Burundi 'pursue' WHO representative comot dia kontri
Di Ministry of Foreign Affairs for Burundi don give di World Health Organization representative for di kontri 48 hours to leave dia kontri, according to one statement from di ministry wey go viral for social media.
Dr Walter Kazadi Mulombo, di WHO representative for Burundi and experts for di join body, Pr. Tarzy Daniel, Dr Ruhana Mirindi Bisimwa and Dr Jean Pierre Murunda Nkata get until May 15th to leave according to one statement wey di ministry write.
Di Burundi foreign affairs Minister, Ezechiel Nibigira no deny or confam di statement for inside telephone interview.
One pesin wey dey work for di ministry confam give BBC say di statement na genuine one.
Dem no tok di reason why dem want make dem comot for di kontri, but BBC try follow di WHO representative, Walter Kazadi Mulombo tok.
Burundi goment dey face tok say dem do election inside coronavirus pandemic.
Di kontri get 27 cases of coronavirus and one pesin don die wit di disease.
Dem do plenty political campaigns before di election wey hold for Wednesday. No clear sign of arrangement on how dem fit control di spread of di virus and dis dey cause fear say di virus fit spread anyhow for di kontri.
For one press briefing on Wednesday to give informate on wetin dey happun for Burundi, di International Crisis Group say goment for Burundi no tok di true number of pipo wey don catch di infection.