Rivers Lockdown: Governor Wike arrest 14 pipo wey hide inside two trailers wey carry cattle
Governor, Nyesom Ezenwo Wike on Thursday 7 April, arrest 14 pipo wey hide inside two trailers wey carry cattle from Adamawa State to Port Harcourt.
Governor Wike say dem catch di trailers after dem get intelligence from well meaning Nigerians wey see as some of dem dey enter and arrest dem for Rumuigbo, Obio/Akpor Local Goment Area.
Di governor bin don give order make dem prosecute di 14 pesins for di Mobile Court under Executive Order 6 wey im sign for di declaration of di lockdown, come also direct di State Ministry of Health to conduct tests on di 14 pesins to ascertain dia coronavirus status.
“Dis fight get nothing to do with individuals. Di law must take im course. You dey aware of wetin dey happen and then some people wan illegally smuggle pipo into di state. Port Harcourt and Obio/Akpor dey under lockdown and we must obey law so di trailers and di cows, dem go auction dem tomorrow."
One of di defaulters, Ahmed Aliyu say dem contract dem to bring di cattle from Adamawa State to one Alhaji for di new slaughter for Oyigbo and im think say di lockdown go start by 10pm.
Meanwhile, Mobile Court don convict 170 pipo wey violate di lockdown of Port Harcourt and Obio Akpor.