Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol
Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.
Live Coverage
All you need know about Zaporizhzhia nuclear plant Russia attack
Evacuees reunite with families in Nigeria
Article Information - Author, Tamara Ebiwei
- Role, BBC News Pidgin

Wia dis foto come from, BBC Pidgin
Wetin we call dis foto, Di two women happy to see each oda again Over 450 Nigerians dem evacuate from di war in Ukraine don reunite with dia families back home.
Nigeria goment bring di evacuees from Romania sake of di Russia invasion of Ukraine.
BBC Pidgin capture some very emotional moments for di parents and children as dem reunite wit dia families and loved ones.
Di day dey special for one woman wey come welcome her two daughters for di Nnamdi Azikiwe International Airport, Abuja
Madam Salka say "I don get peace of mind, wit wetin dey happun for Ukraine, I no fit eat or sleep well, thank God say dem come back safely, God be praised!"
Her two daughters tell BBC Pidgin say; "We no believe say we fit survive am, and we dey happy to comeback home, at least no tension here"
E don pass one week since Russia invade Ukraine. Friday 4 March, 2022 make am nine days since di conflict begin.
Dis na di first batch of evacuees we Nigeria goment bring from Romania.
Nigeriaa goment promise to give dem 100 dollars each to transport di pipo wey no dey stay Abuja.
National Emergency Management Agency(NEMA) na im co-ordinate di evacuation with di Foreign Affairs Ministry.
Head of NEMA, Mustapha Habib say: “For di pipo wey dey stay outside Abuja, we go give dem 100 dollars each for dia transport”
“We go support dem to make sure say dem dey okay” Habib tok.
More Nigerian evacuees dey expected to land di kontri later today.
Many of di returnees be students wey dey study abroad for Ukraine.
Ukraine before now na home to over 76,000 foreign students, according to goment data from 2020.
Nearly a quarter of di students come from Africa, with di largest numbers coming from Nigeria, Morocco and Egypt.
Di students - studying medicine, engineering and business - be one important part of Ukraine economy.

Wia dis foto come from, BBC Pidgin
Wetin we call dis foto, Evacuees don reunite wit dia families after dem run komot from Ukraine war 
Wia dis foto come from, BBC Pidgin
Wetin we call dis foto, Two ladies hug diasef after dem reunite BBC: We go continue our efforts to dey available in Russia

As we bin dey report today (see earlier posts) independent media don dey come under pressure inside Russia during di invasion.
Now di BBC say dem dey try to keep dia news service accessible inside Russia, following reports say goment don block am.
"Access to accurate, independent information be a fundamental human right wey no suppose dey denied to di people of Russia, millions of whom rely on BBC News every week," one spokesperson said.
"We go continue our efforts to make BBC News dey available in Russia, and across di rest of di world."
BBC's Russian language news website has had record audience numbers since Russia invade Ukraine.
Visitors to di English language bbc.com site from Russia also dey up by over 250% last week.
Russian TV don so far describe di war in a very different way to di rest of di world.
Breaking, IAEA boss give update on Zaprizhhia nuclear plant attack
IAEA Director General do press conference just a while ago on di situation in Ukraine.
Rafael Mariano Grossi briefing start at about 10:30am afta Russia take control of Zaprizhhia nuclear power plant wey dey inside Ukraine.
Grossi confam say di Zaprizhhia nuclear plant dey under Russia control.
E however say na Ukrainians still dey inside di control room.
Im call for negotiation afta im return from im mission to Iran.
Di IAEA Director General indicate plans to consult Ukraine and Russia.
Di radiation monitoring system for di plant and oda safety concerns dey normal at di moment, e add.
IAEA - di International Atomic Energy Agency - na di world central intergovernmental forum for scientific and technical co-operation inside nuclear field.
Di agency dey work for di safe, secure and peaceful uses of nuclear science and technology.
E dey also contribute to international peace and security and di United Nations' Sustainable Development Goals.
Skip YouTube postAllow Google YouTube content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites. YouTube content fit contain adverts.Dis article contain content wey Google YouTube provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Google YouTube cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of YouTube post
Asia stocks don drop after nuclear plant attack
Share prices don go down for Asia after fire break out for Zaporizhzhia nuclear power plant for Ukraine, the largest in Europe.
Na Tokyo and Hong Kong face di greatest fall and faced the steepest falls. Japan's benchmark Nikkei index dey 2.5% lower and di Hang Seng for Hong Kong dey down by 2.6%.
Oil prices bin rise for Asia morning trade, and Brent crude bin dey above $112 a barrel.
Di fire bin happen after Russia troops attack di plant.
Ukraine emergency services bin tok say Russian troops block dem from getting to di scene but dem later manage to get to di plant to off di light.
Di concerns of some investors dey calmed after officials tok say di plant safety don dey “secured”.
Di International Atomic Energy Agency (IAEA) later tok say dem don tok to Ukraine leadership and dem say important equipment for di plant still dey work.
Dis attack gather international condemnation.
US President Joe Biden bin join Ukraine President Volodymyr Zelensky to urge Russia to stop di attack and allow firefighters to get access to di site.
Russia invasion of Ukraine shock di global financial and energy markets.
Di week, di cost of Brent crude - wey dey measure di global price of oil – bin jump above $100 a barrel.
E bin rise to more than $119 to di highest since May 2012.
Di cost of natural gas and coal don also jump on global markets.
Wholesale energy prices wey dey go up don push di average cost of petrol and diesel for UK.
Dem don also warn say household energy bill for UK fit reach £3,000 a year.
Meanwhile, di Russian rouble has hit a record low against di US dollar as kontris for di world impose tough sanctions on di kontri.
Johnson: 'Putin reckless actions fit directly threaten Europe'
Britain prime minister Boris Johnson don tok say di "reckless actions of President Putin fit directly threaten di safety of all of Europe", according to one statement from a call between Johnson and Ukraine President Volodymyr Zelensky.
Di call bin take place shortly after di news break about di fire for Zaporizhzhia nuclear power station for southeast Ukraine.
One Downing Street tok tok pesin bin tok say di situation get grave concern. She add: “Both leaders agree say Russia gazz stop di attack on di power station and allow access for emergency service to di plant.”
Johnson also tok say di UK go "do everything dem fit do to make sure say di situation no dey worse.”
Im dey seek emergency UN Security Council meeting in some hours. Im tok say UK go raise di issue immediately wit Russia and close partners.
"Both leaders agree say ceasing fire dey important,” di Downing Street tok tok pesin tok.
Senegal fault Ukraine 'war invite' to dia citizens
Senegal foreign ministry don summon Ukraine ambassador Yurii Pyvovarov after di kontri embassy call on Senegalese volunteers to enlist in di fight against Russia.
Di Ukraine ambassador bin post for Facebook say make Senegalese volunteers join Ukraine war against Russia but di ministry tok say dis kind recruitment dey illegal.
Senegal foreign ministry also tell Pyvovarov to delete di post.
Dem no mention if dem go take further action.
Senegal dey among 17 African kontris wey no vote at di UN General Assembly on resolution and withdrawal of Russian forces from Ukraine as both kontris dey fight war.
Ukraine say Russian forces seize Zaporizhzhia nuclear plant
Ukraine tok say Russian forces seize Zaporizhzhia nuclear plant
Russian troops don seize di Zaporizhzhia nuclear power plant, di Ukrainian authorities tok.
"Operational personnel dey monitoring di condition of power units," one local authority tok on social media, quoted by Reuters news agency.
Station personnel dey continue to work and monitor di state of the power units, dem tok.
Fire bin break out at di plant some hours ago - na di largest for Europe largest - after shelling attack by Russian forces.
Nigerian evacuees set to board from Chopin Airport, Poland
Article Information - Author, Dooshima Abu
- Role, BBC Pidgin, Abuja

Wia dis foto come from, Raphael Oni
Wetin we call dis foto, Nigerians queue up for Chopin Airpot for Poland Anoda batch of Nigerian students wey escape di war from Ukraine and wey hide for Poland, don ready to board from di Chopin Airport for Poland.
Na Air Peace flight A230 na im dey bring dem to Naija.
The Poland Aviation Authority bin cancel dia flight on Thursday afta di crew exhaust dia duty hours.

Wia dis foto come from, Raphael Oni
Wetin we call dis foto, Evacuees sidon for transit hall ready to board 
Wia dis foto come from, Raphael Oni
Wetin we call dis foto, About 50 pesin no fit board sake of say di aircraft full to capacity Di first batch of Nigerian students wey escape Ukraine war don land for Abuja dis morning.

Wia dis foto come from, BBC Pidgin
Wetin we call dis foto, Di first batch of Nigerian students wey escape Ukraine war don land for Abuja BBC dey restricted in Russia, state media report
Russia communication authorities don limited access to BBC Russian Service inside di kotri.
Na wetin goment-owned news agency RIA dey report.
Two oda news outlets - Meduza and Radio Liberty - also don dey blocked, e tok.
First set of Nigerian evacuees don land from Ukraine
Article Information - Author, Dooshima Abu
- Role, BBC Pidgin, Abuja

Wia dis foto come from, Nigerians in Diaspora Commission/@nidcom_gov
Di first batch of Nigerians wey dey stranded for Ukraine sake of di Russia invasion don land Nnamdi Azikiwe International Airport, Abuja Nigeria capital.
Dis first batch of 415 pipo dey come from Romania and na Max Air flight VM602 fly dem into di kontri.
Dem arrive di international airport around 7: 21 am on Friday morning.
More details go follow.
Chairman of Nigerians in Diaspora Commission don also confam di arrival.
Abike Dabiri Erewa say di evacuees were brought back home by Max Air
Nigeria is expected to evacuate 5000 citizens wey don japa from di Russia-Ukraine war.
Many don cross into neighboring kontris of Romania, Poland and Hungary.
Di returning of citizens dem bin earlier announce to start on Wednesday but e delay due to logistics challenges.

Wia dis foto come from, Nigerians in Diaspora Commission/@nidcom_gov

Wia dis foto come from, Nigerians in Diaspora Commission @nidcom_gov

Wia dis foto come from, Rachael Oni
Good morning - If you just dey join us - Dis na di latest updates, Daniel Semeniworima and Solomon Babatunde dey run live updates dis Friday morning.
If una just dey join our live coverage of di Ukraine crisis, welcome.
Dis na wetin happun ontop di Russia-Ukraine war overnight:
- Fire bin break out at di nuclear power plant for Zaporizhzhia nuclear power plant - Na di largest for Europe - after shelling attack by Russian forces. Ukraine responders don manage to off di fire.
- Ukraine State Emergency Services tok say no victims dey for di fire wey no affect di reactor sites but a nearby five-storey training site.
- Russia attack cause immediate condemnation from Western leaders who call am “horrific” and “reckless” act wey threaten di safety of all Europe.
- Ukraine President Zelensky bin call on oda nations some hours ago make dem take more action immediately against Putin "nuclear weapon".
- Im also call on Europeans to “wake up” to di possibility of a global kasala like di 1986 Chernobyl nuclear meltdown. Zelensky tok say Russia na di first country in history wey try to bomb a nuclear power plant
- For oda places, Russia dey strengthen dia campaign for di south of Ukraine, where dem dey close in on di key city of Mariupol after dem capture Kherson two days ago.
- Over a million refugees don run komot from Ukraine. Both Russia and Ukaine don agree to establish “humanitarian corridors” to komot civilians.
Breaking, Russian attack Europe largest nuclear plant for Ukraine - Zelensky

Russian attack Europe largest nuclear plant for Ukraine, according to Ukraine president.
Volodymyr Zelensky accuse Russians of deliberately shooting at di Zaporizhzhia plant six reactors using tanks equipped with thermal imaging.
Zelensky raise fear about di "global catastrophe" wey bin happun for Chernobyl in 1986 and warn say consequences of a meltdown at Zaporizhzhia go be far worse.
Di fire be like wetin dey sparked by artillery shells.
Na around 4:00 GMT Friday morning tori land say firefighters don fit to access the Zaporizhzhya nuclear plant
Dem quench di fire in di training building of Zaporizhzhya NPP in Energodar.
“No victims dey for di fire" di State Emergency Service write on dia social media accounts.
Di fire for Zaporizhzhia nuclear power plant burn for at least four hours before dem quench am at about 06:20 local time Friday
Man wey show Nigerian evacuees road for Ukraine-Poland border
Good night!
Na hia we go end today BBC Pidgin Live Page.
To catch up wit all di tori wey you fit don miss today, make you scroll down di page.
We go return on Friday 7am wit all di latest tori on Russia-Ukraine war as e dey happun plus oda ogbonge tori around di world..
Na Jelilat Olawale,Faith Oshoko,Kareemot Salami,Onyinye Chime and Annette Arotiba bring una all di tori.
Good night.
Wetin don happun today for di Russia-Ukraine war?

Wia dis foto come from, EPA
Civilians continue to make dia way out of Ukraine and into neighbouring kontries as di bombardment of key cities by Russia increase.
Here be di latest:
- Di UN don tok say more dan one million pipo now don japa from Ukraine since di conflict begin seven days ago
- Russian forces don gain control of di key port city of Kherson for Ukraine southern coast, e make am di first major city to fall
- Shelling continue for di strategic port city of Mariupol, and di mayor there say Russia forces don cut off electricity, food, water, and heating
- At least 22 pipo don die for air strikes for Chernihiv, one city around 70 miles north of Kyiv
- One second round of tok between Russian and Ukrainian negotiators don happun for Belarus, Ukraine dey call for ceasefire and humanitarian corridors for di evacuation of civilians
- Vladimir Putin claim for TV tok say di invasion dey "go according to plan"
- Nato no consider one no-fly zone, di US ambassador to di bloc don tok.
- For press conference, Volodymyr Zelensky tell Nato: "If you no get di power to close di skies, den give me planes"
- Zelensky also ask Putin for direct tok
- Russia go challenge di ban wey Fifa and Uefa sama dia football teams
- Di chief prosecutor for International Criminal Court don launch one investigation to chook eye for possible war crimes inside suspected bombing of civilians by Russian forces
Why Russia dey invade Ukraine?
'Register for di newly created polling units ' - INEC
Article Information - Author, Karina Igonikan
- Role, BBC Pidgin

Wetin we call dis foto, Di ongoing voter registration exercise go end for June 2022 Di Independent National Electoral Commission INEC dey tell kontri pipo wey never register for di ongoing voters registration exercise to take advantage of di new polling units wey dem don bring out and register for di ones wey dey near dia house.
Di Resident Electoral Commissioner for Rivers State Obo Effanga tell tori pipo for INEC headquarters for Port Harcourt di Rivers State capital say di commison dey really prepare for di 2023 elections and add say by next week dem go begin di voter registration for wards across di country since di voter registration exercise go end for June 2022.
E explain say dem create di new polling units to decongest some of di old ones because dem dey overcrowded.
"We no want situation wia we gatz transfer pipo to di newly created polling units because dem get zero record naim make we dey encourage pipo wey dey register now to register for di new polling units and encourage pipo wey don register before to transfer dia voting points to di new polling units wey dey near dia house so on election day, dem no go waka go far place before dem cast dia votes."
E also say kontri pipo for use di opportunity of di ongoing voter registration exercise to replace dia voters cards wey don loss and make corrections too but advice dem not to do double registration as dem fit comot such names if dem catch dem from di voter register and such pesin go face di penalty.
Effanga also advise di 18 political parties to abide by di elections timetable wey INEC don bring out so dem go condictvall dia primaries and activities and also submit dia lists with in di period.
On top di electronic transmission of election results, di INEC Resident Commissioner say dem don already start work on dat one because for all di elections dem don do since Covid-19 start, dem open results viewing portal wey dey receive election results from di polling units as dem dey take snap shot of di results sheet from di polling units dey upload am dia.
Dis im say don reduce contention wey concern collation and dem still dey work on am to see more improvements.
Nigerian lawmakers throway bill to stop public officers pikin from studying abroad

Wia dis foto come from, HouseNGR/FACEBOOK
Wetin we call dis foto, Nigeria lawmakers Di House of Representatives don reject one bill wey go chook eye on how public officers dey send dia children go schools abroad.
Some of di lawmakers argue say di bill if dem pass am go dey against di fundamental human rights of Nigerians wey get right to movement and right to education.
Odas argue say public officers no dey in control of public funds and no supposed dey stopped from giving dia children di best education if dem fit afford am.
Di legislation wey dey titled ‘A Bill for an Act to Regulate International Studies for Wards and Children of Nigerian Public Officers, to Strengthen Indigenous Institutions, Provide Efficient Educational Services for National Development; and for Related Matters.’ dey tabled before di floor of di house for di second time in four years. Read more
