You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Una goodnight!

    Na here we go march break today on top our live coverage of di coronavirus and how e affect di world.

    No forget to scroll down for Tuesday tori dem.

    We go leave una with dis foto of dis robots wey go dey help wit coronavirus screening for Rwanda. Di Five humanoid robots go dey help to deliver food and drugs to patients. And dem names na Akazuba, Ikizere, Mwiza, Ngabo and Urumuri.

  2. I leave mallams wey dey abuse me to God - El-Rufai

    Govnor of Kaduna State for northwestern Nigeria, Mallam Nasir El-Rufai say e don leave mallams wey dey abuse am say e no allow prayer for mosque to God to judge dem.

    El-Rufai tok dis one for state-wide address wey im do to di citizens of Kaduna on Tuesday.

    According to di govnor” Even for Mecca wey be holiest land for muslims dis year dem no go pray Eid prayer talk less of here, na im some mallams just dey abuse me up and down, God go judge dem. I fit forgive pipo wey abuse me but I no go forgive those wey lie on top my head.”

    Di govnor also yan say e go make sure say nobody go enter im state from Kano after dia goment announce say pipo go comot pray on Friday and Sallah day.

    “I go personally go stay for road dat day to see pesin wey go enter Kaduna from Kano. Dis disease don enter many pipo and we no go allow dem to carry am enter our state.”

    Unlike some states for northern Nigeria, El-Rufai say make im pipo pray Friday and Eid prayer for dia houses to stop di spread of coronavirus.

    Di govnor also accuse security pipo wey suppose dey stop pipo from entering Kaduna say dem dey colet money allow pipo dey enter.

    Di govnor no announce any timeline wey im go open di state for normal activities to continue.

  3. ...And di latest for Africa...

    • One woman wey get coronavirus for Nigeria don born twins on Tuesday, 19th May, 2020. Authorities say di delivery happun for Lagos University Teaching Hospital.
    • Di Federal Airports Authority of Nigeria (FAAN), wey be agency wey dey manage commercial airports for di west African, don start to dey fumigate airports for Lagos, Abuja and Port Harcourt sake of plan to re-open di airports.
    • Speaker of Parliament for Ghana order for de immediate mass testing of Members of parliament and parliamentary staff for Covid-19. De Speaker issue dis directive to MPs on de floor of de House after dem meet for de chamber for parliamentary business today.
    • Tanzania civil aviation authority don lift every restriction on passengers wey dey travel for dia kontri. As e be, dem no go quarantine any passenger but dem go only check for symptoms.
    • South Sudan vice-president don tests positive for coronavirus
    • Robots don reach Rwanda wey go begin to assist for testing coronavirus. Di Five humanoid robots go dey help to deliver food and drugs to patients. Dem fit even do video-conferencing between patients and doctors. Dem give each of di robot Rwandan name - Akazuba, Ikizere, Mwiza, Ngabo and Urumuri.
  4. If you just dey join us....dis na di latest tori across di world

    • America President Donald Trump don send letter to di head of di World Health Organization with threats to stop to fund di organization ova Covid-19 matter. Di letter give WHO 30-days deadline to commit to "visible improvements or dem dey at risk of losing millions and US membership of di union.
    • US President Donald Trump say im dey take anti-malarial drug hydroxychloroquine as preventive measure against Covid-19, although sabi pipo don warn about di side effects. But sabi pipo still dey study if hydroxychloroquine (and one drug wey resemble am wey dem dey call chloroquine) dey effective against coronavirus.
    • Test don begin for Britain to see if dogs fit use dia ogbonge nose smell coronavirus. Dogs don already sabi how to use dia nose to detect pipo wey get malaria, Parkinson's disease and some types of cancer.
    • France and Germany dey propose €500bn ($545bn) European recovery moni wey dem go give EU kontris wey dey badly affected by Covid-19. French Presido Emmanuel Macron and German Chancellor Angela Merkel agree say di moni go come as grants.
    • And as e be now, 4.8m confam cases of coronavirus n aim dey globally, and 320,000 pipo don kpai.
  5. One Covid-19 patient for Nigeria don born twins

    One woman wey get coronavirus for Nigeria born twins on Tuesday, 19th May, 2020.

    Authorities say di delivery happun for Lagos University Teaching Hospital.

    Di woman born boy and girl through caesarean section. Di pikin dem weigh (boy and girl) 3.25kg and 3.2kg

    Dis na di fourth delivery wey involve Covid-19 patient for di state.

    Dia mama na 22 year old woman wey test positive for coronavirus and dem bin dey on admission for di hospital.

  6. Meet di dogs wey UK goment wan spend £500k train to smell coronavirus

  7. Wetin be hydroxychloroquine? Di drug Trump claim say im dey take to prevent coronavirus

  8. Nigeria police wan support families during di Covid-19 lockdown

    Nigeria Inspector-General of Police, Muhammed Adamu don launch community sensitization campaign to support families during di Covid-19 lockdown for di kontri.

    Di program according to di IGP go also provide palliative support to families wey dey within di police communities.

    Dis initiative according to statement wey police tok tok pesin Frank Mba send, na di idea of serving female police officers and e go involve visits to local communities across di kontri and di capital, Abuja.

    IGP Adamu appoint Commissioner of Police, Aisha Abubakar wey be di most senior female police officer for di Force to coordinate di campaign alongside other female police officers.

    Part of wetin dem go do according to di statement na to "distribute relief materials including food items, beverages and other essentials to families of junior officers and di public".

  9. UK goment don drop £500k to train dog to smell coronavirus, Na only six dogs qualify as di special ones dem go use

    Test don begin for Britain to see if dogs fit use dia ogbonge nose smell coronavirus.

    Dogs don already sabi how to use dia nose to detect pipo wey get malaria, Parkinson's disease and some types of cancer.

    Now, authorities for UK dey hope say di same fit happun for coronavirus wit six special dogs dem wey dem go use four to six weeks train.

    Di UK goment comot £500,000 to use support di project.

    Dia plan be say dem go use dis dogs test pipo wey dey enter di kontri through places like airports, and e go fit test 250 pipo in one hour.

    Dr Claire Guest wey follow dey train dis dogs say: "Di plan na say dis gods go fit test anybody, even those wey dia symptoms never show. E go dey fast, effective and e no go touch pesin body."

    UK no be di first to begin do dis Covid-19 dog training as France bin don get one similar program wey dem start for April.

  10. Premier League clubs record six positive coronavirus tests

    Na six positive test results dem get for coronavirus from three Premier League clubs on Sunday and Monday, as di league dey prepare to resume for June.

    Although dem no announce di players or staff names, dem go proceed on self-isolation for seven days.

    Na total of 748 players and staff from 19 clubs dem don test. Di remaining clubs go do dia tests on Tuesday so dem no go include am for di Saturday results.

    Teams start training on Tuesday but dem no go touch each oda.

    Na since March 13 dem suspend di league sake of Covid-19 pandemic, with 92 fixtures wey still remain.

  11. Wetin dey inside President Trump letter wey blast WHO

  12. Ghana speaker of parliament order mass testing of lawmakers

      • Author, Favour Nunoo
      • Role, BBC Pidgin

    Speaker of Parliament for Ghana, Prof. Aaron Mike Oquaye order for de immediate mass testing of Members of parliament and parliamentary staff for Covid-19.

    De Speaker issue dis directive to MPs on de floor of de House after dem meet for de chamber for parliamentary business today.

    Dis move dey come after some observers talk say MPs for go through Covid-19 tests den set positive example give other Ghanaians.

    “I direct on authority of parliamentary service board, de clerk of parliament and parliament medical officers so say dem go work plus appropriate institutions to immediately testing of all honorable members and staff of the parliamentary service for Covid-19.

    “I dey request your co-operation in this enterprise” he add.

    Before Parliament go on break, ten MPs and five members of staff go into mandatory quarantine after dem arrive for just before Ghana shut en borders.

    Prof. Aaron Mike Oquaye believe say dis tests go help prevent de outbreak of de pandemic for Parliament House.

    Ghana Covid-19 cases rise catch 5,918, out of which 1,754 recover wey 31 die.

  13. 'Madagascar cure tonic wey land Nigeria no be free, goment gatz pay for di drink'

    Nigeria junior Minister for Health, Olorunnimbe Mamora, don tok say di goment go pay for di Madagascar herbal medicine.

    Senator Mamora confam dis give BBC Pidgin wen im apear for Covid-19 Tok Your Own interview on Tuesday.

    Madagascar claim say dem don formulate one herbal medicine wey dey cure coronavirus, according to di kontri President Andry Rajoelina.

    Last week, di kontri send sample of di Covid-Organic herbal medicine go oda African kontri and Nigeria follow carry im own for Guinea Bissau wey di drug land.

    Some local tori pipo for Nigeria dey tok say Madagascar dey demand 170,000 Euro for Nigeria as money for di nergs wey dem send.

    Even though Mamora say im no fit confam di amount wey Nigeria go pay for di medicine, e tok say di drug no be for free dey send am give Nigeria.

    Mamora tok say Nigeria collect di drug to do solidarity for anoda African Kontri wey dey claim say dem don find cure for coronavirus.

    “Wen dem first send dis thing (Covid-Organic herbal medicine), dem first send am to Guinea Bissau. Na dia we con collect our won consignment wey dem bring for Nigeria. SO, di thing dey Nigeria as we dey speak.

    “I no fit tell you di thing wey dem dey ask for but I no say di thing wey dem send, no be free. We know where di consignment dey but di amount wey em dey ask, I no fit confam am now,” na wetin Mamora tok.

    For now, President Buhari don tok say im no go allow make dem give any herbal medicine give Nigerian except dem test am.

  14. Nigeria don begin plan to re-open international airports

    Di Federal Airports Authority of Nigeria (FAAN), wey be agency wey dey manage commercial airports for di west African, don start to dey fumigate airports for Lagos, Abuja and Port Harcourt sake of plan to re-open di airports.

    FAAN announce say dem don start di fumigation on top dia Twitter page on Tuesday.

    Last week, di agency bin warn pipo to disregard guideline wey dey circulate social media as per measure wey go dey in place for airports when dem reopen.

    For di statement wey di agency release, dem tok say dem dey work “seriously” on top guideline on how pipo and airline go dey operate wen dem re-open.

    Nigeria don relax lockdown restriction but airport still dey closed.

    Health authority for di kontru tok say di kontri never ready for total relaxing of lockdown restriction.

    On Monday, di Nigeria president Muhammadu Buhari, through the Presidential Covid-19 Task Force extend di relax measure wey impose curfew for some states.

  15. Allow church service of up to 100 pipo - CAN to Lagos goment

    Joinbodi of Christians for Lagos state south west Nigeria don tell goment make e review dia decision to close all worship centres for di state.

    For statement dem release after dia online meeting wit di state goment, dem say dia stand ontop di mata be say make goment allow church service of up to 100 pipo inside 3 to 4 services on Sundays starting from June 1.

    Dem promise goment say dem go take responsibility for anytin wey dey happun for dia churches.

    Lagos goment on Sunday release new rules wey churches and other religious bodies go follow before goment go allow dem to resume dia activities.

    Religious groups for di state don dey under lockdown for six weeks since covid19 wahala begin worry di state.

  16. Dis lady dey use bread ginger security pipo wey dey fight COVID-19 for Lagos

  17. Why Buhari no dey wear facemask

  18. Nurse disobey coronavirus travel ban to visit her lover

      • Author, Princess Igho Williams
      • Role, BBC Pidgin

    Authorities for Kenya don quarantine one nurse afta she travel from di capital, Nairobi, go Nakuru town for Rift Valley region to visit her boyfriend under di claim say she dey go offer essential services.

    She identify hersef to police wey dey for roadblocks and tell dem say she dey go offer essential services.

    Local broadcaster Citizen TV report say na di neighbours for di area send informate give police wen dem see di nurse.

    Police come carri waka go di house togeda wit health officials wey come later say di nurse temperature dey higher than normal and dem come carri her go put for 14-days mandatory quarantine alias stay for separate room..

    Di goment bin restrict travel in and out of Nairobi except for cargo trucks to stop di spread of coronavirus. Health workers dey among essential service providers wey dem allow to travel out of di capital and to operate during curfew hours.

    Dis na di video wey di Citizen TV share concerning di nurse arrest:

  19. Live from Ghana plus COVID-19 patient who beat de virus afta four weeks of treatment

      • Author, Favour Nunoo
      • Role, BBC Pidgin
  20. Vice-President, im wife, Defence Minister don test positive for coronavirus