Kano Govnorship Elections dey INCONCLUSIVE!

Nigeria election bodi INEC still dey announce results for different states as e concern Saturday govnorship election.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. How tins scata reach for one INEC center for Ebonyi

    Ebonyi

    Wia dis foto come from, bbc

    Ebonyi
    Ebonyi
    Ebonyi
  2. Dis filling station na polling station today

    No be everytime pesin go enta wia im wan buy petrol only to see pipo tanda dey vote for Lagos.

    Dis na 'Total voting station'. Sake of di election, for today di actual name na: Polling unit 23 ward 3, Ikeja LGA

    Dis na 'Total voting station'. Actual name na: Polling unit 23 ward 3, Ikeja LGA
    Dis na 'Total voting station'. Actual name na: Polling unit 23 ward 3, Ikeja LGA
    Wetin we call dis Video, 2019 Governorship Elections: Dis filling station for Lagos na polling station today
  3. , Vote sorting and counting don begin for di different polling unit for Benue State.

    Vote sorting and counting don begin for di different polling unit for Benue State.
    Vote sorting and counting don begin for di different polling unit for Benue State.
    Vote sorting and counting don begin for di different polling unit for Benue State.
  4. Atiku Abubakar dey ask pipo to defend dia vote

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  5. Dem don begin count votes for Nigeria state elections

    Dem don begin count votes for different polling units wia voting happun on Saturday for Nigeria.

    For 29 of di 36 states, pipo vote to elect govnor, while House of Assembly elections take place for all 36 states. Dem also vote for area council elections for di capital Abuja.

    Pipo no too come out to vote across di kontri, and BBC tori pipo carri eye see voters wey some party agents dey give moni to "buy" dia vote.

    Inec
    Wetin we call dis foto, Dis polling unit for Uyo dey count ballots papers afta voting
    Inec
    Wetin we call dis foto, For Port Harcourt, dis polling unit dey count vote too
    Inec
    Wetin we call dis foto, Party agents and Inec officials dey chook eye to make sure say dem mark ballot paper dem no use
    Inec
    Wetin we call dis foto, For Edo state, dis polling officers dey check di remainder of dis ballot papers
  6. Why Bola Tinubu discribe oda political parties for Lagos as crabs?

    APC oga for Lagos State and di party national leader, oga Bola Tinubu say di party go win di state elections.

    Im follow tori pipo yan afta im vote on Saturday.

    Wetin we call dis Video, Na we be di only party for Lagos, di rest dey appear everi four years like crabs - Tinubu
  7. 500 or 1000 naira to buy vote?

    Wetin be di value of vote na im dey touch head for dis video BBC tori pesin take eye see for Bayelsa State.

    E no clear which party dey responsible for dis one, for state wey only House of Assembly election dey happun.

  8. Pipo wey turn road to boxing ring

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  9. Voters no too show for presidential villa polling units

    Voters no too show face for di polling units wey dey inside Nigeria presidential villa.

    As at 12.30pm, Inec officials just dey press phone, some dey gist and odas dey sleep as work no dey to do.

    For di presidential election on February 23, both PDP and APC bin share di two polling units 1-1 wey dey inside di villa.

    Presidential villa
    Presidential villa
  10. "Red hot" Sanwo-Olu don vote

    We no sabi who APC candidate oga Babajide Sanwo-Olu dey blow kiss, but na wetin im do afta im vote for Lagos State.

    Sanwo-Olu
  11. "Na result remain now"

    Voting don end for dis PU under tree along Epe express way for Oko Alangbon village, unit 040.

    INEC Adhoc Staff wey siddon dey wait along wit some pipo say dem don finish as at 12:10pm and dem tanda dey wait till 2:00pm to start vote counting.

    Epe PU
  12. Breaking, Oga di Jagaban don vote

      • Author, Olubunmi Okunnu
      • Role, BBC Pidgin, Lagos

    Leader of di All Progressives Congress for Nigeria, oga Bola Tinubu don vote by 11:55pm.

    Voting no quick start for im polling unit as Inec officials no show early, but as dem come, voting start.

    Wend di APC leader come out to vote, e just waka go front pass pipo wey dey for line, go vote, as Jagaban im be.

    Tinubu
  13. APC Govnorship candidate for Lagos State, Babajide Sanwo-Olu dey vote

    Babajide Sanwo-Olu
  14. Blind voter dey look forward to 2023

      • Author, Mansur Abubakar
      • Role, BBC Pidgin, Kano
    Saifullah Muktar

    Saifullah Muktar don dey blind since dem born am tell BBC Pidgin say e just vote.

    E tok say na im broda help am so e go fit vote for di party im like pass.

    Oga Mukhtar get hope say by 2023, dem go fit dey use d special ballot for di blind fully.

  15. Govnor Ambode na still my hero

    Ambode fan

    Some pipo still dey vex for Epe area of Lagos State say Govnor Akinwunmi Ambode no dey come back for second term.

    Fatimah Salau wey tok to BBC Pidgin say if no be say di govnor beg pipo to come out vote say area for empty like burial ground. Salau say Epe na place wey previous goment bin bone before sotey dem dey call dia road suicide road. But Ambode do road, empower pipo, make belle sweet Epe pipo, boost pipo morale well-well.

    Fatimah say all in all even though APC reject Ambode, Epe pipo no reject am, say infact say na still dia hero.

  16. Dem don break dis polling agent head

    Dis wan hapun for Polling Unit 007 for Oju-Ekun Zarumi, Ilorin West local goment area.

    Kwara agent
  17. Oga Jona and madam Pepe don vote

    Former Nigeria presido Goodluck Jonathan wit im wife Patience and mama Eunice don vote for Otuoke Bayelsa State.

    Jonathan
  18. EFCC don gbab 'moni van' for Benue State

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  19. Jaguda pipo burn election materials for Benue State

      • Author, Dooshima Abu
      • Role, Benue, Nigeria
    Pipo wey dey wait to vote for di area

    Electoral materials burn down for Mbalom ward for Benue State, northcentral Nigeria.

    According to di state INEC, di jaguda boys dem bin start to shoot and INEC officials dem come run leave di materials

    So far report neva dey weda any pesin die for di incident. Security and INEC officials don dey chook eye for di mata.

  20. More govnors don vote

    Wike
    Wetin we call dis foto, Rivers State govnor Nyesom Wike vote for im polling unit for Obio-Akpor area
    Dickson
    Wetin we call dis foto, Though dem no dey vote for govnor for Bayelsa State, Govnor Seriake Dickson come out to vote for di House of Assembly election
    Ganduje
    Wetin we call dis foto, For Kano State, Govnor Umar Ganduje wey dey seek re-election, don vote