Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol
Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.
Live Coverage
Kyiv mayor: Dis na di time to ready for resistance
Di
mayor of Kyiv don warn residents say Russian forces dey move in one Ukraine
capital.
Vitaliy
Klitschko wey be former boxer warn pipo to stay inside dia house and prepare to
defend di city.
"Di
enemy dey advance closer and closer,” Klitschko tok. E add say fight dey go on
for di outskirts of di capital.
"We
dey prepare and we go defend Kyiv! I call on Kyivans make dem no lose dia fortitude.”
So
far Kyiv don resist Russian forces as dem attempt to enter di capital.
One
armoured Russian convoy wey reach 40 miles (65 km) in length dey approach
from di north of Kyiv, and analyst believe say e fit dey dia to provide support
for invasion attempt from di west.
Nigerian women carry protest go National Assembly afta lawmakers throway 'special seats for women bill'
Nigerian women dey protest for equality as dem carry demsef go di National Assembly for di capital Abuja, afta lawmakers throway di bill wey for five women special seat representation as dem dey consider amendment to di kontri constitution.
Di bill on Tuesday face defeat for Senate wit 58 votes out of 91.
For House of Representatives na 208 out of 290 lawmakers vote against am.
Wife of Vice President, Dolapo Osinbajo bin dey present on di floor wen House of Representatives members vote.
Fact Check - Ukraine Russia war viral misinformation for Nigeria
Why petrol pump price dey sell above approved rate for dis oil-rich city in Nigeria
Article Information
Author, Karina Igonikon
Role, BBC Pidgin, Port Harcourt
Wetin we call dis foto, Many filling stations for PHC dey closed as dem no get product
If di Nigerian goment still dey pay subsidy for petrol, why scarcity still dey?
And why pipo dey buy petrol above di goment approved price?
Dis na di question motorists and pipo for dis oil-rich city for southern Nigeria.
Port Harcourt dey ask as dem still dey suffer fuel scarcity and long queues for filling stations for di oil rich city.
As di fuel scarcity for Port Harcourt enter di third week, NNPC Mega filling stations dey sell petrol at N162.50 per litre.
Many filling stations dey closed sake of say dem no get product to sell and di ones wey get dey sell petrol between N195 to N220 per litre.
Sake of dis, di Nigerian Union of Petroleum and Natural Gas Workers (NUPENG) for statement give petroleum products marketers 24 hours to revert to di official price of petrol.
Marketers dey sell petrol from depots at prices wey dey above di official rates and dis dey force illegal increase in pump price.
NUPENG National Treasurer Alex Agwanor tell BBC Pidgin say di 24 hours deadline expire midnight of Monday 28 February 2022.
Agwanor tok say di taskforce dem set up go swing into action to locate those depots and filling stations wey still dey sell above di approved prices.
"Di problem come from some depot owners and also from some stations, even those wey buy normal price wan take advantage of di situation to sell at higher price.
"Some prefer to sell for night when nobody go monitor dem or try to stop dem from selling at di higher price.
"So today our taskforce go visit both di depots and filling stations to see di ones wey dey sell above approved prices and sanction dem," Agwanor tok.
Chairman of Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria (IPMAN) Rivers State, argue say di high price of petrol na sake of say tank farm owners dey sell at higher price to retail marketers.
Dr. Joseph Obele tok say nai make dem too dey sell at higher prices.
Obele say dia members no dey import fuel and dem no own tank farms.
E tok say PPMC wey dey import fuel dey sell to private tank farms owners wey IPMAN members dey buy from.
According to Obele, di cost rate wey PPMC dey sell to private tank farms na between N127 and N135 per litre.
"E go interest you to know say as last weekend, private tank farm owners dey sell to marketers at di rate of N170, N175.
"So marketer wey buy from private tank farm at di rate of N175 no go sell am for anytin less than N190, N200 per litre.
"So we no dey get di products at di official rates wey we suppose dey get am, wey be N148 per litre.
Na only wen marketers buy at N148 we fit sell at N165 per litre," Im tok.
Oil don hit $113 per barrel
As
fighting continue for Ukraine, di conflict don dey push up global oil prices.
Prices dey go up even wen new measures dey in place to calm di markets.
Brent
crude - wey dey measure oil prices internationally - don hit $113 per barrel.
And dis na di highest level since June 2014.
Di oil price bin rise even after members of di International Energy Agency agree to release 60
million barrels of oil wey dem store for emergency.
Russia na one of the biggest energy producers in the world and investors dey worry say oil or gas supplies fit dey affected.
"We trek for three hours to Romania to escape" Russia-Ukraine war
Mixed reports na im dey come out of Kherson
Mixed reports na im dey come out of Kherson
We dey await confirmation of Russia claim to capture di southern Ukrainian port city of Kherson.
Earlier, Moscow say dem now dey in "full control" of di city, wey make am di largest inside Ukraine to fall since di beginning of di invasion.
But di region governor don tok say Kherson dey completely surrounded by Russian forces, appearing to contradict di claim.
Di city's mayor don also post on Facebook say: "We still be Ukraine. Still firm."
We go bring you more updates as dey come.
Wia dis foto come from, Get
Wetin happun for Ukraine overnight
Morning dey
break for Ukraine afta Russian troops advance on di two major cities of Kharkiv
and Kyiv for night.
For yonda, US President Joe Biden tok much of im State of di Union speech
to di situation for Ukraine.
Ukraine-Russia: Dis na wetin
happun overnight
Russian
troops don parachute enta Kharkiv in di past hour, stepping up attack on
Ukraine second-largest city.
Dozens of citizens die for di bombings
yesterday.
Di smaller
southern city of Kherson don also fall to Russian forces, local Ukrainian
officials tok am.
US President
Joe Biden don ban Russian planes from America airspace
For im State
of di Union address, Biden say: “Putin fit circle Kyiv wit tanks, but
im no go ever gain di hearts and souls of di Ukrainian pipo”.
Dem give Ukraine
envoy to di US standing ovation for di address.
Oksana Markarova don deliver
crucial information to US lawmakers dis week – including di claim say Russia don
use vacuum weapons wey dem don ban for warfare
More than
600,000 pipo don run comot from Ukraine so far, di UN tok.
Boeing and
ExxonMobil become di latest Western companies to cut ties wit Russia.
Russia-Ukraine war: Nigeria shift evacuation of citizens from today, Airpeace and Max Air go bring dem from three kontris.
Article Information
Author, Dooshima Abu
Role, BBC Pidgin, Abuja
Nigerian Ministry of Foreign Affairs say di chattered flight wey dem go use to bring back stranded kontri pipo from Ukraine go leave today.
Na Max Air and Airpeace go return di evacuees.
Na wetin di ministry announce for statement wey di permanent secretary, Gabriel Audra sign.
Max Air dey expected to bring back 560 pipo from Romania.
Airpeace go bring 364 person from Poland and 360 pipo from Hungary.
Di first batch of evacuees go arrive Nigeria on Thursday March 3,2022.
At di moment, about 1,940 thousand evacuees dey different embassies for neighboring kontri wit Ukraine.
And di authority say dem di work hard round di clock to ensure say dem brink dem back to Nigeria safely.
Wetin we call dis foto, Press statement from di ministry of foreign affairs
Nigerian student tok about life for Ukraine frontline
Wia dis foto come from, Getty Images
One 22 year-old Nigerian
medical student, Fehintola Moses, don tell di BBC about im unsuccessful attempts to leave
Sumy, for North East Ukraine.
Sumy dey also near another frontline for Khakiv and na wia fighting bin dey happun wit Russian troops.
Through WhatsApp message and
voice notes, di Nigerian student tok of how im no fit leave di city.
Im
university tell am say Russian forces don take ova di train lines.
E say dem tell am to stay for
di campus.
Di Nigerian medical student tok say public transport no
dey for di city as dem don damage some roads.
"We still dey get good
supply of food, grocery shops still dey open – my fear be say e fit no last
long.
"Di school dey provide foodstuff for pipo wey need am. We no get water. We
still dey try to sleep and wake up.”
“Wetin we need na pesin wey
fit comot di Russian soldiers from di street, pesin wey fit repair di bridges,
pesin wey fit make sure say di railroads dey safe.
"Dat na wetin we honestly
need right now.”
Moses say im feel mentally
drained and im wish di whole situation fit end.
Over half a million civilians
don run comot from Ukraine, according to di UN.
Una good morning
BBC Pidgin live
coverage of all di news around di world go begin from here.
Stay tuned for reports from Ukraine as Russian invasion dey happun for dia and all oda news for across Africa.
Daniel Semeniworima and Olaronke Alo go run dis live coverage dis morning.
Zelensky say Russia attack on Ukraine Kharkiv na war crimes
Heavy Russian military convoy dey near Kyiv
Good night
Na here we go end today BBC Pidgin Live Page.
To catch up wit all di tori wey you miss today, make you scroll down di page.
We go return on Wednesday 7am wit all di latest tori on Russia-Ukraine war as e dey happun plus oda ogbonge tori around di world..
Na Jelilat Olawale, Faith Oshoko, Kareemot Salami, Onyinye Chime and Annette Arotiba bring una all di tori.
Good night.
Recap: Wetin di situation be today for Russia-Ukariane war?
Wia dis foto come from, Getty Images
Here be di latest developments so far today:
One senior US defence official tok some Russians don surrender
Russia foreign minister, Sergei Lavrov, receive diplomatic boycott for di United Nations for Geneva.
Many civilians for Ukraine exchange pen and keyboards for guns as dem ready to fight to death to protect dia kontri.
Di Russian
defence ministry bin warn residents of Kyiv say dem dey prepare to hit targets for
di capital
One large
plume of smoke rise near di capital city TV tower – e no dey clear if e dey
directly hit
One big
convoy of armoured vehicles dey move close to di city but dia progress dey
frustrate by breakdowns, analysts tok
Earlier
today one Russian missile hit government offices for Ukraine second city
Kharkiv, kill at least 10 pipo
Ukrainian
President Volodymyr Zelensky say no military targets for di area, and say
Russia dey commit war crimes.
E bin
address di European Parliament for videolink and beg for EU membership for
Ukraine
Di UN
refugee agency tok say more dan 660,000 pipo don japa from Ukraine so far
Nato chief
Jens Stoltenberg accuse Vladimir Putin say e "shatter peace for
Europe"
UK Prime
Minister Boris Johnson, for trip to Poland, say di Russian president dey engage
for "barbaric and indiscriminate" tactics wey target civilians
FG, ASUU hold tok to end one month strike
Wetin we call dis foto, ASUU president
Di Academic Staff Union of Universities and Nigeria goment delegation don resume tok on how to end di lingering ASUU strike.
Dis be di second time wey representatives from both group dey meet to chook mouth on top ASUU demand since dem declare dia one month warning strike on February 14.
ASUU go strike sake of say dem dey demand improved welfare, revitalisation of public universities and university autonomy and dem want goment to implement dia 2009.
Briefing tori pipo before dem enta close door meeting wey don last close to 5 hours, Emmanuel Osodeke say dem don tire to di sign memorandum of understanding and dat dem no ready to sign any letter or document again and dat dem want specific action from goment.
E explain give say if goment ready to tackle dia problem, three days dey enough to solve am.
E yarn give say di way dem di handle di education sector for di kontri, e fit cause wetin dey happun for Ukraine.
Di Minister of Labour and Productivity, Chris Ngige say goment go do everytin to ensure say dem shaperly resolve dia mata.
But e say e no happy on top di slow process wey ASUU group di handle di process wey go lead to di evaluation process for dia payment system wey be UTAS.
Ngige say di union dey delay di process to finalise wit di National Information Technology Development Agency (NITDA) wey be di agency wey dey in charge to test weda di payment system dey okay.
Some Russians don surrender but situation remain grave - US
Wia dis foto come from, Getty Images
One senior
US defence official don tok about di latest assesment of di Russian invasion,
as di Pentagon see am.
Dio official
bin report low morale among some Russians, wey still never establish air
superiority afta six days and never take over di port city of Mariupol. Some
units don surrender, di official tok.
However,
Russian troops don take di nearby port city of Berdyansk, and Metropol town
further inside di west.
Di Pentagon
add say:
Russia don
launch some 400 missiles, but di Ukrainian anti-missile defence system still dey
effective.
Launchers wey
fit dey used for thermobaric weapons don dey seen inside Ukraine, but US
intelligence no fit confam if any thermobaric weapons dey di country
Some 80% of
Russian troops wey bin don surround Ukraine now dey inside di country
Sign dey say
some Russian units dey run out of food and fuel
Aid dey flow
enter di country, but to establish one no-fly zone dey outside of possibility
of options ,di official tok.
Western ambassadors turn dia back waka comot from Russian foreign minister
Russia foreign minister, Sergei Lavrov, receive diplomatic boycott for di United Nations for Geneva.
Lavrov, wey bin dey address both di UN human rights council and di UN conference on disarmament, receive walkout as greeting by Western ambassadors just as im begin to speak.
Im bin dey look forward to striding di diplomatic stage again for Geneva - Europe closed airspace put full stop to dat.
Instead, wen im speech through video link begin to play, Western ambassadors waka comot - Oga Lavrov spoke to dia backs as dem dey waka comot.
Russia foreign minister den go, virtually, to di UN human rights council. Dia too di chamber dey empty.
Di irony: much of Lavrov speech na actually about security – or Russia idea of am.
E allege say Ukraine fit try to acquire nuclear weapons but no give evidence, come add say time for US missiles for Europe to go home don reach.
How di sanctions dey affect Russians
Pipo for Ukraine don exchange dia pen and keyboard for guns
Many civilians for Ukraine don exchange di pen and keyboards for guns as dem ready to fight to death to protect dia kontri.
Ukraine goment give thousands of weapons to civilians for di kontri capital Kyiv.
Wetin we call dis Video, Exchange pen and keyboards for guns