You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. La Liga fit resume from 8 June? Wetin we know

  2. 12-year-old dey among latest coronavirus deaths

    NHS England say 157 more pipo wey test positive for coronavirus don die.

    Among di latest deaths wey dem announce na one 12-year-old wey get underlying health conditions.

    Di youngest death wey NHS England announce na one six-week-old baby.

    Dis don carry di total number of confamed reported deaths for hospitals for England go 25,545. Di deaths happun between 1 and 22 May, except three pipo wey die for April.

  3. Gaza record first Covid-19 death as dem relax lockdown

    One 77-year-old woman don become di first pesin to die wit Covid- 19 for Gaza Strip, one day afta dem relax lockdown.

    According to di health official, di woman bin get some health wahala and she bin travel go Gaza from Egypt for 19 May and she bin dey quarantine since den.

    Dem relax lockdown for Gaza Strip make pipo fit go mosque go pray for di first time since dem ban worship centres two months ago. Plenty pipo also don dey gada for markets to arrange for di Eid al-Fitr holiday.

    This don create fear say plenty pipo fit catch di disease as di number of local cases rise from below 20 to 55 for dis week.

  4. Immune sign wey give coronavirus treatment hope

  5. Nigeria COVID-19 cases na scam? - See wetin we sabi

  6. 'I bury my cousin on Facebook Live'

  7. Nigeria record 245 new cases

  8. Una goodnight!

    Na here we go march break today on top our live coverage of di coronavirus and how e affect di world.

    No forget to scroll down for Friday tori dem.

    We go leave una with dis cartoon wey NCDC bin put for dia twitter page.

    Make una remember to dey wash una hands. Covid-19 dey real.

  9. Cameroon don register 112 new cases of Covid-19

    Cameroon don register 112 cases of Covid-19 for total 4400 cases of Covid-19, Health Minister, Manaouda Malachie tok.

    Some sabi pipo don di compare Cameroon now with kontris laik Brazil and Spain where Covid-19 cases reach 500 for one day.

    Cameroon don confirm 528 cases for one day before.

    Plenti pipo di fear say de situation fit climb ceiling, as of now space no dey for hospital, call centre di tell some for stay for house but deh no di get any answer or get help.

    Just now 1690 patients don recover, (14 today), 159 don (die three) today and close to 2500 pipo na active patients.

    Manaouda Malachie say goment di try for get beta strategy for limit spread for inside communities, manage cases, and reduce de effect for how de kontri di waka and business.

    De challenge for now na for make sure say population get correct informate for helep kontri pipo for respect protection measures.

    Covid-19 situation in Cameroon

    • Total Positive cases: 4400
    • Active cases: 2454
    • Recovered Patients: 1690
    • Total Deaths: 159
    • New Positive cases: 112 (in 24hrs)
  10. India go gree make rail ticket counters open

    At least 200 trains go begin work for India from 1 June as goment don decide to open counters for some cities and e go allow pipo fit book online.

    Online booking for these trains don already start but to open di counter na im be di main tin.

    Train na one of di major means of transportation for India and millions of pipo dey depend on am every day, and na for di counter most of dis pipo dey go collect ticket as dem no get smartphones to take book online.

    Di decision na beta news for plenty migrant workers wey wan go back dia house and as most of dem no get choice some don begin waka. Di ministry say dem go observe social distancing but e go dey hard.

    When authorities open one temporary counter for migrant workers for early dis week for Ghaziabad city, thousands of pipo na im gada there to hussle for ticket so tey space no even dey to maintain social distancing.

  11. Places wia schools don reopen and how dem dey keep children safe from COVID-19

  12. Family of 10 catch coronavirus for Kaduna

    All di 10 pipo for one family wey dey Kaduna state, Northern Nigeria, don test positive to coronavirus.

    Na di state govnor Nasir El-Rufai give di informate come add say di 10 dey among di 18 new cases wey dem record for Kaduna.

    E tok say on Friday, out of the 18 new cases of COVID-19 wey dem confam for di state, 10 be members of di same family.

    According to di govnor, 14 of di new cases bin from Kaduna North, two from Zaria and one each from Chikun and Sabon-Gari.

    Di govnor don beg im pipo to obey social distancing rule and oda guideline dem put in place to take control di spread of coronavirus.

  13. Tanzania politician say make im pipo party, as coronavirus don end for di kontri

    A senior politician for Tanzania don cause disbelief among im pipo when im claim say coronavirus don end for di kontri.

    Paul Makonda, regional commissioner for Dar es Salaam, tell im kontri pipo to celebrate for street. He even add say make dem go buy new clothes so dem go fit fine go party.

    Dis comment dey against do recommendations of di World Health Organization (WHO) on social distancing.

    Tanzania stop to dey publish daily figure of coronavirus cases for di kontri weeks ago but as at last time 509 pipo don carry coronavirus for di kontri and 21 pipo don die.

    Di kontri President John Magufuli sef ask pipo to pray from today till Sunday and praise God say cases don dey reduce.

    But opposition party no believe di goment

  14. Zimbabwe teachers say dem go strike if schools reopen

    Teachers for Zimbabwe don go against di plan to begin open school small-small say safety measures neva dey in place wey go stop di spread of coronavirus, according to tori wey di state-owned Herald newspaper carry.

    Chairperson of di Teacher Union, Sifiso Ndlovu say if goment continue wit dis plan, dem go strike.

    Zimbabwe education ministry bin tok say plans dey to reopen schools and dem go start wit final year students wey wan write national examinations wey go start for 29 June.

    Oga Ndlovu tell goment may dem reason if dem fit cancel di exams like wetin di private Cambridge international examinations body do.

    Plenty African countries dey plan to reopen schools for June including Tanzania and South Africa.

  15. Takeaway food and supermarket dey safe during coronavirus?

  16. 'Dis locks just paralyse us'

  17. Ten ministers and former members of coronavirus task force test positive for virus

    Ten ministers for South Sudan don test positive for coronavirus.

    Information Minister Michael Makuei tell BBC say all former members of di high-level task force on coronavirus - apart from di health minister - test positive for Covid-19.

    But im don deny report say dia President Salva Kiir - who bin member of di team – test positive.

    Dis dey come just days after first Vice-President Riek Machar announce say im don test positive alongside im wife, Defence Minister Angelina Teny.

    Dey test positive after dem come in contact with one former member of di team, wey get Covid-19.

    All di ministers wey dey infected don dey self-isolation and di goment say dem dey good health.

    Dozens of bodyguards and staff of di officials also test positive and dem don quarantine dem.

    Cases of coronavirus for South Sudan don increase in recent days with 481 confam cases and six deaths.

    Fears bin dey say di virus fit cause katakata for South Sudan, wey dia healthcare system no dey function well after decades of conflict, while hundreds of thousands dey live for camps for displaced people.

  18. Fotos: Many pipo for Kano no use facemasks, observe social distancing during Friday prayers

  19. Kuwait dey deport 245 Ghanaians over illegal stay

  20. Ghana Covid-19 death toll remain stagnant for 31, total infections hit 6,486

    Ghana manage keep de Covid-19 death toll stagnant at 31 deaths dis week, according to wetin BBC Pidgin Reporter Favour Nunoo find out.

    Since Tuesday de country no death case despite new cases of infections den death.

    Ghana record de first death case around March 14, 2020.

    From dat time till now, 31 people wey die including de youngest wey chop 9 years.

    De country record 217 newly confirmed cases of Covid-19.

    Official figures wey Ghana Health Service release dey place total infections at 6,486.

    Meanwhile, de country dey experience steady rate of recovery as some 53 more test negative for de virus after treatment.

    Total number of recoveries dey stand at 1,951.

    Prez Nana Akufo-Addo task citizens say dem for learn to live plus de virus as both short term and long term measure to reduce infections.

    Ghana make de wearing of nose masks compulsory for public places, as business owners dey follow strict hand washing directive for all dema patrons.