Kano Govnorship Elections dey INCONCLUSIVE!

Nigeria election bodi INEC still dey announce results for different states as e concern Saturday govnorship election.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Breaking, LIVE result announcement for Delta State

  2. Six LGAs don show wit result for Benue State

    INEC collation centre for Makurdi Benue State don ready and so far 6 local goment don arrive wit dia result. Di Local goment wey don ready na Ogbadibo,Gwer-West, Gwer-East, Oju, Ohimini and Agatu

    INEC Makurdi
  3. Kano dey redy

    INEC say only 10 of di 44 LGAs don bring result.

    Kano banner
  4. "We no go gree"

    Women for Ogu/Bolo area for Rivers State wey dey protest.

    Wetin we call dis Video, Women protest say army wan change election result
  5. Women protest say pipo wey wear Nigerian army uniform wan change election result

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Port Harcourt
    Ogu women

    Wia dis foto come from, Kelvin Franklin

    Women for Ogu/Bolo area of Rivers State carri protest waka go di Council Secretariat for early mormor on Sunday, as dem claim say some pipo wey wear Nigerian army uniform wan hijact election results.

    Local tori pesin Olufemi Ogunkilede report say di women say make noting happun to tamper wit di election results for di local goment and make dem announce di correct result.

  6. Kwara State govnorship result LIVE

    BBC Yoruba dey live for di Kwara State collation centre for Illorin, di state capital.

  7. Welcome

    Na hia we go begin our election coverage dis Sunday. Nigerians bin vote for 29 states to elect govnors and for all di 36 states to elect local lawmakers on Saturday.

    Most of di INEC collation centres go open on Sunday to begin announce results.

    Proverb
  8. Na here we go march break until Sunday

    Na here we go march break for di live tori dem until Sunday.

    No forget say BBC reporters full ground all over Nigeria dey cover dis election tori for Govnorship and State House of Assembly.

    We go drop dis we post for Facebook make you sef share your election experience:

  9. Kano Govnorship Election results collation update

      • Author, Mansur Abubakar
      • Role, BBC Pidgin, Kano

    INEC tok-tok pesin for Kano State north central Nigeria Garba Lawal tell BBC News Pidgin say collation of results for Saturday Govnorship Election go start by 9am on Sunday.

    Meanwhile Kano Police say make any party neva dey celebrate as INEC neva announce anybody or party as winner.

    Di police say dem dey try avoid wetin go cause bkasala for Kano na why dem say make everybodi hold im celebrations until INEC finish dia work and announce winner.

    Kano Govnorship Election  Collation Centre
  10. Breaking, EXCLUSIVE: Pipo wey wear military uniforms harass INEC Returning Officers for Rivers State

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Lagos
    Wetin we call dis Video, EXCLUSIVE: Pipo wey wear military uniforms harass INEC Returning Officers for Rivers State

    "Pipo wey wear military uniforms harass INEC Returning Officers for Rivers State"

    Na wetin di oga for Voter Education and Publicity of INEC inside Rivers State tell BBC News Pidgin Reporter for Port Harcourt.

    Edwin Enabor say delay for di result collation dia na because say some pipo wey wear military uniform harass dia officials for some collation centres for local goment areas and dem neva now who dem really be.

    But dem don send security pipo to go verify and release dem.

    Edwin Enabor na oga for Voter Education and Publicity of INEC inside Rivers State
  11. Rivers State Collation centre ready

    Di place where dem go count and declare Rivers State Govnorship Election results wey be di Collation centre don ready.

    Rivers State Collation centre ready
  12. Bauchi Govnor lost election for im unit

    Governor M.A Abubakar of Bauchi loss polling unit to PDP candidate Bala Muhammad (former FCT Minister)

    Bauchi Govnor lost election for im unit
  13. Election Security: Police on election duty get accident

    Skip X post, 1
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 1

    Skip X post, 2
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 2

  14. Police arrest van wit ballot papers for Kano

    Kano Police confam say dem arrest van loaded with ballot papers inside Kano.

    Tok tok pesin DSP Haruna Abdullahi tell BBC Pidgin say dem arrest di car for Magwan Area dis afternoon and di car dey CID wey investigations don dey follow.

    Police arrest van wit ballot papers for Kano
  15. Bayelsa election latest

    INEC for Bayelsa state say say election no hold for some areas for Southern Ijaw local goment and di Officers wey dem send go dia don come to dia state head office.

    Wilfred Ifogah wey be INEC head voter education and publicity say di officers say jaguda pipo for southern Ijaw no gree dem enta di area na im make dem turn back.

    Ifogah say e no sure how polling units dey affected.

    Wilfred Ifogah
  16. Some election results

    Lagos govnor Akinwumi Amobode win for im unit.

    Ambode party wey be APC wear PDP shirt for Ogunmodede Polling Unit 003, Ajaganabe Ward 5, inside Epe LGA

    RESULTS:

    House of Assembly: PDP: 61 APC: 253

    Govnorship PDP: 62 APC: 262

  17. Breaking, Shooting, stabbing kill pipo for Rivers Govnorship election gbege

    Shooting, stabbing kill pipo for Rivers Govnorship election gbege

    Wia dis foto come from, Tasie Amadi Wenenda

    Two pesins don die for gbege wey happen for Akinima, Ahoada West Local goment inside Rivers State.

    Pesin wey dey live dia, Ovie Emmanuel tell BBC Pidgin say na jaguda pipo wey stab one of dem bottle for chest im die on di spot while di second one dem shoot am for leg but im come later die for hospital.

    Ahoada West na one of di local goment wey Presidential and National Assembly election bin dey inconclusive sake of violence wey make INEC reschedule supplementary election to hold dia today.

    Also for Andoni local goment, jaguda pipo also don kill former caretaker chairman, Hon. Emilia Nte.

    One local pesin Hannah Innocent tell BBC Pidgin say na yesterday dem kill her for di boundary between Asarama and Egendem as she dey go her village for Unyada all for Andoni local goment

  18. Breaking, INEC to conduct fresh Govnorship election for Benue sake of violence

    Wetin we call dis Video, 2019 Governorship Elections: INEC to conduct fresh vote for Benue sake of violence

    Nigeria election office, di Independent National Electoral Commission for Benue State don announce say e go conduct election for four local goment sake of say jaguda pipo burn, snatch electoral material for di area.

    Di four local goment na Logo, Gwer-East, Takar, Gboko.

    E also explain give say Jaguda pipo for Takar local goment, kidnap four adhoc staff and election materials.

    INEC Resident Commissioner, Nentawe Yilwada say police dey chook eye to investigare di mata wen e brief press.

  19. Watch BBC News Pidgin Live for di latest election tori

    BBC Pidgin Reporters dey all over Nigeria.

  20. Breaking, Militants attack INEC officials for Bakassi, waylay election materials

    Militants attack some polling units for Bakassi Local goment area of Cross Rivers State as pipo come out to vote.

    Dr Frankland Briyai wey be di Resident Electoral Commission confam di tori to BBC Pidgin say di militant carry di boat wey bring di Ad hoc staff run but dem no wunjure anybody.

    Oga Briyai say Navy don go to rescue di INEC officials dem.