China 'dey willing to look at' how dem go relief di gbese wey African nations dey owe
China fit temporarily freeze di gbese wey African nations dey owe to free up cash for di kontris to fight coronavirus outbreak.
Tori pipo for Reuters report am. China na major creditor to African economy after dem don borrow dem billions of dollars ova di last two decades.
"Di origin of Africa gbese dey complex and di moni wey each kontri dey owe dey different. " China foreign ministry tell Reuters.
"We dey aware say some kontris and international organisations don call for debt relief programmes for African kontris, and we dey willing to study am with international community to see how e fit dey possible.
” Di International Monetary Fund (IMF) and World Bank dey also push for debt relief to help poor kontris during dis outbreak.