Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol
Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.
Live Coverage
Who vote against condemning di invasion?
Wia dis foto come from, Getty Images
Five kontries
bin vote against condemning Russia invasion for di emergency UN General
Assembly for New York. E no dey surprising, one be di Russia Federation self.
But who be di odas?
Equally e no
dey surprising, Belarus also oppose di motion. One long-time Russia ally, di
small kontri dey described by analysts as Moscow "client state". Some
Russia troops enter Ukraine from Belarus territory.
Anoda to
oppose be Syria – wey im leader Bashar al-Assad rely on large-scale Russia
military assistance to stay for power during Syria civil war.
Eritrea for
di Horn of Africa also oppose, as did North Korea for Asia.
However
China – wey earlier dis year join Russia say dem oppose further Nato expansion .
Last week dem no dey there during one similar vote for di UN Security Council.
UN condemn invasion and demand withdrawal
Di UN General Assembly don vote in
favour of one resolution wey condemn Russia invasion and don ask make Russia immediately
pull all dia forces comot from Ukraine.
141 out of di 193 members support di resolution for one rare
emergency General Assembly session wey di UN Security Council arrange.
Ahead of di vote,
Ukraine UN ambassador Sergiy Kyslytsya say Russia bin "come to deny Ukraine
of di very right to exist".
Russian Ambassador
Vassily Nebenzia say Russia wan stop separatist conflict for eastern Ukraine
and accuse di West say e use "open and cynical threats" to get
countries to vote for di resolution.
Dis na di assembly first
emergency meeting since 1997.
Breaking, Ukrainian negotiators don depart for Belarus, Russia claim
Russian officials say dem dey expect Ukrainian negotiators to arrive for di Polish-Belarusian border for di next round of peace toks on Thursday morning, wia dem expected to discuss ceasefire.
Moscow's chief negotiator, Vladmir Medinsky, tell Russian media say di Ukranian delegation don leave capital city of
Kyiv and dat Russian troops dey are provide security corridor for di delegates.
Russia's foreign
minister Sergei Lavrov tok say earlier on Wednesday say Moscow remain committed
to di "demilitarisation" of Ukraine and add join say a list
of specified weapons wey dem must never be deployed for Ukrainian territory suppose dey.
But he tok say Vladimir Putin's regime recognise di Ukrainian pipo's right to chose dia own leader and dat Russia accept Volodymyr Zelensky as di legitimate
president.
In pictures: Shelter below Kyiv maternity hospital
As Ukraine
capital dey encircled by hostile Russian forces, authorities for di city dey tell
civilians to stay inside preferably underground.
One
maternity hospital for di capital don convert a basement floor to medical ward wey
allow pregnant women and newborn babies to dey cared for away from di
crosshairs of Russian weaponry.
Dis
pictures, wey dey taken today, show as expectant parents and some of Kyiv
youngest new residents dey tak shelter for di hospital basement.
Wia dis foto come from, Anadolu Agency
Wia dis foto come from, Andadolu Agency
Wia dis foto come from, Anadolu Agency
Wia dis foto come from, Anadolu Agency
Nearly 900,000 pipo don run comot Ukraine since Russia launch attack
Di United Nations Refugee Agency (UNHCR) say nearly nine hundred thousand pipo don comot Ukraine since Russia launch dia attack last week Thursday.
Di UNHCR dey beg for nearly $2bn (£1.5bn) for relief operation.
E add say di number of pipo wey go still run comot for Ukraine go pass di four million dem dey reason.
Breaking, Nearly 500 Russian troops don die - Moscow
Russia defence ministry don
give im first numbers for soldiers wey don die during im invasion of Ukraine.
E say 498 Russian soldiers
don die and 1,597 wound so far, according to Russian media report.
Di claim dey seriously
less than Ukraine assessment of Russian deaths - Kyiv claim say e don kill
5,840 Russian troops.
Russia don also
claim say more dan 2,870 Ukraine service members don die and about 3,700
wounded. Kyiv neva give any figures.
BBC no fit independently
confam either di Russian or Ukrainian claims, but UK Ministry of Defence
believe say Moscow forces suffer heavy loss.
Earlier Ukraine emergency
services say more dan 2,000 civilians and 10 emergency services workers don die
so far.
Winter Paralympics 2022: Russia and Belarus athletes dey classed as neutral afta Ukraine invasion
Wia dis foto come from, gett
Wetin we call dis foto, Di 2022 Paralympic opening ceremony go take place on Friday for Beijing
Athletes from Russia and Belarus go dey allowed to compete as neutrals for di 2022 Winter Paralympics for Beijing afta di invasion of Ukraine.
Di International Paralympic Committee (IPC) say di two countries "go compete under di Paralympic flag and no go dey included for di medal table".
Di opening ceremony be Friday, wit competition to start on Saturday.
IPC president Andrew Parsons say di measure be di "harshest possible punishment" under dia constitution.
"Di IPC and wider Paralympic Movement dey worry sake of di serious violation of di Olympic peace by Russia and Belarus goments for di days bifo di Beijing 2022 Paralympic Winter Games," Parsons tok.
"Di IPC Governing Board dey united for how dem condemn di actions and dem agree say dem no fit go unnoticed or unaddressed.
"To decide di kind action wey di IPC suppose take,we go first work wit wetin dey our new constitution so we go remain politically neutral.
"Dat kind neutrality be strong belief say sport hold di power to overcome our mistakes, and call from inside us di best of our humanity, especially in the darkest of moments."
UK Secretary of State Nadine Dorries say she dey " disappointed" wit IPC decision.
"I call on dem to urgently reconsider," she tok. "Dey must join di rest of di world to condemn dis barbaric invasion, make dem ban Russia and Belarus athletes make dem no compete.
"We go consider di full range of options for di protest of dis decision, for consultation wit UK Sport and di British Paralympic Association. I go also meet wit my international colleagues dis week to tok about how we fit answer together."
Heartbreaking farewells as fighting close for Dnipro
Dis
na desperate scenes for di train station for Dnipro, as Russia war on Ukraine dey
get uncomfortably close and families don begin dey run from west, from di
fighting.
E no get any time or
destination on di departures board, just big crowds of people for di station
steps, for di halls and platforms.
As train dey enta di
station, crowd go begin push forward to squeeze on board.
Nobody dey even ask wia e dey go.
Most
people dey carry only small bags: plastic bag - but some carry dia pets inside
crates becos dem dey fear say dem fit no come back.
For
di crowd, men dey shout orders for dem to make way for women and children to pass;
na so so screaming and tears and last hugs.
Fathers
kiss di train windows and press dia hands for di glass.
Den
dem go pull away in tears, so dia children no go see.
One man tell me say im dey
stay to fight. We go win, im tok, like say im dey try convince imsef – not telling
me.
But dis goodbyes dey heart breaking.
Russian drivers in Formula 1 dey banned from competing for UK
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Nikita Mazepin join Haas F1 team for 2021, e partner wit Mick Schumacher
National Motorsport Authority don ban Russian drivers from competing for
UK.
Motorsport UK gp
refuse to recognise licences of competitors from Russian federation until
further notice.
Dis one mean say
Nikita Mazepin no go fit race for July British Grand Prix even if e continue to
be part of Haas team.
Mazepin papa, Dmitry
na im dey provide financial backing to Haas and e dey close to Russian
President Vladimir Putin.
Haas dey expected to cut
ties wit dia Russian driver.
Motorsport UK decision
dey come afta FIA, di international governing body wey dey decide to allow
Russians compete for events ban teams from di kontri.
Roman Abramovich wan sell Chelsea?
Wia dis foto come from, Getty Images
One Swiss
billionaire Hansjorg Wyss don tell tori pipo, Blick say Roman Abramovich don
offer am di chance to buy Chelsea football club.
E say di Russian
billionaire “wan offload Chelsea sharp-sharp” afta dem threaten am with
sanctions for Parliament.
Wyss bin also tok say, “I and three oda pipo bin get di offer to buy Chelsea. Abramovich dey try sell all im villas for England and also wan comot Chelsea from in hand sharp-sharp.”
Abramovich
bin hand ova “stewardship and care” of di club give dia foundation trustees
afta Russian invasion of Ukraine last month.
Howeva neither
Chelsea or Abramovich don ansa di clams by di 86 year old Wyss. Even as di club don tok before say e no dey for sale.
Since Abramovich
buy di club for 2003, Chelsea don win all di trophies wey dem fit winm
including two Champions League, Five Premier League and FA Cup, twpo Europa
League and three League cups and di 2021 Uefa Super Cup and club World Cup.
Breaking, Mass casualties feared for Mariupol - official
Officials for di south-eastern city of Mariupol, near di border
wit Russia don express fear say many pipo fit don die for di area sake of
continuous shelling on di city.
Deputy Mayor Sergiy Orlov say one riverside district wey
normally be home to 130,000 pipo including im papa don dey "nearly totally
destroyed".
“We no fit count di
number of victims there, but we believe say at least hundreds of pipo don die.
We no fit enta go carry dia deadi bodies," e tell BBC for phone.
"Di Russian army dey
use all dia weapons work for - artillery, multiple rocket launch systems,
airplanes, tactical rockets. Dem dey try destroy di city,” Orlov tok.
E say Russian forces dey
for several kilometres away on all sides.
"Ukrainian army dey
very brave and dem go continue to defend di city but di style of di Russian
army be like pirates. Dem no dey fight with dia army, dem go just destroy
entire districts," Orlov tok.
Breaking, Ukraine War: Buhari don pproves $8.5m to evacuate stranded Nigerians
Nigeria President Muhammadu Buhari don approve $8.5 million to
evacuate at least 5,000 Nigerians wey dey stranded sake of di war between
Russia and Ukraine.
Di Ministry of Foreign Affairs and di Ministry of Humanitarian
Affairs, Disaster Management and Social Development do joint memo wey di FEC
approve on di moni wey dem go use evacuate Nigerians wey now dey for Romania,
Hungary, Slovakia, and Poland.
Wia dis foto come from, Buhari Sallahu
EU condemn Museveni tweet ova Ukraine Kasala
Wia dis foto come from, AFP
Wetin we call dis foto, Lt Gen Muhoozi Kainerugaba na di commander of Uganda land forces
European Union (EU) diplomats don condemn di tweet of di powerful son of Uganda President Yoweri Museveni, Lt Gen Muhoozi Kainerugaba, say im support for di Russian invasion of Ukraine.
On Tuesday, Gen Kainerugaba tweet say "di majority of mankind (wey no be white) dey support Russia stand for Ukraine. Putin dey absolutely right!"
Di deputy oga of di European Union delegation for South Sudan, Dionyz Hochel, say di comment dey unacceptable and Uganda fit face ogbonge consequences if dem officially suppot Russia invasion.
E tell tori pipo for Juba say, "We condemn dis statement. We dey expect sensitivity and say kontris for dis region go dey collabo with EU and oda like minded kontris to condemn di Russian attack for Ukraine".
Di United Nations General Assembly go vote on Wednesday on resolution to condemn Russia invasion on Ukraine.
Why Russia dey invade Ukraine?
Wetin we call dis Video, Why Russia dey invade Ukraine?
As di Russian invasion of Ukraine dey enta one week, wit casualties on both sides, many pipo still dey wonder, wetin cause di kasala.
No worry. We get di ansa for here.
And as dat one dey pipo mind, Europe and di rest of di world dey ask again, wen di fighting go end.
Nigerian singer get appointment as Africa jab ambassador
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Yemi Alade don already featured inside one of It's Up to Us' YouTube videos
Nigerian Afropop star, Yemi Alade, don dey appointed as di
Global Ambassador for one pan-African campaign wey dey in partnership wit di
Africa Centre for Disease Control (CDC) and Mastercard to encourage Africans to
dey vaccinated against Covid-19, wey dem call - It's Up to Us.
Di campaign warn say Africans
dey behind wen e come to mata of Covid vaccinations.
On top her Twitter page,
Alade say she happy well-well to join Africa CDC, Mastercard and thousands of
Africans to stop di spread of coronavirus "one shot at a time".
According to di Africa
CDC, na just 12.33% of di continent population dey fully vaccinated and na only
0.91% don collect dia booster shot.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Analysis: Wetin Russian control look like?
Article Information
Author, Frank Gardner
Role, BBC Security Correspondent
Apart from di
claims and counter-claims, how we go take know for sure if Russia dey control any
Ukraine city or district?
Mainly, na wen di
fighting stop.
Once Russian troops
fit dey able to continuously patrol on foot, without any opposition, for streets
by day or night den dat na fair sign say dem get di city under dia control.
Oda signs na say
dem dey in charge of di local TV station, di municipal offices, di police
headquarters and who dey di utilities and emergency services, even sometin
as small as directing traffic.
E dey perfectly
possible say e fit no ever happun for dis conflict wen Russia fit truthfully claim
say e get full control of di whole kontri.
Watever go happun
in di next days, Ukraine pipo dey likely to resist occupation somehow.
But for now, Russia
main effort na to seize control of di main cities of Kyiv and Kharkhiv, even if
e mean to practically burn dem to di ground in di process.
Breaking, More dan 2,000 civilians don die for Ukraine - Ukrainian authorities
In di last few minutes, di Ukrainian authorities tok say more dan than 2,000 civilians don die so far for Russia's invasion, wey begn nearly a week ago.
Dem don kill ten rescuers, di Emergencies Service tok.
Rescuers put out more dan 400 fires wey break out afta Russian shelling across di country and defused 416 explosives.
"During di seven days of war, Russia don destroy hundreds of transport hubs, residential buildings, hospitals and kindergartens," e tok.
'Only Ukraine pipo, if you be black make you trek'
Nigerian
medical student Jessica Orakpo tell the BBC about her ordeal and di racism wey she
experien as she attempt to comot Ukraine following Russia's invasion.
Based in the
western city of Ternopil, she first try to reach di Polish border on foot – but
for di end she enat train goHungary.
She tok say bout
di discrimination wey she and oda Africans face from Ukrainian officials.
Wetin we call dis Video, 'Only Ukraine pipo, if you be black make you trek'
Russian Ukraine war - Summary of wetin dey happun right now
Wia dis foto come from, Reuters
Russia say e don take control of di
southern port city of Kherson. Ukraine deny am.
Ukrainian military say Russian
paratroopers don begin fight for Kharkiv.
40 mile on convoy 15 miles from Kyiv.
Russia don warn pipo to move away from government installations ahead of
strikes.
Russian authorities don further tighten dia
control of di media, take one independent radio station off-air.
The Moscow stock exchange don remain
closed for di third day running as sanctions bite.
NATO Secretary General Jens Stoltenberg
press conference for Brussels.
We dey expect decision on di
participation of Russia for di Paralympics. 13.00GMT
Sport dey look into reports say Roman
Abramovich don put Chelsea football club up for sale.
Fotos of welcome for thousands of Ukrainians wey escape