You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. APC dey mourn Abba Kyari death from coronavirus

    Di ruling All Progressive Congress don tell sorry give di Presido and im family on top di death of im former Chief of Staff, Abba Kyari.

    For statement dem call oga Kyari, "na pesin wey get brain die and na pesin wey don dey successful for private waka, professional hustle and for public service."

    Dis na as tori don comot say dem don begin burial rites on am and dem go do am for private ceremony as NCDC advise.

    Abba Kyari bin dey recieve treatment for coronavirus when im die.

  2. See wetin social media dey yarn about Abba Kyari, Nigeria President Chief of Staff wey die

    Di death of Nigeria former Chief of Staff, Abba Kyari, don gather mixed reactions from Nigerians.

    Abba Kyari, wey be di President Chief of Staff die of coronavirus on Friday.

    For social media, many leaders like Nigeria former President Goodluck Jonathan, former Vice President, Atiku Abubakar, Former senator Shehu Sani and odas don pay condolence to di family of late Kyari.

    While some goment officials dey pay condolence to im family odas pipo for social media dey tok say “dem no care” say di man die.

    But one Bashir Ahmed, wey dey work for presidency tok say nobody for life know wen dem go die, as e bi Kyari turn, e go be everybody turn one day.

    Anoda Twitter account tok say make anybody no “guilt” anybody on top di matter.

    President Buhari Senior tok tok person, Garba Shehu announce Abba Kyari death for Friday night and dem don bury am this morning around 11am according to Islamic rights.

  3. Trump don defend tweets against lockdown for some US states

    President Donald Trump don defend tweet wey im do to dey endorse protests against strong lockdown measures for some US states.

    For im Friday briefing, he say some measures wey Minnesota, Michigan and Virginia dem bin impose "too dey tough".

    Earlier, he write for im tweets: "LIBERATE MINNESOTA", "LIBERATE MICHIGAN" and then "LIBERATE VIRGINIA".

    Di restriction bin include stay-at-home orders make e for slow di spread of coronavirus.

    But protesters say dem dey hurt citizens by limiting movement unreasonably and e dey affect di economy.

    Di three states di Republican president tok about for im Friday tweets na Democratic governors state. Mr Trump dey seek to encourage im political base to protest against Democrats.

    But Mr Trump no mention Ohio and Utah wey get Republican governors.

    Im comments dey come after di US confam dia highest daily number of death from coronavirus.

    Di kontri record 4,591 deaths in 24 hours on Thursday.

  4. Ogun go relax lockdown on some days

    Ogun state for south Nigeria, go open again for business on Monday, 20th April, 2020, Wednesday, 22nd and Friday, 24th to allow for businesses dem and so pipo go fit buy tins dem need like food items among odas from 7am to 2pm.

    Na di State govnor, Dapo Abiodun tok dis one for inside statement on Friday say dis one comot afta dem analyse di extension wey Federal goment put for di lockdown.

    E say dat window come mean say di state go dey on total lockdown on Saturday 18th; Sunday, 19th; Tuesday, 21st; and Thursday, 23rd.

    Ogun State na one of di three states wey Presido Buhari bin put on lockdown ontop di outbreak of coronavirus for di kontri.

    As at now, Ogun get ten confam cases of di virus for dia state.

  5. Coronavirus: 'One World, Together At Home' concert go hold online with plenty celebs

    On international organisation, Global Citizen movement don joinbodi with World Health Organization (WHO) to hold one special live concert online where plenty celebrity go perform.

    Di special concert ''One World: Together At Home'' na to support health workers wey dey frontline for dis coronavirus pandemic.

    Di show go get more than 100 artists including the Rolling Stones and Billie Eilishw wey go perform live from dia homes.

    Di collabo go also happun with di support of superstar Lady Gaga.

    American TV star Stephen Colbert, Jimmy Kimmel and Jimmy Fallon go host di show, wey go feature Elton John, Taylor Swift and Oprah Winfrey among others.

  6. Nigeria record 51 new coronavirus cases

    Nigeria Center for Disease Control don confam fifty-one new coronavirus cases.

    32 for Lagos, 6 for Kano, 5 for Kwara, 2 for FCT, 2 for Oyo, 2 for Katsina, 1 for Ogun and 1 for Ekiti

    As at Friday, 17th April na 493 confam cases dey for di kontri.

    159 pipo don dey discharged and 17 die.

  7. Una Goodmorning!

    Welcome to our live coverage of all di tori ontop coronavirus and how e dey affect di world.

    For tori from Friday, make una scroll down.

    But na sad news we begin wit dis morning! Make you stay wit us for all di details.

    Even so wetin this today proverb mean to you?

  8. Who be Abba Kyari, Nigeria President Muhammadu Buhari Chief of staff wey die?

  9. Na here we go march break for today

    Na here we go march break for update of di coronavirus pandemic wey dey worry for di world today.

    Join us tomorrow for more update.

    No forget to screw down and catch up with di ogbonge tori dem wey we don yarn.

    Also no forget to always wash your hands

  10. ...and from around di world

    Latest update from di world.

    • More dan 2.15 million confamed cases of COVID- 19 na im dey di world now and 145,000 pipo don die from di virus.
    • Interior Ministry for Tunisia say dem don gbag two pipo wey dem suspects to be jihadist wey fit get plan to infect dia security pipo wit coronavirus.
    • Di pipo wey don die from Coronavirus for UK don reach 14,576 as hospital record 847 pipo wey just die.
    • Germany say dem dey manage di coronavirus outbreak for dia side.
    • UK Health Secretary Matt Hancock say dem go begin test pipo wey dey work for public service like police, fire and prison staff for COVID- 19.
  11. In case you just dey join us...

    Latest update from Nigeria, Africa.

    • Nigeria second largest state don begin 7 days lockdown.
    • Di second Covid-19 patient for Rivers State don test negative and dem go discharge am today.
    • Nigeria Private hospitals wey dey secretly treat coronavirus patients fit chop sanction.
    • Africa Centre for Disease Control and Prevention say di continent need one million coronavirus testing kits.
    • United Nations say Coronavirus pandemic fit kill at least 30,000 pipo for Africa and make 30 million Africans dey poor.
    • Di World Health Organization say e possible make Africa COVID- 19 cases enta 10 million as time dey go.
    • Malawi kontri pipo do protest sake of Coronavirus lockdown Tanzania Presido John Magufuli say make im pipo use di weekend pray make coronavirus no spread for di kontri.
  12. COVID-19 get Vaccine?

  13. 'Di outbreak for Germany dey under control'

    Germany Health Minister Jens Spahn say di kontri coronavirus outbreak dey under control, afta dem record reduction in di rate of di infection.

    Mr Spahn say di number of recovered patients say don remain higher dan di number of new infections - im say e show say di lockdown dey successful.

    "Di outbreak, as of today, don become controllable and manageable again," he tell news conference, come add say di health care system no "at any get work wey pass wetin dem fit handle so far".

    Figures wey Germany disease control agency publish show say di infection rate don drop to 0.7 - meaning each infected person pass di virus to less dan one other.

    However, di number of pipo wey dey die still dey rise, so also di number of health care workers wey dey infected.

    Germany don collect accolade for dia ogbonge testing efforts. Dem get almost 138,000 positive cases, according to Johns Hopkins University tracking, and 3,868 pipo die around di kontri with di virus, wey be number wey no too high.

    • Africa fit be di next centre of di coronavirus outbreak- WHO

      World Health Organization (WHO) don sama warning say Africa fit become di next big centre of di coronavirus outbreak.

      For di past week, sharp rise in cases of coronavirus na im don dey happun. Almost 1,000 deaths and more than 18,000 infections na im don dey across Africa so far, although dis rates dey far lower than those wey dey for parts of Europe and US.

      WHO say di virus appear to dey spread comot from African capitals. Dem also highlight say di continent no get enof ventilators to deal with di pandemic.

      Di Africa director of di organization, Dr Matshidiso Moeti, tell BBC say dem don witnesse di virus dey spread from capital cities to "villages" inside South Africa, Nigeria, Ivory Coast, Cameroon and Ghana.

      She tok say dem dey focus on prevention rather than treating di virus because African kontries no get di capacity to treat many coronavirus patients.

      "We want to reduce di proportion of pipo wey get to di point of needing serious care for ICU, because we know say dis types of facilities no dey enof by any means for plenti of African kontries," she tok.

      "I get to say di issue of ventilators na one of di biggest challenges wey di kontries dey face."

      For patients wey dey seriously dey sick with Covid-19, access to ventilator fit be matter of life or death.

      Di machines get oxygen wey dem go put inside di lungs and remove carbon dioxide from di body wen pipo dey too sick to breathe on dia own.

    • Breaking, No date yet for Premier League conclusion

      Premier League clubs say dem remain committed to finishing di 92 remaining fixtures of di current season but no gree discuss deadline by which play must resume for one meeting wey happun on Friday.

      Clubs suppose debate di 30 June deadline to resume play but instead discuss di "possible scheduling models".

      Di Premier League say e "remains our objective" to complete matches but currently "all dates no sure". Dem suspend di league since 13 March due to di coronavirus pandemic.

      Tori be say some clubs go discuss di proposed 30 June deadline for Friday meeting but dem decide say now no be di right time to do so.

      "Togeda with oda businesses and industries, di Premier League and our clubs dey work through some planning scenarios," di Premier League tok. "We dey engage stakeholders, including broadcast partners, and our aim na to ensure say we dey in a position to continue playing when e dey safe to do so and with di full support of di goment. Di health and wellbeing of players, coaches, managers, club staff and supporters na our priority and di League go only restart wen medical guidance allow am to. "Today shareholders meeting give us opportunity to discuss possible scheduling models. Na still our objective to complete di 2019-20 season but at dis stage all dates no sure as Covid-19 still dey worry."

      Earlier dis month di Premier League say dem go resume play wen "e dey safe and appropriate to do so" and di number of coronavirus deaths for UK since den don rise to more dan 12,000.

    • Second patient test negative for Covid-19 for Rivers state

        • Author, Karina Igonikan
        • Role, BBC Pidgin

      Di second Covid-19 patient for Rivers State don test negative and dem go discharge am today.

      Governor of Rivers State, Nyesom Wike announce dis one for State broadcast today.

      Im add say, im no go allow anybody bring coronavirus come inside Rivers again, come cut warning give security pipo make dem no carry out any presidential directive wey fit jeopardise di State.

      Im commend di health workers wey make sure say di two case wey dem record for di state recover well.

      Im add say di preventive measures wey dem put in place don pay off with dis result.

      “E get some decisions wey go hurt di pipo but at di end of di day e go help di pipo. Make we see dis coronavirus as war time so we fit contain am, no be say anybody want to suffer pipo.”

      Di Governor say di safety of Rivers pipo naim be im first priority so im go do everything to protect dem.

    • ‘Stay home or dance plus us’ – How dancing Ghana pallbearers turn Covid-19 sensation

    • Nigeria Private hospitals wey dey secretly treat coronavirus patients fit chop sanction

      Nigeria federal and state goment don threaten to close private hospitals wey dey secretly treat rich pipo wey get coronavirus.

      Presidential task force on Covid-19 say if anybody get symptoms of di virus make dem no go hospitals wey no dey accredited but contact NCDC.

      Tori be say many big men and big women wey get Covid-19 no dey gree go Nigeria Centre for Disease Control isolation center, instead dem dey go private hosiptals wey no get any training to manage di outbreak.

      According to NCDC rule for coronavirus, any hospital wey get dat kain patient must to send dem go health centre wey dem already approve.

    • Coronavirus: Magufuli say make pipo carry dia weekend do prayer

      Tanzania Presido John Magufuli don beg im kontri pipo make dem use dis weekend pray sake make Coronavirus no reach dia sia.

      E no clear weather pipo go gada for worship places do dis prayer as di kontri neva give order wey say make pipo no go church or mosque.

      One devoted Catholic, Mr Magufuli tweet:

      "My fellow kontri pipo, sake of dis coronavirus, I dey beg una say make we use three days from 17th – 19th April, 2020 (Friday, Saturday and Sunday), pray to Almighty God, make e deliver us."

      Di Tanzanian goment don do some tins make Coronavirus for no spread like dem close schools, colleges and universities but dem neva do one particular tin wey most kontris wey near dem do, lockdown.

      As e dey now, di kontri get 94 confamed cases of Coronavirus, 4 don die and 11 don recover.

    • Coronavirus: Cameroon wan make school resume for June if Covid-19 reduce

      Joseph Dion Ngute, Cameroon Prime minister afta checking how kontri di fight Covid-19 for de pass one moon say school go fit start for June 1 if de situation change.

      “Depending on how de situation di progress, schools and university institutions go re-open”, Dion Ngute tok.

      Cameroon bi close schools for March 17 two weeks afta kontri record first case for Covid-19 for March 6 among oda measures for fight de pandemic.

      One moon afta, Cameroon get close to 1000 cases, 22 pipo don die and over 165 don well from Covid-19.

      For now school, borders go remain closed; drinking spots, restaurants di close by 6:pm; no over loading for motorcycle, taxis and bus and kontri pipo get for continue respect distancing for anoda two weeks.

      Many kontri pipo di fear say de situation fit worse for Cameroon as de virus de number for pipo weh deh test positive di so-so increase.

      Goment don pass command for 300,000 test kits and 100 ventilators weh fit enta kontri tomorrow April 18, for boost fight for Covid-19.

      Health Minister, Malachie Manaouda say de youngest pesin weh e get Covid-19 for kontri na 3 months pikin weh e mami contaminate, de oldest pesin fit bi about 80 years.

      New treatment centres for Military Stadium and Carrefour Zoe, Mbappe Leppe stadium and Yassa for Douala go soon open.

      As some hospitals bi di take plenti moni for patients before deh treat dem of Covid-19, Health minister insist say treatment na free for all hospitals.

      Manaouda de decision afta some kontri pipo tok how deh di ask dem pleti moni for hospital before deh treat dem.