Di Russian invasion
of Ukraine don enta di 10th day. Dis na di recap of di major developments since
di invasion begin:
·Di number of civilian casualties still dey unclear but di UN refugee
agency tok say more dan one million pipo don run komot from Ukraine since
February 24 and millions more dey on di move.
·Di first major Ukrainian city wey fall na Kherson. Di city dey where the
Dnieper river meets the Black Sea.
·Russian missiles bin don dey target di capital Kyiv and di
second-largest city Kharkiv. One massive armoured convoy approaching Kyiv by
road dey currently stalled.
·Di southern port of Mariupol still dey under siege and Russian troops dey
head towards anoda port, Odesa – to capture both go cut off Ukraine maritime
access.
·Russian troops don also seize di Zaporizhzhia nuclear plant on Friday after
dem shell am for hours. Di Zaporizhzhia nuclear plant na di largest for Europe.
Di move bin alarm world leaders who tok say di attack fit cause kasala.
·Di Chernobyl plant, di site of di 1986 nuclear accident, also dey under
Russian control.
·Ukraine President Volodymr Zelensky don condemn di West for dia refusal
to enforce no-fly zone over im kontri. Im tok say "all di pipo wey go die go
die because of you".
·Di US and EU don impose sanctions on Russia. Dem freeze Russian assets
and target di kontri central bank and President Vladimir Putin and im inner
circle. Di rouble don go down sake of di restrictions wey also hit trade,
investments and travel.
·Independent media wey include di BBC don suspend dia work in Russia after
di kontri approve one draconian law wey go censor reporting of di war for
Ukraine.
·Companies like Samsung, Airbnb and Cartier don suspend exports to / or
operations for Russia.