Nigeria election bodi INEC still dey announce results for different states as e concern Saturday govnorship election.
Live Coverage
Daniel Semeniworima
Imam Nazifi Inuwa of Kano state for north west Nigeria pray for peaceful conduct of Saturday elections for di state, e tok say make every voter choose di candidate wey im want without allowing anybodi to force am.
“Tomorrow everybodi get right to vote any candidate wey im want, our prayer na to God to help us choose leaders wey go move di state forward."
How some pipo Cali town feel about di Govnorship election
Article Information
Author, Fiona Equere
Role, BBC Pidgin
See wetin some pipo for Calabar, Cross River State inside south southern Nigeria feel about Saturday govnorship and state house of assembly election.
Wetin we call dis Video, Wetin Calabar feel about di govnorship and state house of assembly election tomorrow.
Breaking, Akwa Ibom INEC office don burn down
Article Information
Author, Moseph Ekine
Role, Broadcast Journalist Pidgin
Jaguda pipo don burn down INEC office for Ibesikpo Asutan LGA for Akwa Ibom state.
For now, nobody know wetin cause di fire.
State INEC Resident Electoral Commissioner, Mike Igini don go visit di area to see how di building burn reach and if election materials follow burn.
Tension dey for Akwa Ibom ahead of di Governorship election wey Gov Udom Emmanuel of PDP dey seek second term.
Wia dis foto come from, Cletus Ukpong
Port Harcourt women dey celebrate International Women's Day, How di International Women's Day dey shele for Port Harcourt
Article Information
Author, Karina Igonikan
Role, BBC Pidgin
Meanwhile, election mata no stop women, both young and old to gather for Port Harcourt to celebrate di International Women's Day wit waka-waka to promote peace and justice.
Wetin we call dis foto, Even boys waka come celebrate di women
New police oga for Edo State
Security arrangement no change from wetin im be during di presidential and National Assembly election for Edo state.
Na still Danmallam Mohammed be di Commissioner of Police for di state.
15,000 men and women of di security forces n aim dem go send out on state house of assembly election duty for di state.
Dem come from police, army, civil defence, immigration FIRS, NDLEA.
Wetin we call dis foto, Danmallam Mohammed
Benue State don distribute sensitive and non sensitive material
Article Information
Author, Dooshima Abu
Role, Benue, Nigeria
Independent National Electoral commission for Benue State, for north central Nigeria don distribute all di sensitive and non sensitive material to di 23 local goment for di state.
According to Emmanuel Okpe di Makurdi LGA Electoral oga, by afternoon on Friday all di materials go land for RAC centers to ensure say delay no dey for di like di presidential one.
How INEC Adhoc Hoc staff dey prepare for Kano
Article Information
Author, Mansur Abubakar
Role, BBC Pidgin, Kano
Supervising officers dey rush to check dia names and wia INEC post dem go against tomorrow for Kano state.
Sand miners and fishermen dey prepare to vote for Benue
Article Information
Author, Dooshima Abu
Role, Benue, Nigeria
Fisher men and local sand miners for Benue State, north central Nigeria say dem prepare to go vote tomorrow.
Some of dem wey speak to BBC Pidgin say dem wan elect leader wey go provide dem employment and give dia pikin dem school.
Bayelsa don get new Commissioner of police
Article Information
Author, Gift Andrew
Role, BBC Pidgin Reporter, Bayelsa State
New commissioner of police don land for Yenegoa Bayelsa State south south Nigeria.
Im name na Shola David and im go dey incharge of House of Assembly elections for di state.
CP David dey replace CP Aminu Pai Saleh wey bin dey in charge for di Presidential election for Bayelsa state.
Court throway birth certificate case to disqualify Govnor Wike
Federal High Court for Abuja don dismiss case against Governor Nyesom Wike ontop birth certificate forgery case wey for disqualify am from contesting for di 9 March Governorship election.
Justice Ekwo say di case don become 'status barred' and no dey qualified for law as dem file am outside di mandatory 14 days as Section 385 subsection 9 of di 1999 constitution tok.
Only few days ago, one court judgement for Federal High Court Jalingo bin knack di APC Governorship Candidate for Taraba State Alh. Sani Abubakar Danladi comot but Court of Appeal for Abuja grant stay of execution order against dat judgement.
Wetin we call dis foto, Nyesom Wike dey contest for second term election inside Rivers State
Sojas attack Ateke Tom palace ahead of Rivers Govnoship election
Wia dis foto come from, Miebaka Fubara
Protest dey happun for Okochiri, Okrika to vex ontop how sojas burst enta di alace of one former Niger Delta militant Ateke Tom wey don become clan chef for Okochiri village inside for Okrika local goment for Rivers State, south-south Nigeria.
Tori be say di sojas bin arrest some boys for di palace but Nigeria Army neva tok anytin on top di mata.
Pesin wey dey live for Okochiri area tell BBC Pidgin say e bin happun around 4-5pm on Thursday eveningb but no fit confirm if any pesin die for di attack.
Ateke bin no dey palace wen di sojas burst enta.
Dis one dey coem afta anoda raid bin happun inside di same Okrika but for Ogu community.
Meanwhile Chiefs and community pipo protest inside Okochiri, Okrika sake of di mata.
Wia dis foto come from, Miebaka Fubara
No Govenorship election for Bayelsa state
Article Information
Author, Gift Andrew
Role, BBC Pidgin Reporter, Bayelsa State
INEC for Bayelsa state don begin distribute election materials for dia head office for Yenegoa.
Bayelsa get eight local goments only but 24 constituency seats na im pipo dey contest.
Govnorship election no go hold for di state till December 2019
Rivers Govnroship election: No movement order go start from 12 midnight on Friday
Inter-Agency Consultative Committee on Election Security say 17,000 security pipo dey ground to make sure di election dey peaceful, free, fair and credible and dem go deploy three security polipo for all di 4442 polling units for di state.
Head of di Committee and Rivers state police commissioner Usman Belel say no movement go dey for both land and water and e go start from 12 midnight on Friday till 6pm on Saturday and dem go block all di entry and exit points for di state.
Wetin we call dis foto, Head of di Committee and Rivers state police commissioner Usman Belel dey middle
Delta State Govnorship Elections
Article Information
Author, Princess Igho Williams
Role, BBC Pidgin
Wetin we call dis Video, Police for Delta State say dem ready for govnorship election
Delta state police command say dem don prepare well well for the election and na like over 8,000 police officers dem don deploy for di election.
Di Acting Police PRO ASP Chuks Orisewezie say dem don send officers go everi place wey dem get small small palava before.
Dem don even drop numbers for ground wey pipo fit call dhould in case gbege dey hsppun for dia area.
Meanwhile Delta state police deny di rumour wey dey spread say dem gon change dia commissioner of police.
Police tell BBC Pidgin say na lie for di rumour wey dey spread say dem change the Commissioner of police inside Delta state.
E say Adeyinka Adeleke na im still be di commissioner of police inside di state.
"Maybe pipo dey miss issues, with di first commissioner wey come and no stay long before dem promote am to DIG and transfer am. Dis one happun even before di presidential election."
Wetin we call dis foto, CBN Asaba wia INEC dey move election materials for Saturday election.
INEC don complete distribution of election materials for Rivers State
Article Information
Author, Karina Igonikan
Role, BBC Pidgin
INEC don complete distribution of both sensitive and non sensitive materials for all di local goment areas for Rivers State as dem start di distribution on Thursday.
Head of Voter Education and Publicity for INEC Rivers State Edwin Enabor confam dis one to BBC Pidgin, come add say all di Adhoc Staff go di refresher training on Friday for di Registration Area Centres RAC to prepare dem for work tomorrow.
Im say investigation still dey go on for all di Adhoc Staff Security pipo arrest for election malpractice and dem don replace those ones with some Adhoc Staff wey bin dey on standby and dem sef go follow di di refresher course toda.
Kano Govnorship Election, Kano don dey 100 percent ready for tomorrow election.
Article Information
Author, Mansur Abubakar
Role, BBC Pidgin, Kano
INEC tok tok pesin for Kano State Garba Lawal say dem finish distribution of all sensitive and non sensitive materials to all 44 LGAs of Kano Thursday night and dem dey 100 percent ready for Saturday vote.
Election fever dey worry pipo for Edo state
Article Information
Author, Onyinye Chime
Role, BBC Pidgin, Lagos
Afta di way presidential election take waka for Edo state, e no clear weda voters for di state go still wan comot vote for di State Assembly election.
Na dis one make Edo state govnor Godwin Obaseki meet wit labour leaders on Wednesday March 6.
Obaseke tell NLC leaders for di state say make dem helep am ginger dia pipo to go vote on Saturday.
Wetin we call dis foto, Edo NLC meet wit Obaseki
No govnorship election for Edo state until 2020
Na on Wednesday 6 of March Edo state INEC send out all di materials wey dem go take do State Assembly Election.
Both di sensitive and nonsensitive election materials don already dey wit di local goment electoral officers for di 18 local goment areas for di state.
Edo state no go do govnorship election until 2020.
Wetin we call dis foto, Na only House of Assembly elections go happun for Edo
Akwa Ibom State Govnorship Elections, We don ready for Saturday elections - Mike Igini
Article Information
Author, Moseph Ekine
Role, Broadcast Journalist Pidgin
Resident Electoral Commissioner for Akwa Ibom, Mike Igini say di state INEC dey ready for Saturday Governorship elections as everything dey on ground.
Igini tell tori pipo say make everyone come out come exercise dia civic rights and make dem no fear anything.
Im say:
"tok of how military personnel dey plan to hijack di elections and intimidate pipo no dey true as dem only dey to do dia security work."
Already di Akwa Ibom state goment don declare today as public holiday so dat civil servants go fit travel go dia LGA go vote.
Public Holiday for Rivers State
Article Information
Author, Karina Igonikon
Role, BBC Pidgin, Lagos
Di Work free day wey Rivers State goment declare on Friday don take effect as workers no come work.
Dis na to allow pipo travel go wia dem register so dem for participate for di governorship and state assembly elections wey go hold tomorrow for all di 23 local goment areas for di state.
Wetin we call dis foto, Rivers State Secretariat inside Port Harcourt
Wetin we call dis foto, Even di workers for courts and bank dey observe di work free day as di busy Bank road for Old GRA dey free of di normal heavy traffic