Nigeria election bodi INEC still dey announce results for different states as e concern Saturday govnorship election.
Live Coverage
Daniel Semeniworima
Cross River Govnorship update: Calabar south results don hang
Di Returning Officers from Calabar south not fit balance dia figures for over one hour dem dey struggle with dia result for Cross River Govnorship update.
So far INEC don announce 16 out of di 18 Local Goment Areas wey dey di south southern state.
And wetin remain to know di final results na Boki and Calabar South.
Di current Govnor Ben Ayade wey be PDP candidate dey lead for all di 16 LGA results INEC don collate.
Wetin we call dis foto, Di Returning Officers from Calabar south not fit balance dia figures for over one hour dem dey struggle with dia result for Cross River Govnorship update.
Breaking, Akwa Ibom Govnorship Election update: Govnor Udom dey lead afta INEC final results
Akwa Ibom State current Govnor Udom Emmanuel dey lead final results, wey Nigeria Election INEC count from Govnorship election inside all di 30 Local Goment Areas of di south-southern state.
From di final results Udom Emmanuel of PDP score 307,507 while Nsima Udo Ekere of APC get 109,180 votes as di closest rival.
Governors David Umahi of Ebonyi, Okezie Ikpeazu of Abia & Ifeanyị Ugwuanyi of Enugu win re-election to return as state Govnors.
Nigeria election office INEC declare Okezie Ikpeazu of PDP wit 261,127 votes against Uche Ọgah of APC wey get 99,574, and Alex Otti of APGA wey get 64,366 votes.
INEC declare Ugwu anyị of PDPwinner wit 449,935 votes while im closest rival wey be Ayogu Eze of APC 10,423
Wia dis foto come from, OTHER
Wetin we call dis foto, Governors Okezie Ikpeazu (L), David Umahi (M) Ifeanyi Ugwuanyi (R)
Breaking, Di deciding LGAs for Benue State Governorship Election results
Na only election result for two local goment areas out of di 23 local goment remain to decide who go run do affairs of Benue State for di next four years.
Although na 32 pipo bin di contest for di post of govnor for di north-central state but di race now na between di current Gov. Samuel Ortom of di Peoples Democratic Party and Emmanuel Jime of di All Progressive Congress.
So far dem don announce result for 21 local goment areas.
While PDP don chop eleven local goment, APC get eight.
Collation centre for Benue State don close to resume by 9am on Monday.
Only 2 local goment remain to announce dia result.
Meanwhile Benue INEC don step down governorship election result for 3 polling unit for Kwande local goment sake of complain from APC say di election get K-leg.
APC accuse say PDP agent bin dey do mago-mago for three polling unit and dat is why dem cari complain come come tanda for INEC office.
INEC REC for Benue, Nentawe Yilwatda say dem go call all di collation officers from di wards to come explain do mata
Kano governorship elections for north-western Nigeria na one of di toughest sake of di struggle na between two men wey strong well well.
Former Kano Governor Rabiu Kwankwaso founder of Kwankwasiya get loyal supporters wey ready to do anything for am while Governor Abdullahi Ganduje wey don do four years in power don use di opportunity comot from Kwankwaso (im former boss) shadow form im own loyal followers wey dem dey call Gandujiyya.
So in essence pipo dey wait to see who go come out on top between Kwankwasiya and Gandujiyya members.
Kano Police arrest man wit 720 cutlasses before govnorship vote
For Kwankwaso wey be like Nigeria main opposition PDP leader inside Kano, di stakes dey higher because e no dey go back Senate so if im in-law wey hold di Peoples Democratic Party ticket to be Governor, Abba Yusuf no win, e fit affect Kwankwaso political career
Breaking, Imo Govnorship Election results update
Imo State Resident Electoral Commissioner Prof. Francis Ezeonu, togeda wit relevant security pipo don begin collation of di Imo govnorship election results.
Na tight race for Uche Nwosu, Ikedi Ohakim, Ifeanyi Ararume, Emeka Ihedioha and Hope Uzodima wey be di five major candidates wey dey contest di election.
Breaking, Jimi Agbaje just congratulate Sanwoolu for phone before INEC declare am winner of Lagos Govnorship Election
Wia dis foto come from, Instagram/ @ademolaniran
Wetin we call dis foto, Jimi Agbaje just congratulate before Sanwoolu INEC go finally declare winner of Lagos Govnorsip Election
Oga Babajide Olusola Sanwo-Olu don carry di Lagos State govnorship Elections as im party APC maintain dia grip on Nigeria commercial center, like dem dey do come since 1999.
Di INEC returning officer for Lagos Prof. Temitope Ogunmodede declare Sanwo-Olu winner afta di ruling APC party cari total of 739, 445 votes to beat main opposition PDP candidate Jimi Agbaje wey get 206,141 votes.
Di representative for APC and PDP don already carry ink sign ontop di result sheet, to say "I agree".
Wia dis foto come from, Akinwunmi Ambode
Wetin we call dis foto, Out-going Lagos Govnor Akinwunmi Ambode don sama congratulobia to Lagos State Governor-Elect, Babajide Olusola Sanwo-Olu and the Deputy Governor-elect, Dr. Obafemi Hamzat.
Wia dis foto come from, Sanwo-Olu
Police parade pipo wey dem suspect ontop Election offence
Police for Imo state south-eastern Nigeria on Sunday parade pipo wey dem suspect ontop Election offence.
Wia dis foto come from, Orlando Ikechukwu
Lagos Govnorship Election update: Drama for INEC collation centre
Drama for INEC collation centre as one representative of di party raise objection before dem call results of di last LGA, to say di election no suppose hold.
Di man para for almost 6 minutes wey for one point security nearly carry am comot di center.
Di man objection be say electoral act say na until all materials complete for ground, di elections fit start proper but as CBN bin don comot to say dem never release materials finish, why INEC come start di elections.
INEC declare APC winner of Kwara Govnorship Election
All Progressives Congress (APC) beat Peoples Democratic Party (PDP) inside all 16 local government areas of Kwara state, for di 9 March Govnorship election .
Independent National Electoral Commission (INEC) on Sunday afternoon declare Abdulrahman Abdulrazaq of APC winner.
Abdulrazaq score 331,546 votes, while im opponent Razak Atunwa of PDP get 114,754 votes afta INEC count all 6 local goment results.
Wia dis foto come from, Other
Breaking, INEC don suspend Rivers Govnorship election
Nigeria Election office, INEC don march break ontop anitin wey concern govnorship election for
Rivers state.
Di suspension na fall out of meeting wey INEC do today wia dem torchlight all di katakata wey bin happen for plenti polling units and
collation centres during di 9th March elections.
INEC say dia staff no dey safe again for Rivers State.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Rivers Govnorship Election: Make dem allow INEC staff to do dia job without intimidation - UK
"Make dem allow INEC staff to do dia job without intimidation"
Na wetin British High Commission dey advice authorities for Rivers State, south-southern Nigeria wia Returning Officers of di kontri election office wey be INEC neva fit begin announce dia govnorship election results from Saturday voting.
UK High Commissioner for Nigeria say dem dey concerned about di di kain tori dia observers dey report ontop di elections wey happun yesterday for Rivers State and dem dey monitor di situation closely.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
INEC neva begin announce govnorship result for Port Harcourt
Nothing dey happun for INEC Collation Centre for dia office for Port Harcourt as security pipo full ground, both police and military. Dem dey do strict screening of pipo wey dey enta di compound both tori pipo and INEC staff and adhoc staff.
About yesterday
LIVE from Uyo wia INEC dey announce govnorship election result
Oyo State govnorship election LIVE
Breaking, Kano govnorship election LIVE
All di election result for one place
As results don begin come in for di govnorship election wey happun for 29 states inside Nigeria, click here to see di latest result.
Breaking, Lagos collation centre dey LIVE
No result for areas wia dem hijack Cross River election materials - INEC
Article Information
Author, Fiona Equere
Role, BBC Pidgin
Collation centre for Cross Rivers State don open na only Akpabuyo local goment dey ground.
Na 18 local goment area dey di state.
Di state INEC bin announce say jaguda pipo hijack electoral materials foŕ Abi, Bakassi, Obubra and Etung local goment area for di state.
Dr Frankland Briyai wey be di resident electoral commissioner say INEC go score di area dem wey di jaguda pipo carri election materials dem zero.