Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol

Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.

Live Coverage

  1. Bye bye!

    Na here we go end today Live Page.

    We don bring you report say 97 children naim don die since di Russian invasion of Ukraine start according to Ukraine's president, Zelensky.

    Woman land behind bars ova accuse she burn her lover pikin nyash.

    Ukraine-Russia war dey make Kenyans pay more for fuel.

    You fit scroll down to read all di tori wey you miss out during di day.

    Na Jelilat, Helen, Ronke, Faith and Tunde bring una all di tori for today.

  2. How many nuclear weapons Russia get plus list of oda kontries wey get too

  3. Russia journalist wey interrupt news wit anti-war placard don chop fine

  4. EFCC arraign man for alleged 19 Million naira fraud, Mohammed Abdullahi Kulloma kolet di money on false pretence

      • Author, Tamara Ebiwei
      • Role, BBC News Pidgin

    Nigeria corruption Police EFCC don arraign one man for alleged N19m fraud for Maiduguri, Northern Nigeria.

    Mr Muhammad Abdullahi Kulloma and Mbuta Criterion Nigerian Limited na im dem arraign before Justice Umaru Fadawu for di Borno State High Court, Maiduguri.

    Na two count chargesdem arraign dem for wey include obtaining Nineteen Million, Nine Hundred and Fifty Thousand Naira (N19, 950,000) by false pretence.

    Di Maiduguri Zonal Command of EFCC, on Tuesday, March 15, 2022, arraign one of di defendant wey use mago-magokolet di money from Abdulwahad Abba Aji, as payment for contract wey dem award di second defendant to supply water pumps to Norwegian Refugee Council, one Non-Governmental Organisation.

    Muhammed Abdullahi Kulloma wit im EFCC crime tag

    Wia dis foto come from, EFCC

  5. Wetin don happun today for Russian invasion of Ukraine?

    In case you just dey join us, see wetin happun on di 20th day of Russian invasion of Ukraine:

    • Ukraine President Volodymyr Zelensky tok say make Ukraine accept say dem no go join Nato. Im say Ukrainians dey adequate and dem understand say dem no be Nato member.
    • During im address to MPs, di Ukrainian president tok say 97 children don die since di Russian invasion of Ukraine start.
    • One woman for Ukraine called Anna Tymchenko bin born her first pikin for inside heavy bombing for her one sitting room without light, running water or even doctor.
    • Ukraine President Volodymr Zelensky tell European leaders for London say dem dey rely for di support of dia international partners and not Nato.
    • As Ukrainian refugees enta three million, 70 buses bin go Sumy to rescue civilians.
    • Di mayor of Kyiv, Vitali Klitschko tok say four pipo die afta airstrikes hit di capital overnight. Klitschko yarn dis one ontop Telegram.
    • Ukrainian President Volodymyr Zelensky bin tell Russian soldiers to surrender.
    • Prime ministers of Poland, Czech and Slovenia bin travel by train to Kyiv for tok-tok wit Ukraine president and prime minister.
    • Di EU bin unveil dia fourth package of sanctions against Kremlin. Dis time di target na luxury goods exports as well as investments for Russia energy sector.
    • Russian missile bin hit more residential building for Kyiv dis morning. Ukraine authorities bin release foto of di damage.
    • Advisor to di Ukrainian president chief of staff, Oleksiy Arestovich tok say e expect di war to end by early May latest, wen Russia run out of money to attack dia neighbour.
  6. Russian TV journalist don resign

      • Author, Tamara Ebiwei
      • Role, BBC News Pidgin
    MARINA OVSYANNIKOVA

    Wia dis foto come from, MARINA OVSYANNIKOVA

    One ogbonge TV journalist wey dey work for Television station wey Kremlin dey control don resign.

    Di journalist resign sake of di screen protest wey Channel One journalist Marina Ovsyannikova do.

    Vadim Glusker, NTV Brussels correspondent don confam di resignation by state news agency RIA Novosti.

    NTV tell RIA Novosti say Glusker don stop to work for dem “since early March” and say im decision “na sake of health reasons” NTV na di third Television Station wey popular well well and ogbonge gas company Gazprom na im get am and na ogbonge pro-Kremlin.

    Tori still dey fly upandan say Zhanna Agalakova Channel One correspondent for Paris don resign too, but dem neva confam dis one.

    Well tell una before say one news presenter from NTV resign come waka comot from di kontri

  7. Zelensky say make Ukraine accept say dem no go join Nato

    Zelensky tok say make Ukraine accept say dem no go join Nato

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Ukraine President Volodymyr Zelensky

    Ukraine President Volodymyr Zelensky don appear to suggest say make di kontri accept say dem no go join di Nato military alliance.

    Di Ukrainian president bin speak for one video conference wit military officials earlier today.

    Im tok: "Ukraine no be member of Nato. We understand am. We be adequate pipo."

    Di president continue: "We don hear for years say di doors dey open, but we also hear say we no fit join. Na di truth and e gass dey recognised.

    "I dey glad say our pipo don dey begin to understand am and rely on diasef and our partners wey help us.”

    Before di invasion, Vladimir Putin bin don demand say make dem ban Ukraine from ever joining Nato, as one of di “security guarantees” Moscow bin dey seek.

  8. 97 children don die since Russian invasion of Ukraine - Zelensky

    During im address to Canadian MPs, Zelensky say almost a hundred pikin don die during Russian's invasion of Ukraine.

    Ukraine's president tok say di southern besieged city of Mariupol don dey without communication networks and dey nearly running out of food.

    Zelensky add say 97 children don dey reportedly killed since di war begin

  9. Ukraine war: Baby Alisa come di world as bombing bin dey go on outside

    Anna Tymchenko and her pikin Alisa

    21 year old Anna Tymchenko bin born her first pikin for inside heavy bombing for her won sitting room without light, running water or even doctor.

    Tori be say as dem bin dey born di pikin afta Russian soldiers hold dia doctor, baby Alisa bin dey blue and dem need to slap am plenti times before she start to cry.

    She bin dey stay for one town wey dem dey call Bucha, with her husband and brother,

    Di town dey close to di Ukraine capital Kyiv and don suffer severe bombing since di war start.

    Anna with heavy belle for January before di war start
    Wetin we call dis foto, Anna with heavy belle for January before di war start

    Because of dat, Anna, her husband and brother bin dey stay for di basement of her apartment, till dey take di light and di place become very cold.

    Na so dem return back to dia house afta attempt to run comot di town meet Russian convoy hold up.

    So dem go back house to born her first dauhter with candles for light and cold water wey dem fit get from inside bottles.

    Anna say she and her pikin dey fine as dem don fit reach di capital of Kyiv tow days afta she born, however dem no fit leave di kontri, and dat one dey fear here.

  10. Suspected thief chop arrest afta im sleep off inside di car e break into

    One man wey fall asleep for inside di motor wey im allegedly break into don chop arrest for Phoenix, north of Durban for South Africa on Monday.

    KwaZulu-Natal VIP Protection Services’ confam di incident for one Facebook post say dem find di man dey sleep inside di motor for Kranpalm Close for Palmview.

    “Na resident wey see say pesin don break into di car alert us. Dem see di suspect dey sleep inside di car afta im allegedly attempt to tiff valuables,” dem tok.

    KZN VIP Protection Services say dem detain di man and hand am over to di police.

  11. Di Nigerian doctor wey dey try to help Africans for Ukraine

    Wetin we call dis Video, Di Nigerian doctor wey dey try to help Africans for Ukraine

    Nigerian Dr Awofaa Gogo-Abite don live for Ukraine for 14 years.

    Im work as a surgeon and lecturer. Im run from di kontri sake of di war and feem im jony to Poland.

    For interview wit BBC, e share im experience about di racism im face for border and how im wan help others wey dey face di arduous journey.

  12. woman wey allegedly maltreat lover pikin dey behind bars- Kogi goment

    One boy lie for ground

    Wia dis foto come from, Kogi state Govt.

    Kogi State goment don order di arrest and prosecution of one woman, Elizabeth Abu, wey allegedly maltreat her lover pikin and burn im nyash.

    Di state Commissioner for Women Affairs and Social Development, Fatima Buba, order di arrest afta di governor, Yahaya Bello order say make dem arrest her afta video of wetin she allegedly do di boy go viral

    Madam Buba say dem don charge madam Elizabeth to court and dat di pikin dey hospital dey receive treatment for Specialist Hospital for di capital.

    She explain give say di woman claim say di pikin dey stuborn and dat e tear im school uniform to take use do duster and she decide to use cable to beat am and dat she no use hot iron to take burn di pikin for nyash.

    One woman kneel down for ground while one soja and anoda woman dey stand wit one boy

    Wia dis foto come from, Kogi state Govt.

  13. Weapons wey una dey send dey finish in a few hours - Zelensky

    Di Euroopean leaders meeting

    Wia dis foto come from, PA Media

    Ukraine President Volodymr Zelensky tell European leaders for London say dem dey rely for di support of dia international partners and not for Nato.

    E say, "of course, Ukraine no be Nato member, we sab am. We don hear for plenti years about open doors, but we also sabi say, we no fit enta those doors".

    E say make oda kontris wey dey di border of Russia, make dem dey tink dia "independent defence capabilities" outside Nato.

    Zelensky also tok about oda tins for im address like:

    • E say di shipments of Supplies wey UK and oda nations dey give dem dey quick finish: "Di amount wey dey get per week, in 20 hours e don finish".
    • Because of dat, dem dey use captured Russia equipment and old Soviet-era kit.
    • E say di Western sanctions na beta tin but e no dey enough to end di Russian gra-gra and dey ask make dem sama full trade embargo.
    • E call out companies wey still dey do business for Russia.
    • E also call for di barring of Russian navy vessels from ports around di world, and make dem ban Russian banks from di Swift financial messaging system.
  14. 70 buses dey go Sumy to rescue civillians, as Ukraine refugees enta three million

    Sumy Info packet

    Di Red Cross wan evacuate civilians comot di north-eastern city of Sumy, as heavy shelling still dey shele, with 70 buses wey go land for two convoys two.

    Tok-tok pesin for di organisation say di mata also bad for di southern port city of Mariupol, wa pipo "dey suffocated for di city without any aid".

    Dis dey come as di number of pipo wey dey run comot from Ukraine don enta three million, according to UN, with around 1.8 million wey dey for POland.

    Unicef don hala say almost half of all di refugees na pikin dem be, wey fit mean say every second, one Ukrainian pikin go turn refugee.

    Plenti of di refugees no get any family ofr Europe, no get wia to go and don dey traumatised by wetin dem don take eye see.

  15. Four pipo die for Kyiv inside overnight strikes - Mayor

    Apartment building for Kyiv

    Wia dis foto come from, Reuters

    Di mayor of Kyiv don reveal say four pipo don die afta airstrikes hit di capital overnight.

    Vitali Klitschko tok for Telegram, say "rescuers still dey off di fire since early mor-mor".

    Before, emergency services bin report say na two pipo die for one apartment block afta di blast.

  16. Three-year-old pikin shoot, kill im mama for US

      • Author, Dooshima Abu
      • Role, BBC Pidgin, Abuja

    Three-year-old American pikin don accidentally shoot and kill im mama as e dey play wit gun for di suburbs of Chicago, Police took on Monday.

    According to Dolton police, di tragedy happun on Sarurday for 8:30 pm evening for parking lot of one supermarket for Dolton, a suburb of Midwestern city.

    Di young boy bin sidon for child seat for di back of im papa car and im papa bin sidon for driver seat while im mama, for passenger seat.

    E no dey clear how e mange to get di pistol gun wey belong to im papa- but agency report yarn give say di boy bin dey play wit di gun for inside car.

    At some point, di pikin come pull di trigger come shoot im mama wey im name be Deejah Bennett, 22 years old for back of her neck.

    Di Dolton Police oga, Robert Collins say dem rush di mama to hospital for University of Chicago Medical Centre.but dem pronounce am dead.

    E explain give say detectives dem do forensic interview wit di pikin and di boy gree say na im shoot im mama. Dem don gbab di papa of di pikin and dem dey chook eye on top di mata to find out wether e possess di gun legally.

  17. Zelensky tell Russian sojas to surrender

    Ukrainian President Volodymyr Zelensky

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Ukrainian President Volodymyr Zelensky don tell Russian soldiers to surrender.

    President Zelensky for im usual TV address say Russian forces don suffer worse losses during di invasion of im kontri pass wetin dem see for di Chechnya conflict.

    E say dem don already begin see say dem no fit achieve anything by war.

    "I know say una wan survive," e tok, adding say dem go treat those wey surrender "as pipo, decently".

    Zelensky also pay tribute to Marina Ovsyannikova, di woman wey interrupt Russian state TV news by holding up an anti-war sign.

    Negotiations between Russia and Ukraine dey expected to continue later, wit Zelensky saying dem don make "pretty good" progress so far.

  18. Prime Ministers of Poland, Czech and Slovenia dey go Ukraine

    Michal Dworczyk, head of Polish prime minister office tok about di visit for Warsaw

    Wia dis foto come from, EPA

    Wetin we call dis foto, Michal Dworczyk, head of Polish prime minister office tok about di visit for Warsaw

    Prime ministers of Poland, Czech and Slovenia dey travel by train go Kyiv for tok-tok wit Ukraine president and prime minister.

    Dem dey travel as representatives of di European Union and go present details of dia actual support package for Ukraine, Michal Dworczyk, di head of di Polish prime minister office tok.

    Dem arrange di visit during di recent EU summit for Versailles, Dworczyk add.

    Di three leaders, wey di head of Poland governing party, Jaroslaw Kaczynski dey follow on di trip, go present broad package of EU support for Ukraine, e tok.

  19. EU ready to slam more sanctions on top Russia

    Di EU don unveiled dia fourth package of sanctions against Kremlin. Dis time di target na luxury goods exports as well as investments for Russia energy sector.

    More oligarchs and pipo wey dey spread so-called "disinformation" go join for di list of individuals wey di EU asset freeze go affect. Sources don tell di BBC say di list go include Chelsea football club owner Roman Abramovich, wey UK goment don already sanction.

    Di ban go also affect exportation of luxury goods, such as expensive cars and jewellery, to Russia. Also, restrictions on di import of Russian steel products and on new investments for Russian energy sector.

    While di EU don go further and faster on sanctions dan many expect, diplomats don tell di BBC of increasingly obvious quarrel between Poland and Baltic states - wey want stronger measures - versus a more cautious approach wey kontris like Germany and Italy like.

  20. Ukraine-Russia war dey make Kenyans pay more for fuel

    From Tuesday Kenyans go begin pay more for fuel as di Russian invasion of Ukraine continue to affect di price of crude oil and refined products.

    Di East African kontri petroleum regulator say di price of petrol and diesel will increase by five Kenyan shillings ($0.044: £0.034)

    Di fuel prices regulator say di price of kerosene, wey many poor Kenyan households dey take cook, “neva change”.

    Kenya petroleum subsidy programme don make fuel prices neva change for four months in a row.

    Afta Russia invade Ukraine, Brent crude oil hit 14-year high. Di price of essential commodities dey expected to go up for di East African kontri.

    Fuel prices for Kenya neva change for four months now

    Wia dis foto come from, AFP

    Wetin we call dis foto, Fuel prices for Kenya neva change for four months now