Cameroon authorities don write for aviation director say
make e open Douala and Yaoundé airports for Air France one taim every week from
May 4 go reach June 30.
Cameroon bi close e borders for March 17, as one measure for
fight Coronavirus, afta deh confirm
first case for March 6.
Just now, kontri don confirm 2689 cases and plenti na pipo
weh goment bring back for kontri afta deh lock border.
Just now de borders still be locked and airport bi di open
only for receive Cameroonians dem weh deh block dem for oda kontris and ova
500,000 enta kontri since May 10.
Letter weh transport minister write for Airport Director
show say president Biya order make deh open airport for Air-France business
flight.
Deh flights suppose start from June 4 end for June 30, but
de condition na say any man get for show e Covid-19 negative test before deh
enta plane.
Also, deh get for sign agreement say deh go self-quarantine
wit dia own moni wen deh enta kontri.
Air France get for make sure say deh follow de passengers
one by one for, and deh get for respect barrier measures, wear masks,
authorities add.
But kontri pipo di wanda why goment open airports only for
Air France wen oda companies too dey.
Some pipo check say France na one of de kontris for Europe
weh Covid-19 hit dem badly and e no good for let pipo for dat side enta kontri
now.