5,000 Nigerians workers protest for Abuja, see wetin dem want, Di workers unda di Nigeria Labour body do protest for Abuja, di nation's capital to clamour for changes for Nigeria constitution

Over 5,000 members of di Nigeria Labour Congress (NLC) on Monday, March 28, cari waka from Labour House go di National Assembly complex for Abuja, di kontri capital.
Dem tok say dis dia waka na to highlight some changes dem want for di review of di 1999 constitution wey di lawmakers dey currently do.
Part of wetin dem wan be local goment, judiciary and legislative autonomy. Dem follow tok say want changes to tins wey dey affect Nigerian workers and citizens in general like welfare.
As e be so lawmakers for di Senate and House of Representatives dey review di constitution of Nigeria wey di kontri dey use since 1999 afta di end of military rule.
Some of di laws wey Nigeria dey use dey very old and di lawmakers dey review di constitution as dem wan make di news laws wey go dey in place, go fit help reflect di current issues of administration.












