Kano Govnorship Elections dey INCONCLUSIVE!

Nigeria election bodi INEC still dey announce results for different states as e concern Saturday govnorship election.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Pipo no dey smile for Port Harcourt

  2. INCONCLUSIVE don show face for Edo House of Assembly election

      • Author, Onyinye Chime
      • Role, BBC Pidgin, Lagos

    Edo state INEC Resident Electoral Commissioner; Emmanuel Alex Hart say di State Assembly election for di go well a except for one constituency.

    Oga Hart say dem declare di election for Orhionmwon II constituency inconclusive because of ballot box snatching plus election violence. Im say now dem go cari all di election results go INEC headquarters for Abuja. Anytin wey Abuja tell dem to do, na im dem go do. APC win all di 23 constituencies dey dem don declare dia results.

    List

    Wia dis foto come from, Edo assembly list

  3. Breaking, Protest don begin for Port Harcourt

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Port Harcourt
    Port Harcourt protest

    Some civil society groups organise protest for Port Harcourt, say make INEC release di results of elections.

    Chancellor for International society for social justice and human rights Dr. Omenazu Jackson wey follow tori pipo tok, say wetin dem want na peace for Rivers State.

    Di protest waka start from Polo Club to GRA Junction as security pupo wey block di road no allow dem reach INEC office wia dem bin wan go.

    Port harcourt protest
    Port Harcourt portest
  4. Wetin fit make INEC declare election inconclusive

      • Author, Faith Oshoko
      • Role, BBC Pidgin, Lagos

    Monday morning land and Nigeria election bodi INEC just dey announce say some state govnorship election dey inconclusive.

    Plateau, Bauchi, Adamawa and Sokoto states na di ones dem don put for dis basket so far.

    But wetin fit make dem declare election as inconclusive?

    According to law, INEC fit call an election inconclusive if di number of cancelled votes big pass di number of votes di candidate wey score pass take beat im runner-up.

    Di same constitution still say, e suppose take seven days afta dem announce di election result for dem to arrange anoda election for di state.

    Dis election go dey between di candidate wey get di most number of votes overall and di candidate wey win for di most local goment areas.

    From di way wey election dey run for Nigeria, di re-run dey hold for polling units wey dem cancel di results during di first collation.

  5. Breaking, Pipo don begin do hands up for Port Harcourt

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Port Harcourt

    Road no dey again for di popular Aba Road for Port Harcourt di Rivers State capital as security pipo block from Waterlines to GRA junction.

    Dis wan don cause serious traffic jam as pipo wey dey work for di area no see road pass. Pipo wey dey waka for road get to raise dia hand up before dem fit pass as security pipo no wan take chances.

    Na for dis road di state headquarters of INEC dey, and on Sunday small gbege bin happun dia wen police and army drag who suppose dey incharge. Later dat same, INEC say dem don suspend all election process for di state till further notice.

    Tori be say some pipo dey plan to do protest for di Rivers State capital on Monday, and dis fit be why security don block road begin do hands up.

    Pipo dey raise hand to pass for road
    Traffic for Port Harcourt

    Wia dis foto come from, bbc

    Pipo dey waka for road with dia hands up
    Wetin we call dis foto, Rivers don go through plenti kata-kata since di elections start
    Hold-up dey don stand gidigba for Rivers State Capital
  6. Breaking, INEC say dem go resume Kano governorship collation as pipo dey panic

      • Author, Mansur Abubakar
      • Role, BBC Pidgin, Kano
    Kano

    INEC for Kano State say dem dey do meeting and dem go resume to finish di last local goment wey remain to conclude counting for govnorship election wey happun on Saturday.

    Na around 2am reports say police gbab di deputy governor Yusuf Gawuna and Commisioner of local goment Sule Garo as dem dey try causa wahala for Nasarawa collation centre.

    Dem still dey with police as at dis time of writing dis tori and tok tok pesin for Kano Police, DSP Abdullahi Haruna yan say dem go release statement before 10am on di arrests.

    For di city, pipo just dey panic as schools and banks no gree open for fear of wetin fit happun.

    One Kano resident Sani Abu tok say na house e go dey today because e no know wetin go happun outside considering di tension wey hold everybodi.

    Police go round city on Sunday night to pursue crowd wey don dey gada for different corner dey shout different political slogans.

  7. No retreat, no surrender for Imo State

    Afta party agents bin tear govnorship election result sheets for Imo State wey make dem pause, Inec don return.

    You fit watch am hia through BBC Igbo.

  8. Breaking, How PDP and RP party agents tear govnorship result sheets for Imo State

      • Author, Chiagozie Nwonwu
      • Role, BBC Igbo, Owerri

    INEC collation centre for Imo State no fit conclude dia work to announce di govnorship election result, as kasala burst inside di hall early mor-mor Monday.

    BBC Igbo tori pesin wey see evitin wey happun, confam say na PDP and RP party agents tear di result sheets.

    Di first pesin to tear result na di PDP man for di collation centre, Uche Onyeagocha, wey tear di Ideato South local goment area result.

    Oga Paschal Onwukaike wey represent RP for di collation centre, come go di table, tear all di results dem don already announce.

    Na so drag-drag start inside di hall wey make dem stop, and carri Inec officials wey dey ground comot.

    Our tori pesin dey confam say di result dem tear already get duplicate, so di information neva loss and dem go resume by 9am.

  9. Breaking, Bauchi State govnorship election don join inconclusive list

    Saturday govnorship election for Bauchi State dey hang, as Inec say nobodi don win am.

    Di Returning Officer for di state, Prof. Mohammed Kyari say di candidate of di People's Democratic Party, Sen. Bala Mohammed get 469, 512 votes while di candidate of di All Progressives Congress, Govnor, Mohammed Abubakar, get 465, 453 votes.

    Prof. Kyari say di gap between di PDP and APC candidates na 4,059 votes while di cancelled votes na 45, 312.

    Im say as e be say wetin dem cancel plenti pass wetin first take dey gap second, say dem no fit declare winner until dem do rerun election in 21 days.

  10. Prof. Ben Ayade go do four more years as Cross River State Govnor

      • Author, Fiona Equere
      • Role, BBC Pidgin
    Wetin we call dis Video, Ben Ayade win Cross River govnorship election

    Di People's Democratic Party candidate, Prof Ben Ayade na di winner of Saturday govnorship election for Cross River state.

    Returning officer for di state Prof Akii Ibhadode announce di result early mor- mor on Monday for INEC headquarters for Calabar. Prof Akii say Ayade score 381,484 votes to defeat Owan Enoh of All Progressives Congress party wey get 131,161 votes.

    PDP win for all di 18 local goment area of di state.

  11. Plateau State govnorship election dey inconclusive

    INEC don declare di govnorship election for Plateau State as inconclusive.

    Di All Progressives Congress candidate, Simon Lalong, get 583,255 votes while di People's Democratic Party candidate, Jeremiah Useni, get 538,326.

    As e be say di gap between dem na 44,929, and di number of cancelled votes na 49,377, di Returning Officer for Plateau State, Prof Richard Kimbir, say di election dey inconclusive.

    As e be so, dem go hold rerun election in 21 days according to wetin law tok.

  12. Good Morning o!

    Election tori don already start to dey hot dis morning. Take dis proverb from Don Federico JP take cool bodi.

    Proverb of di day
  13. Oga Fayose dey pepper Govnor Amosun

    We neva see dis type before, wia dem dey congratulate pesin wey lose election.

    But na di shade wey former Ekiti State Govnor Ayo Fayose throw Ogun Sate Govnor Ibikunle Amosun.

    Skip X post, 1
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 1

    Skip X post, 2
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 2

  14. Sokoto govnorship election dey inconclusive

    Aliyu Ahmad
    Wetin we call dis foto, Aliyu Ahmad na APC govnorship candidate for Sokoto State

    Election bodi INEC don declare di Sokoto State election as inconclusive.

    Fatima Mukhtar, di INEC returning officer wey announce di decision for di collation centre for Sokoto, say di number of valid votes na 987, 942, rejected votes na 30,082 while di total pipo vote na 1, 019,024.

    Di result show say di Sokoto state govnor and candidate of di People's Democratic Party, Aminu Tambuwal, get 489,558 votes while Aliyu Ahmad of di All Progressives Congree APC get 486,145. Di gap between dem na 3, 413.

    As e be say di number of votes wey dem cancel plenti pass di gap between di two leading parties, di INEC madam say dat wan reach to say di election no get end.

    Dem gatz do anoda election wey dem dey call rerun, to take settle mata.

    Tambuwal
    Wetin we call dis foto, Govnor Tambuwal wan do four more years as govnor
  15. Kano deputy govnor dey police hand

    Kano commissioner

    Wia dis foto come from, Kwankwasiya Reporters

    Kano State Police don gbab di state deputy Govnor, Nasiru Gawuna and di state Commissioner for Local Govnment, Alhaji Sule Garo say dem dey cause kasala.

    Dem arrest di two of dem ontop accuse say dem scata things for di govnorship election for Nasarawa local goment area collation centre as dem dey gada results.

    Tori be say di kasala wey happun around 2:00am for early mor-mor on Monday na im make dem delay to release di final result for di election wey suppose announce di winner.

    Kano deputy govnor

    Wia dis foto come from, Kwankwasiya Reporters

  16. Watch as party agents take tear govnorship result sheet for Imo State

  17. Adamawa govnorship election dey inconclusive - INEC

    Election bodi INEC say di Adamawa State Govnorship election dey inconclusive and say dem go announce new date for di rerun.

    According to tori pipo News Agency Of Nigeria, di Returning Officer.Prof. Andrew Haruna, say di number of cancellations wey dem get big pass wetin pesin wey dey carri first position, take di lead pesin wey follow am for back.

    Prof. Haruna mention about 44 polling units wey dey affected across di state.

  18. Breaking, Heavy kasala for Imo State as party agent tear result sheet

    Wia dem dey announce result for Imo State INEC collation centre end for katakata for early mor-mor on Monday.

    As dem dey announce di result, one party agent vex stand up begin protest. Before you go say Owerri, di man don waka go di table wia di Returning Officer siddon, carri di big result sheet wey dey table, tear am into pieces.

    You fit watch di whole thing hia from BBC Igbo, or you fit fast forward sharperly go around 20mins inside di video, wen kasala burst.

  19. Goodmorning and welcome

    Na hia we go begin dis Monday as more reactions dey come from across Nigeria wia govnorship and House of Assembly elections bin hold on Saturday.

  20. We go stop here for now until later on Monday

    We go stop here for now until Monday.

    As we dey waka, make we show you dis tweet on top election mata from former Govnor Ayo Fayose to out going Gov. Ibikunle Amosun