In di past few days,
states like Cross River, Nasarawa and Benue states
don announce say dem go begin open places of worship.
Di Benue state goment order
Churches and Mosques make dem begin dia activities from Thursday.
Di goment make dis
announcement afta di state Executive Council meeting and di committee on Covid
19 meet for goment house for Makurdi.
Di Cross River state Governor,
Prof. Ben Ayade on Wednesday also give executive order to say make churches
and mosques open from Sunday, May 24, 2020.
Di govnor for statement say
im make di decision because of di spiritual economy wahala wey di
covid 19 pandemic don cause.
Di state goment explain say
make all di church and mosque pipo dem wear mask plus make dem no pass di
number of dia siting capacity
Also di Nasarawa state and
Adamawa state goment don join to re-open places of worship .
But di Chairman of di
Presidential Taskforce, Boss Mustapha don shake head say e dey unwise for di state goments to
allow pipo to gada togeda as dat one fit spoil all di success wey dem don get
in di fight against di virus.
E say all di state must
follow di guidelines and ensure say make no gathering pass 20 pipo.
Oga Boss say as e be now, to
gada pipo plenti for one place fit increase di number of coronavirus cases for
di kontri as di kontri already dey community level transmission.