown wit curfew, plan to share free face mask

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Lagos

    For Delta State, southern Nigeria, di govnor,don announce no movement of pipo from night till morning sake of coronavirus.

    Di curfew go dey from 7pm to 7am for di period of di lockdown.

    Govnor Ifeanyi Okowa say na measure to stop di spread of covid-19.

    E also announce extension of di 14-day Lockdown wey bin start on April 1, for another two weeks

    "We believe say for di next two weeks we fit track all contacts, identify all possible cases and take needed actions. We go use dis opportunity to produce enough quantities of face masks for our pipo.”

    Delta State get three confam cases of Coronavirus and one death.

    Di Govnor say some of di pipo wey contact di active cases wey dem don trace dey self-isolation for dia house but di ones wey no fit isolate for dia house dey do di isolation for three different centres for di state.

    Okowa say dem go soon begin share food for di State food bank within di next 72 hours and di face mask wey di State dey produce, dem go distribute am free of charge for di State by di end of dis week.

  13. See di tins you fit do & di ones you must avoid for dis coronavirus lockdown

  14. Breaking, Ghana Covid-19 case jump catch 636

      • Author, Favour Nunoo
      • Role, BBC Pidgin

    Coronavirus cases for Ghana jump catch 636 confirmed cases today. Out of de 636 confirmed COVID-19 cases, officials discover 268 of dem from routine surveillance. Meanwhile, dem find 253 from enhanced surveillance activities wey dem discover 115 from travellers wey dey under mandatory quarantine.

    Health Officials say dem test 44,271 people for Ghana out of which 636 test positive.

    17 people wey recover from de disease, 8 people die for Ghana. Ghana dey inside week three of lockdown after Prez Akufo-Addo extend de lockdown by one week starting from Monday, April 13, 2020. 10 regions for Ghana so far record cases of COVID-19.

  15. EU donate 21 billion Naira to Nigeria to fight covid-19

      • Author, Moseph Ekine
      • Role, Broadcast Journalist Pidgin

    European Union don donate 21 billion Naira (€50 million) to Nigeria to support di kontri for di fight against coronavirus pandemic.

    Members of di European body make dis donation wen dem visit President Muhammadu Buhari for Abuja on Tuesday.

    President Buhari for im thank you message to di EU say di money wey be di highest donation of di Union to any African kontri go go a long way to support Nigeria efforts to control community spread of di disease and strengthen Nigeria healthcare system.

    As at April 14, Nigeria get 343 cases of coronavirus and di kontri dey under lockdown to reduce di spread of di virus.

    Di number one citizen for Nigeria also tell leader of di delegation, Ambassador Ketil Karlsen sorry ova di way coronavirus don affect EU-member kontris.

  16. Compulsory mask, but cost force Cameroonians for sew dia own

  17. Covid-19 in 60 Secs - Hot weather fit kpai coronavirus?

  18. Amazon wan hire 75,000 new staff to meet customer demands, Amazon continue to dey hire new staff as online order dey increase.

    Afta dem hire 100,000 extra staff last month, online retail giant Amazon dey look to employ 75,000 more pipo.

    Di tech giant say dem need more workers to cope with di high demand as more pipo stay for house and dey order online as plenti kontris dey on lockdown.

    Amazon dey beg US workers wey don lose dia jobs for oda divisions to apply for di new jobs.

    Di firm still get long list of customers wey dey wait.

    Millions of Americans don lose dia jobs because of di coronavirus shutdown and about 16 million pipo don submit form say dem no get jobs again.

  19. IMF order immediate debt relief give 19 African kontris

    Di International Monetary Fund don approve immediate debt service relief for 19 African kontris for di next six month make dem for fit use di moni fight di coronavirus pandemic for dia kontri.

    Burkina Faso, Chad, Central African Republic and Mozambique dey among di kontris wey go benefit from dis relief.

    Odas na Benin, Comoros, Democratic Republic of Congo, The Gambia, Guinea, Guinea-Bissau, Liberia, Madagascar, Malawi, Mali, Niger, Rwanda, São Tomé and Príncipe, Sierra Leone and Togo,

    Dis move na to allow di most vulnerable kontris cope as di pandemic dey worse.

  20. 17 patients recover from COVID-19 for Ghana, Ghana record total of 566 COVID-19 cases out of which 8 people die

    Seventeen confirmed COVID-19 patients for Ghana test negative for coronavirus.

    Ghana Health Service officials say after repeat tests on de patients, dema results come out as negative.

    Dr. Patrick Aboagye, Director-General for Ghana Health Service talk for press briefing today say “we get 17 people wey record double negatives which show say dem be clinically cured.”

    Information Minister, Kojo Oppong Nkrumah say de enhanced testing for Ghana be very successful sake de country dey within de top ten countries wey dey do more testing.

    “Health officials test 44,221 people which dey represent 1,480 tests per 1million of de population” Kojo Oppong Nkrumah add.

    Ghana record total of 566 COVID-19 cases out of which 8 people die.