National grid wey collapse don recover - Minister, Electricity go return to normal afta two days of blackout for some parts of di kontri
- Author, Tamara Ebiwei
- Role, BBC News Pidgin

Wia dis foto come from, Getty Images
Minister of Power, Abubakar Aliyu, say dem don restore di the national grid wey collapse few days ago.
E tok on Wednesday during briefing afta di Federal Executive Council (FEC) meeting say plenti resolutions don come out afta plenti emergency meetings wey di Ministry of Power hold wit all stakeholders, and dem extensively discuss di issues and resolved all di problems.
Di minister emphasise say Nigeria dey generates up to 8,000 Mega Watts of power
According to Aliyu, di shortage of gas and maintenance of generators,plus di current fuel situation combine to make di problem worse for di national grid.
E assure say di Federal Executive Council don approve Five billion Naira to open up and expand Lagos/Ogun, to reinforce power supply to dat region.




















