You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Nigerians react to Adeboye words say ‘dis coronavirus palava go soon end’

    Social media start to dey vibrate today afta popular Nigerian Pastor Enoch Adeboye announce say di coronavirus palava go soon reduce.

    Pastor Adeboye tok dis one for im online service today on top video sharing sites and Dove TV on top announcement to stop all public gathering.

    Federal goment extend di lockdown for two weeks from 13 April on top di spread of di virus for di kontri.

    As at now, Nigeria get 541 cases with 19 deaths from di virus.

    See some of di tweets.

  2. NCDC correct number of coronavirus case for Ekiti

    DI Nigeria Centre for Disease Control don tok say Ekiti get three coronavirus cases, no be four like dem first report yesterday.

    “Yesterday, we mistakenly report one new case for Ekiti. Dis na mistake and wetin cause am na error during verification process.

    “Therefore, as at April 18 2020, na 541 be confam cases, 166 don discharge and 19 pipo don die. Ekiti state get 3 confam cases, no be 4” di centre tok.

  3. 42 pipo die with Covid-19 for Cameroon as positive cases pass 1000

      • Author, Leocadia Bongben
      • Role, BBC Pidgin, Yaounde

    De latest figures from Cameroon Public Health Minister, Malachie Manaouda show say 305 pipo don recover, but 42 pipo also die from Covid-19.

    Just now de number of positive cases don pass 1000, and de virus don touch seven out of ten regions.

    “We get for for bi more careful, respect goment rules especially wear masks. Make we protect others, make we bi responsible” Manaouda tok.

    Goment priority na for search, test pipo wit de virus.wit support from United Nations Development Programme, UNDP and e partners World Bank and Global Fund, Cameroon don bring plenti medical supplies from China.

    Dis first part for medical equipment, two tons, about $3.9 million (FCFA 2 billion) enta Douala airport for April 18.

    De equipment na 20 ventilators, 100 infusion pumps and 2000 infra- thermometers.

    Anoda set for equipment go include 3million surgical masks, 1.1million gloves, 25,000 test kits 20 defibrillator and odas.

    For Jean Luc Stallon resident Representative UNDP, dis equipment go improve de way Cameroon di fight Covid-19.

    ust now for manage de situation, military stadium weh e go treat Covid-19 patients don get beds and authorities

  4. Burna Boy, oda world celebrities perform for health workers around di world

    Nigerian singer Burna Boy dey among top artistes for di world wey perform for Lady Gaga concert for health workers

    Di concert wey hold on Saturday na with partnership with Global Citizen and di World Health Organisation. Lady Gaga na im organise the line-up and she call am “love letter to the world".

    Di concert na for all health workers wey dey frontline of coronavirus pandemic.

    Gaga tok say all di artiste wey dey dia bin wan give back a little kindness wey di health workers don show dem.

    Di online show start with pictures of pipo under lockdown wey dey clap for healthcare workers around di world - from France, Spain, UK, US and oda places.

    Celebrities like Taylor Swift, Billie Eilish, Lizzo, Jennifer Lopez, Stevie Wonder, Paul McCartney and LL Cool J also join for di event.

    Stevie Wonder also do tribute to late soul legend Bill Withers. Im play “Lean On Me” before im play “Love’s In Need Of Love Today”.

    Sitting at his home piano, Wonder, who turns 70 next month, played “Lean On Me” before launching into his own “Love’s In Need Of Love Today” in his singular crystal-clear voice.

    Any money wey dem gather for di show go be for di Covid-19 Solidarity Response Fund for di WHO, but Lady Gaga make am clear say di show no be for fundraising and go focus on entertainment and messages of solidarity.

  5. Do Bingo challenge to kill boredom - NCDC

    The Nigeria Centre for Disease Control say make pipo play bingo game to kill boredom wey fit dey do dem for house.

    NCDC tok say to dey engage in game activitites with family and friend go help dis lockdown time.

    Many states for Nigeria don dey lockdown sake of coronavirus pandemic.

    If you dey wonder Wetin be di Bingo challenge, check am inside NCDC tweet.

  6. Fact-check: Pastor Chris yan about 5G and Covid-19, wetin expert tok

  7. Nigeria coronavirus cases don rise to 542

    Nigeria don record 49 new cases of coronavirus.

    Dis na according to di kontri Centre for Disease Control.

    Di new cases na 23 for Lagos, 12 for FCT, 10 for Kano, 2 for Ogun, 1 for Oyo and Ekiti.

    With dis one, di total number of coronavirus cases for Nigeria don rise to 542.

  8. Una Goodmorning!

    Welcome for our live coverage of all di tori on top coronavirus and how e dey affect our world.

    For tori on wetin happun on Friday, make una scroll down.

    But before we enta di mata, check out today proverb.

  9. Na here we go march break today

    Na here we go end our live updates on top coronavirus and how e dey affect di world.

    Abeg make una join us again tomorrow.

    Good night!

  10. America evacuate over 340 of dia citizens from Nigeria

    Anoda batch of American citizens don comot for Nigeria afta US send aeroplane to come carry dem.

    According to US embassy for Nigeria, na over 340 of dia citizens comot from Lagos.

    Di Omni air international flight wey America charter go carry dem go Dulles airport near Washington DC.

  11. Coronavirus: Rivers State declare complete lockdown for areas wey disobey social distancing rule

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Lagos

    As Rivers State no get any coronavirus case with di discharge of di second patient of COVID19 wey don recover and test negative, some areas for Port Harcourt city dey complete lockdown as dem no observe social distancing restrictions and continue to dey conduct business activities.

    Governor Nyesom Wike for State broadcast commend pipo for di state for di way dem cooperate with all di measures wey dem put to fight di coronavirus but declare say Creek Road including Prison junction, Nembe Waterside, Cultural Centre, Yam zone and Ahoada Street for Old Port Harcourt Township go dey complete lockdown till further notice.

    For Diobu area: Education Bustop, Kalabari Street by Odi Street, Afikpo Street, Gambia street, di entire Ikoku spare parts zone, Rivers State University roundabout and Abali Park under di flyover (both descending and ascending) sef dey complete lockdown till further notice.

    Di Governor say make evri pesin wey dey live dia and pipo wey dey visit dia stay for dia house and all shops and business activities must stop with immediate effect.

    Im also warn some areas for Obio Akpor local Goment wia dem don dey convert some places to small marketsto comply if not di entire Obio Akpor LGA go dey complete lockdown.

    For commercial taxi drivers wey still dey disregard social distancing dey crowd dia motor with passengers, di Governor say dem go take appropriate action of dem no adjust.

    Im encourage pipo for di State to continue to practice all di health practice wey dey recommended to sustain di fight against Covid19.

  12. Who be Abba Kyari?

  13. ...and from around di world

    Di number of pipo wey don die from coronavirus for UK don pass 15,000

    More dan 4.5million pipo don dey under quarantine as coronavirus deaths pass 150,000 for di world.

    Pipo for US dey plan to protest di coronavirus lockdown for di kontri

    Queen Elizabeth say make dem no use gun salute take mark her birthday wey go hold for Tuesday UK sake of di Covid- 19

    Prime Minister Boris Johnson don dey recover as im don meet wit some ministers

  14. in case you just dey join us...

    From Africa, Nigerians dey react to di death of di kontri Chief of Staff, Abba Kyari.

    Confam cases of Covid- 19 don dey seven regions out of di 10 regions wey dey Cameroon

    Covid-19 cases for Ghana don enta 834 afta de country record 193 new cases today.

  15. Govnor Ganduje sack commissioner for Facebook post about Kyari death

      • Author, Mansur Abubakar
      • Role, BBC Pidgin, Kano

    Govnor Abdullahi Ganduje of Kano, North West Nigeria, don sack im commissioner of works Engr Muazu Magaji after di commissioner write for Facebook say Nigeria don dey free after Abba Kyari die.

    For statement wey commissioner of information Muhammad Garba release, Ganduje tok say e sack di commissioner for di bad tin wey im write as di nation dey mourn di late chief of staff to President Buhari.

    For Facebook post, Engr Muazu write say “Nigeria don dey free as Abba Kyari don die for dis pandemic, if e get good faith for islam e go rest well.”

    Ganduje add say wetin di former commissioner write go reflect on im goment na why to sack am dey necessary.

  16. Coronavirus: Seven of Cameroon ten regions don confirm Covid-19 cases

      • Author, Leocadia Bongben
      • Role, BBC Pidgin, Yaounde

    Coronavirus, Covid-19 di da so spread for Cameroon sotei de virus don cross to Adamawa region, doorway to de northern regions.

    Seven out of ten regions don confirm Covid-19 cases and just now only Northwest, North and Far North still stand wit no case.

    Dis new case for Adamawa region bi among de more dan 1000 cases for Covid-19 weh Cameroon don register.

    Just now Centre region na de highest wit, 558; Littoral follow wit 381; den West wit 60, Southwest 11, South 4, East 2 cases and now Adamawa 1 case for Covid-19.

    From de pipo weh deh test positive 24 of dem na hospital workers-doctors nurses, den 168 pipo don recover and 22 die.

    Health minister di warn pipo weh continue for doubt dis virus, say Covid-19 no know any age or colour, man or woman.

    Authorities warn say as pipo continue for bi careless de virus go continue for spread.

    Sensitisation di continue for make pipo wash dia hands wit soap and running wata or use hand sanitiser, wear masks for public and stay for housefor remain safe from Covid-19.

  17. Ghana coronavirus cases rise to 834

      • Author, Favour Nunoo
      • Role, BBC Pidgin

    Covid-19 cases for Ghana rise catch 834 after de country record 193 new cases today.

    Data wey Ghana Health Service publish dey show say 16 people also recover from de virus, dis dey bring total recoveries to 99.

    Meanwhile, one more person die, dis mean total deaths be 9 now.

    According to Ghana Health Service, dem test over 57,000 people

    Accra, Tema, Kasoa den Kumasi be some of de cities wey record more cases.

    Prez Akufo-Addo place three-week lockdown on these areas.

    Some Ghanaians start dey wonder if time catch for de whole Ghana to go under lockdown sake of de increasing case count.

  18. Queen cancel gun salute for her birthday sake of coronavirus outbreak

    Dem no go use gun salute take mark di Queen 94 birthday celebration on Tuesday because of di coronavirus outbreak.

    One official for Buckingham Palace say di Queen decide say e no dey right for dis kain time. Tori be say dis go be di first time for her 68-year reign wey dem no go do salute wey dey normally happun for Hyde Park and di Tower of London.

    Di Trooping of di Colour parade for June wey dem dey take mark di Queen official birthday celebrations dem don cancel am. Dis announcement dey come afta goment introduce tough restrictions for UK for pipo to stay for house.

  19. Family, friends bury Abba Kyari for Abuja

    Family and friends don gather to bury Abba Kyari, chief of staff to President Muhammadu Buhari, for Gudu cemetery wey dey Abuja di kontri capital on Saturday.

    On Friday, tok tok person of President Buhari, Garba Shehu, announce say Kyari die sake of coronavirus.

    Kyari don dey hospital since March wey im test positive for COVID-19.

    Shehu announce say dem go open condolence register for di office of di secretary to di federation from Sunday.

  20. NCDC join to mourn Nigeria Former Chief of Staff, Abba Kyari

    Di Nigeria Centre for Disease Control, NCDC don join mouth to mourn di death of di kontri chief of staff Abba Kyari.

    Di NCDC for dia Twitter page say '' even at dis time, as we mourn loved ones wey don die from Covid-19 plus including di President Chief of Staff..''.

    But dem draw ear give pipo say make dem no attend mass gatherings to prevent di further spread of di virus.