Ghana dey explore legal options which go make failure to
wear nose masks criminal.
After govment use law criminalize dis, e go mean say
wearing nose mask go be compulsory to all persons for Ghana as part of Covid-19
personal preventive protocols.
Govment say people wey go fail to wear nose masks in
public spaces go fit go jail for up to 3 months.
Information Minister, Kojo Oppong Nkrumah talk say “legal
options dey wey we dey consider to ensure strict enforcement of personal
preventive etiquette like wearing of mask.”
“Hopefully, we go announce de legal options soon,” he add.
President Akufo-Addo after lifting lockdown on parts of
de country announce say, Ghanaians for wear nose mask if dem dey public places.
But de directive no sheda go down plus some people who
still dey walk around in public without nose masks.
BBC Pidgin talk plus some residents of Accra who dey town
but no wear nose mask.
“I know how I dey do myself for house wey I no go get de
virus. I dey wash my hands, I use hand sanitiser but nose mask wey I no wan
wear,” Bernard talk BBC Pidgin.
Another worker for Accra, Justice who talk say “I no dey want wear nose mask sake of I no like am. Also e dey make my customers feel like I dey sick.”
Sake of de shortage of nose masks, Ghana govment partner local garment producers who dey make nose masks locally for health sector den frontline workers.
Govment say people go fit wear nose mask which dem make from local fabrics wey vendors dey sell or any material which dey cover dema nose dem mouth well.
Total coronavirus cases for Ghana dey stand at 5,530, out of which 674 recover wey 22 die.