Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol
Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.
Live Coverage
Na here we go stop!
Una do well, so we say well done!
Dis na wia we go end today's Live page.
Among di ogbonge tori wey we don bring una way na:
- Wife of popular Nigerian musician 2baba, Annie Idibia cry as she tok about her husband and marriage
- We also tell una say African kontris come under fire for staying neutral on Ukraine war
- Court order Nigeria goment to delete Section 84 (12) of di amended constitution
- Reports of mass casualties from missile strike for Mykolaiv as Russian invasion of Ukraine dey continue
What to know about Dapivirine vagina silicone ring and why dis African kontris approve am for women
South Africa na di latest kontri to approve di use of di Dapivirine vagina silicone ring for women to use.
Dem design di vagina silicone ring to reduce the risk of HIV infection.
Dis na significant move for a kontri wia nearly two thirds of di new HIV infections dey among women
Zimbabwe bin approve di use of di ring last year and e don dey on trial for many African kontris including Malawi wia some women bin don already start dey use am.
South Africa Health regulatory authority approve di use of di ring for women wey dey di age of 18 years and above.
However, di roll out go still delay small as health department still dey study di effectiveness of di ring and di cost.
According to UN, na South Africa get di highest number of pipo wey dey live wit HIV for di world Link
‘E dey worry me as 10.5 million children no dey go school’ Gbajabiamila, Many States for Nigeria dey do free Education yet many children no still get access to education
Article Information - Author, Tamara Ebiwei
- Role, BBC News Pidgin
Speaker of di Nigeria House of Representatives, Femi Gbajabiamila don describe di situation as “worrisome” as reports show say about 10.5 Million Children no dey go school for di kontri.
Na for di opening of one enrollment of 500 children for schools and free education outreach for 10,000 resident for Zamfara State, Northen Nigeria, e make di statement.
Chief of Staff, Garba Rikji wey tok on behalf of di Speaker describe di situation as unacceptable.
Im add say na time bomb wey leaders and citizens for di kontri suppose joinbodi togeda to address am before water pass garri.

Wia dis foto come from, Gbajabiamila
Court order FG to delete Section 84 (12) of di amended constitution, National Assembly bin troway dis same request wen President Muhammadu Buhari ask dem to delete am

Wia dis foto come from, Malami
Federal High Court for Umuahia, Abia state southeast Nigeria don order di Attorney-General of di Federation Abubakar Malami to delete Section 84 (12) of di Amended New Electoral Act.
Justice Evelyn Anyadike say di section dey unconstitutional, invalid, illegal, null, void and e no effect anytin, therefore e no go stand as na violation of di clear provisions of di Constitution.
Di section say “No political appointee for any level fit be voting delegate or be voted for any Convention or Congress of any political party for di purpose of nomination of candidates for any election.
National Assembly bin troway dis same request wen President Muhammadu Buhari tell dem to delete am.
Lawmakers say to amend an mean say dem dey go against di Civil service ways and no go dey good for di society.
Zelensky: Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol

Wia dis foto come from, Telegram/Zelensky Official
Ukraine's President Volodymyr Zelensky say Russian shelling dey prevent authorities for di besieged southern city of Mariupol to establish humanitarian corridors well-well.
Di Russian military say fighting don reach di centre of di city, wia thousands of people still dey trapped.
For im latest address to di nation, Zelensky say hundreds of pipo still dey trapped umder di rubble of one theatre wey dem bomb on Thursday.
Zelensky also tok say Western deliveries of arms to Ukraine dey too slow.
"We again remind certain Western leaders say na moral defeat e go be for them... if Ukraine no receive advanced weapons," he tok.
'My first pikin na im fifth' Annie Idibia tok about relationship wit husband, 2baba

Wia dis foto come from, Annie Idibia/ Instagram
Nigerian actress and wife of popular singer 2baba, Annie Idibia don open up about her husband and im relationship wit oda women wey born for am.
Annie wey dey participate for one Netflix show "Young, Famous and African" begin dey cry as dey tell her co-stars her tori and how she take know her husband.
She reveal say di fact dat 2baba bin get two women pregnant bin get her humiliated and embarrassed many times.
She say love dey more dan wetin pipo say e be.
Di actress reveal say her first pikin be 2baba’s fifth pikin even though na she first know am
“Wen you meet someone and den you sabi dem first. But when you wake up, two different pipo dey have beby for am,” Annie tok.
Annietok further, “E get five kids wit oda women. My first pikin be im fifth, and I meet am befor everybody. So you sabi wetin dat be. Do you know how much humiliation and embarrassment I don faced?”
2baba get seven pikins by three women, wey include im wife, Annie wey im marry for 2012.
Annie get two girls, another baby mama, Sumbo Adeoye get two boys and Pero Adeniyi wey base for US get three pikins for di musician.
Putin no dey serious about peace toks, former Russian PM tok
Former PM of Russia, Mikhail Kasyanov, no believe say President Vladimir Putin no dey "serious" about peace toks, and dey unlikely to offer any solution to di conflict "wey go comfortable for Ukrainian pipo".
Beyond di promise of neutrality -wey mean say dem no go apply to join Nato or di EU - Kasyanov believe say Putin go insist upon "official recognition" say Crimea dey part of Russia.
"Dis dey absolutely crucial, Mr Putin dey craze about Crimea," he tell BBC World News.
Kasyanov - wey be prime minister between 2000-2004 - say e dey doubt any deal wey be stuck as a result of current negotiations between di two sides, suggesting say e dey merely affording di Russians "time to regroup".
E say Putin and im closest political padis dey "nervous" about di extent of di "devastating" economic sanctions wey di West sama dem, suggesting say di Russian leader "no expect di sanctions go dey so harsh".
But he say any decision to stop di military operations for Ukraine "go be the beginning of im [Putin's] end".
"I think e go continue to oppress and increase di invasion," tok Kasyanov, e add join say e "very worried... say something awful fit happen for di battlefield".
Reports of mass casualties from missile strike for Mykolaiv
We dey hear reports of mass casualties following one missile attack for Ukrainian army barracks for di southern city of Mykolaiv.
One report say at least 45 pipo don die.
Our correspondent Andrew Harding, for Odesa, say at least two missiles dey reported to bin hit army barracks for di northern suburbs of di city.
Rescue efforts dey go on..
Harding tok say dem dey use di barracks to train local soldiers for di city wey don dey hold back one major Russian offensive along di Black Sea coast.
"Mykolaiv don experience weeks of intense bombardments, afta Russian troops dey pushed back from di city," he tok.
"Russian forces bin try to bypass di city to di north but den dey thwarted by di Ukrainians.
"Many civilians don already japa from west."

Foto of baby strollers wey symbolise di war child victims for Ukraine

For one historic centre of Lviv, dem place 109 strollers for front of di city hall on Rynok Square, to represent di children die during di war for Ukraine.
Di prosecutor general office says more than 130 others don injure. E tok say di number fit dey higher sake of di inability to reach areas wia fighting dey taking place.
Di office also say 439 schools na im shelling and bombing don hit, out of dem 63 dey completely destroyed.
Russia deny say dem attack civilian buildings, although a number of non-military facilities dey hit across di kontri, including countless apartment blocks.

Wetin be di latest for Russia-Ukraine war?
Hia na di latest developments:
- Dem destroy aircraft plant: Russia don fire several missiles near Lviv's international airport for western Ukraine, destroying one aircraft repair plant qwey dey nearby, according to local officials. Lviv dey close to di Polish border and don dey act as a safe haven for thousands of refugees
- Oda cities dey shelled: Several major cities don also faced fresh aerial attacks. For di eastern city of Kharkiv, one university building and two blocks of flats dey shelled, killing one person and injuring 11. Further south, for Kramatorsk, dem kill two pipo and injure six for missile attack. And doe di capital Kyiv, one person die after one downed missile explode for one residential neighbourhood
- Noose tighten for Mariupol: Russia say separatists for eastern Ukraine, wit help of im armed forces, dey "tightening di noose" around di Ukrainian city of Mariupol, for southern Ukraine. Tens of thousands of civilians dey believed to be trapped dia.
- Dem rerscue Theatre survivors:Ukraine's human rights chief tok say di first civilians wey dey hide inside one bombed theatre for Mariupol don show from di rubble. So far dem don rescue 130 pipo, she tok, afta di attack wey Ukraine dey blame Russia for.
- Two million pipo don cross enta Poland: Poland's border guard say more dan two million refugees from Ukraine don cross enta di country, most of them women and children
- UK block RT:Britain's broadcasting regulator Ofcom don revoke Russia's state-funded TV channel RT

Wia dis foto come from, B
Teachers go on strike for Akwa Ibom as schools dey closed
Article Information - Author, Karina Igonikon
- Role, BBC Pidgin, Port Harcourt
Few days after di Academic Staff Union of Universities ASUU extend dia strike action, di Nigeria Union of Teachers for Akwa Ibom State declare indefinite strike action against di State goment and order all teachers of public primary and secondary schools to proceed on strike.
For statement wey di senior State Secretary of di Union, Victor Amirize sign, e say di strike dey come after all avenues of negotiations to resolve dia issues with di State goment fail.
Part of dia demands include payment of gratuity/harmonisation of pension to retired teachers and some oda demands wey concern dia welfare
Di teachers bin give di goment dem bin don give 28 working days ultimatum for di State Goment to address dis demands before di strike start on 15 March, 2022.
Sake of di strike wey di Nigeria Union of Teachers declare, di Akwa Ibom State Ministry of Education don tell pupils and students of public primary and secondary schools to stay for house until dem give dem notice to resume school again.
Permanent Secretary, Lady Rose N. Bassey for statement on behalf of di Commissioner for Education Mrs. Idongesit Etiebet say di State Goment dey work hard to resolve all di issues as soon as possible.
Dis strike dey come wen school children dey prepare for dia second term examinations before di Easter holiday.
Ukraine war: AfDB to plan to raise $1bn fund to stop Africa food shortage

Wia dis foto come from, AFP
Wetin we call dis foto, Sudan dey import most of dia wheat from Russia and Ukraine Di African Development Bank (AfDB) plans to raise $1bn (£759m) one week time to support agricultural production for Africa and shield di continent from potential food shortages wey dey come as a result of di ongoing Russian invasion of Ukraine.
Most African countries dey rely on di two warring nations for their grain supplies.
Somalia, Benin, Egypt and Sudan top di list of countries wey go heavily rely on Russia and Ukraine, more than 70% of their wheat dey come from di two countries.
“Di AfDB see these increase in prices of wheat, maize and soya beans as sometin wey go potentially go worsen food insecurity and raise di way tins go begin cost,” AfDB President Akinwumi Adesina tok.
Di Bank say dem go hold meeting of finance and agriculture ministers for Africa to roll out dat plan.
Through di fund, AfDB target to increase production of wheat rice, maize and soya beans wit di use of climate-resilient technologies, including heat-tolerant and drought tolerant crop varieties. Dem don already do trial for di heat-tolerant wheat variety for Sudan and Ethiopia.
According to di United Nations Conference on Trade and Development (UNCTAD), at least 25 African countries import more than one third of their wheat from Russia and Ukraine.
Nigeria former governor chop arrest from EFCC
Nigeria’s corruption police, di Economic and Financial Crimes Commission don arrest one former governor from di southeastern state of Anambra, hours after im leave office.
Spokesman for di EFCC Mr. Wilson Uwujaren tell BBC Pidgin say dem hold di ex-governor to answer some questions. Im refuse to torchlight on wetin dem dey investigate Mr Obiano for.
In di past many Nigerian ex-governors don face arrest soon after dem leave office and face prosecution for corruption - mostly money laundering.
Earlier in di day, di former Governor wife bin involve for faceoff with di widow of former Nigerian separatist leader Odumegwu Ojukwu.
Several videos wey don go viral on social media show di two women stand toe-to-toe as dem exchange words and show aggression for di venue where Mr. Obiano bin hand over power to newly elected governor. But e no dey clear wetin cause di quarrel.

Wia dis foto come from, Willie Obiano
Netflix go begin test-charge customers wey share dia password wit pipo outside dia household

Wia dis foto come from, Getty Images
Netflix wan make pipo stop to dey share dia passwords wit friends and dem dey carry out one new effort wey fit make am stop.
Di streaming service say e go soon launch one test wey e wan use crack down on password sharing outside di user household.
“We don always make am easy for pipo wey live togeda to share dia Netflix account, wit features like separate profile and multiple streams for our standard and Premim plans”, Netflix tok for one blog ppost on Wednesday.
“While dis don become popular, e don also create some confusion about wen and how pesin fit share Netflix. Sake of dis pipo dey share accounts between households and e dey affect our ability to invest in great new TV and feem for our members.”
Dis test go start in di new week for three American kontris: Chile, Costa Rica and Peru.
Through dis test, Netflix go start to let Standard and Premium plan customers add accounts for up to two people wey no dey live wit dem, and dem go pay extra monthly charges.
Dis extra member go get dia own profile plus personal recommendations, login and password.
African kontris come under fire for staying neutral on Ukraine war

US ambassador to United Nations say African kontirs no fit remain neutral on di war for Ukraine.
Linda Thomas-Greenfield remind BBC say for di General Assembly vote two weeks ago to frown on Russian invasion of Ukraine, 17 African kontris - half of di world total - abstained and anoda eight no vote at all.
Di ambassador say e no get any nueutral ground, and say dis crisis no be just about Cold War competition between di West and Russia.
Madam Thomas-Greenfield add say US bin dey plan to help find alternative sources of commodities wey kontris bin fit import from Russia.
Di diplomat also say di US go support South Africa offer to mediate between Russia and Ukraine.
Welcome to Friday big stories
Good morning inside dis morning.
TGIF!
Make we begin wit our proverb of di day.
"Life be like farm, na wetin you plant you go harvest."
Na here we go march break..., Una bye-bye!

Wia dis foto come from, Anambra goment
Na here we go march break today with our live coverage of all di top tori dem from Nigeria and around di world.
Make you scroll down to get all di updates of today, till we see una again tomorrow by 7:00am.
But as we dey waka, we leave una with dis quote and foto of di newly sworn in Govnor of Anambra state, Prof. Charles Soludo.
Im inauguration happun today and im say work don start for am immediately.
Nigeria Presidential Aspirant Kingsley Moghalu condemn di 'drama' for Soludo inauguration, Videos dey fly upandan as small yawa wey involve two women gas for di swearing -in ceremony
Article Information - Author, Tamara Ebiwei
- Role, BBC News Pidgin

Nigeria Economist Kingsley Moghalu wey from Anambra state say belle no sweet am, as e hear di tori of wetin happun for Anambra State.
E say inauguration ceremony no be wia any katakata or yawa suppose gas at all.
Moghalu dey tok about di kwanta wey happun between Bianca Ojukwu and Ebele Obiano wey e wife of di former state govnor.
E tell BBC Pidgin say e dey" embarrassing" as e condemn am totally.
"I just weak wen I see dis kain tin dey happun for inauguration of Governor, I no know who slap who but e no good say dis kain tin happun in di first place" e tok
"My own hope be say wetin dey quarel di two women make dem settle am, I don also see say Governor Soludo don apologise to di pipo of Anambra, so make we just leave am like dat, but e no good at all." E tok.
'Dem dey lie give una' - Arnold Schwarzenegger tell Russians

Wia dis foto come from, Getty Images
Arnold Schwarzenegger don post one video message to Twitter wey ask Russians to push back against di pro-war narrative wey di Russian goment dey push forward.
Inside one clip wey run for over nine minutes- wey pipo don view for over one million times in like two hours - Schwarzenegger speak of im love for Russia and recall trips to di kontri during im career as a bodybuilder.
Di feem star and former California govnor tell Russians say dem "no dey tell dem di truth about di consequences of dsi war" and inform dem say "bombs dey rain down on innocent civilians".
Di Terminator star conclude im tok by praising di thousands of Russia protesters wey dey detained by police in recent weeks, e tell dem say "di world don see your bravery", adding say "you be my heroes".

