You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. “We no forget Lassa fever sake of Covid-19”

    Coronavirus no go make us forget wetin we dey do to fight Lassa fever for di kontri.

    Dis tok dey come from, di incident manager of di Nigeria Lassa fever Emergency Operation, Chioma Dan Nwafor.

    For her interview with tori pipo for Naijainfo, Chioma say since dis year (2020) Nigeria don record963 cases of Lassafever and 188 pipo don die from am.

    Di Nigeria Centre for Disease Control NCDC put am for dia twiiter page.

    “We dey advise health care workers to get high index of suspicion of patients and we dey advise dem to use di standard precautions all di time. “ Chioma Dan Nwafor tok.

    Dem don discover Lassafever for Nigeria since over 50 years ago and e still dey kill pipo for di kontri. According to WHO, na just one percent dey die from Lassa fever.

  2. Coronavirus: Hennessy don deny rumor say 'dia brandy dey cure Covid-19'

      • Author, Olaronke Alo
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin

    Makers of Hennessy type of brandy don draw ear warn say make no bodi believe say driking alcohol go protect dem against di coronavirus.

    Di manufacturers of Hennessy wan specially clear dim mata of one govnor of Kenya capital, Nairobi.

    “Hennessy go like stress am say if you drink our brand or any other alcohol beverage e no go protect you from di virus,” di alcohol manufacturer tok.

    Tori be say, Govnor Sanko yesterday tok say im go include some bottles of di brandy inside food packs for pipo wey no fit work becos of coronavirus.

    WHO say drinking alcohol no dey protect pipo against di coronavirus, but dem no tok say make pipo no dey use alcohol based gel to clean dia hands.

    To dey drink alcohol no go destroy di virus and e dey possible say if you dey drink am e go increase di health risk if you dey infected with di virus.” WHO tok.

    To drink plenti alcohol go weaken di immune system and e fit lead to death.

  3. Covonavirus: Samuel Eto’o fils, partners di contribute for fight Covid-19

    Cameroon football star, Samuel Eto’o Fils don gada some partners and wit e foundation deh go sensitise and share sanitary kit and chop for Yaoundé, Douala, Buea and Bafoussam.

    Cameroon don confirm 855 cases, majority for Yaoundé, Douala, Bafoussam and Buea.

    Wit de partner, 1000 players for top flight championship first and second division and first division for women competition go get sanitary kit and chop.

    Anong Bernadette, president for Social du Mbam, women’s football club, don gals for dis Eto’o e initiative.

    “Sanitary kit and chop go helep players for dis taim weh Covid-19 don force all football and sports competitions for stop” Anong tok.

    For de campaign, Samuel Eto’o go give Stop Covid-19 kits 50,000 houses for de four regions, 50,000 masks for taxi and bensikin (bike) drivers.

    Also, deh go dash 50,000 families for de four regions hand washing kit, wata, soap, and bleach plus chop, (rice, salt).

    Eto'o say de objective for di initiative na for add for weti weh goment and oda kontri pipo don already do and dia target na pipo weh deh get.

  4. Pregnant UK based Ghanaian nurse wey get COVID-19 die after she give birth, Pregnant Ghanaian nurse die for UK, but baby dey 'well' after delivery

    De baby of one "highly valued and loved" Ghanaian nurse who die for UK after she contract Covid-19 dey well after delivery.

    Mary Agyeiwaa Agyapong, 28, work for Luton and Dunstable University Hospital, for five years before she die for there on Sunday.

    One hospital trust spokeswoman talk say de nurse en "child dey do very well" but e no give further information.

    Dem admit Ms Agyapong for hospital on 7 April, after she test positive for Covid-19 two days earlier.

    David Carter, chief executive for Bedfordshire Hospitals NHS Foundation Trust, talk say den she be "fantastic nurse den great example of what dem dey stand for…”

    "Wana thoughts den deepest condolences dey go to Mary en family and friends around dis sad time," he add.

    Ms Agyapong en husband currently dey inside self-isolation as dem test am for Covid-19.

    Colleagues pay tribute to Ms Agyapong, who dem dey call by en marital name Mary Boateng. Dem set up fundraising page to support en family.

    De page already raise almost £4,500 since dem start on Wednesday morning.

    One former colleague talk say Ms Agyapong "devote en life give de NHS as a nurse".

    Renai Mcinerney write: "Sister Mary be my colleague, I worked plus am for a few years.

    "She deserve say dem go look after en family, sake of she devote en life give NHS as a nurse.

    "E be time say people go look out/after wana own and return de selflessness lifestyle wey Mary live den give something small, but big to en family around dis time. RIP sister Mary!"

  5. Police go charge minister wey buy alcohol during lockdown

    Police for Lesotho say dem go charge di minister for Police and public safety wey dem catch for CCTV camera dey buy alcohol drink during lockdown wey goment put to stop di spread of coronavirus.

    Just like South Africa, Lesotho ban di selling of alcohol during lockdown.

    Video wey go viral for social media show as di minister, Lehlohonolo Moramotse, dey collect boxes of alcoholic drink.

  6. How you fit survive Coronavirus, why you fit also die

  7. Coronavirus outbreak for Sahel region fit increase terrorist activities- Foreign ministers

    Foreign ministers for Sahel region dey call for international support against al-Qaeda as dem draw ear give say di current health crises go fit ginger di terrorist military activities.

    Local tori pipo for Mali say more dan 270 soldiers from Spain don go back to dia kontri sake of fear of coronavirus.

    Two soldiers for disunite bin test positive for di virus.

    Mali follow among kontris for di Sahel region, and terrorists wey dey loyal to al Quaeda for di region say, di virus na “God send am.”

    Di terrorists dey happy say coronavirus don make di international military group wey dey fight against dem to dey weak.

    Na dis make foreign ministers for di Sahel region dem need to shine eye for dis period.

  8. Nigerian doctor die from Covid-19

    One Nigerian doctor don die from Covid-19 afta e catch coronavirus wen e dey manage one infected patient for im private clinic.

    Lagos University Teaching Hospital bin admit di doctor on Monday and e die on Wednesday, according to di hospital director, Chris Bode.

    Oga Bode say di doctor bin come di hospital with severe symptoms.

    Di Nigerian Medical Association (NMA), president, Dr. Francis Faduyile confam say di doctor, Dr. Chugbo Emeka, dey exposed as e dey manage di patient wey also die on Friday.

    Vanguard newspaper n aim quote di association wey tok say the 51-year-old doctor dey asthmatic.

    Pesin wey tweet share di doctor's photo.

    Di NMA don tok say make state governments dem provide enough protective gear for all health workers as against wetin NCDC tok say PCR testing wey even though dey take time to turn out results, fit dey used only once to test for di virus.

    NMA tok say e dey slow and go make medics dey really at risk.

    Dey also tell patients say make dem dey honest about dia medical, travel and contact history, make dem helep doctors quickly identify pesin wey be potential coronavirus case.

  9. Coronavirus: Germany don dey reduce lockdown slowly

    German Chancellor Angela Merkel don announced plans to slowly reduce restrictions for movement to stop spread of coronavirus.

    Social distancing rules go still dey in place until 3 May. Madam Merkel don also recommend di use of face masks for shops and in public transport.

    But from next week shops under a certain size go fit open dia doors.

    And schools go gradually start to reopen from 4 May.

    Ms Merkel say di country don achieve "fragile intermediate success" through di strict measures.

    Di chancellor say di country "must keep focuse and keep going".

    Large public gatherings including religious services go remain close until 31 August. Bars, cafes, restaurants, cinemas and music venues go dey closed.

    According to Germany's Robert Koch Institute (RKI), the country get 127,584 confam cases and don report 3,254 deaths.

    Ms Merkel's announcement make Germany di latest European nation to start to dey relax restrictions.

  10. How to take care of pesin wey dey self isolate

  11. Nigeria record 34 new cases of Covid-19

    Di number of positive COVID 19 cases continue to dey rise for Nigeria.

    34 new patients don test positive and as e be di kontri don confam 407 cases in total.

    Di kontri don also record anoda death, bringing di total to 12.

  12. Ghana COVID-19 recovery cases rise from 17 catch 83, De 83 recovered patients dey among 268 cases wey dem discover through routine surveillance.

    Ghana record big progress in COVID-19 recovery cases as number of patients wey recover jump catch 83.

    Ghana Health Service reveal say all de 83 patients recover from after repeat tests on dem produce negative results for de virus.

    Officials say de 83 be part of some 268 cases wey dem discover through routine surveillance.

    Dis be de highest recovery case wey de country record since de outbreak of de pandemic for Ghana.

    Meanwhile, case count for Ghana also rise slightly catch 641. Ghana Health Service say dem test 50,719 people out of which 641 test positive for coronavirus.

  13. Una Goodmorning!

    Welcome to our live coverage of all di tori ontop coronavirus and how e dey affect di world.

    For tori from Wednesday, make una scroll down.

    How you see dis proverb wey Badmus Oluwashinaayo Pamilerin sama us today? Oya use am begin your day but no forget to drop your own for our facebook, Twitter or Instagram page @bbcnewspidgin.

  14. Wednesday tori go march break hia

    Na hia we go march break ontop tori for Wednesday 15 April, 2020 as e dey hot ontop coronavirus all ova di world.

    Make we leave una wit dis wonderful video post for Twitter from one of awa colleagues wey dey work from home.

    And based on who you be, we also wan make you enjoy anoda Instagram video post from ogbonge footballer Ronaldo wey dey train for house wit im pikin.

    In case you just dey see dis page for di first time, no worry, just take time now scroll down to read all di tori wey we don cover - yes you go enjoy am.

    From Princess, Ronke, Faith & Daniel, una goodnight!

  15. Cameroon president cancel prisons terms as fear for Covid-19 di high

  16. Coronavirus Lockdown: Five pipo injure for Sapele protest

    Five pipo na im injure today during di 'we no go gree waka' wey pipo for Sapele, Delta state Nigeria do against di lockdown wey di Governor, Ifeanyi Okowa put to stop di spread of coronavirus inside di state.

    Di Governor bin put 7pm - 7am curfew as im extend lockdown by 14 days on Tuesday.

    Im do am because di state don record three confam cases of COVID-19 and some pipo no dey obey di restriction rules.

    Di tok-tok pesin for Police inside Delta state, Onome Onovwakpoyeya tell BBC pidgin say no body die during di protest wey happun today and di five pipo wey injure dey for stable condition inside hospital.

    "Yes protest happun for di state. At one point e come dey rowdy and five pipo injure.

    Di pipo say wetin make dem dey protest na because of say di state goment extend di lockdown by anoda 14 days."

  17. How South Korea take hold dia elections inside Covid-19 pandemic

  18. Kenyan govnor wan give free alcohol on top fight against coronavirus

      • Author, Faith Oshoko
      • Role, BBC Pidgin, Lagos

    Di govnor of Kenya capital, Nairobi don make pipo start to tok afta im announce plan to add alcohol for di food packs im dey give poor families wey dey miss work because of coronavirus.

    Govnor Mike Sanko don dey trend for social media afta im tell tori pipo say e go add “small bottles of Hennessy for di food packs we dey give we pipo”.

    E tok say, “na WHO tok say alcohol get major role to kill coronavirus or any oda kain virus”. Kenyans don dey yab for social media on top Wetin e tok. No be today Govnor Sanko don get wahala for im head.

    Dem don accuse am of drug trafficking and money laundering, prison authorities say im run comot prison 20 years ago and in fact for December 2019, Presido Uhuru Kenyatta take ova im job afta court block am to enta im office ova 3.3 million dollars wey lost.

  19. How Cameroon IDP women di produce masks weh CHRDA go share for fight Covid-19

  20. Coronavirus: Demark don tell children to go back school

    Children up to di age of 11 don return to school for Denmark, as di goment become di first for Europe to relax lockdown restriction sake of coronavirus pandemic.

    Di Kontri Prime Minister Mette Frederiksen welcome children as dem back school for di capital, Copenhagen.

    Denmark dey among di first kontris for Europe to impose lockdown.

    Di kontri close school on 12 March and Infection rates don dey low but critics tok say di strategy dey risky.

    "We all dey nervous and we need to ensure say we stick to hygiene rules," Elisa Rimpler for di BUPL, the Danish Union of Early Childhood and Youth Educators, tell di BBC.

    "We get plenty time to dey wash hands during di day. We no get masks and we need to keep good distance from each other so that one na very difficult task."

    Denmark be just one of di kontris wey don take steps to relax lockdown measures dis week.