Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol

Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.

Live Coverage

  1. Kremlin demand make Ukraine recognise Crimea as Russia

    Dmitry Peskov, Russia's Presidential Spokesman

    Russia don say e fit stop operations at "any moment" if Ukraine meet Russian conditions.

    Kremlin tok-tok pesin Dmitry Peskov says Ukraine must recognise Crimea as Russian, and Donetsk and Luhansk as independent states.

    In addition to dis, Peskov say Ukraine must amend im constitution and reject claims to enta any bloc (like Nato, for example).

    E add say Russia go finish di "demilitarisation" of Ukraine, and if dem meet dis conditions Russia military action go "stop in a moment".

    Kremlin tok-tok pesin insist say Russia no get plans to make any more territorial claims on Ukraine.

    Russia takeover Crimea for March 2014, and weeks later im throw im support behind pro-Russia separatists for Ukraine eastern Donetsk and Luhansk regions.

  2. Zelensky ask kontris make dem no buy Russia oil

    Ukraine President Zelensky dey call for more sanctions against Russia.

    During im daily briefing, Zelensky says di continuous invasion show say "Russia neva abandon im plans against Ukraine" - therefore, im add, "we need new sanctions package".

    Zelensky dey call for "a boycott of Russian exports, in particular e want make pipo reject oil and gas products from Russia".

    E add say dem fit call dis tougher measures "embargo, or just morality".

    President Zelensky

    Wia dis foto come from, Getty Images

  3. Trapped Africans dey drink melted snow for Ukraine city

    Sumy city dey without water and electricity

    Wia dis foto come from, Reuters

    Nigerian, Ghanaian and Somali students dey among hundreds of foreign nationals wey dey stuck for Ukraine north-eastern city of Sumy wey Russian forces dey hit for days now.

    No food for di market, cashpoints no dey work and di students dey drink melted snow afta dem run out of water.

    One Indian student, Vipin Yadav, wey be part of di group wey dey trapped for di city, estimate say about 1,300 foreign students still dey trapped for dia including pipo from Bangladesh, Pakistan and Turkey.

    For one phone interview, Mr Yadav tell BBC Danny Aeberhard say notin dey to eat for di last four to five days.

    Nigerian and Ghanaian goment don dey commot dia nationals wey dey japa from di conflict for Ukraine. Di first groups bin arrive back home last week.

    More dan 1,000 Ghanaian students dey live for Ukraine until Russia invade di kontri. Di West African nation so far make two repatriation missions.

    Nigeria dey expected to evacuate 5,000 citizens wey cross from Ukraine to di neighbouring kontries of Romania, Poland and Hungary.

  4. Goment ban Nigerians from going to fight for Ukraine

    Ukranian embassy

    Wia dis foto come from, EPA

    Nigeria don tok say di kontri no go allow dia nationals to dey enlisted to fight for Ukraine wia Russian forces dey bomb cities and scata neighbourhoods wit gunfire.

    Dis one dey follow reports of one allege recruitment of volunteers for di kontri to fight on di side of Ukraine.

    Nigeria foreign ministry say di Ukrainian embassy bin deny say dem get hand for di alleged exercise.

    But di embassy confam say some Nigerians bin approach dem to show willingness to join di war, according to one ministry statement.

    Di embassy also distance demself from claims say dem dey request $1,000 (£800) from each Nigerian volunteer for air ticket and visa.

    "Nigeria discourage di use of mercenaries anywia in di world and no go tolerate di recruitment, for Nigeria, of Nigerians as mercenaries to fight for Ukraine or anywia else for dis world," di ministry tok-tok pesin explain..

    Dis dey come days afta Senegal warn against volunteers wey dey enlist to fight against Russians for Ukraine.

    Dem also order di Ukrainian ambassador to take down one Facebook post wey don call on Senegalese volunteers to enlist to di war.

  5. Nigerian man say im never hear from di 'love of im life' since war start

    Musa and im babe

    Wia dis foto come from, Ibrahim Aliyu Musa

    Ibrahim Aliyu Musa spend five years for Ukraine between 2010 to 2015 as e travel to study Nursing for Ternopil university for the eastern European kontri.

    For 2012, Ibrahim wey speak exclusively to BBC Pidgin say fate connect am to Olya Vladimir as dem jam for market.

    “Like play like play ordinary meeting for market wia we chat and exchange numbers come turn to friendship and from dia something more serious.

    We come become very close and even as I come back for 2015, we continue to keep in touch until few days before dis war start.”

    Ibrahim wey be director for school nursing wey dey for Kwankwaso town for Kano yan say e dey really miss Olya and some oda friends wey e make during im time dia.

    “I miss her a lot and my wish na to re-connect with her also i never hear from some of my friends like Dr. Natasha and Mariyana and everyday my hope be say dem dey safe.”

    Ibrahim hail Ukraine as very hospitable kontri wey get amazing quality of education and na why many Africans dey rush go dia.

    Ibrahim say im and Olya chat two days before di Russia invasion begin and she assure am say she dey safe.

    “Just two days before dis kasala start na im we chat and she assure me say she dey okay but unfortunately, I no fit reach her since start of dis war.” E tok.

  6. Five ways di war for Ukraine fit end

  7. Which kontris Ukrainians dey run enta?

    For wetin United Nations don call Europe fastest growing refugee crisis since World War Two, more dan 1.7 million civilians don run comot Russia sake of Russia invasion.

    Di European Union say up to four million pipo fit still try comot di kontri.

    So wia all dis pipo dey enta?

    Refugees dey mostly pack demselves go West especially to Poland and also Romania, Slovakia, Hungary and Moldova. Smaller numbers sha dey enta Russia and Belarus.

    Which kontris Ukrainians dey run enta?
  8. Wetin dey happun for Ukraine?

    If you just dey join us, dis be wetin don happun over di last few hours:

    • Russia say dem go open new humanitarian corridors for different Ukrainian cities, including di capital Kyiv, on Monday to allow civilians to commot - e dey come days afta di same attempts for Mariupol fail afta shelling continue from Russia forces during di ceasefire hours wey dem agree, according to Ukraine
    • Ukraine President Volodymyr Zelensky don accuse Russia say e dey kill civilians, afta one Russian attack on Sunday for Irpin kill one young family
    • Ukraine defence officials claim say dia forces don re-take di eastern city of Chuhuiv
    • Renewed Russian shelling happun for di southern port city of Mykolaiv
    • Di UK don tok say dem go give extra $100m (£74m) to Ukraine to helep keep di government running inside di Russian invasion
    • Oil price don go up to di highest level since 2008 afta di US say dem dey discuss potential embargo on Russian supplies wit allies.
  9. Court deny Adedoyin and six odas bail application for Timothy Adegoke murder case

    Di suspects in court
    Wetin we call dis foto, Di suspects in court

    For Nigeria, di Osun State high court on Monday 7, March refuse di bail applications for Rahmon Adedoyin and seven odas wey dey charged in di murder case of Timothy Adegoke, one master student of Obafemi Awolowo university, Ile-ife wey dem allegedly kill for di Hilton Royal Hotel, Ile-Ife.

    Di presiding judge wey be di chief judge of Osun state, Justice Adepele Ojo for her ruling refuse dia bail applications base on di nature of di case and on di ground say di correctional centre get all di necessary facilities to cater for those wit medical conditions wey dey "not critical".

    Di owner of Hilton Hotel and Oduduwa University Ile-Ife, Adedoyin and six odas dey face 11 count charge wey include murder wey dem don plead not guilty too.

    Dem bring di suspects come court on Monday wen di trial also begin from Ilesa Correctional Facility wia dem bin order make dem dey remanded.

    Di wife and broda of di late Adegoke also bin dey court.

  10. India doctor wey dey stranded wit one jaguar and panther

    Russian-Ukranian invasion

    Wia dis foto come from, GIRIKUMAL PATIL

    For more dan one week, one Indian doctor for war-torn Ukraine don dey holed up for basement at home wit im pet big cats - one black panther and one jaguar.

    Girikumar Patil, wey bin buy di two cats from Kyiv zoo about 20 months ago say e no go commot home without im pets.

    E don live for over six years for Severodonetsk, one small town wey dey located for di Donbas region of eastern Ukraine.

    After di war begin, Mr Giri, wey dey single, bin dey only come out of im cramped basement to buy food for im cats - di male jaguar be 20 months old and di female panther be six-month-old cub - afta di curfew end early in di morning. (Di jaguar na one rare hybrid between one male leopard and one female jaguar, e tok.)

    So far, Mr Giri say e don buy 23kg of sheep, turkey and chicken meat from neighbouring villages at prices four times higher dan normal.

    "My big cats bin dey spend nights wit me inside di basement wit me. E bin get plenti bombing wey dey happun around us. Di cats dey fear. Dem dey chop less. I no fit leave dem," Oga Patil, wey be 40 years old, tok.

    "Dis be di second war I dey live through. But dis one dey scarier". E tok.

    Oga Giri say e bin earlier dey live for Luhansk, where Russian-backed rebels bin dey fight Ukrainian troops since 2014 despite one ceasefire agreement. During di fight for di region, im house and one Indian restaurant wey e open for di area dey destroyed, e tok.

    He come move to Severodonetsk, about 100km (62 miles) away, buy new place, begin practise medicine and buy im new pets.

    "Now I dey stuck in a war zone. Dis time I dey really worried. My parents don dey call me and ask me to come home, but I no fit leave di animals," Mr Patil tok.

    Russian-Ukranian invasion

    Wia dis foto come from, GIRIKUMAL PATIL

  11. Nigeria to evacuate Nigerian students wey hook for Sumy

    Nigeria goment go from today begin evacuate Nigerian students wey trap for Sumy for Ukraine.

    Sumy na one of di cities wey dey currently under significant attack from Russian military.

    Skip X post, 1
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 1

    Skip X post, 2
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 2

    Nigeria goment chook mouth ontop di mata as one video go viral wey show Nigerian students dey call for help to evacuate dem from di city.

    Skip X post, 3
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 3

    Skip X post, 4
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 4

    Skip X post, 5
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 5

  12. Russia say dem go hold fire to allow civilians escape

    Russia go open new humanitarian corridors across multiple Ukrainian cities on Monday to allow civilians to evacuate, na so state media dey report.

    Di ceasefire go take place from 10:00 local time according to Russia defence ministry, with evacuation routes wey dem set up for di capital Kyiv, as well as Kharkiv, Mariupol and Sumy.

    All of dis cities dey currently under significant Russian assault operation.

    Ukrainian officials never yet confam dis.

    Over di weekend, two efforts to open a route to allow civilians to evacuate from Mariupol for di kontri south-east collapse.

    Ukraine officials say dis na because Russia continue to dey shell di city during di agreed ceasefire hours.

  13. Russia invasion Day 12..., Wetin you need to know

    Soja dey ride armoured personnel carrier

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Before we go on, make we give you di load down of wetin you fit don miss as di Russian invasion of Ukraine enta di 12th day:

    • UK defence officials say dem believe say Russian forces make small gains over di last 48 hours, wit dia troops wey face strong Ukrainian resistance and poor logistical support
    • But Ukrainian commanders don warn say Russian forces dey regroup and dey prepare to launch big attack on di capital Kyiv
    • Moscow forces dey attack towns near di city and dey re-suppl tank units with fuel dem move in from Belarus in preparation for di attack, officials tok
    • For di south-eastern city of Mariupol, Russian shelling don kill dozens of pipo and Ukrainian President Volodymyr Zelensky don warn Moscow troops say im forces go pursue any soja wey commit war crimes to di grave
    • Senator Marco Rubio, di highest-ranking Republican for di Senate Intelligence Committee, tell CNN on Sunday say to impose a no-fly zone over Ukraine go almost certainly mean "starting World War Three”
    • Sanctions continue to dey target Moscow economy, with Netflix, American Express, KPMG and PricewaterhouseCoopers among di latest major companies to suspend services in Russia
  14. Good morning!

    Una welcome to our live coverage today of tori from around di world.

    We go bring una tori from Nigeria, across Africa and di rest of di world.

    Di biggest tori for di world na still di Russian invasion of Ukraine.

    Today na day 12 since President Vladimir Putin send troops enta Ukraine.

    We go bring una all di latest wey dey happun wit dat tori as we dey get dem including oda top gist from around di world.

  15. All wey happun dis weekend for Ukraine-Russia war

  16. Make British pipo consider leaving Russia - UK Foreign Office

    British pipo wey dia presence for Russia no dey essential don get strong advise to consider leaving, UK Foreign Office don tok.

    UK Foreign Office say make dem pass through di remaining commercial routes.

    Di office also advise dia kontri men make dem travel to Russia.

    E advise any British kontri man wey need consular assistance make e call di British Embassy for Moscow.

  17. Loudspeakers for Mariupol announce postponement of evacuation

    More informate from Mariupol city council on di postponement of di evacuation from di city.

    For one post on Telegram, di council say police dey use loudspeakers to inform residents of di latest information on di evacuation and im postponement.

    Di post say negotiations dey happun currently wit Russia over establishing ceasefire and making sure safe humanitarian corridor out of di city dey.

    Earlier, both Ukraine and Russia say dem don agree on temporary ceasefire around cities of Mariupol and Volnovakha.

    But deputy mayor of Mariupol and one resident for di city both told tell BBC say Russian forces continue dia bombardment.

    Areas under Russia control
  18. Samsung and Paypal stop business for Russia

    Foto of Samsung and PayPal

    Samsung and Paypal don become di latest global businesses to change dia operations for Russia.

    Samsung wey be di leading supplier of smartphones for Russia go suspend shipments to di kontri "due to current geopolitical developments."

    Tori be say Ukraine vice prime minister, Mykhailo Fedorov, wey dey responsible for digital operations, write to Samsung vice chairman to ask di Korean tech giant to temporarily cease supplying services and products to Russia.

    “We believe say dis kain actions go motivate di youth and active population of Russia to proactively stop di disgraceful military aggression,” Fedorov tok for letter wey im post on Friday on im Twitter account.

    For one statement di South Korea company say e go “continue to actively monitor di complex situation to determine im next steps.”

    E neva clear if Samsung shops go close.

    Meanwhile, di online payments company Paypal don also close down services for Russia sake of the war.

    "Under di current circumstances, we dey suspend PayPal services for Russia," President and Chief Executive Dan Schulman tok for statement. Im add say di company "stand wit international community condemn Russia violent military aggression for Ukraine."

    One company tok tok pesin say PayPal go support withdrawals "for a period of time, to make sure say account balances disperse in line wit applicable laws and regulations.”

    Ukraine goment officials don bin dey call on PayPal to leave Russia and help dem wit fundraising.

  19. Ukraine don top Winter Paralympics medal table

    Ukraine don top di medal table on di first day of di Winter Paralympics for Beijing, with three golds and seven medals overall.

    Di kontri delegation wey include 20 Athletes travel to China despite di Russian invasion.

    Biathlete Grygorii Vovchynskyi na im win Ukraine first medal in di men's sprint. Im dedicate im race to peace in Ukraine.

    Dem ban Russian and Belarusian athletes from di competition.