Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol

Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.

Live Coverage

  1. Three oda wars wey Russia Putin get hand for, how dem start and how dem end

  2. Mass burial for 13 victims wey die inside Appiatse mining truck explosion go happun today

      • Author, Favour Nunoo
      • Role, BBC Pidgin
    Baby wey die inside Appiatse explosion

    Wia dis foto come from, OTHER

    Wetin we call dis foto, 15 months old baby wey die in de explosion

    Tears flow as Ghana dey hold mass burial for some 13 victims wey die after mining truck explosion hit Appiatse community for Western Region.

    De victims of de explosion dey range from one 15 months old baby to one 80-year-old woman.

    Govment fine de mining company, Maxam Company Limited $6million dollars after investigations show say dem breach regulations in de transport of explosives.

    Preliminary reports wey police officials release be say de accident happen sake of crash between vehicle which dey carry mining explosives, motorcycle den a third vehicle close to electricity transformer cause de huge explosion.

    Inside videos wey dey circulate for social media, you go see as one truck dey burn in de middle of de road wey people dey video de incident dey walk towards am.

    While dem dey approach de burning truck, de tin just explode with a loud bang, tear down buildings, create big hole in de middle of de road wey e finally kill 13 people.

    Ekua Nyame be one of de victims of de explosion

    Wia dis foto come from, OTHER

    Wetin we call dis foto, 80 year old Ekua Nyame lose her life in Appiatse explosion
    Dem lay de victims in state for public viewing
    Wetin we call dis foto, Hundreds gather to mourn de dead
    Hundreds gather to mourn de dead
    Wetin we call dis foto, Dem lay de victims in state for public viewing
    Poster of victim

    Wia dis foto come from, OTHER

    Wetin we call dis foto, Poster of one of de victims of de explosion
  3. Di super-rich Russians wey dey face sanctions sake of Russia-Ukraine war and why

  4. Fotos: Next Batch of Nigerians wey run from Ukraine War don land

    Nigerian Evacuees

    Wia dis foto come from, NidCom

    122 Nigerians wey don run from di war from Ukraine don land Abuja di, Nigerian capital today.

    So far Nigeria don evacuate one thousand and seventy six Nigerians including students from Ukraine.

    Di kontri don gada money to helep about 5,000 Nigerians from di kontri wey Russia don dey attack since last month.

    Dis na some fotos of dia return:

    Nigerian Evacuees

    Wia dis foto come from, Abike Dabiri

    Nigerian Evacuees

    Wia dis foto come from, Abike Dabiri

    Nigerian Evacuees

    Wia dis foto come from, Abike Dabiri

  5. Fotos: Life for Kyiv as Russian attack still dey go on

    Life for Kyiv

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Ukraine capital, Kyiv and di places wey surround am still dey under serious attacks by Russian forces.

    May residents don run go west to find safer place to dey.

    Odas wey wan hide from air raids dey for metro stations deep underground.

    Dis na some fotos of how life be for Kyiv dis week:

    Life for Kyiv

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Life for Kyiv

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Life for Kyiv

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Life for Kyiv

    Wia dis foto come from, Getty Images

  6. Dem approach South Africa to mediate for di Ukraine war - Ramaphosa

    Putin and Ramaphosa

    Wia dis foto come from, AFP

    President Cyril Ramaphosa say dem don approach South Africa to play mediation role for di conflict between Russia and Ukraine.

    Mr Ramaphosa no say who approach dem, but say e speak with Russian President Vladimir Putin on Thursday and ask am to use mediated solution to solve di conflict.

    "President Putin appreciate our balanced approach. We believe dis position enable both parties to subject di conflict to mediation and negotiation. Based on our relations with di Russian Federation and as a member of Brics, dme don approach South Africa to play a mediation role, "Mr Ramaphosa post on Twitter.

    South Africa position for di conflict come under di spotlight last week afta dem abstain and dem no gree vote on a UN resolution wey condemn Russia invasion of Ukraine.

    Mr Ramaphosa say di kontri abstain becos "di resolution no put as part of am di call for meaningful engagement", and accuse di UN Security Council

    say dem dey unable to discharge dia responsibility to maintain peace and security.

    E add say South Africa response to di war no be indication say dem no get regard for human rights.

  7. Russia go lose 'most favoured nation' status

    Joe Biden

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Di United States, di European Union and di Group of Seven kontries dey expected to revoke Russia "most favoured nation" trading status over dia invasion of Ukraine.

    US President Joe Biden dey set to announce dis wan by 10:15am EST (15:15pm UK time), according to media reports.

    "Most favoured nation" kontries generally no fit dey discriminated against or say make dem limit dia access to markets, under di World Trade Organization guidelines.

    Dis move go open di way make dem impose tariffs on Russian goods on top di growing economic sanctions dem dey face.

    Earlier on Friday, White House press secretary Jen Psaki condemn reports say Moscow fit seize di assets of businesses wey don stop operation for Russia.

  8. Russia confam strike on Lutsk and Ivano-Frankivsk

    Russia Defence Ministry don confam di strikes on Lutsk and Ivano-Frankivsk, local media dey report.

    Dem quote Moscow defence officials wey dem say dia "high-precision, long-range attacks" don strike two military airfields for di cities for Ukraine west.

    Dis wan mark new territory for di Russian attack wey bin focus on di Kyiv capital and cities for di east and south of Ukraine.

    Di mayor of Ivano-Frankivsk don confam Russian shelling of im city for south-western Ukraine.

    Inside Facebookmessage, e say: "Di enemy strike Frankivsk."

    E ask pipo not to share fotos and videos of di explosions and seem to dey suggest say one missile strike alarm system bi no work.

    And e warn residents of Krykhivtsi, Chukalivka, Opryshivtsi, Gorodok districs not to comot dia homes.

    "Stay for house for your safety! Wen di danger pass - I go let you know," e add.

  9. Nigeria seize hundreds of bags of donkey meat

    Donkeys

    Wia dis foto come from, AFP

    Nigerian customs officials say dem don seize 1,390 bags of donkey meat for Kebbi, north west Nigeria near di border with Niger.

    Joseph Attah reveal wetin di first investigate show say, na about 1,000 donkeys dem bin kill and pack dia meat inside bags.

    E say na "illegal trade of wildlife" wey dey against di law for Nigeria.

    Di place wia di truck wey bin dey carry am go, customs say dem neva know.

    Howeva dem don arrest di driver of di truck and one oda suspect.

    Nigeria don dey struggle to stop di killing of donkeys and selling of dia bodi parts sake of say dia numbers don dey drop steady.

    Before-before, Nigerian officials say dem dey use donkey body parts plus di skin, sell give Asian kontris including China wia dem dey use am for traditional medicine and cosmetics.

  10. Akwa Ibom State High Court sentence man to death by hanging for kidnapping

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Lagos

    One Akwa Ibom State High Court don sentence one 36 year old man, Monday Okon to death for kidnapping a three-year-old girl for Mbierebe Obio community in Ibesikpo Asutan LGA.

    Justice Okon Okon convict Monday Okon for kidnapping and conspiracy and sentence am along with one Cecilia Ebong, wey assist am hold di pikin inside keke napep dem enter to AKTC Park, wia dem bin wan carry her go Aba, Abia State, to a standby buyer.

    Monday Okon confess to police say im kidnap di pikin on 20 July 2018 during a graduation party for her school and keep her for im house in Ibesikpo Asutan for three days until im wife advise am to return di girl to wia e pick her from, but im no gree.

    Luck run out on di convicts on 24 July 2018 while on dia way to AKTC Park, a good Samaritan see as dem cover di pikin with cloth inside di keke napep, come raise alarm for Aka Road-IBB roundabout in Uyo, wey lead to dia arrest.

    Monday Okon confess say im bin wan deliver di pikin to one Charity Nwachukwu, wey im say im don sell one male pikin to her before for 2017 and get N50,000 for di transaction but Cecilia Ebong, however, claim to be di grandmother of di victim.

    Delivering judgment, Justice Okon sentenced Monday Okon to death by hanging, while im sentence Cecilia Ebong to five years in prison.

    Di judge say, “e dey unfortunate and depressing say pipo still dey into dis callous trade of human beings, particularly children, despite efforts of di goment to stop di ugly trend.

    Di option of child buying and selling dey very bad and e no get any defence at all, and no punishment go dey too much to stop pipo from such tendency.”

  11. Russia call meeting today to accuse America say dem dey use biological weapons

    Chernobyl nuclear facility

    Wia dis foto come from, Reuters

    Di United Nations go siddon today to solve one kasala between America and Russia concerning di use of biological weapons.

    Na Russia call for di meeting as dem accuse America say dem dey run one biological warfare programme for Ukraine.

    Dem also accuse dem say dem dey use excuse of cleaning Soviet era research labs to take cover up wetin dem dey really do.

    But Washington don say di mata no get head as e dey happun in di middle of Russian invasion of Ukraine even as Russia neva produce evidence for dia accusation.

    Meanwhile, America don accuse Russia say na dem go fit already dey use chemical or biological weapons for dia invasion of Ukraine.

    Dem add say di plan na to use di weapons come blame am on Ukrainian soldiers.

    United Nations bin ban di making and use of biological weapons for war afta World War 1 under di Biological Weapons Convention.

  12. Di latest headlines on Day 16 of di war

    Volodymyr Zelensky

    Wia dis foto come from, facebook

    If you just dey follow, see wetin you need to know about day 16 of di Russian invasion:

      • Ukraine president Volodymyr Zelensky don for inside one video addressrubbish Russian claim say dem dey develop chemical weapons or weapons of mass destruction for Ukraine. E also warn say Russia go get "di most severe sanctions response" if dem use such weapons against Ukraine
      • Im comments echo wetin US tok earlier: say Russia claim of Ukraine hosting US-backed chemical weapons facilities na "false flag", wey dey intended to justify Russia possible use of such weapons
      • Di UN go hold emergency meeting on Friday, for Russia request, to discuss dia claims
      • Satellite images show say Russian sojas dey slowly advance, and don re-deploy into forests, as dem continue to push towards di capital Kyiv
      • Putin forces according to reports dey circle several Ukrainian cities, with emergency officials warning say siege-like tactics mean say cities like Mariupol dey run out of food
      • Toks between di foreign ministers of Russia and Ukraine for Turkey end with leaders saying dem no see hope for a lasting ceasefire in di near future
      • Meta, di company wey get Facebook and Instagram, say dem go suspend rules wey ban violent speech in order to allow users in certain kontries to call for di deaths of Russian sojas
      • More western companies don cut ties with Russia, including Western Union, JPMorgan Chase and Warner Music on Thursday
    • Una good morning!

      Una welcome to our live coverage today of tori from around di world.

      We go bring una tori from Nigeria, across Africa and di rest of di world.

      Di world eye still dey Ukraine afta Russian invade dem.

      E don pass two weeks now since di invasion.

    • Wetin to sabi about Russia President Vladimir Putin wey invade Ukraine

    • Make you scroll down to read today stories

      Na here we go match break for today coverage of wetin dey happun as e concern Russia invasion of Ukraine and all the oda big tori from around di world.

      No forget say you fit scroll down to read more on di tori wey you fit don miss today.

      Make you join us tomorrow for more coverage on di tori wey dey make headlines around di world.

      You fit follow us for Facebook, Twitter and Instagram.

    • Nigeria evacuate students from Sumy to Hungary

      African students

      Wia dis foto come from, AFP

      One group of Nigerian students wey goment evacuate from north-east Ukrainian city of Sumy don arrive Hungary. Di students bin hook for frontline before dia evacuation begin on Tuesday.

      Di students bin dey on di road for almost two days.

      Reports say dem bin first move dem from Sumy to di Ukrainian central city of Poltava from where dem joine train enter Hungary.

      On Thursday, di students meet with representative of di Nigerian embassy for Gyor, for northwest Hungary before dem put dem for anoda train.

      One of the students, Samuel Otunla tell BBC say dem bin don travell for about 30 hours. Im express relief after e leave Sumy and add say Nigerian government dey do very good job so far.

      Before di evacuation, several Sumy students bin no fit leave di city due to di blockade of the access routes.

    • Pfizer dey set to supply Covid pills to Africa

      In other news, Pharmaceutical company Pfizer dey set to supply Africa top health body with dia coronavirus drug.

      Di drug - Paxlovid - dey intended for use soon after symptoms develop for pipo wey dey at high risk of severe disease.

      Paperwork for di deal between di Africa Centres for Disease Control and Pfizer now dey in di hands of di African Union legal office - after which dem go make formal announcement, na so Africa CDC director John Nkengasong tok.

    • UK saction Abramovich - Wetin e mean for Chelsea FC?

      Abramovich sanctioned

      Wia dis foto come from, Getty Images

      Roman Abramovich attempt to sell Chelsea don dey on hold after di oligarch chop sanction from UK government as part of dia response to Russia invasion of Ukraine.

      Di Russian put di European champions up for sell after UK parliament bin raise threat of sanctions.

      Freezing of Abramovich's assets,wey include Chelsea, mean say di club no go fit sell match tickets.

      Di intention of di move na to stop Abramovich from making money from Chelsea.

      Season-ticket holders fit still attend games wey dem bin don already buy tickets but di club no go fit sell any more tickets from today.

      Chelsea go also dey unable to buy or sell players, or offer new contracts, while di sanctions dey for Abramovich head.

      Dem don also close di London club merchandise shop.

      You fit read more on di tori for here: Wetin UK sanction on Abramovich mean for Chelsea.

    • No progress on ceasefire after Kyiv-Moscow toks

      Attack on Mariupol

      Wia dis foto come from, AP

      First round of toks between di foreign ministers of Russia and Ukraine don fail to yield progress on ceasefire, na so Ukraine tok.

      Speaking after di meeting wey hold for Turkey, Dmytro Kuleba say di demands im Russian counterpart Sergei Lavrov make amount to surrender.

      Mr Lavrov meanwhile say im kontri military operation dey go according to plan.

      Di toks dey come after Russia bomb children's hospital, which Ukraine say be "war crime".

      Officials say three pipo including one pikin die for di attack wey happun for south-eastern city of Mariupol.

      Russia launch a full-scale invasion of Ukraine two weeks ago and more than 2.3 million pipo don run comot from di country.

    • Bombs dey fall for Mariupol - reports

      Ukraine conflict

      Wia dis foto come from, Reuters

      Bombs reportedly dey fall ontop homes for di Black Sea port city of Mariupol again, according to one Telegram post from di city council.

      A humanitarian convoy wey dey try reach di south-eastern city don has turn back sake of di fighting, according to one social media post from Ukraine's deputy prime minister, Reuters bin report.

      One Ukrainian presidential advisor tok say on social media dat Russia dey deliberately block di evacuation of civilians from di city sake of dem fail to seize di strategically-important port, Reuters tok.

      Di south-eastern city don be di site of di fighting. Yesterday, dem bomb one maternity hospital, killing three pipo, wey include one child, Ukrainian officials tok.