Kano Govnorship Elections dey INCONCLUSIVE!

Nigeria election bodi INEC still dey announce results for different states as e concern Saturday govnorship election.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. How voters dey chill across Nigeria

    Voting still dey on for different polling units across Nigeria.

    But for some areas, dem still dey wait for INEC officials.

    Party agent
    Wetin we call dis foto, Dis party agent get drink e wan share to voters for Kano State
    voter
    Wetin we call dis foto, Dis woman don get drink and chop to take hold bodi for line
    Voter
    Wetin we call dis foto, Dis old man wey wan vote for Kano say im wan siddon rest because of leg wey dey pain am
    Voter
    Wetin we call dis foto, Dis baba don vote finish, but e say e wan rest, before e begin waka go house
    Lagos voter
    Wetin we call dis foto, Dis man carri im book come polling unit for Lagos State. Anytime INEC ready, im go vote
    Lagos voter
    Wetin we call dis foto, Dis woman for di Ikeja area of Lagos State dey chill, wait for INEC officials wey neva show face for her polling unit
  2. Oga and madam dem still dey fall out for Lagos

    Femi Hamzat wey be deputy of APC govnorship candidate don vote for PU 002 Oke Balogun Central mosque Epe area.

    Hamzat
    Osinbajo
    Wetin we call dis foto, Nigeria vice presido Prof Yemi Osinbajo don vote for im VGC area for Lagos. Im bin lose for dis polling unit for presidential election
  3. Wetin Abuja pipo dey vote for?

      • Author, Faith Oshoko
      • Role, BBC Pidgin, Lagos
    Di landmark to enta Abuja

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Abuja na di capital of Nigeria and as such no get govnor or state house of assembly or even local goment areas.

    But dem get six area councils wey be, Abuja Municipal Area Council, Gwagwalada, Bwari, Kwali, Abaji and Kuje.

    For dis election, Abuja dey vote to pick six chairmen for di area councils as well as 62 Councillors for di di same areas.

    But di oga pata-pata for di FCT, na di Minister of State and na di presido of di kontri dey appoint dat one.

  4. Voting neva start for Bola Tinubu polling unit

    10:30am and INEC officials or materials neva show face for di polling unit of APC leader oga Bola Tinubu for Lagos State.

    Tinubu PU
  5. EFCC arrest 'vote buyer'

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  6. Breaking, Govnor Ambode don vote

      • Author, Helen Oyibo
      • Role, BBC Pidgin, Lagos

    One govnor wey no dey come back afta May 29 na Akinwunmi Ambode of Lagos State.

    Di APC govnor travel go im polling unit for di Epe area of di state, to cast im vote.

    Dis for be vote for imsef for re-election, but oga Ambode lose im party primary election to oga Babajide Sanwo-Olu.

    Ambode
  7. INEC temporary staff wey protest for Lagos State

    Wetin we call dis Video, INEC temporary staff wey protest for Lagos State
  8. Breaking, Lagos politician wey dey buy vote tear BBC reporter slap

    Wetin we call dis Video, Politician wey dey buy vote slap BBC reporter

    Segun Adewale wey be popular politician for Lagos wey pipo dey call Aeroland slap BBC tori pesin wey feem as e dey buy vote.

    For di polling booth wey dey Pleasure bus stop area of Lagos-Abeokuta expressway, BBC Pidgin reporter, Ajoke, see as oga Segun Adewale wey pipo dey call Aeroland, dey give voters N1,000 afta dem don vote finish. Im tanda for one corner dey give pipo di moni afta dem vote finish.

    As im see say our tori pesin dey see wetin im dey do, Adewale come attack di BBC reporter. Im slap our reporter as im thugs too collect her phone. Na di police wey dey dia come helep di reporter to collect her phone back.

    Adewale na one Lagos politician wey don try be Ekiti State govnor before.

    Aeroland
  9. How some candidates take vote

    Different candidates, both those wey wan make dem elect dem again, and those wey wan enta new, don begin vote for di govnorship election for Nigeria.

    For Imo State, Uche Nwosu, wey be di govnorship candidate of di Action Alliance vote for im polling unit wit im wife.

    For Delta state, govnor wey dey for seat, Ifeanyi Okowa vote for im own polling unit.

    Benue State Govnor, Samuel Ortom wey cast im vote for im polling unit for Gbajimba, say im victory dey assured.

    Nwosu
    Wetin we call dis foto, Uche Nwosu vote for Imo State
    Okowa
    Wetin we call dis foto, Govnor Okowa vote for Delta state, wia im want four more years

    My victory dey assured Benue State Governor, Samuel Ortom tok say im victory dey assured. Di govnor tok dis one afta im cast I’m vote for im polling unit for Gbajimba. E say im happy say INEC start di election quick dis time and security full ground to ensure say kata-kata no dey. Governor Samuel Ortom di contest for second term for office and im main rival na Emmanuel Jime of All Progressive Congress.

  10. Foto of di day

    BBC Pidgin tori pesin for polling unit 2 and 4 ward 4 Yenegoa local goment Bayelsa State, snap dis foto of dis woman wey come vote.

    Dem carri di old woman wey no fit waka well come her polling unit to come vote.

    Voter
  11. Why Edo State Police oga patapata dey provoke?

      • Author, Onyinye Chime
      • Role, BBC Pidgin, Lagos
    Edo CP

    Commissioner of police for Edo state, Danmallam Mohammed enta road mount road block by imsef.

    Even though Saturday na no movement day sake of di elections, Benin pipo bin enta road dey do dia own tin like say notin dey happun.

    Commercial bus dem plus private cars bin full road. Na dis one make oga Commissioner provoke enta road imsef to make sure say area pipo obey di order.

  12. Materials neva land some polling units for Bayelsa

    9:06am: Election materials neva arrive polling unit 2 and 4 for ward 4 Yenegoa local goment area Bayelsa State.

    Plenti pipo for dia dey para unto say dem don show face to vote but no materials to vote wit.

  13. Igbo, Yoruba and Hausa; BBC dey dia

    Depending on your language and how you wan take enjoy BBC Nigeria elections coverage, you fit join di Live tori pages of BBC Igbo, BBC Yoruba and BBC Hausa.

    No forget say BBC Pidgin dey live for Facebook, Twitter and Instagram. Just search for BBCNewsPidgin and hala at us, make we for roll togeda.

  14. Wetin dey happun for Calabar?

    If you no look well, you go think say state elections no dey happun for di capital of Cross River state.

    From young pipo wey dey play ball, to market pipo wey dey do dia bizness, some pipo no just send wetin dey happun.

    Voting don start for di state and many pipo already dey vote for dia polling units.

    Calabar
    Calabar
  15. Presido Buhari don vote for Daura

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  16. Di oda elections wey dey happun for Rivers State

      • Author, Karina Igonikan
      • Role, BBC Pidgin

    Apart from di governorship and state assembly elections wey go hold for Rivers State, additional elections go also hold for two senatorial districts and five federal constituencies wey election bin dey inconclusive for February 23 sake of violence wey bin happun.

    Dis additional election go hold for Rivers East and Rivers West senatorial districts and for Akuku Toru for AsariToru/Akuku Toru federal constituency, Bonny for Degema/Bonny federal constituency, Ikwerre and Emohua for Ikwerre/Emohua federal constituency and for Ahoada West for Ogba-Egbema-Ndoni/Ahoada West federal constituency.

    Nineteen political parties dey participate for di guvnorship election and na 32 seats na im dey to fill for di Rivers State House of Assembly.

  17. , 8:28am First set of voters don cast dia vote as voting don begin for Uyo.

    Uyo voter
    Uyo voter
  18. Breaking, Why only 29 states dey vote for govnorship election

      • Author, Faith Oshoko
      • Role, BBC Pidgin, Lagos

    Well, in di beginning for 1999, no be so e bin dey. All di states dey hold govnorship election on di same day.

    But now seven states dey wetin political sabi pipo dey call "off cycle."

    Wetin happun be say court orders bin enta mata for dis states, wia be say dem bin don already swear in govnors wey "win" election.

    According to di Electoral Act, if govnor election dey nullified and e win di rerun, e go continue im tenure as govor from di first swearing in, but if na anoda pesin win di re-run, im tenure go start from wen dem swear di pesin as govnor.

    So na why, states like Anambra, Edo, Ondo, Bayelsa, Kogi, Ekiti and Osun elections date no dey in sync wit di rest of di kontri.

    But dis ruling no dey affect state house of assemblies election, though, so dat one go run for all di states of di federation.

  19. Voters neva too begin show face

    As at 8:20am, voters neva too show face for most polling units across Nigeria.

    By dis same time for di presidential and national assembly elections, long lines bin don full many areas.

    BBC tori pipo wey dey ground dey report say Inec officials don show face for most polling units dem visit, but na voters wey dey do yanga to come out.

    Calabar voters
    Wetin we call dis foto, Few voters na im show for state housing primary school for Calabar Municipality but voting neva start as @ 8:10am
    Kano voters
    Wetin we call dis foto, Kano state bin see plenti voters by dis tiem for presidential election. But for Masallacin Murtala voting unit, small crowd of pipo gada dey wait for inec officials
    Lagos voter
    Wetin we call dis foto, Dis na di polling unit of APC leader, Bola Tinubu for Lagos and inec officials neva even land
    Port Harcourt voters
    Wetin we call dis foto, Inec officials dey ground for Port Harcourt, Rivers State dey wait for voters
  20. Roadblock Port Harcourt

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Port Harcourt

    Port Harcourt di Rivers State capital for south-south Nigeria na area wey don see plenti security presence because of election.

    Security don block di popular Aba road for di city around di Waterlines area.

    PH