Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol
Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.
Live Coverage
Russian missile hit more residential building for Kyiv dis morning
Ukraine
authorities don release more foto of a separate nine-storey residential tower
for Svyatoshinsky district of Kyiv on fire afta shelling.
Dem put out
di fire at 05:36 local time (03:36 GMT).
Authorities
neva tok if pipo die for di .
Wia dis foto come from, UKRAINE STATE EMERGENCY
Wia dis foto come from, UKRAINE STATE EMERGENCY
Goment reach agreement wit airlines over scarcity of aviation fuel
Wia dis foto come from, Other
Nigeria
goment don assure say aviation jet A1 fuel go sell at N500 within di next three
days.
Dis na to
prevent airlines from shutting down.
Mele Kyari, Group
Managing Director of di Nigerian National Petroleum Corporation (NNPC) give di
assurance afta meeting marketers, regulators and operators for di aviation
industry.
E say operators
go get license to import aviation fuel.
Na di Deputy
Speaker of the House of Representatives, Ahmed Wase preside over di meeting as
dem continue di investigation over di scarcity
and high cost of aviation fuel wey lead to di increase in price of airline ticket.
Nigeria Police deny tori say officers plan to go strike
Wia dis foto come from, Reuters
Di Nigerian
police Force don deny tori say dia officers dey plan to go strike over
non-implementation of di new salary package goment approve for police.
Olumuyiwa
Adejobi, force tok-tok pesin make di denial for statement e release.
E say police
officers know say strike na mutiny for di police force.
“Di Nigeria
Police Force wishe to say di publication dey fake and na mischievous attempt by
corrupt individuals to bring di Force to disrepute, misinform di general public
and heat up di polity.
“Di Federal goment
dey fully committed to di implementation of di new salary package.
Tori bin
come out say police wan go strike on March 26, 2022.
War fit end by early May - Ukrainian advisor
One
Ukrainian goment advisor say e expect di war to end by early May latest, wen
Russia run out of money to attack dia neighbour.
"I tink
no later dan for May, early May, we go peace agreement," Oleksiy
Arestovich tok, advisor to di Ukrainian president chief of staff, late on
Monday.
E outline
two possible outcomes for di months ahead.
"Na either
we strike peace deal very quickly, within one week or two, wit troop withdrawal
and everi tin or attempt to jam dem togeda.
Di Pentagon don
earlier claim say Russia dey try recruit Syrians to fight for Ukraine - though we
neva verify dis one.
Arestovich no
dey personally involved for talks between Ukraine and Russia
Welcome to Tuesday live-text of big-big tori dem
Good morning!
Welcome to Tuesday live-text report of all di main tori dem you suppose know around di world.
Our today proverb na from Ezeka Elvis wey say.
"Today overfeeding no go stop tomorrow hunger"
Goodnight!
Na here we go end today Live Page.
So far, we bring you report say one of di wives of di suspended DCP Abba Kyari faint for court as dem try hear her husband bail application.
Cameroon ban smoking of shisha pipes as dey say e get health risk for young pipo.
Pregnant woman and her baby die afta Ukraine hospital attack.
You fit scroll down to read all di tori wey you miss out during di day.
Na Jelilat, Helen, Ronke, and Tunde bring una all di tori for today.
Fotos: See how missile fragments hit neighbourhood for Kyiv
One
person don die and six more don dey injured after missile fragments fall ontop
road for Kurenivka area of Kyiv today.
Di mayor of di capital Vitaliy
Klitschko tok say di debris na from a missile wey don dey by Ukrainian air
defences.
Di BBC bin dey di scene
where di fragments hit, and we capture some fotos.
Wetin we call dis foto, One trolley bus dey completely destroyed, but luckily no passenger bin dey inside
Wetin we call dis foto, Dem shatter di windows of di nearby buildings. Di balconies and commercial property on di ground floor also dey damaged.
Wetin we call dis foto, Mayor of Kyiv Vitaliy Klitschko, on di right, bin visit di scene earlier today.
Wetin we call dis foto, Pipo bin dey clear debris from buildings wey dey damaged.
Russia show off navy boats wey dem capture
Russian state TV don show wetin e tok say be Ukrainian navy boats being disarmed for di port of Berdyansk wey don dey captured
Di fast patrol boats Akkerman and Vyshhorod dey abandoned along wit a tug called Korets, di defence ministry channel Zvezda bin report.
Russian forces capture Berdyansk two weeks ago, on di Sea of Azov. E lie between Crimea and Ukrainian city of Mariupol wey dey besieged.
One reporter wey dey tour one of di vessels show ammunition and "personal belongings" allegedly leave behind by Ukrainian crew members as dey run comot di Russian assault.
Wia dis foto come from, TV Zvezda screenshot
Di women wey dey volunteer on Ukraine front line as Russia's invasion continue
Countless
Ukrainian families don dey separated as women and children evacuate and leave
men behind for di war zone. But many women don choose to remain on di front
line. Di BBC speak to five women about di reason why dem dey stay.
Kira
Rudik - 'e dey scary, but I dey vex'
Wia dis foto come from, Kira Rudik
Wetin we call dis foto, Kira Rudik say she never touch gun before until di war start.
"I
never touch gun until di war start,” member of parliament Kira Rudik tok. “E no
just dey necessary.
She tok say wen di invasion bin start and di possibility to get a
gun happunn, she dey shocked say she decide to carry am.
Marharyta
Rivachenko - 'I no get anywhere to run to’
Wia dis foto come from, Marharyta Rivachenko
Wetin we call dis foto, Marharyta Rivachenko say her life depend on dis war
Regular
women also join politicians to volunteer for di war effort.
Marharyta don learn how to sleep wit di sound of air
sirens for shelters sake of say her city don dey bombarded by Russian forces.
"When di war start, my family bin dey Kharkiv and
I bin dey alone for Kyiv. I no get anywhere to run," di PR manager tell di
BBC.
Yustyna
Dusan - 'My priority na to survive'
Olena
Biletskyi - 'I want make my daughter dey born inside free Ukraine'
Wia dis foto come from, Olena Biletskyi
Wetin we call dis foto, Olena Biletskyi get six months pregnancy
"For di first few days, fear and anxiety bin hold
me well,” Olena tok. “But now fear no dey again, na just di desire to defeat di
enemy.
Olena tok say she dream to have her third daughter for inside free and independent Ukraine.
Yaryna
Arieva - 'I no dey scared for myself'
Wia dis foto come from, Yaryna Arieva
Wetin we call dis foto, Yaryna Arieva say she no dey scared for herself
Yaryna bin move to di territorial defence base with her
husband, but she never dey experienced enough to go on combat missions yet.
Yaryna tok say before di war, she bin get a lot of
fears.
"But right now, di only fear wey I get na to lose
my husband - I no dey scared for myself.”
Former Boko Haram members to rejoin communities afta dem graduate de-radicalisation programme
Wia dis foto come from, Reuters
Di authorities for Nigeria say 559 ex-Boko Haram members don graduate de-radicalisation programme and dey expected to re-enter di society soon.
Di graduation ceremony wey hold ova di weekend at a de-radicalisation centre for di north-eastern state of Gombe.
For di event, di graduands pledg dia allegiance to di Nigerian authorities dey once fight against.
Di military-run initiative dey introduced for 2015 by di Nigerian goment and become operational for 2016 as part of im counter-terrorism strategies.
Members of Boko Haram wey voluntarily lay down dia arms and surrender to di authorities collect special training wey nclude vocational skills, religious reorientation and psychological support to de-radicalise dem before being reintegrated into di society.
Di total number of those wey don complete di programme now be 1,629.
Sense of mistrust still dey di society towards former Boko Haram members given di level of violence wey di group don comit.
Di Boko Haram insurgency wey begin for 2009 don cause di deaths of about 350,000 pipo wit millions of odas displaced for Nigeria and several oda kontris for di Lake Chad region.
Wetin be di latest from Ukraine?
Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, Firefighters dey put out fire
In case you just dey join us, see wetin dey happun on day 19th of Russia invasion of Ukraine:
Russian and Ukrainian representatives do tok-tok to try end di fighting, Ukraine negotiator say di tok go focus on establishing a ceasefire, di withdrawal of Russian troops and security guarantees for Ukraine
Tok-tok dey set to resume on Tuesday afta a "technical pause", Ukrainian presidential adviser Mykhaylo Podolyak tok
But fighting don continue with bombardment for Kyiv wey kill at least one pesin afta one block of flats dey hit
One pregnant woman wey dem bin take her foto ontop stretcher form di maternity hospital dem bomb for Mariupol don die togeda wit her baby according to reports.
Russian bombardment of some towns don dey so serious sotay dem dey bury civilians wey die for mass graves, including for Mariupol
China say claim by US officials say Russia ask Beijing to provide dem wit military assistance for Ukraine na "disinformation", while di Kremlin don also deny am - say dem get resources to meet dia goals independently
For UK, Levelling Up Secretary Michael Gove dey due to set out details of one cheme for pipo to host Ukrainian refugees for dia house
And riot police don begin dey pursue squatters from di London home of Russian billionaire Oleg Deripaska.
Pictures of How Abba Kyari Wife faint for court today
Small drama bin happun for Federal High court, Abuja as wife of di suspended Deputy Commissioner of police, Abba Kyari slump afta proceedings.
Wetin we call dis foto, Abba Kyari First wife dey suffer from asthma
Wetin we call dis foto, Pipo help her into one office for di third floor of di Federal High court
Wetin we call dis foto, Dem cari her from di 5th floor to di 3rd floor and she bin dey lifeless
Dem don ban shisha smoking for Cameroon
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Pipo get misconception say shisha dey less harmful dan cigarette.
Cameroon don ban di smoking of shisha pipes as dem tok say e
dey cause health risk to mostly young pipo who use am for bars and homes.
About 46% of young Cameroonians dey smoke di substance according
to di health ministry – wey be mixture of tobacco, molasses, glycerine and
flavourings.
Doctor tok say misconception dey about shisha as pipo think
say e no dey harmful as cigarettes. Dem tok say di British Heart Foundation say
one hour of smoking shisha fit be di same as smoking more dan 100 cigarettes.
“Traditionally shisha tobacco contain cigarette tobacco, so
like cigarette e contain nicotine, tar, carbon monoxide and heavy metals, such
as arsenic and lead,” di foundation tok.
For recent years, shisha don dey banned for Tanzania and
Sudan – though di ban dia don dey reversed and introduced again several times
since.
Ghana court adjourn Oliver Barker Vormawor bail application
Article Information
Author, Favour Nunoo
Role, BBC Pidgin
Wia dis foto come from, Favour Nunoo/BBC
Wetin we call dis foto, Oliver Barker Vormawor as he dey enter court
High Court for Ghana adjourn bail application case of #FixTheCountry campaigner, Oliver Barker Vormawor.
Lawyers for Mr Barker Vormawor plead wit de Court say dem get de discretion to grant de bail despite de treason felony charge against dia client.
Dis be after state prosecutors argue say Oliver Barker Vormawor be flight risk sake of he no get place of residence.
But en legal team, led by Lawyer Akoto Ampaw debunk de claims as plus details of de residence of Mr Vormawor.
He argue say de state also get de accused en travel passports so that again go make an difficult for him to leave de country.
After hearing both arguments from prosecution and defense, Justice Daniel Mensah adjourn hearing to Wednesday, March 16, 2022 for en ruling.
Abba Kyari first Wife faint for Abuja court
Di first wife of di suspended Deputy Commissioner of Police, DCP, Abba Kyari, Ramatu on Monday, faint for Federal High Court, Abuja.
She fall for ground as armed NDLEA officers dey try carri Kyari comot from di courtroom afta di trial judge, Emeka Nwite adjourn ruling on Kyari and four odas bail application to 28th of March, 2022.
Kyari lawyer bin file application to release am on bail pending di determination of di case against am.
Kyari wife bin wear black cloth and bin hold her husband hand as dem stand close to di elevator wey dey go di fifth floor of di Federal high court - suddenly she fall for ground.
She later regian consciousness afta some minutes.
Wia dis foto come from, Other
Wetin we call dis foto, Pipo for court dey try save Abba Kyari wife
Pregnant woman and her baby die afta Ukraine hospital attack
Ukraine-Russia begin anoda round of tok-tok
One of Kyiv
negotiators don share image of tok-tok between wey don start Ukraine and Russia for di fourth time.
Di tok-tok
between di two kontris dey hold through video conference call.
Ukrainian
official Mykhailo Podolyak says both sides have now laid out their positions.
Earlier im
bin tok say di discussion go focus on on establishing a ceasefire, di
withdrawal of Russian troops, and security guarantees for Ukraine.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Aguleri widow: Police arrest one, rescue victim
Anambra State Police don arrest one suspect after dem rescue one woman from angry mob for Aguleri, Anambra State, for southeast Nigeria.
Di rescue come as a result of one report dem see for one trending video wia crowd of pipo dey molest and assault one lady publicly say she allegedly cause di death of her late husband.
Police tok tok pesin DSP Ikenga Tochukwu say further information reveal say dem don already bury di dead husband before di video start to trend.
E add say di victim dey receive medical care for hospital.
Anambra Commissioner of Police, Echeng Echeng wey describe di act as barbaric, don order immediate study of di video to identify di suspects, arrest and bring dem to book.
E also beg members of di public to stop sharing di video to protect di dignity of di woman.
Many pipo don dey call for justice for di woman as dem say wetin di mob do di woman na dishonor to womanhood.
We fight well but we need help to stop WW3, Ukraine tok
Ukraine don repeatedly call for Western countries to give dem more help for di fight against Russia - and di kontri Foreign Minister Dmytro Kuleba don reiterate di plea again.
"Ukraine fights back successfully," im tok "We need you to help us fight. Provide us wit all necessary weapons.."
"Apply more sanctions on Russia and isolate dem fully. Help Ukraine force Putin into failure and you go stop larger war."
Some Western governments fear say getting more involved fit escalate di situation.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
'Vice President Osinbajo presidential declaration na fake news'
Article Information
Author, Onyinye Chime
Role, BBC Pidgin, Lagos
Wia dis foto come from, Prof Osinbajo
Office of Nigeria Vice President, Yemi Osinbajo, say news wey say di VP don declare im intention to run for president na "fake news."
Tori bin dey fly upandan say Osinbajo declare im interest give President Muhammadu Buhari.
Dem also bin report say di VP dey meet wit all di state chairmo dem of di ruling All Progressive Congress patty on Monday, March 14 before I'm officially declaration.
Local tori pipo wey do di reports of di VP declaration bin say na "credible sources," nak dem inside gist.
But one of di VP aides tell BBC Pidgin say, all dis credible sources na for di mind of di pipo wey write di story.
E add say, "as long as no be di media unit of di Office of di Vice President release di story, abeg consider am as fake news."