You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Di couples wey dey do wedding ontop Zoom

  2. Pipo no dey too dey knack again during dis lockdown- Durex

  3. Wetin we sabi about di number of coronavirus cases wey dey rise

  4. Lagos still dey lead with 176 new coronavirus cases

    Una good morning! Di Nigeria centre for disease control don announce anoda 386 new cases of Covid-19 and Lagos bin dey di top with 176 new cases. Kano do follow follow with 65 cases.

    As e be so, Nigeria get 3912 confam cases of coronavirues.

    Make you dey wash your hands.

  5. Goodnight!

    Na here we go march break with our live coverage today ontop coronavirus and how e dey affect di world.

    Join us again tommorrow.

    No forget to scroll down for Friday tori dem.

    Bye bye!

  6. Anoda 12 health workers don catch coronavirus for Kano

      • Author, Mansur Abubakar
      • Role, BBC Pidgin, Kano

    12 health workers on Friday test positive to coronavirus for Kano state Nigeria, to make am 34 workers wey don get di disease for di northwestern state.

    According to di Joint Health Workers Union oga Dr Murtala Isa, na on Wednesday 14 health workers test positive to add to di eight wey don already get di disease before now.

    On Monday, di National Medical Association chairmo for Kano Dr Sanusi Bala tell BBC say, 34 pipo don test positive for coronavirus for Kano.

    One doctor wey speak with BBC say di reason why plenti health workers dey catch di disease for Kano be say dem no get enough protective equipment to helep dem.

    Overall Kano get 482 cases of covid 19 and 13 deaths.

  7. Record 921 new Covid-19 cases for Ghana push total infections go 4,012

      • Author, Favour Nunoo
      • Role, BBC Pidgin

    Record 921 new Covid-19 cases for Ghana push total infections go 4,012.

    Ghana health service data wey dem release on Friday show say additional 20 people recover.

    Dis push de total recoveries go 323, meanwhile de death toll dey stand at 18.

    According to de health service, over 50% of de new cases wey Ghana record dey come from one industrial facility where out of 1,300 workers, 533 test positive for Covid-19.

    Ghana health officials dis week argue say Ghana reach peak of covid-19 infections but observers criticize de claims.

  8. ‘COVID 19 disease fit escalate for Rivers State sake of sabotage’ - Governor Wike

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Lagos

    Rivers State Governor,Nyesom Ezenwo Wike say di coronavirus pandemic fit escalate for Rivers State because of di sabotage from security agencies.

    For State Broadcast on Friday 8 May, 2020 Governor Wike say e dey necessary to alert di world of di situation and for pipo to stay for dia house and treat di matter as life and death issue as dat be di best option.

    Im say as dem wan start intense testing for di State, di numbers go increase well well.

    "Our borders dey continue to experience serial acts of sabotage by security operatives, wey dey allow, and in some cases, dey personally help pipo with risky COVID-19 status enter di State.

    "As recently as yesterday, we catch one lorry-load of livestock with 22 pesins wey bribe dia way into Rivers State from as far as Adamawa State despite di restriction on inter-state travel wey Federal Goment claim say dey ground and even as we don close all entry routes into di State.

    For pipo wey disobey di lockdown, even though well meaning Rivers pipo dey beg make dem forgive dem, Governor Wike say dem go face di law as dem put demsef and odas at risk to get di disease.

    Rivers State for southern Nigeria currently get 17 cases of covid-19.

  9. Wetin be covid-19 R number and why e matter?

  10. Di number of pipo wey don die for Italy don reach 30,000

    Italy don become di first kontri for European Union to register more than 30,000 coronavirus-related deaths.

    Di kontri report 243 new deaths on Friday - down from 274 di day before - and dis come make di total number climb go 30,201.

    Di daily number of confirmed new cases fall small to 1,327, bringing di total number of infections to 217,185.

    Italy get di third highest number of officially recorded coronavirus deaths in di world, afta United States and the UK. Britain pass di 30,000 mark on Wednesday.

    Di third kontri for Europe wey dis virus affect well-well na Spain with more than 26,000 deaths.

    Italy na di first kontri for Europe to impose lockdown wen coronavirus cases first start to surface for northern regions during February.

    Di kontri don begin to dey ease restrictions, although fotos wey some pipo share for social media wey show as pipo dey ignore distancing rules and no dey wear protective masks for busy areas don led to serious hala.

  11. Why Wike coronavirus lockdown style dey totori pipo

  12. Nigerians wey land Lagos from UK complain of 'long wait'

    Some Nigerians wey just land di Muritala Muhammed Airport Lagos from UK don tell BBC say dem don dey wait for airport for hours since dem land with no idea as to di next step.

    Nigerian goment bin announce di evacuation of 270 citizens from UK, but some of di citizens wey land di kontri around 1:30pm tell BBC say upon dia arrival for MMA, Ikeja na waiting game dem dey as nobody dey to welcome dem.

    Some of the returnees wey speak with BBC say dem pay for dia travels and accommodation but dem only tell dem say dem go carry dem go Abuja for di compulsory 14 days isolation.

    Some of dem no find am funny as dem complain say 90 percent of dem be residents of Lagos and dem go get problem with travelling back to Lagos from Abuja afta di expiration of dia isolation because of di interstate ban wey currently dey in place across di kontri.

    Chairman of di Nigerians in Diaspora Commission, Abike Dabiri-Erewa respond say na di ministry of Foreign affairs dey in charge of travel arrangements for di returnees.

  13. Coronavirus push US jobless rate to 14.7%

    Di US unemployment rate don rise to 14.7%, with 20.5 million jobs wey lost for April, as di coronavirus pandemic worry di economy.

    Di rise mean say di jobless rate now don worse dan at any time since di Great Depression of di 1930s.

    Since di pandemic start, di US don suffer dia worst growth numbers in a decade and di worst retail sales report for record.

    Just two months ago, di unemployment rate dey for 3.5%, wey be 50-year low.

    Di report from di Labor Department show di slowing down for every sector of di economy.

    Leisure and hospitality na im e hit especially hard, with payrolls wey fall by 7.7 million or 47%. Employers for education and health services cut 2.5 million positions, while retailers lose 2.1 million.

  14. Lagos fit battle with coronavirus till July or August - Abayomi

  15. ...And from across di world

    • Confamed cases of coronavirus for di world tanda for 3.8m wit 268,000 deaths.
    • World Health Organization say e fit take at least one year to know di exact origin of coronavirus.
    • Europe mark di 75th anniversary of Victory in Europe Day under lockdown
    • Australian PM Scott Morrison don announce plan to reopen di kontri starting wit di gatherings of 10 pipo.
    • Facebook and Google too don announce plans to reopen but say dem go allow dia employees still dey work from house.
  16. If you just dey join us...

    Dis na di latest from Nigeria and di rest of Africa...

    • Nigeria record 381 new cases of coronavirus and dat don carry di total number of confamed cases enta 3,526.
    • Commissioner of health for Lagos state, Prof. Akin Abayomi say di rumour say im don catch coronavirus na fake news.
    • Residents of Ogun state for Nigeria go face arrest if dem no wear face masks for public, according to police tok-tok pesin, Abimbola Oyeyemi.
    • United Nations say 85 children don comot from detention for South Sudan as part of effort to reduce crowd for jail for dis coronavirus pandemic time.
    • One major South Africa brewing company say dem fit destroy 130 million litres of beer if dem no sell dem soon. Di lockdown for di kontri don affect di sales of di beer.
  17. African students wey dey help fight coronavirus

  18. Ogun state go arrest pesin wey no use face mask for public

    Residents of Ogun state for Nigeria go face arrest if dem no wear face masks for public, according to police tok-tok pesin, Abimbola Oyeyemi.

    Dem consider di state as hot-spot for coronavirus and e bin dey lockdown for 35-days wey end last week.

    Governor Dapo Abiodun order say to wear face mask don become compulsory to take stop di spread of coronavirus.

    Di order bin start for May 1 and community leaders say pipo no dey follow di order.

    Police say enforcement go begin dis weekend and dem go quarantine anybody wey dem arrest, di pesin go do community work join.

    Ogun state so far get record of 100 cases of Covid- 19 and e dey at risk sake of im closeness to Lagos state.

    .

  19. How free online consultation for Cameroon di helep for advice patients

  20. WHO say coronavirus fit kill 190,000 pipo for Africa

    World Health Organization (WHO) tok say coronavirus fit kill up to 190,000 pipo for Africa for di first year if di control measure dem take dey manage am fail.

    Di health body warn say di numbers fit pass di medical capacity di continent get as dem cite one new study.

    WHO Africa Director Regional Director Matshidiso Moeti, say di transmission of di virus for di continent dey slow but e fit cause di outbreak stay long.

    Di agency dey propose strong health care systems for di continent.

    "Covid-19 fit remain for our lives for plenty if dem no take b could become a fixture in our lives for the next several years unless goments for di region take practical step to quech am. We need do test, trace, isolate and treat,” Dr Moeti tok.