Kenya President Uhuru Kenyatta don order di closure of land border wey dem share wit Tanzania and Somalia
except for trucks wey dey carri goods.
Presido Kenyatta order take effect from Saturday midnight.
Di Kenyan leadet tok say e don become by force alia compulsory to do coronavirus test for drivers for border posts.
78 truck drivers na im test positive to di
virus last week and dem no allow dem enta di kontri.
Long queues na im dey between Uganda and
Kenya border now, wia compulsory COVID-19 test don begin.
E dey quick and easy for dem to sabi lorry
drivers wey dey at high risk sake of dia experience and knowledge on how dem handle HIV/AIDS.
President Uhuru Kenyatta also don extend di nationwide
overnight curfew and ban on all movement in and out of plenty towns and cities
including di capital, Nairobi.