Premier League clubs don agree to di stage one of di return
to training protocols wey go allow teams to start training for small groups from
Tuesday.
All di clubs vote on top di decision for dia Monday
"Project Restart" meeting.
Players must to observe social distancing rules, and to dey
touch oda pipo during training no dey allowed.
Di statement tok say dem agree on di
first stage after dem consult with players, managers, club doctors, independent
experts and di government.
Di Premier League statement add say: "Strict medical
protocols of di highest standard go dey in place to ensure everyone return to
training for di safest environment possible.
"Di health and wellbeing of all participants be di
Premier League's concern, and di safe return to training be step-by-step
process.
"Full consultation go continue with players, managers,
clubs, di PFA and LMA as dem dey protocols for full-contact training ."
Official protocols wey dem send give players and managers last
week and wey BBC see show say dem go disinfect corner-flags, balls, cones,
goalposts and even playing surfaces after each training session.
Surveillance measure wey dey go on include twice-weekly
testing and one daily pre-training questionnaire and temperature check.
Clubs don dey do coronavirus testing dis weekend.