Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol
Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.
Live Coverage
Three ways war for Ukraine fit escalate
Boris Johnson meet President Zelensky - See wetin dem discuss
US explain why dem sanction Putin daughters
How much of di world dey rely on Russia for oil and gas?
Chelsea owner Abramovich suffer suspected poisoning
Wetin be di security Measures dem dey take to protect President Putin
Russia aim to divide Ukraine - intelligence chief
Second Niger bridge near completion

Wia dis foto come from, FMHS
Wetin we call dis foto, Foto of second Niger bridge for Southern Nigeria March 8, 2022 Di completion of di Second Niger Bridge wey link Anambra and Delta states for Southern Nigeria don dey near.
Dis na according to Nigeria federal goment wey say di project don reach 91 per cent completion.
Minister of Works and Housing, Babatunde Fashola tok dis one during di special weekly ministerial briefing for State House, Abuja on Friday.
E say di “206 billion naira project don employ 1,486 pipo wit 8,110 indirect jobs”.
Second Niger bridge near completion

Wia dis foto come from, FMWS
Wetin we call dis foto, Foto of secong niger bridge for Southern Nigeria March 8, 2022 Di completion of di Second Niger Bridge wey link Anambra and Delta states for Southern Nigeria don dey near.
Dis na according to Nigeria federal goment wey say di project don reach 91 per cent completion.
Minister of Works and Housing, Babatunde Fashola tok dis one during di special weekly ministerial briefing for State House, Abuja on Friday.
E say di “206 billion naira project don employ 1,486 pipo wit 8,110 indirect jobs”.
10 key events during one month of Russia invasion of Ukraine
Putin critic Navalny chop nine years in jail wey pipo condemn
Rafael Nadal out for up to six weeks wit rib injury

Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Nadal receive treatment from di ATP Tour trainer during im semi-final for Indian Wells Rafael Nadal no go dey available between four and six weeks afta e suffer a stress fracture of di rib.
Di injury occur on Saturday during di Spaniard win against Carlos Alcaraz for di Indian Wells semi-final.
To breath begin hard dey hard for di 21-time Grand Slam champion wey say e dey feel dizzy as he lost di final to Taylor Fritz.
Nadal, 35, dey expected to miss both of next month clay court events for Monte Carlo and Barcelona, while di French Open dey start for Paris on 22 May.
Nadal don win di title for Roland Garros a record 13 times.
In one social media post, e say wen e return to Spain "I immediately go visit my medical team to do tests afta I play wit discomfort for di final".
He add say: "As e turn out, I get stress crack for one of my ribs. Dis no be good news and I no expect dis."
Nadal don be di form player for di world dis year, headlined by im victory for di Australian Open wen e beat Daniil Medvedev for one epic final.
Im defeat against Fritz for California na im first of di year, wey bring im 20-match winning run to end.
Nadal no dey expected to fit start practising again for four weeks and im next tournament go be di Madrid Open in six weeks.
Why Asamoah Gyan dey para ahead of Ghana vs Nigeria

Wia dis foto come from, Other
Veteran striker of Ghana national football team don criticize di decision of di kontri coach to drop Majeed Ashimeru from di squad wey go play against Nigeria.
Di Black stars captain Asamoah Gyan take to social media to call out di FA say e understand why dem leave out Ashimeru from di squad.
Ashimeru wey dey play for Anderlecht football club for Belgium dey in form and some Ghana fans including Gyan expect say FA for invite am afta e miss out of di 2021 Africa Cup of Nations.
However, di 24-year-old no follow for Otto Addo 27-man squad wey dem release on Tuesday.
"I still insist say Ashimeru deserve to dey dis current Black Stars," Gyan post for Twitter.
Four reason why Mariupol dey so much important to Russia
President Buhari 'summon' Imo govnor, two odas
President Muhammadu Buhari don ‘summon’ Governor Hope Uzodinma of Imo.
Di president also summon Minister of Power, Abubakar Aliyu, and im Chief Economic Adviser, Prof Doyin Salami to meeting.
Garba Shehu, di president adviser on media for statement say di meeting go hold for Presidential Villa on Monday.
Shehu say di president go meet wit em separately on top latest developments for Imo, di power sector and di state of dieconomy.

Wia dis foto come from, Presidency
Wetin we call dis foto, Foto of one of di meeting between President Muhammadu Buhari meeting wit Imo state govnor Hope Uzodimma Timothy Adegoke Death: Prosecution close case

Wia dis foto come from, Other
Wetin we call dis foto, Late Timothy Adegoke wey die Di prosecution don close im murder case of Timothy Adegoke.
Di prosecution, M. O. Omosun close im case afta e take di last witness wey testify before di court.
Di hearing bin resume on Monday for Osun State High Court for Osogbo wia di prosecution lead Samuel Odeh, a Deputy Superintendent of Police in evidence.
Odeh, wey be officer from di Force Criminal Investigation Department, Forensic Laboratory say e receive letter of request from di IPO to analyse samples wey dem bring as part of di investigation.
"Di request na to identify di substance on di curtain swab stick and we do am den issue report to dat effect,” e tok.
But afta di testimony all di defence counsels including Yusuf Ali SAN, Kehinde Eleja, SAN, Muritala Absulrasheed, SAN and Okon Italian say make court no accept di police report.
Trial judge, Justice Adepele Ojo adjourn di matter to March 25 for di adoption of all written addresses.
Adegoke na di post graduate student of Obafemi Awolowo University, Ile-ife wey allegedly die for Hilton Royal Hotel, ile-ife, Osun State.
Kaduna goment declare 24-hour curfew for to Local goment areas

Wia dis foto come from, KDSG
Wetin we call dis foto, Nasir El-Rufai, Kaduna state govnor Kaduna state goment don declare 24-hour curfew for Jema’a and Kaura local government areas of di state.
Di declaration follow di attack by gunmen for Southern Kaduna communities on Sunday night.
Commissioner for Internal Security and Home Affairs for statement e release on Monday say goment declaration of curfew na based on advise from security agencies.
“Dis na to assist security agencies to stabilize di situation for di areas, save lives and property and enable the restoration of law and order,” Samuel Aruwan tok.
Di Kaduna state goment beg all residents of Jema’a and Kaura local government areas to cooperate wit di security agencies as dem dey work to restore peace.
35 churchgoers die for bus accident for road to attend Easter service
Wetin be Hypersonic Missiles wey Russia claim dem use against Ukraine?
