Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol

Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.

Live Coverage

  1. 800,000 pikin dem dey among two million wey dey run from Ukraine: Save the Children

    One boy, Hassan, wey be 11, arrive safely for Slovakia yesterday afta a 1,200km journey on im own

    Wia dis foto come from, Slovak Interior Ministry

    Wetin we call dis foto, One boy, Hassan, wey be 11, arrive safely for Slovakia yesterday afta a 1,200km journey on im own

    Save The Children say an estimated number of 800,000 pikin dem dey among di two million pipo wey don run comot Ukraine afta Russia invasion begin.

    Many of dem dey make di trip on dia own di agency don warn.

    “Parents dey take di most desperate, heart-breaking measures to protect dia pikin. Dis one include to dey send dia pikin away with neighbours and friends, to seek safety outside of Ukraine, while dem stay home to protect dia homes,” na so Irina Saghoyan from di NGO tok.

    Report come yesterday of one of such case– one 11-year-old boy, Hassan, wey leave im home for Zaporizhzhia on im own because im mama no fit leave im grandmother,

    He arrive safely for Slovakia, afta one 1,200km train journey, e carry just two small bags, im passport, and im relatives phone number wey im write for im hand.

    Dem write Hassan relative for Slovakia im number for im hand

    Wia dis foto come from, Slovak Interior Ministry

    Wetin we call dis foto, Dem write Hassan relative for Slovakia im number for im hand

    More dan half of di refugees wey dey leave Ukraine dey go Poland, and den Hungary and Slovakia.

  2. Wetin dey happun for Ukraine?

    Pipo dey run comot from one city for Ukraine wey come under attack

    Wia dis foto come from, reuters

    Na Day 14 of Russia full-scale invasion of Ukraine. See wetin you need to know about di main developments in di last 12 hours:

    • Reports say air sirens sound on Wednesday morning for several Ukrainian cities, including di capital Kyiv
    • Both evacuation stages from di north-eastern city of Sumy - wey for days bin don dey under serious Russian shelling - dey successfully completed, Ukraine tok
    • Ukrainian President Volodymyr Zelensky give one ogbonge address from im office for Kyiv to UK lawmakers for di House of Commons
    • E refer to Winston Churchill, wia e warn Russia say "we go fight for di forests, for di fields, on di shores, for di streets"
    • US President Joe Biden announce a complete US ban on Russian oil, gas and coal imports
    • UN say two million refugees now don run go Ukraine - in wetin now don become di fastest growing refugees crisis for Europe since World War Two
    • McDonald's, Starbucks and Coca-Cola become di latest Western companies to stop dia work for Russia
  3. Una good morning

    Una welcome to our live coverage today of tori from around di world.

    We go bring una tori from Nigeria, across Africa and di rest of di world.

    Di world eye still dey Ukraine afta Russian invade dem.

    Today make am 14 days - Two weeks since di invasion.

  4. Good Night

    We go end today Live Page here.

    No forget to scroll down to read all di tori wey you miss out during di day.

    Na Faith, Helen, Victor, Dooshima and Onyinye bring una all di tori for today.

    Una bye bye for now!

  5. President Zelensky speak to UK MPs

    President Volodymyr Zelensky address united Kingdom House of Commons and promise to continue fighting against Russia.

    Two weeks afta di invasion of Ukraine begin, Zelensky quote William Shakespeare, thank Boris Johnson and call for more sanctions on Russia.

    Di leader spoke virtually from Ukraine capital – dis na di first time wey foreign leader dey address Members of Parliament inside chamber.

    "We no go give up and we no go lose. We go continue fighting for our land, whatever di cost."

    President Volodymyr Zelenskey
  6. PDP announce replacement for Govnor Umahi and im Deputy

    PDP

    Wia dis foto come from, PDP

    Wetin we call dis foto, PDP make di announcement as e address tori pipo for di capital

    Nigeria main opposition party, PDP don submit di name of Iduma Igariwe and Fred Udogwu as govnor and deputy govnor of Ebonyi State to Independent National Electoral Comission (INEC).

    National chirman of di party Iyorchia Ayu say dem select dem afta plenti consultation within di party and in line wit di court order for di party to submit replacement for both di govnor and deputy seat.

    Ayu make di announcement afta di Federal High Court for Abuja declare di porting of Ebonyi state govnor and im deputy govnor illegal, null and unconstitutional.

    Justice Inyang Ekwo make dis judgement based on case wey PDP file to ask for di removal of govnor and im deputy from office.

  7. Bamise: Lagos state govnor say ‘no plan to cover up’

    Wetin we call dis Video, Lagos state govnor Babajide Sanwo-Olu tok about Bamise mata

    Lagos state goment say dem no get any plan to cover-up di investigation concerning di killing of late Ayanwole Bamise, di 22-year old fashion designer.

    Govnor Babajide Sanwo-Olu wey tok one wen e dey yarn wit tori pipo on Tuesday, say goment no go fit cover up any tin wey concern di killing of Ayanwole Bamise wey die as as she enter BRT bus.

    Police confam di arrest di BRT driver wey carry 22-year-old Oluwabamise Ayanwole on Monday.

  8. UK Parliament give President Zelensky standing ovation

    Ukraine president Volodymyr Zelensky dey address UK MP

    Wia dis foto come from, UK Parliamentary Recording Unit

    Ukrainian President Volodymyr Zelensky don receive ovation from British politicians for di UK House of Commons.

    Zelensky wey tok to di House of Commons through live video link compare Ukraine fight against Russia to di British war against Nazi Germany for World War Two.

    "Una no wan lose una kontri wen Nazis wan take una kontri and una need to fight for Britain," e tok.

    E call for more sanctions especially di ones wey go keep dia sky “safe”.

    "We no go give up and we no go lose. We go continue to fight for our land, whatever di cost," President Zelensky

    Responding to Zelensky speech to di MPs, UK Prime Minister Boris Johnson say ordinary Ukrainians dey inspire millions by dia courage.

  9. Desperate attempts to run from home unda heavy Russian fire

    Children and adults wey dey run from Russian bombardments near di Ukrane capital don dey forced to escape while shooting dey happun.

    Families gats waka 20 kilometres to Kyiv, as dem dey find cover from shelling. Some children and adults don die.

    Di BBC follow groups wey climb ova one destroyed bridge for di town of Irpin, near wia one huge Russian convoy arrange demsef.

    Wetin we call dis Video, Desperate attempts to run from home unda heavy Russian fire
  10. US announce ban on Russian oil

    President Joe Biden don announce a complete US ban on Russian oil, gas and importation of coal.

    E say di move mean say "American pipo go deal anoda powerful blow" to Putin leadership.

    "We no go dey part of subsidising Putin war," Biden add.

    Despite mounting fears of rising gas price, all di different political party for di US accept dis action.

    Oil prices don begin increase ahead of Biden announcement - wit di price of brent crude, di international benchmark, rising more dan 5%, to $130 per barrel.

    President Joe Biden during im address

    Wia dis foto come from, Pool

  11. 'Make una ignore dat judgment’ , Umahi tell Ebonyi pipo

    Wetin we call dis Video, Ebonyi govnor Dave Umahi react

    Ebonyi state govnor, Dave Umahi say di judgement of Justice Inyang Ekwo no fit remove am as govnor of di state.

    Oga Umahi for interview e do wit tori pipo for Abakaliki, di state capital say nobody fit sue govnor on di basis of im election afta di tribunal.

    E add say di Nigerian constitution don tok how dem fit take remove governor wey pipo elect.

    On Tuesday, one federal High Court for Abuja declare di porting of Ebonyi state govnor and im deputy govnor illegal, null and unconstitutional.

  12. Six-year old girl die from lack of water - Mariupol mayor

    Di mayor of di city of Mariupol wey troops don subdue, Vadym Boychenko, say dem pull out di body of one six-year-old girl wey her name na Tanya from di wreak of one residential building wey bomb touch.

    E say di girl die from lack of water.

    “Her mother bin don already die. We no know how long di girl dey fight for her life. We no fit imagine how much suffering she endurre bear. For di last minutes of her life she dey alone, weak, fear, and thirsty.”

    Di mayor say President Volodymyr Zelensky also mention di tori of di girl earlier today for im address, saying wetin happun to girl na “one of many tragic tori of Mariupol, di city swey dey blockade for di past eight days”.

  13. Court no fit remove me from power - Dave Umahi

    Ebonyi state govnor, Dave Umahi say im go appeal di decision of di Federal High Court for Abuja wey sack am sake of im defect or port go APC.

    On Tuesday, di Abuja High Court declare di porting of Ebonyi state govnor and im deputy govnor illegal, null and unconstitutional.

    Justice Inyang Ekwo make dis judgement based on case wey PDP file to ask for di removal of govnor and im deputy from office.

  14. Sumy road don open – if you go fit make am to di meeting point

    Buses position for di outskirts of Sumy, dey wait to carry pipo comot from di city

    Wia dis foto come from, Reuters

    Wetin we call dis foto, Buses position for di outskirts of Sumy, dey wait to carry pipo comot from di city

    Buses wey dey carry pipo wey wan escape from di northeastern city of Sumy don dey road and dem dey go di central city of Poltava, according to Ukrainian authorities say. Dem bin stop small sake of shooting wey bin shele as dem dey try cross di Ukrainian checkpoint.

    Russian military vehicles bin just show and start dey shoot but dem no aim di buses na so di head of Sumy administration Dmytro Zhyvytskiy tok.

    E no dey clear if anybody injure.

    Inside Sumy, pipo still dey struggle to reach di meeting point for evacuations - e dey shele for di outside parts of di city.

    BBC bin tok to Otunla Samuel wey dey study for di Sumy National Agrarian University and dey trapped inside bunker wit 60 oda international students.

    E bin tok say dem dey trapped and movement for dat side dey risky as di side dey suffer serious military attacks.

    Im bin dey hope for goment response to rescue im and di oda students before dem run out of supplies.

  15. US dey expected to ban importation of Russian oil

    US President Joe Biden and Vlamdir Putin of Russia during last physical meeting

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, US President Joe Biden and Vlamdir Putin of Russia during last physical meeting

    US President Joe Biden dey expected to announce ban on US importation of Russian oil later today.

    Di announcement wey fit happen anytime soon go become di latest latest sanction in response to Moscow invasion of Ukraine.

    Di White House say Biden go speak at 15:45 GMT to "announce actions to continue to hold Russia accountable for dia unprovoked and unjustified war on Ukraine" .

    Biden administration don dey under increased pressure from US lawmakers to take dis step.

  16. Bamise Awanwole: Protests ova killing of 22-year-old BRT Bus passenger for Lagos

    Protest over killing of 22 year-ol Bamise for Ayobo area of Lagos
    Wetin we call dis foto, Protest over killing of 22 year-ol Bamise for Ayobo area of Lagos

    Many sympathisers and well wishers enta street for Ayobo area of Lagos state, southwest Nigeria to protest di killing of 22-year-old Bamise Awanwole wey miss afta she bin enta BRT bus on 26 February.

    Police announce on 7 March comfam inside statement say dem don find her deadi bodi and investigations don start.

    As pipo hear di news of her death, na fear and para dey dia bodi as dem don dey wonder weda dem go feel safe for public transport.

    Anoda protest suppose happen for Ojota area of di state, but di heavy security presence, no give pipo mind to arrange anytin on di mata.

    As e be so, di Lagos state Govnor, Babajide Sanwo-Olu don promise say dem go do evri-evri to help Bamise family seek justice.

    See more fotos of di protest:

    Protest over killing of 22 year-ol Bamise for Ayobo area of Lagos
    Protest over killing of 22 year-ol Bamise for Ayobo area of Lagos
    Protest over killing of 22 year-ol Bamise for Ayobo area of Lagos
  17. Nigerian lawmakers make u-turn on top gender bills dem bin reject

    House of Representatives

    Wia dis foto come from, NASS

    Di House of Representatives don reverse itsef on three gender-related bills wey fail to pass for di ongoing amendments to di 1999 Constitution.

    Di Speaker, Femi Gbajabiamila, call for cancellation of votes on di affected bills after di lawmakers hold one executive (closed-door) session on Tuesday.

    While na five gender bills dem bin reject, di ones dem wan revisit na: Bill 36 to “expand di scope of citizenship by registration;” Bill 37 to “provide for affirmative action for women in political party administration;” Bill 38 to “provide criteria for qualification to become an indigene of a state in Nigeria.”

    Di ones dem drop na Bill 35 to “provide for special seat for women for di National and State Houses of Assembly;” and Bill 68 “to give women a quota for di federal and state executive councils or ministerial and commissionership seats.”

    Gbajabiamila say dem go include di three bills for di second batch of amendment bills wey dem go consider in about four weeks’ time.

    After di lawmakers unanimously approve di reversal by voice vote, female members of di House as well as some male members give di Speaker a standing ovation.

    Lawmakers for di two chambers on Tuesday last week, bin don vote on di 68 recommendations by di Joint Senate and House Special Ad Hoc Committee on di Review of di 1999 Constitution.

    Di gender bills fail despite say wife of di President, Aisha Buhari and some female ministers go di NASS to lobby di lawmakers and di fact say Vice President wife, Dolapo Osinbajo and minister of Women Affairs, Pauline Tallen bin dey korokoro to observe as members of di House vote on di recommendations.

  18. Nigerian Association of women journalists mark IWD 2022

    To mark di international women’s day 2022, di Nigerian Association of women journalists Rivers State along wit National Youth Council of Nigeria and oda groups do protest waka go di Rivers State House of Assembly.

    Di women say dem no happy wit di way National Assembly reject di five gender bills wey dey promote women rights and di active participation of women for politics.

    ‘No society fit grow without recognizing di rights of women’ - Speaker RSHA
    Wetin we call dis foto, Speaker RSHA say di Assembly stand with women as dem don pass bills wey uphold di rights of women
    RSHA say women rights na human rights
    Wetin we call dis foto, RSHA don pass many bills wey protect di rights of women
  19. Wia Ukraine citizens dey run dey go?

    United Nations latest report say ova two million pipo don run comot di fight for Ukraine.

    See map of wia dem dey go.

    Ukraine Map
  20. Two Million Pipo don run comot Ukraine - UN

    Pipo wey dey comot Ukraine

    Wia dis foto come from, EPA

    Di number of refugees wey don run comot di war for Ukraine don pass two million, according to wetin United Nations tell BBC.

    Filippo Grandi, wey be di UN High Commissioner for Refugees, bin call di way pipo dey run comot Ukraine say na di fastest growing refugee crisis for Europe since World War Two.

    So far Poland don reveal say e pass 1.2 million refugees wey don enta dia kontri.